Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,154,599 members, 7,823,607 topics. Date: Friday, 10 May 2024 at 12:17 PM

Naija Love Rhymes For Valentine - Literature (12) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Naija Love Rhymes For Valentine (61267 Views)

Must Read: Naija Love Part 1 (one) / Re: Naija Love Rhymes For Valentine / A Space For Peoms, Hot Rhymes, Quotes And General Sayings (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (9) (10) (11) (12) (13) (14) (15) ... (40) (Reply) (Go Down)

Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 3:00pm On Jun 18, 2009
@ Maedan

Me no dey form innocenty
On top dis pidgin rhyme country
Wey get enuff bounty
The fact be se na u be president
And as u be the incumbent
I go dey show my respect
Becos u dey always circumspect
And ur style come dey reflect
Like shoe wey chop quality polish
So I no go dey rogue-ish
Cos if I no display refinement
U fit put me for solitary confinement.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 3:48pm On Jun 18, 2009
@ semid4lyfe

how i go throw u put for inside jail
when for rhyming skills, u no dey fail
God say make we be head no be d tail
anyone wey hate, make dem jump inside pail cool
ur big big grammar, i go always dey hail
big ups as u dey keep this our ship for sail!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by sugabelle: 6:43pm On Jun 18, 2009
this no be d time for too much repetition
but truly dis thread pass all d competition
as maedan and co. dey wax stronger and stronger
dem dey make me feel younger and younger
as I dey laff dey enjoy all of ur sweet& good lines
e dey make me to always remember d good times.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 9:46pm On Jun 18, 2009
For me na rhyme till infinity
Cos dis na my vicinity
And no be by my ability
But by Baba God magnanimity
Me no go throw in towel
When I no get problem 4 bowel
So make I complete my story
Wey be to Bros Gode' glory
No be se I too holy
And I no get folly
Unlike D.M.T's, dis biz no dey shitty
Cos brain no dey empty
When my rhymes still plenty
But make I take rest
Make others take d test
For dis pidgin rhyme fest
After all, I get better trainin'
Wey go make my presence everlastin'.
Pls, For here no fakin'
No frontin'
No slackin'
And no dullin'
But I no go relent
to dey try cement
My top position
In this naija flow competition.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:23am On Jun 19, 2009
@ sugabelle, u try well well
u too get ur own testimony to tell
if u ever need to laff, make u no hesitate
to come dis side, we dey always regulate grin
every one dey welcome, na free for all
if u fit join d crew, make u answer d clarion call wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:48am On Jun 19, 2009
@ semid4lyfe

we no dey do anything like "rival"
after all nobody dey on trial
no be competition, although na game
our ambition, e dey the same
to make eachother smile and laff
with this our native pidgin gaffe tongue

e be like say me sef dey lose steam
i go relax dey let others live d dream cheesy
my brain no be machine, e don do
if u like, i go turn d reins over to you grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 12:37pm On Jun 19, 2009
Maedan! Maedan! Maedan!
How many times I call ur name?
U neva tire 4 dis game?
Cos me don dey tire
And small time I go retire
But u, u no wan gree
Cos rhymes u still dey spree
I dey admire ur versatility
Wey u spice with creativity
together with ur longevity
Abeg, u fit tell me ur secret
Cos me dey discreet
And I go keep am till I die
U know se me no dey lie
Besides no be today
E don tey
Wey we don know
So na ur line I go dey tow
So make u tell me how
U still dey sustain
Abi u don dey take cocaine?
If na so, make u no get migraine
Anyhow sha,
Small time me go waka
pack and comot
For dis ur pidgin rhyme doormot.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:49pm On Jun 19, 2009
@ semid4lyfe

dis ur talk don give me d motivation
never to relent for dis my vocation
since you say u go soon pack
i no go let my faithful readers lack
i go still dey house to greet each guest
and i go do my duty with zeal and zest grin tongue cool
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 7:58am On Jun 20, 2009
@ Maedan

I happy se u dey motivated
Cos me still dey captivated
Make u pray to dey elevated
So ur soul go dey uplifted
where my bro ruudie?
Abi e don retire like whoopie?
If na so, dat one na 4 em pocket
Becos here be like Oyingbo market
Wey no get permanent customer
Cos 4 here, all man na redeemer
So dis thread we go deliver
From the pidgin english unbeliever.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 7:14pm On Jun 20, 2009
na d love of my life dis wan be about
lai lai dis baby she no be tout,
of dat i no get doubt,
she no dey shack stout,
her steppings omo i no fit shout,
wen we comot go out,
dis wan no be sey i dey make mouth,
her levelz correct north to south. . . . .

she delicious like sumtyn to lick,
wen she halla na sharply i dey pick,
her voice dey make my heart tick,
1 minute and e be like make i return quick,
if she free me like dodo i go weak,
in fact i go jus turn to stick. . . . .
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 7:33pm On Jun 20, 2009
hmm'n, romantic mr RuuDie
ur rhymes dey sweet like goodygoody cheesy
na wetin this our thread dey here for
naija luv rhymes go make u win am4sure
no be flower, no be diamond or chocolate
no be even to buy champagne by d crate
na sugary words with plenty of sincerity
and d girl go fall into ur arms with alacrity cheesy wink

and just by the way
i get this much to say:
semid4lyfe dey wonder d source of my inspiration
and as to how i dey flow without much prespiration
no be by power, no be by might
na God dey make me do am right wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 8:03pm On Jun 20, 2009
@ semid4lyfe

e good say u don change ur mind
e for be a shame if u leave us behind
good talent wey u get, u must to share am
make others appreciate say e no be yam
na plenty effort to task the brain
to rhyme sweet lines to ease our pain wink smiley

in fact, i dey very glad say u go stick around
and also RuuDie, whose heart dey lost and found grin
i hope say him and him babe go soon be altar-bound wink

but one thing wey go please me pass,
na if my roty join us fast fast
i know say e dey occupied with business concern
but we need am here so we go dey learn
without him, we for no get this idea
and it go dey more sweet if he dey near wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by sugabelle: 11:49pm On Jun 22, 2009
@ Maedan
i no wan make you ever relent
me sef i no go repent cheesy
i go still dey watch dis thread progression
u go soon make am ur new profession grin
never mind the yeye recession
u don get a better employment:
to give us plenty pidgin enjoyment! tongue wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 3:07pm On Jun 23, 2009
To rhyme 4 pidgin no easy
Especially when person dey do am with enuff efizzy
Walahi, I don tire 4 my critics
And all the pidgin rhyme cynics
Dem say I too dey blow grammar
And my rhymes get too much drama
I tell dem se I no be Mary.J.Blige
So their request, I no go oblige
So dis pidgin rhyme, I go still dey do my style
With panache but without guile
So to this pidgin rhyme thread,Me go stay true
Even if my enemies turn green and blue.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 3:10pm On Jun 23, 2009
I get illness of malaria
So I bin take small break from dis area
My lapy sef don go for operation
Cos I don carry am go redington
Cos on top am I get guarantee
Wey dey backed by 1yr warranty
So me no go pay money as all service na free
But no le le, rhymes I go still dey spree
For dis our pidgin zone
Even if na to use my phone
So make una no fear
As I no go disappear
For dis pidgin rhyme territory wey no get barrier
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 4:24pm On Jun 23, 2009
shuo, semid na fight ?
ol' boy no vex, u get right,
some people no dey see even sey dem get sight,
u no jus try, in fact u tight,
see d way u dey flow like light,
ur gist clear sotey e dey bright,
pesin wey no like fit carry flight,
go obodo oyibo find im height,
no mind dem, dem no fit bite,
if dem no like, make dem leave we site. . . . .
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by sugabelle: 7:20pm On Jun 23, 2009
who talk am say una no dey try? angry
if na book, my bros, i for buy
in fact, 100 copies go be my own
and if friends beg me, i no go loan grin
all of d rhymes dey come from gifted brains
una just dey drop dem quicker than electric trains cheesy
make we quick do, make d compilation
and ask Seun to sponsor d publication cheesy tongue
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 8:48pm On Jun 23, 2009
Biko, make we no fight
Instead make we keep am tight
With better pidgin rhyme flow
So make una no throw verbal blow
On top dis thread
Wey get enuff rhymers with plenty pidgin cred
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 6:59pm On Jun 25, 2009
my fellow rhymers, una dey fantastic,
in fact un don too coca-stic,
i hear sey we thread don cross atlantic,
dis wan no be yam, beans, stone or plastic,
d levelz don high sotey e dey enter systematic,
ogbonge people yanfu with orishirishi ogbonge tactic,
anyhow u want am, as long as sey na poetic,
shey u dey find romantic,
abi na pesin wey go analyse like critic,
or d magic wan wey oyinbo call mystic,
abi na plenty grammar wan wey my teesha call scholarstic,
or d wan wey get plenty katakata wey oyinbo call dramatic,
any which wan, we go scatter ya head like mr. boombastic. . . . . grin grin grin grin grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 7:05pm On Jun 25, 2009
chei, she don run me down,
wetin i go come talk sey i be 4 dis town!?
in fact, now dem dey call me clown,
to God if i see road, i go drown,
i siddon look loss my crown,
people yarn me but i no gree da'un,
she remove me sokoto gimme gown,
now see me, plenty regret and frown. . . . .

omo e no funny,
come see cunny,
use one mouth dey call me honey,
meana while'a 4 1 corner she dey saa'ma my money,
grooving from shell estate to natony,
all dis with dat ur pastor bro. Tony,
i no soji sey all na wetin oyibo call phony. . . . . .

anywhere i go 4 warri,
na so people dey tell me sorry,
shame dey heavy my head to carry,
well sha i no too worry,
sometimes d thing dey be like curry,
other times e go sweet like strawberry,
i know sey 1 day God go send my own to marry. . . . . .
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 7:08pm On Jun 25, 2009
baby from d moment i set my eyes on u,
i be like small pikin wey jus comot belle,
sick don run leave me,
i no fit even remember how dem dey cry,
and frown no dey my dictionary again,
my whole mind na so so smiles,
i been no fine but u touche' me up,
book i no sabi but u teash me well,
na different, different love song ur heart dey play,
all na to remind me sey u always dey near
evryday u jus dey love me dey go,
show me another u wey go make me trip d more. . . . . .

baby from d day wey u enter my life,
things jus dey happen like dream,
everything about me just begin set,
even my pepper rest,
e be me like rainy season 4 waterside,
d blessings jus dey pour non-stop
and miracles na my daily bread,
i dey waka now like odeshi,
my mind dey cu'lee,
and i stand well well 4 ground. . . . .
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 3:16pm On Jun 27, 2009
who talk am say pidgin na for lowlife
when for here na wizards dey burn d mike
Ruudie, ur own pass bombastic, na tornado
ur lines dey sweet and dey burn like hot dodo
Semid4life na anoda rhymeking with high cred
wey go make any rival shake gidi-gidi with dread
Sugabelle dey represent our homegirl corner
her bam lines na sure page-turner
Me sef dey proud to be part of this prestigeous clan
and I go dey keep am tight, or my name no be Maedan cheesy wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 6:49pm On Jun 27, 2009
i swear dis wan no be commentary,
baby walahi na only ur name full my diary,
i no wan yarn plenty like documentary,
my love 4 u don pass elementary,
e full throwey pass sand sand for kalahari,
becuz of u i fit burn my salary,
swim atlantic ocean with ferry,
even sef fight lion inside kenya safari,
4 ur hand i go taka with uncle sege, IBB plus Buhari
if u gree 4 me to God i no go f**k up like scolari,
if u no come gree nko, nna d sick go pass dysentery. . . . .
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 7:07pm On Jun 27, 2009
Una dey always display correct attitude
And as such una dey stand out in the multitude
Una too sabi rhyme
E be like se una dey for una prime
Well, that one no be crime
Me just wan yarn se I don come back from my absence
So dis thread go feel my presence
Dat one be se here go sweet like song by evanescence
Cos my pidgin rhymes too dey make sense
Anyhow sha, how una weekend?
Cos me dey enjoy for my end
In short I dey party dey gyrate
I just say make I take small time partake
For dis pidgin rhyme thread wey sweet pass party cake
So make una no vex 4 dis my senseless yarn
Cos to post pidgin rhyme on top phone no be yam.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by just2nice(m): 7:17pm On Jun 27, 2009
Una slick rhymes dey make me dey kolo
tosay remainda milliseconds for me to tear my polo
some people dey tell me say for rhyming,me na aficionado
but this thread make me know say for where una dey,i be dodo
una lines na gbosa,e get power pass tornado
no body feel this thread pass the way I do
poetry I no too sabi
but I know say I go learn from una dem rabbi
I dey feel semid 4 lyfe lyk his alibi
Rotimy flows dey make me go hysterical lyk Lady Gaga
Maedan sabi her onus lyk Ali Baba
her lines go make good sales for Alaba
I just dey holla, make I go greet my friend from Taraba
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:44pm On Jun 27, 2009
just2nice, thanx 4 d spice,
na your own turn to throw d dice wink
no hesitate to join dis circle of friends
our pidgin show get plenty dividends grin
e dey cool d soul, and train d mind
if u join us, na jolly-jolly u go find
we go dey flow pass Kool & d Gang
Our CD must to sell with a big bang!!! grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 8:38am On Jun 28, 2009
@ Just2nice

For dis ur debut, u no dissapoint
Cos ur pidgin rhymes dey on point
As e don become ur vocation
U no need to write examination
Cos u don get automatic promotion
Me go soon send u letter of commendation
But make u go prepare 4 ur induction
Into the pidgin rhyme hall of fame
Cos u don live up to ur name
For dis our broken english game.


Eeeya
So Baba God don call M.Jay
Aaah, O ma se
Anyway,na bros Gode know best
So em will, make we no contest
But to talk true, I go miss Wacko jacko die
And that one no be lie
Nobody fit be like am
Cos to be M.j no be yam
Who go come be the next king of pop?
As all dem other musicians na flop
Anyhow, dis 1 na my small pidgin rhyme of remembrance
Filled with admiration and reverence
For M.J, as em soul don go eternal silence.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by sugabelle: 6:55pm On Jun 28, 2009
I no know wetin i go say
dis thread dey shaq like play like play
d skills dey very high-rate
i like how una dey demonstrate
from page one up to now
d talents dey make person 2 bow!!!
i go dey always trip for una know-how wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 9:52pm On Jun 28, 2009
Wetin man pikin wan talk
As all man don waka d walk
For here, all man na star
Cos our rhymes sweet like nectar
For me, this thin don become addiction
E come be like virus infection
Wey doctor? Abeg, I need medication
Becos my pidgin rhyming skills too sick
Me no be ajebo and I no be geek
So come rain, come sunshine
Na on top dis thread, I go dey wine and dine
Otherwise make una call me swine.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:01pm On Jun 28, 2009
no be only geek, na greek wink
we go use dis thread do hide& seek
some dey use style enter to peek
but our secrets, we no go leak
as we don strong like wood of teak
we go still stay humble and meek
and keep rhyming all d days of d week! cheesy
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 1:00am On Jun 29, 2009
Maedan, For dis thread u strong kakaraka like concrete wall
Infact u still dey waka tall
I dey surprised se u never fall
Cos u don dey drop pidgin rhymes since day one
And ur delivery never wan
By the way, I be ur greatest fan
How u dey take do am?
Cos me know se no be yam
Those wey start with u don fall yakata
As all of dem don scamper and scatter
But u, u still dey go strong
Sometimes u dey post rhymes all nite long
Anyhow sha, more grease to ur elbow
And make ur brain no dey hollow
Cos na ur steps me go dey follow.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by TOYOSI20(f): 1:14am On Jun 29, 2009
na wah oo see love!! cheesy cheesy cheesy

(1) (2) (3) ... (9) (10) (11) (12) (13) (14) (15) ... (40) (Reply)

Oyeku:story Of Lust,injustice, Destiny And Human Wickedness, 18+ / Nephilim / Wole Soyinka: Things You Never Knew About Him

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 72
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.