Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,151,098 members, 7,811,088 topics. Date: Saturday, 27 April 2024 at 11:07 PM

Naija Love Rhymes For Valentine - Literature (5) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Naija Love Rhymes For Valentine (61116 Views)

Must Read: Naija Love Part 1 (one) / Re: Naija Love Rhymes For Valentine / A Space For Peoms, Hot Rhymes, Quotes And General Sayings (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (40) (Reply) (Go Down)

Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 8:03pm On Mar 25, 2009
lagbaja:

These love birds no go ever tire
See as their vibes still dey on fire
Like joke it started the game is so funny
True to God love sweet pass honey
At 42 Roty keep on rocking
Go lovers till death comes knocking



You never hear dem oyibo say life dey start at forty?
At this age I no fit behave like a boy wey dey naughty.
Life like good wine dey mature well well with time.
Dat explain why Me & Maedan de do our love rhyme.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 8:11pm On Mar 25, 2009
safex101:

rotimi u dey burst my head ohhh with ur rhymes,i kn say na to ask 4 her number or email na dey ur mind lol ,more patrol to ur car

Stainless Safex, I beg make your fine head no burst,
As you de get and enjoy this e-love story at no cost.
Make you use am clean your relationship if e get dust,
For in dis world we de, we must dey in love or we get lost.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by BILILIS: 9:51pm On Mar 25, 2009
Hmm this tread is really interesting
makes me wanna start my own rhyme testing
meanwhile, i"m tryn to find out
before i take my time out
props and big ups to y'll even dropped lines not wack
and a very big hug to maedan, cos u got it like dat
i feel u girl
u got flows dat make my toes curl
am seriously trippn , no bullsh*tting,
cum into my world
we can make d best valentine date
cos u deserve my love n no jealousy and hate
from dudes who show no love n neva know how to relate
trust me i got the solar power
supply u full current every other hour
gotta take a bow
and hope we later connect somehow
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by heyo: 12:41am On Mar 26, 2009
@maedan

am d newest loverboy on this tread
even tho da sparkle of luv here is dead
am gonna bring some spice of romance like red roses on a bed
i am here 2 capture ur heart
with my words 4 a start
i believe u r so sweet like fanta
if i hav u,u go always dey my medulla oblanganta
u gonna b d only bullet in my gun
while i'l be ur sunshade from da sun
i no send where u come from
i go stick 2 u pass paper gum
i'l prove my luv by buyin u gucci watch than flower
then send u sweet poems 2 ur phone hour after hour
i don't need 2 hav a bath cz ur luv wd b my shower
and ur care my towel
while my tender kisses wd fill up ur bowel
don't take dis hard on me
sayin all dis 2 u even tho we no go see
but 2 say this is 2 break free
and 2 prove that in love rhyminothology,
i gat a master's degree
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by kingzli(m): 12:49am On Mar 26, 2009
Nice rhymes guys. Keep it up
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by heyo: 1:16am On Mar 26, 2009
@roty

u think u r smooth like butter
but am here 2 make u smell like gutter
i am the villain of this luv drama
u don't need 2 talk,ur relationship already gat stammer
don't worry u would be the dishwasher
at my wedding when i take maedan 2 d altar
don't cry yet cuz i gat a better offer
hw about u bein in control of the video camera
so u can witness hw ur luv has been taken away
no matter hw hard u fast and pray
it wouldn't stop the baby from comin our way
so think twice before u send ur reply
or else i would send u to a pig sty


@maedan

no matter hw deep ur luv is 4 roty
i would erase it by gettin u a bentley
i v observed this guy is so broke
cant even buy a bicycle's spoke
i go take u go st.tropez,paris
we wd live in a duplex with well-mowed grasses
am givin u romance backed with finance,wat more cd b chasis?
ignore rotimy's village man's style of making passes
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 4:16am On Mar 26, 2009
Like play like play, heyo wan come put asunder
But i hope say heaven no go strike am with thunder. tongue
Even Maedan head go don dey swell like balloon
While him roty bobo go dey quiver like baboon.
Who no go even shake if him dey compete with a business tycoon?
Walahi, those guys dey spend money like say dem go die soon.

Roty, take heart even if heyo take your woman
To fight with am no be the way to know a real man
But if you wan win a naija babe love back
Then get ready to pack enough expensive goodies for sac
Though none of these go make sense if u no buy her a house and a car
Cos na so she go dey nag you anytime she see girls in convertibles for park
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 5:20am On Mar 26, 2009
But this na big challenge for maedan
Like how my teacher test me last night with mandarin
Luckily, i pass the test cos i dey impress her for bed
She even confirm say my skills dey sweet her like mad
Say she don test other guys but them performance dey bad
Na why she dey always call me for night so go i fill in the gap. cheesy

Ahh. . . so she too dey jolly with other guys? shocked
Na 'im me i come tell am say make she take a hike
After all plenty cinco girls dey wait to be chiked
Na to take my time to find the one wey i like
I only go dey hope say my teacher no go find out
Cos if she do, i know say she go quick quick strike
And i no go like anything wey go disturb my psyche
Cos i dey always like my grades for class to dey high. tongue
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by kidgenious(m): 5:38am On Mar 26, 2009
Roty n maedan,una don try
i dey fil u guyz lyk chicken n fried rice
no mind al dis yeye rats wey wan chop where dem no invest
dey r pest al nairalanders go kill wit nest
kari on we dey await news of una union
cuz dat will d icing on d cake 4 al dis notion.Luvly thread!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 6:00am On Mar 26, 2009
kidgenious:

Roty n maedan,una don try
i dey fil u guyz lyk chicken n fried rice
no mind al dis yeye rats wey wan chop where dem no invest
dey r pest al nairalanders go kill wit nest
kari on we dey await news of una union
cuz dat will d icing on d cake 4 al dis notion.Luvly thread!

Na so me too wish them
Hoping say them no go fall into winch den
Like how dem accuse and kill Akwa-ibom children
Dem even drive 6inches nail into the head of Eden angry
Him papa wey be Akpan even disown am
Na so oyibo come show them for TV like comedians. tongue
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 8:31am On Mar 26, 2009
from heyo wey flow like neyo cheesy
2 bililis wey do im ryhmes justice
even denony get im own harmony -
and thanx 2 oluwdashmi, d official bridesmaid
na u go dey wit me 4 d bridal escalade grin
2 evryone wey take d tyme
to write and post even one line
u all dey cordially invited,
2 d wedding of rotimymaedan united!!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 8:38am On Mar 26, 2009
nuzo:

Like play like play, heyo wan come put asunder
But i hope say heaven no go strike am with thunder. tongue
Even Maedan head go don dey swell like balloon
While him roty bobo go dey quiver like baboon.
[/b]Who no go even shake if him dey compete with a business tycoon?
Walahi, those guys dey spend money like say dem go die soon.

Roty, take heart even if heyo take your woman
To fight with am no be the way to know a real man
But if you wan win a naija babe love back
Then get ready to pack enough expensive goodies for sac
Though none of these go make sense if u no buy her a house and a car
Cos na so she go dey nag you anytime she see girls in convertibles for park

nuzo:

[b]But this na big challenge for maedan


u dey very very funny grin
u must 2 b d MC for d ceremony
which go surely take place soonest
b4 anyone try tiff me from my roty dearest grin
dem fit promise to give me even buckingham palace
but d sweet naija luv 4 my roty no go lose balance!!! cool
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 8:45am On Mar 26, 2009
kidgenious:

Roty n maedan,una don try
i dey fil u guyz lyk chicken n fried rice
no mind al dis yeye rats wey wan chop where dem no invest
dey r pest al nairalanders go kill wit nest
kari on we dey await news of una union
cuz dat will d icing on d cake 4 al dis notion.Luvly thread!

thank u for all d good advice
with my lv i no go gamble nor throw d dice
u go see 4 d wedding how my lv 4 roty go true true stay
in fact, na u i don appoint to be d father of d day! wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 8:55am On Mar 26, 2009
roty sweety, to pick honeymoon site no be beans, cheesy
but as u insist, i go choose d carribeans . . .
dem get plenti palmtree n coconut for dia
we go relax n drink 4 d beach without fear
u know say na from d start
u use ur lv rhymes capture my heart
with this, no one fit compete
i go stand by u til dis journey go complete

n for all wellwishers for nairaland, una dey welcome
d wedding go hold, both thru sunshine n rainstorm! wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by chubistone: 10:14am On Mar 26, 2009
, can i contribute?
i dont mean to intrude
dis is just an interlude
pls dont be rude!!!!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 12:00pm On Mar 26, 2009
maedan:

roty sweety, to pick honeymoon site no be beans, cheesy
but as u insist, i go choose d carribeans . . .
dem get plenti palmtree n coconut for dia
we go relax n drink 4 d beach without fear
u know say na from d start
u use ur lv rhymes capture my heart
with this, no one fit compete
i go stand by u til dis journey go complete

n for all wellwishers for nairaland, una dey welcome
d wedding go hold, both thru sunshine n rainstorm! wink

As I dey read de latest post from my Sugarcane, big smile dey my face,
Oh my belle come de sweet me pass honey as my life de enter new phase.
My heart come jolly like dat Mama Cas jollyof rice because I go soon marry,
My own country men and close paddies dey worry say the d-day don tarry.
De finest lady for the whole world and nairaland go soon be my wife,
God I no go thank you enough as you don use her better my own life.
I go prove in our marriage say African men true true sabi romance,
De kin sweet kiss I go give Maedan go even suprise oyibo men from France.
As she still dey relax for bed, I go prepare for her a delicious food,
After she don eat, I go carry her go bath so she go de always look good.
I agree with you, our honeymoon na carry-go to Carribieans for romantic mood.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by ebami007(m): 1:38pm On Mar 26, 2009
warri chicks go really trip 4 this poem
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by heyo: 2:22pm On Mar 26, 2009
@roty

u talk 2 much but show no workings
maedan is gonna fit me like feet 2 a stokings
this is beyond literal mockings
only that i compete with real men not dumplings


like i said i am the villain of this show
and i v got the right swagga so let go
i no be mike adenuga but i go make maedan glo
u would earn my respect if u cd buy her lambourgini diablo

u said no one can compete
if u hav a car, i v got a fleet
u would be drinking in the beach with no fear?
homeboy,when coconuts go hammer ur head
then u would have a lot 2 fear
cuz i would be everywhere
u take my maedan 2 and even if u r not there
i got not only my eyez on her but also the C.I.A's
no she's not a criminal
i am just bringing more game 2 ur league like the NBA's
stay clear and stop sending more love trash 2 maedan
cuz on this thread,am ur nitemare,and i got the upperhand





@maedan

tanx 4 identifyin me with loveboy neyo
but this tyme u r dealing with money speaking heyo
u and i know that roty can't take u 2 da carribeans
just 4 d simple fact that he has no financial means
baby we gonna blend like gin and juice
lovin roty when there's no doe,what's d use?
my love tanda gidigba like mount everest
if u r in doubt,come and put my limit 2 a test
pastor chris is gonna be our wedding pastor
using a limo 4 our bridal train wouldnt be a major factor
wole soyinka go b the father of the day
onyeka onwenu mother of the day
fashi oluwa whoeva,genevive go b ur brides maid
eko le meridian thats where we would get laid
on our wedding night,power speaking,roty can't fight
think about this darling maedan
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by gReenmAn(m): 4:19pm On Mar 26, 2009
Coooool stuff cheesy

But can you guys fast-forward please, am eager to see the end:

~ and they lived happily ever after

or

~ and maedan left rotimy for heyo tongue

waiting!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Ascony(m): 4:32pm On Mar 26, 2009
chai!!!!!
This thread don dey shark me like tombo
but maedan, mind u say rotimy dey eye ur tonto
Him na old skul guy wey still dey wear bongo
Be careful b4 u follow am dance tongolo
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by denony(m): 5:55pm On Mar 26, 2009
Rotimy and maedan make una no mind heyo
na him kind of person na him dey sleep with person wife
what God has joined together let no man put assunder
If your na asumpta make u dey use sawanata

Heyo the wey u dey talk e be like say u be yahoo heyo
abi u be militant wey dey kindnapp people for business
You self wey dey promise am heaven and earth
u sure say u fit surface when she deman for any?

i mean no harm, but u are puting assunder
i beg u make u do aswire

my dear maedan make u shine your eyes,
some men can be dangerous just like women grin

i know say girls dey trip for this kind heyo empty promise
make u no change your mind because alarm go blow
cos' as i dey see things roty fit dye because of you.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 6:36pm On Mar 26, 2009
Ascony:

chai!!!!!
This thread don dey shark me like tombo
but maedan, mind u say rotimy dey eye ur tonto
Him na old skul guy wey still dey wear bongo
Be careful b4 u follow am dance tongolo

I dey happy and jolly say I be old school,
Maturity and wisdom de make life just cool.
To fall in love, I no go cover my eyes with wool,
Because I no be a yahoo boy wey use lies as a tool!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by BILILIS: 6:38pm On Mar 26, 2009
like play like play
dis thread don dey cause traffic
but today na today
me i must score my own hatrick
e no matter whether na valantine or not
becos we go just dey jolly everyday like say we hit jackpot
to rotimi n neyo
walahi una dey try una best
but here, i'm d hero
so make una no try contest
unless d end go dey too grotesque
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Chuckdee(m): 8:07pm On Mar 26, 2009
my oh my!!!

Roty-mi grin & Maedan you guys are sooooooo Hot!!

I dey feel the rymes like hell!
Una too much nobe beans.
One tin i dey promise una, i no go fail:
weda for calabar, Aruba or Yaba
Una wedding me most show!!!!

lol!,  big ups to you guys for real. I cant believe i read thru 5 pages of rymes w/out blinking and still on it. Thats how captivating you guys creativity are.
I like!!!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:51pm On Mar 26, 2009
d thing wey impress me pass wit all dis publicity
b say NL guys true true dey rhyme with alacrity
see heyo n bililis, dem really get good taste
if only dem go face other babes make d skillz no waste cheesy
as for me, i dey hooked
and d day of the ceremony don dey booked
from february come reach march
d love grow strong like say e get starch
i know say in my choice i no go regret
& no matter d temptation, i must pass d test! wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 11:22pm On Mar 26, 2009
to chuckdee n denony,
i no go 4get say u stand by me
tho' heyo wan turn my head with im promises
i go need to take care b4 i fit be im "Mrs"
some guys go wan tiff person wife 4 tiffing sake wink
no be say dem true true lv d thing wey dem wan take
so even bililis i go also ignore,
tho' he dey threaten n dribble more n more
but in dis case he go miss d goal cheesy
no way for hat trick, im don hit d pole!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by heyo: 12:03am On Mar 27, 2009
@denony

hey denony y r u lookin 4 ma attention? u r a nobody
i aint a yahoo boy
just wanna give maedan so much pleasure and joy
but u cd call me a millitant
cz am here 2 kidnap maedan's heart
with her consent and make her life more pleasant
i can prove myself worthy if she demands anything
am not like u dats hungry,u r thinner than a pin
this is true love not a fling
so close ur mouth up or u want some bling?
nah i no be gay so i aint buying u sh*t
i cd help u pay ur bride price with what's on my wrist
and yes i am here 2 put asunder
cuz roty and maedan together is a total blunder
so if u have a problem it
u can kip typing or maybe grow hairs on ur teeth
don't have ur time so free me like terry gee


@maedan


why r u so blind 2 see
dat u r meant 4 me
they say the best things in life r 4 free
my luv is the best thing 4 ur life so roll wit thee
cuz am worthy
and wealthy
so fresh and so clean not dirty
u r conversatin with one of N/land's enviable bachelors
get u designer bags and shoes of different colours
u said i am wasting my skills
u aint seen nothin yet
come check out more skills when i take u 4 shoppin sprees
and 4 wat i can see,u r stickin with roty bcz of una 5pages
just giv me 3 pages with ya,i would take u thru real stages
dat would erase that brokea** from the picture
and soothe ur nerves,heart even throat like cough mixture
make warri boy vex call men from hin area
no doubt say i don put omo 4 hin ariel
but i dont giv a damn
my care,tender touch is seekin 4 ur demand
enough said
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 1:50am On Mar 27, 2009
@ heyo

how i go fit convince u say u dey waste ur effort cheesy
roty get all i need to give me comfort
even tho' u feel u get more levels
u no supposed pick quarrel like say we b rebels grin
dis place na love zone, make we keep am cool
next tym u wan vex, make u chill 4 ur swimming pool smiley cool
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by ashmanpolo: 2:06am On Mar 27, 2009
@maedan, hope ur sista name no bi kate. My last date name was kate. She almst make me suffocate.Wen we start 2 date, she con de behav lik say we be mate. Girl wey de eat rice like 5 plates, drink beer like 2 crates. Serious i no de exaggerate. So i pray make her name no bi kate. I prefer immaculate
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by kidgenious(m): 5:23am On Mar 27, 2009
Like play like play,heyo wan use brute force open lock
wey roty n maedan don clock wit rock
guy go write ur rhymes com 4rm heaven
i assure u say she no go chop am like pringles
cos roty boy waz so creative n inventive
2 start sumtin conjugative n superlative
so stop al dis deceptiveness
beta stil find anoda chick 2sing al ur shitfulness.4k!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by BILILIS: 8:18am On Mar 27, 2009
wetin N/L don join together
abeg make no man put asunder
becos me and meadan
na bumper to bumber
as una see us so
we don already dey jolly dey go
but just incase u neva know
she dey kill me soo sloww
tru tru i serious i no dey try dey funny
as dem other dudes like heyo, roty n denony
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by BILILIS: 8:36am On Mar 27, 2009
kai who dey claim loverboy for this thread
abeg to the left go chop ur akara n bread
no come here dey form superhero
but rather keep ur cool instead
slow and steady
they say wins d race
n me i dey ready
for meadan to cure my craze
ahead ahead i go dey flow dey go
with my style too numerous to mention
n nothing can stop me except divine intervention

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (40) (Reply)

Shadows From The Past....[The Past Came Haunting]-- A Short Story. / Nephilim / Wole Soyinka: Things You Never Knew About Him

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 89
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.