Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,151,050 members, 7,810,922 topics. Date: Saturday, 27 April 2024 at 06:25 PM

Naija Love Rhymes For Valentine - Literature (10) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Naija Love Rhymes For Valentine (61112 Views)

Must Read: Naija Love Part 1 (one) / Re: Naija Love Rhymes For Valentine / A Space For Peoms, Hot Rhymes, Quotes And General Sayings (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (7) (8) (9) (10) (11) (12) (13) ... (40) (Reply) (Go Down)

Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 5:16pm On Apr 07, 2009
@rotylovy
i don almost finish 2 dey compile
i know say e go take a while
bt d long list dey almost ready
2 invite al those who dey hold us steady
4rm olulu 2 even dat tayo-d
both d haters & naysayers,make dem no talk say i dey heady
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 7:03pm On Apr 07, 2009
maedan:

@rotylovy
i don almost finish 2 dey compile
i know say e go take a while
bt d long list dey almost ready
2 invite al those who dey hold us steady
4rm olulu 2 even dat tayo-d
both d haters & naysayers,make dem no talk say i dey heady

My egg-yolk,I sabi say you dey wetin oyibo de call meticulous,
U go make sure all are invited so dem go take us very serious.
I happy say soon I go de eat your food wey go dey delicious.
I beg no forget all those wey dey cheer & those wey dey jealous!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by TayoD1(m): 7:06pm On Apr 07, 2009
@Ritimy,

Na wa for this man way say I get clue,
May be him dey suffer from de bird flu.
Ha-tchoo! God bless me too much
This sneezing, where hin come from
To say na bird flu or cold I catch
I still no go dey sneeze like that.

Surely this na case of allergy
My only way to detect true bullshit
Inside wetin Rotimy write and tell
There is a lie hin dey try to sell

Last week d guy say hin dey too broke
To manage money be hin only goal
This week hin dey throw dollar around
Like I no know what its all about

You know from time I dey by your side
To marry Maedan my hand dey inside
But no try to score a cheap point
By throwing your guy under the bus!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by TayoD1(m): 7:20pm On Apr 07, 2009
@Maedan,

which kain dirty good intention
with all d useless ideas wey u dey mention
as for roty pimping me, thenk u
better than 2 self-love-vendor which is wetin u dey do
i go advise say make u just stay ur own
any good chance u for get 4 here has flown!
Now there is some misunderstanding
Evident by your misrepresenting
Still with you I am not venting
Even if your post is upsetting

Anyway sha, I shall concentrate
Time and effort must not go to waste
In God I trust, and in you I must
Because we shall soon become in-laws.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 7:33pm On Apr 07, 2009
@tayo d
i go take am say u dey apologize
but next tym no make my temper rise

&pls no dey yab my roty,he no b pauper
he jus dey humble which is v.proper!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by BonHomme(m): 7:01am On Apr 08, 2009
@maeden & roty

Abeg una too try
i just gbadun una stlye
Make una carry go
With dis naija love flow

as i dey jack dis una story
i feel una no need to worry
no matter wetin haters wan spring
cos dis una love no be small thing
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 11:01am On Apr 08, 2009
BonHomme:

@maeden & roty

Abeg una too try
i just gbadun una stlye
Make una carry go
With dis naija love flow

as i dey jack dis una story
i feel una no need to worry
no matter wetin haters wan spring
cos dis una love no be small thing


bonhomme, you be our good hommie cheesy
if u know any beta couple, make u show me grin
but i no think say any 2 pple dey wey like themsef
pass maedan & roty, we dey sell pass ovation 4 shelf! wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 11:04am On Apr 08, 2009
rotimy:

My egg-yolk,I sabi say you dey wetin oyibo de call meticulous,
U go make sure all are invited so dem go take us very serious.
I happy say soon I go de eat your food wey go dey delicious.
I beg no forget all those wey dey cheer & those wey dey jealous!

verrry nice cheesy

but i must to warn u say, i no b fantastic cook
instead 2 dey stay kitchen, i go dey read book
but i sabi prepare indomie well well
e beta pass pounded yam wey go make ur belle swell! cheesy grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by TayoD1(m): 1:06pm On Apr 08, 2009
@maedan,

but i must to warn u say, i no b fantastic cook
instead 2 dey stay kitchen, i go dey read book
but i sabi prepare indomie well well
e beta pass pounded yam wey go make ur belle swell!
Which one you dey sef
Why reveal this bombshell
U for wait till after wedding
To reveal this shortcoming

Rotimy no dey play with hin food
Steaming hot, no be one wey don cool
Nothing dey remain mama sikira soup
Which hin dey chop everyday at noon.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 3:00pm On Apr 08, 2009
Lol @ tayo-d
u don come again
u 4 know say,no pain,no gain
roty must 2 b told im stomach go suffer
bt e go get maedan as im blanket cover!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 6:41pm On Apr 08, 2009
Tayo-D:

@Ritimy,
Ha-tchoo! God bless me too much
This sneezing, where hin come from
To say na bird flu or cold I catch
I still no go dey sneeze like that.

Surely this na case of allergy
My only way to detect true bullshit
Inside wetin Rotimy write and tell
There is a lie hin dey try to sell

Last week d guy say hin dey too broke
To manage money be hin only goal
This week hin dey throw dollar around
Like I no know what its all about

You know from time I dey by your side
To marry Maedan my hand dey inside
But no try to score a cheap point
By throwing your guy under the bus!

A man wey wan be true man no dey annouce all him wealth,
Rotimy no dey very broke, just dey save and dey tight my belt.
When I wan insist that our honeymoon must be for Calabar,
Abi I no agree to take her to Carribben when she shout "haba"?

Rotimy don dey poor before and no wan be poor again,
He dey reluntant to throw money around which can't be regain.
In dis e-love story, him strong love for de wife dey motivate him,
To make his pretty caring wife happy now seems to be his life aim.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 6:57pm On Apr 08, 2009
maedan:

verrry nice cheesy

but i must to warn u say, i no b fantastic cook
instead 2 dey stay kitchen, i go dey read book
but i sabi prepare indomie well well
e beta pass pounded yam wey go make ur belle swell! cheesy grin

My African Princess, Cook or no cook no go be a problem to us,
I no go marry you make you come work and tire like a horse.
But I think say dat Indomie na for our children wey dey come?
Na true na only dat kind oyibo food country man go chop for home?
Anyway shaa,I sabi cook very well and go take time teach you gently,
When you get belle, I go dey cook all de food and feed you lovingly.
You go try read all the fine cooking books and about men & their lives,
Even films go help you adjust esp dat series about " Desperate Housewives".
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 7:08pm On Apr 08, 2009
Tayo-D:

@maedan,
Which one you dey sef
Why reveal this bombshell
U for wait till after wedding
To reveal this shortcoming

Rotimy no dey play with hin food
Steaming hot, no be one wey don cool
Nothing dey remain mama sikira soup
Which hin dey chop everyday at noon.


Walai you be true son of your father,
But I get cooking training from my mother.
Mama Sikira dey use white maggi dey cook,
E don tey I went there to eat or to book.
True true I No dey play with my correct African delicious food,
I go prove to Maedan say I dey cook food wey dey very good.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:07pm On Apr 08, 2009
@roty
my lovy jus dey use im discretion
he always get smthing positive 2 mention
datz y many girls dey jealous me 4 nairaland
dey wan dyyyeee bc roty ask 4 my hand!!!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 2:20pm On Apr 09, 2009
@ Nairalanders, count down to d our e-wedding!
Easter Sunday, April 12,2009.10.00AM @ Abuja.

If you never get our card.
I beg make U no dey sad.
Make you drop your name and address,
We promise to get to you without stress.

signed , MAEDANROTIMY
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by TayoD1(m): 4:37am On Apr 10, 2009
@Maedan,

my lovy jus dey use im discretion
he always get smthing positive 2 mention
datz y many girls dey jealous me 4 nairaland
dey wan dyyyeee bc roty ask 4 my hand!!!
Which kain yeye descretion
Let me bring to your attention
Person wey like humility
No go marry Maedan the beauty

Person wey drive Bentley go turn head
Especially if hin go Ajegunle
Maedan too na head turner
Hot mama, like Tina Turner

Like many people, me sef I wonder
How Rotimy manage be your lover
But if I dey think like that
Wetin I go say for Ojukwu and Bianca

I know money fit do anything
Bring together, Beauty and the Beast
Seal and Heidi Klum tell me say
With money, you go get the whole package
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by princesa(f): 11:19am On Apr 10, 2009
was up all of you
am loving thia hread invincibly
Maedan a lady that rule supreme
nice flow u got whatever language to use
nice up rotimy too and tayo d

i never could rhyme in pidgin
not my knack
besides my fire is out
i can t even rhyme for a money sack

later then wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 6:33pm On Apr 10, 2009
princesa:

was up all of you
am loving thia hread invincibly
Maedan a lady that rule supreme
nice flow u got whatever language to use
nice up rotimy too and tayo d

i never could rhyme in pidgin
not my knack
besides my fire is out
i can t even rhyme for a money sack

later then wink

Thanks for de encouragement,
I go soon hear of ur engagement
And me & Madam Maedan go come for enjoyment.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 6:41pm On Apr 10, 2009
Tayo-D:

@Maedan,
Which kain yeye descretion
Let me bring to your attention
Person wey like humility
No go marry Maedan the beauty

Person wey drive Bentley go turn head
Especially if hin go Ajegunle
Maedan too na head turner
Hot mama, like Tina Turner

Like many people, me sef I wonder
How Rotimy manage be your lover
But if I dey think like that
Wetin I go say for Ojukwu and Bianca


I know money fit do anything
Bring together, Beauty and the Beast
Seal and Heidi Klum tell me say
With money, you go get the whole package

Maedan dey make my heart yori-yori,
And our royal marriage go be jolly-joli
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by BonHomme(m): 11:56pm On Apr 11, 2009
i just dey coutdown to d wedding
of roti baba and sweet maeden grin
dis na true NairaLand love story
na baba God we give all the glory smiley
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 5:29pm On Apr 15, 2009
I jus say make i hail evryone
as i dey enjoy 4 d carribean sun
dis honeymoon no get equal
i beg make una watch out 4 d sequel!!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 4:49pm On Apr 16, 2009
cool cool cool
To marry the person you love and enjoy your honeymoon dey cool,
Maedan sweet love don turn me to an aje butter from de old school
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 6:45pm On Apr 20, 2009
@ all

this na the official thank u message
to all of una wey pray for the smooth passage
of dis our naija luv rhyme journey
and who kept us company during d romantic tourney
big-ups to those who attend the wedding
there was plenty plenty happy tears-shedding! wink

my good friend[b] olulu,[/b]
i no go eva forget u
even meexteriox, so mysterious
hope u no still dey too furious smiley

to the babes akaraoku, moyola and firestar
plus including oluwdashmi and stillwater
and especially the sweet-talking princesa
i don take am say i be una e-sista wink

i remember jollof, who add im own curry & thyme
to sweeten our aromatic love rhyme
not forgetting pureminded and deoye05
una try as u keep the dream alive!

djlimpse & lagbaja, safex101 & cvibe
no matter d distance, we all be d same tribe wink

vanosa and kingzli, chuckdee and nuzo
kidgenious, chubistone and plus ashmanpolo
i hapi say una make sure me & roty no go solo!

ebami007 wey talk of d girls of warri
make u carry all d good tidings back with big lorry! cheesy
greenman, hope u enjoyed d fairytail ending
now u see say, we were neva pretending!

ascony and denony
na una make am more funny
to heyo, wey bring im own hip-hop
if u still dey vex4me, pls make u stop smiley

then bililis and zillionair, and of course bonhomme
i happy well well  say una come wink

of course, tayo-d, malthuss and dimitri
una really help us in d making of history cheesy

last but not least, lexdino and dalaha
una come see say, all tears don turn to laughter wink

in conclusion. make i make dis resolution
say no matter wot, i go always continue to mention
all of una in my morning prayer
make Baba God always cover u with Him Strong Layer!!


p.s.

e good to dey proud of our pidgin culture
make neo-colonialism no overtake us like hungry vulture tongue
we must to always promote our rich heritage
make history remember us with high percentage! grin cool
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 5:33pm On May 26, 2009
For all of una wey make dis marriage divine,
I go send una two kegs of African palmwine!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 8:15am On May 29, 2009
rotimy:

For all of una wey make dis marriage divine,
I go send una two kegs of African palmwine!

palmwine na for drunkard angry cheesy
u wan make our pastor ban us for d churchyard
instead we go share plenty new naira
wey CBN governor dash us for Zaria tongue



i try now, e don tey u know wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 12:54pm On Jun 04, 2009
This tin wey una start so,
no be only una go enjoy am oh. . . .
God forbid bad tins,
I been think sey I wan read about love & sins. . . . .
Na im I waka kuru kere enter this thread,
See kolo inside everybodi head. . . .
Maedan & rotimi,
road una no lef for we. . .
BonHomme & Princesa,
sef come follow donate to d kasala. . .
I wait small look again, na wetin i see,
like play, like play na Tayo-Dee. . . . .
Ol' boy, no do no do
e be like sey na swine flu. . . .
cuz me sef don siddon dey type,
my craze cure sotey e dey ripe. . . . .
my hand dey pain,
shirt don stain. . . . .
but wusai i no go carry last,
to give up na tory wey don past. . . . . .
me sef i must write my own,
if u no like am make u bone. . . . .


grin grin grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:35pm On Jun 04, 2009
RuuDie:

This tin wey una start so,
no be only una go enjoy am oh. . . .
God forbid bad tins,
I been think sey I wan read about love & sins. . . . .
Na im I waka kuru kere enter this thread,
See kolo inside everybodi head. . . .
Maedan & rotimi,
road una no lef for we. . .
BonHomme & Princesa,
sef come follow donate to d kasala. . .
I wait small look again, na wetin i see,
like play, like play na Tayo-Dee. . . . .
Ol' boy, no do no do
e be like sey na swine flu. . . .
cuz me sef don siddon dey type,
my craze cure sotey e dey ripe. . . . .
my hand dey pain,
shirt don stain. . . . .
but wusai i no go carry last,
to give up na tory wey don past. . . . . .
me sef i must write my own,
if u no like am make u bone. . . . .


grin grin grin



how we no go like am
as u too come join d naija luv jam
but how u come call am swine flu angry cheesy
e be like say u no get d clue
how this thread come be an inspiration
and last last, a nairaland pidgin sensation! grin

u fit be last, but not d least
congrats as u enjoy the rhyming love feast wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 6:14pm On Jun 05, 2009
maedan:

how we no go like am
as u too come join d naija luv jam
but how u come call am swine flu angry cheesy
e be like say u no get d clue
how this thread come be an inspiration
and last last, a nairaland pidgin sensation! grin

u fit be last, but not d least
congrats as u enjoy the rhyming love feast wink

erhm. . . erhm, no fear i jus dey clear my throat,
no go think say i be ewu-goat,
to all una wey start am,
dis no be beans talk or yam
tu'gbaski to all una,
later we go jam for iya basira corner,
madam maedan I thank you very much,
as greet me so my heart jus flash waaaa like torch,
una do well for this kain jolly wey una arrange,
as e be say man jus dey manage,
na die to keep bodi and soul kan'pe,
to stand fit omo gats take se'pe,
night and day na hassle,
if no be brain na muscle,
economy don wear jacket,
no show for omo boy racket,
evryday nuttyn for pocket,
but yet we can cry full bucket,
evrywhere for town people dey fear fear,
but anytime i waka enter here,
omo na heaven,
i fit tan'da here till eleven,
mind no dey to tire,
na only down the keyboard go dey fire,
even if this we small market no sell,
una too try well well. . . .
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:13pm On Jun 05, 2009
RuuDie:

erhm. . .  erhm, no fear i jus dey clear my throat,
no go think say i be ewu-goat,
to all una wey start am,
dis no be beans talk or yam
tu'gbaski to all una,
later we go jam for iya basira corner,
madam maedan I thank you very much,
as greet me so my heart jus flash waaaa like torch,
una do well for this kain jolly wey una arrange,
as e be say man jus dey manage,
na die to keep bodi and soul kan'pe,
to stand fit omo gats take se'pe,
night and day na hassle,
if no be brain na muscle,
economy don wear jacket,
no show for omo boy racket,
evryday nuttyn for pocket,
but yet we can cry full bucket,
evrywhere for town people dey fear fear,
but anytime i waka enter here,
omo na heaven,
i fit tan'da here till eleven,
mind no dey to tire,
na only down the keyboard go dey fire,
even if this we small market no sell,
una too try well well. . . .



na wow abi na wa, i no know which one i go talk
see as ur poem long an' sweet pass jack & im beanstalk cheesy
i dey wonder dey ponder where u dey all dis while
u for don dey on top of the pidgin rhyming pile
2nd to my roty of course grin
u know with him na beta 4 worse

as d rhymes don dey mature from the love zone
come enter into a more serious life tone
in fact, i too much appreciate
how d economy don depreciate
people dey waka around with a big frown
and blood pressure dey rise all over d town

but as u talk say, for here u find comfort,
i happy say u dey recommend our effort
to put a little smile for the face of the masses
and crack d ribs of both the low and high classes grin
i mean dem dem wey think say we dey too local
to dey rhyme for this naija pidgin vocal
as always i go say, make we always dey real
b4 our beautiful identity, westernisation no steal wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:29pm On Jun 05, 2009
na now i understand, why my roty say make we always dey prudent cheesy
becos when suffer go come, e go teach u lesson like jamb student tongue
now wey d economy dey bite with im credit crunch
and person no fit buy one whole plantain bunch
I happy say we remember to pinch and manage
Or else, after d big society wedding, nothing for remain for us to salvage! tongue grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 10:11am On Jun 06, 2009
grin

No need for me to repeat
I no go even try say I wan even compete,
Becuz I know say my own go be defeat,
you and roty na stew and meat. . . .
no matter how e be ma mind no jus reesh,
me i be student na una dey teesh
roty na shark me i be crayfish,
if i tranga too mush d end na inside dish,
as per the love matter me still dey wish,
to find that babe wey go complete me finish. . . .
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 4:52pm On Jun 06, 2009
Madam maedan me soji say u na correct,
no need to vote na u i go elect,
something dey worry my brain,
and i sure sey u get d melecine 4 d pain,
abeg neva hiss,
me know say u no be pastor chris,
i know sey u can fit helep me,
na who wear shoe know as e dey be,
i don culee arrange d wahala list,
but b4 i give u d gist,
i dey feel sey make i first collect oga roty allowance?
becuz i dey fear 4 im annoyance,
abi make i begin download,
dis matter wey don carry me enter road. . . . .

(1) (2) (3) ... (7) (8) (9) (10) (11) (12) (13) ... (40) (Reply)

Shadows From The Past....[The Past Came Haunting]-- A Short Story. / Nephilim / Wole Soyinka: Things You Never Knew About Him

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 80
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.