Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,151,004 members, 7,810,790 topics. Date: Saturday, 27 April 2024 at 03:31 PM

Naija Love Rhymes For Valentine - Literature (9) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Naija Love Rhymes For Valentine (61110 Views)

Must Read: Naija Love Part 1 (one) / Re: Naija Love Rhymes For Valentine / A Space For Peoms, Hot Rhymes, Quotes And General Sayings (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (6) (7) (8) (9) (10) (11) (12) ... (40) (Reply) (Go Down)

Re: Naija Love Rhymes For Valentine by oluwdashmi(f): 3:41pm On Apr 02, 2009
@ the NL intending couples
na ur choice of inviting onyenka for vibes
to give us rhymes of different tribes
makes me think we could dish in some jokes
as people dey drink their bottle of cokes

what if some comedians con do their jokes like that
leaving in us memories we no go fit format
so te e go pass night of a thousand lafter
make u think of that and lets organize that after
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by TayoD1(m): 6:54pm On Apr 02, 2009
@Maedan,

jus 4 d record,no get d wrong impression
even tho dem say we dey 4 recession
hw i go advise u2 share my sista
i mean say u get chance2 b d star
if only u go persevere
u go overthrow d bobo wey dey4 reserveĀ”!
Even though u talk say u go put me on trial
I take style reveal wetin dey your oblongata
And thru d demonstration of my shakara
I don know say u be correct gal!

Tell your sista say she no need d reserve
I fit guarantee to play an extra half
After the full time, na so she go dey shout wink
'Cos I go still dey stand after penalty shootout. grin cheesy
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 8:47pm On Apr 02, 2009
@oluwdashmi
hw i go 4get my right-hand chick
hope u don decide d bridal colors we go pick
i no mind golden green and burnt orange
or bright shocking red2 give us courage
i hear say u go help organise d buffet
in dat case i go arrange am so na u go catch d bouquet!!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:01pm On Apr 02, 2009
@ tayo-d
e don reach d stage 2 give u commendation
na only u persist with all concentration
e seem say, u b d kind dey call "finisher"
so far, IF u get my sis,u no go turn 2 "punisher"!?!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by TayoD1(m): 9:15pm On Apr 02, 2009
@Maedan,

Dem call me Mr Lover
Smooth talker, not a Punisher
The more you get to know it
Na so you go dey feel me!

Naughty no dey my nature
Look well, no indignation
And if you see my future
U go see your Sista feature!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by sugabelle: 10:33am On Apr 03, 2009
na wa o

for dis thread, i dey trip
e dey make me wanna skip
take care to keep am going
make sure no space 4 overthrowing!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 12:40pm On Apr 03, 2009
oluwdashmi:

@rotimy
heyo, bililis, dahala etc, think say dem get mouth
but u don show dem say ur love na meadan couch
with your promise to bring her comfort
even without much effort




I never come shake for de sake of other men,
As dem fit try their luck on plenty of other women.
Maedan no be de type dem call girl next door,
She agree to marry me when I dey very poor.
Because I dey very bold to tell her de truth from day one,
E come dey hard for Heyo & others to truly turn her on.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 3:53pm On Apr 03, 2009
sugabelle:

na wa o

for dis thread, i dey trip
e dey make me wanna skip
take care to keep am going
make sure no space 4 overthrowing!

Make u no skip de trip for Abuja come Easter Sunday,
The Rotmy-Maedan wedding go give you joy all day.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by sugabelle: 8:08am On Apr 04, 2009
rotimy:

Make u no skip de trip for Abuja come Easter Sunday,
The Rotmy-Maedan wedding go give you joy all day.

nice smiley

i just dey feel ur ringtone
e for nice to add my own to the love zone
but i no wan maedan to break my head
if i try thief her roti sweetheart 4rm this thread tongue
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by firestar(f): 8:46am On Apr 04, 2009
Chei!

The next episode of super story be say


The clanking gongs of nl's towncriers of Mae and Roti's wedding day


I hope say una go sing lyrics, inspired from Roti's cynic critics!


Chorused by well wishers, friends and family. . .

De song go reach top music charts for MTN, Music Africa and Soundcity. . .


Abi?


Yu gree?
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:26am On Apr 04, 2009
sugabelle:

nice smiley

i just dey feel ur ringtone
e for nice to add my own to the love zone
but i no wan maedan to break my head
if i try thief her roti sweetheart 4rm this thread tongue

lol
madam sugabelle, make u think well well
i know say u dey joke, so i no go carry d yoke
i dey busy dey write up all d invitation
wey go attend the special occasion
so i no get time to break ya head
i go dey plan for my wedding instead! tongue
but if u want, u fit try ur luck
tho i kno say with me, my roty don dey stuck! wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:30am On Apr 04, 2009
Tayo-D:

@Maedan,

Dem call me Mr Lover
Smooth talker, not a Punisher
The more you get to know it
Na so you go dey feel me!

Naughty no dey my nature
Look well, no indignation
And if you see my future
U go see your Sista feature!


no vex say i no reply since all dis time
e no easy to dey always rhyme
i get a lot of shopping to do
i neva even buy d wedding shoe
in any case, my sista still dey on hold
to be captured only by d one wey dey v.bold! smiley
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:36am On Apr 04, 2009
firestar:

Chei!

The next episode of super story be say


The clanking gongs of nl's towncriers of Mae and Roti's wedding day


I hope say una go sing lyrics, inspired from Roti's cynic critics!


Chorused by well wishers, friends and family. . .

De song go reach top music charts for MTN, Music Africa and Soundcity. . .


Abi?


Yu gree?

how i no go gree grin
so far u dey wish good thing 4 me!
e go sweet if i make some pay from d effort
at least after d wedding, we go still need to live in comfort
so i no mind make we release an album
if e sell well well, i go know say, d good times don come!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 3:57pm On Apr 04, 2009
***********For MY MAGNIFICENT MAEDAN***********
[color=#990000][/color]
Eletric current de run for my bodi as I dey look your foto,
My heart dey sweet me as if I don win a very big lotto.
Your face no just dey very fine but na shining angel face,
No beauty contest you enter which u no go win the race.
Your eyes dey shine as de bright early morning sun wey rise,
And your smile dey very unique and fit break all de Eskimo ice.
You fine nose dey well pointed as if Baba above put am fertilizer,
And when you talk and laugh, it be like say your voice get equalizer.
Your teeth dey white as if angels brush them with super bleach,
And when we marry I go take time and lick them inch by inch.
Your lips dey so succulent pass the Obalnde suya,
And I go soon enjoy your kiss pass de Benue doya.
With only one week to our speacial wedding,
I wan promise that our love go be unending.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by heyo: 4:30pm On Apr 04, 2009
Posted by: rotimy
Insert Quote
***********For MY MAGNIFICENT MAEDAN***********

Eletric current de run for my bodi as I dey look your foto,
My heart dey sweet me as if I don win a very big lotto.
Your face no just dey very fine but na shining angel face,
No beauty contest you enter which u no go win the race.
Your eyes dey shine as de bright early morning sun wey rise,
And your smile dey very unique and fit break all de Eskimo ice.
You fine nose dey well pointed as if Baba above put am fertilizer,
And when you talk and laugh, it be like say your voice get equalizer.
Your teeth dey white as if angels brush them with super bleach,
And when we marry I go take time and lick them inch by inch.
Your lips dey so succulent pass the Obalnde suya,
And I go soon enjoy your kiss pass de Benue doya.
With only one week to our speacial wedding,
I wan promise that our love go be unending.

@so disgusting brother,
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by heyo: 4:35pm On Apr 04, 2009
Posted on: Today at 03:57:47 PMPosted by: rotimy
Insert Quote
***********For MY MAGNIFICENT MAEDAN***********

Eletric current de run for my bodi as I dey look your foto,
My heart dey sweet me as if I don win a very big lotto.
Your face no just dey very fine but na shining angel face,
No beauty contest you enter which u no go win the race.
Your eyes dey shine as de bright early morning sun wey rise,
And your smile dey very unique and fit break all de Eskimo ice.
You fine nose dey well pointed as if Baba above put am fertilizer,
And when you talk and laugh, it be like say your voice get equalizer.
Your teeth dey white as if angels brush them with super bleach,
And when we marry I go take time and lick them inch by inch.
Your lips dey so succulent pass the Obalnde suya,
And I go soon enjoy your kiss pass de Benue doya.
With only one week to our speacial wedding

@roty

dats so disgusting brother
ur sexual tactics are like those of a villager, yulk!!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 6:11pm On Apr 04, 2009
@ heyo
i no jus understand
i think say u b civilized man
those very lines u dey call disgusting
be d kind wey dey last without rusting
na so he take capture me 4rm d 1st page
so i beg make u save ur rage
me wey don already write ur special I.V. Card
bt now i go tear am bc ur heart too dey hard
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 6:21pm On Apr 04, 2009
@ my romantic, caring, sexy & CIVILIZED rotimy,
sweet'art, pls no mind heyo, e no get clue,
about d diamond wey dey deep inside of u
na ur kind humble guy dey get all d chicks wey hot,
while d show-offs dey get d back of pot.
In fact, na dat ur poem we go print 4 d wedding programme
make pple see say u truly luv ur maedan!

***kisss***
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 6:07pm On Apr 05, 2009
maedan:

@ my romantic, caring, sexy & CIVILIZED rotimy,
sweet'art, pls no mind heyo, e no get clue,
about d diamond wey dey deep inside of u
na ur kind humble guy dey get all d chicks wey hot,
while d show-offs dey get d back of pot.
In fact, na dat ur poem we go print 4 d wedding programme
make pple see say u truly luv ur maedan!

***kisss***

))))))))))))))))TEN WORDS TO DESCRIBE MY MAEDAN((((((((((((((((((((((

Princess
Priceless
Gift
Lift
Diamond
Almond
Rose flower
Mind blower
Lovely Maedan
My only Madam
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 6:18pm On Apr 05, 2009
maedan:

@ heyo
i no jus understand
i think say u b civilized man
those very lines u dey call disgusting
be d kind wey dey last without rusting
na so he take capture me 4rm d 1st page
so i beg make u save ur rage
me wey don already write ur special I.V. Card
bt now i go tear am bc ur heart too dey hard


I beg you my love make Heyo still get our speacial card,
Two people at the time no de show say dem dey mad.
No matter wetin e say he no go succeed to me make sad,
Make e come dat day look as Roty & Maedan go[b] kiss [/b] hard.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 6:31pm On Apr 05, 2009
heyo:

Posted on: Today at 03:57:47 PMPosted by: rotimy
Insert Quote
***********For MY MAGNIFICENT MAEDAN***********

Eletric current de run for my bodi as I dey look your foto,
My heart dey sweet me as if I don win a very big lotto.
Your face no just dey very fine but na shining angel face,
No beauty contest you enter which u no go win the race.
Your eyes dey shine as de bright early morning sun wey rise,
And your smile dey very unique and fit break all de Eskimo ice.
You fine nose dey well pointed as if Baba above put am fertilizer,
And when you talk and laugh, it be like say your voice get equalizer.
Your teeth dey white as if angels brush them with super bleach,
And when we marry I go take time and lick them inch by inch.
Your lips dey so succulent pass the Obalnde suya,
And I go soon enjoy your kiss pass de Benue doya.
With only one week to our speacial wedding

@roty

dats so disgusting brother
ur sexual tactics are like those of a villager, yulk!!



Bros wetin dey disgusting for couple wey don marry?
No be anyhow dem like am na so dem go try & no tarry?
When you marry your own, make you no kiss d mouth but her toe,
No matter how you abuse or curse me, I no go ever be your foe.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by TayoD1(m): 9:15pm On Apr 05, 2009
@Maedan,

no vex say i no reply since all dis time
e no easy to dey always rhyme
i get a lot of shopping to do
i neva even buy d wedding shoe
in any case, my sista still dey on hold
to be captured only by d one wey dey v.bold!

Your silence has been astonishing
And your reply is no less comforting
Per your Sista I am still pursuing
Though her hand you are witholding

He dey hard to always rhyme
No matter how hard a broda try
But so far luv dey abound
Inspiration go come around.

Good luck on your your shopping spree
But tell me who dey pay the bill
Rotimy talk say hin no get any dough
How u come dey manage am so?

Let me know if you need a sponsor
I know one for the city of London
All dey need is a night with the bride-to-be
And with dat they go meet your every need.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:16am On Apr 06, 2009
Tayo-D:

@Maedan,

Your silence has been astonishing
And your reply is no less comforting
Good luck on your your shopping spree
But tell me who dey pay the bill
Rotimy talk say hin no get any dough
How u come dey manage am so?

Let me know if you need a sponsor
I know one for the city of London
All dey need is a night with the bride-to-be
And with dat they go meet your every need.


see dis one, i no blame you
dem say in d end, person go talk true
from ur words, i see say u fit cause a lot of strife
na so u suppose yarn to person wife?
anyway, my roty no talk say e no fit afford,
he only say make we manage in one accord
even millionaires dey spend their money with sense
abeg my guy no come here dey yarn nonsense
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:24am On Apr 06, 2009
rotimy:

))))))))))))))))TEN WORDS TO DESCRIBE MY MAEDAN((((((((((((((((((((((

Princess
Priceless
Gift
Lift
Diamond
Almond
Rose flower
Mind blower
Lovely Maedan
My only Madam

kiss cool

so i be a princess wey dey priceless
and a gift wey dey give person heart a lift?

diamond wey dey like almond, na only me? grin
even a rose flower and mindblower -chei, see me see

i sure say u dey sweeten me up for that our honeymoon
u wan make sure we rock am pass d one for mills & boon
no wahala, as an e-hubby, u go electronically enjoy ur maedan shocked cheesy
and then carry am go ur house make i come be your madam! wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 1:56pm On Apr 06, 2009
maedan:

kiss cool

so i be a princess wey dey priceless
and a gift wey dey give person heart a lift?

diamond wey dey like almond, na only me? grin
even a rose flower and mindblower -chei, see me see

i[b] sure say u dey sweeten me up for that our honeymoon
u wan make sure we rock am pass d one for mills & boon[/b]
no wahala, as an e-hubby, u go electronically enjoy ur maedan shocked cheesy
and then carry am go ur house make i come be your madam! wink

}}}}}}}}}}}}}}DAYS AND NIGHTS OF OUR HONEYMOON{{{{{{{{{{{{{{{[

Days of lovely laughter,
Nights of inimate matter.

Days of sweet kiss,
Nights of honey bliss.

Days of watching de waves,
Nights of making de moves!

Days of feeding each other,
Nights of loving each other!

P.S,
Onyeka Onwenu for our show charged five hundred thousand naira,
I do pay am and she promise her best for people from land of naira.
Pls suggest the man of God wey go officiate for de Church,
Dem be so many now and I want de best from de bunch!
My travel agent don book our 1st class flight to Island of Bahamas,
De beach of that Caribbean and their hotel go make us go bananas
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 2:11pm On Apr 06, 2009
Tayo-D:

@Maedan,

Your silence has been astonishing
And your reply is no less comforting
Per your Sista I am still pursuing
Though her hand you are witholding

He dey hard to always rhyme
No matter how hard a broda try
But so far luv dey abound
Inspiration go come around.

Good luck on your your shopping spree
But tell me who dey pay the bill
Rotimy talk say hin no get any dough
How u come dey manage am so?


[s]Let me know if you need a sponsor
I know one for the city of London
All dey need is a night with the bride-to-be
And with dat they go meet your every need. [/s]
[/quote

Na before Rotimy say he no get money,
But God come butter my bread with honey.
I no fit afford all de fine things in dis world,
But I not fit leave my sweet wife naked for cold.
We dey take wisdom dey spend for dis marriage,
Maedan na very good wife who know how to manage.
Tayo, you kin sponsor na type wey get big K-leg,
because your type dey pursue person's wife with him 3rd-leg
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 2:15pm On Apr 06, 2009
rotimy:


@ TAYO-D
Na before Rotimy say he no get money,
But God come butter my bread with honey.
I no fit afford all de fine things in dis world,
But I not fit leave my sweet wife naked for cold.
We dey take wisdom dey spend for dis marriage,
Maedan na very good wife who know how to manage.
Tayo, you kin sponsor na type wey get big K-leg,
because your type dey pursue person's wife with him 3rd-leg
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by TayoD1(m): 6:18pm On Apr 06, 2009
@Rotimy,

Na before Rotimy say he no get money,
But God come butter my bread with honey.
I no fit afford all de fine things in dis world,
But I not fit leave my sweet wife naked for cold.
We dey take wisdom dey spend for dis marriage,
Maedan na very good wife who know how to manage.
Tayo, you kin sponsor na type wey get big K-leg,
because your type dey pursue person's wife with him 3rd-leg
If to say you use the "big" qualify my 3rd-leg
I for no tell everyone say your tory get k-leg
Abi you don go London go see that marriage sponsor
'Cos this sudden money you jam dey raise big question.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by TayoD1(m): 6:37pm On Apr 06, 2009
@maedan

see dis one, i no blame you
dem say in d end, person go talk true
from ur words, i see say u fit cause a lot of strife
na so u suppose yarn to person wife?
anyway, my roty no talk say e no fit afford,
he only say make we manage in one accord
even millionaires dey spend their money with sense
abeg my guy no come here dey yarn nonsense
See me see wahala, abi na trouble
Why this unnecessary hustle and bustle
You overlook my very smart and good intention
Designed to help you for your special occassion

I say I know a generous sponsor
No be by force by force make u concur
All I know be say u get power to choose
If u no like am, make you just press snooze

No be say I wan cause any wahala
But funding a wedding no be small matter
As for Rotimy, hin don catch my clue
Him luv don drive am to love-vendor for you
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 8:22pm On Apr 06, 2009
Tayo-D:

@maedan
See me see wahala, abi na trouble
Why this unnecessary hustle and bustle
You overlook my very smart and good intention
Designed to help you for your special occassion

I say I know a generous sponsor
No be by force by force make u concur
All I know be say u get power to choose
If u no like am, make you just press snooze

No be say I wan cause any wahala
But funding a wedding no be small matter
As for Rotimy, hin don catch my clue
Him luv don drive am to love-vendor for you


Na wa for this man way say I get clue,
May be him dey suffer from de bird flu.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:03pm On Apr 06, 2009
rotimy:

Na wa for this man way say I get clue,
May be him dey suffer from de bird flu.


lolxxxx kiss


Tayo-D:

@maedan
See me see wahala, abi na trouble
Why this unnecessary hustle and bustle
You overlook my very smart and good intention
Designed to help you for your special occassion

I say I know a generous sponsor
No be by force by force make u concur
All I know be say u get power to choose
If u no like am, make you just press snooze

No be say I wan cause any wahala
But funding a wedding no be small matter
As for Rotimy, hin don catch my clue
Him luv don drive am to love-vendor for you

which kain dirty good intention
with all d useless ideas wey u dey mention
as for roty pimping me, thenk u
better than 2 self-love-vendor which is wetin u dey do
i go advise say make u just stay ur own
any good chance u for get 4 here has flown!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 2:05pm On Apr 07, 2009
@ Nairalanders

If you never get our card.
I beg make U no dey sad.
Make you drop your name and address,
We promise to get to you without stress.

signed, ROTIMAEDAN

(1) (2) (3) ... (6) (7) (8) (9) (10) (11) (12) ... (40) (Reply)

Shadows From The Past....[The Past Came Haunting]-- A Short Story. / Nephilim / Wole Soyinka: Things You Never Knew About Him

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 79
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.