Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,154,621 members, 7,823,719 topics. Date: Friday, 10 May 2024 at 01:52 PM

Naija Love Rhymes For Valentine - Literature (11) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Naija Love Rhymes For Valentine (61268 Views)

Must Read: Naija Love Part 1 (one) / Re: Naija Love Rhymes For Valentine / A Space For Peoms, Hot Rhymes, Quotes And General Sayings (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (8) (9) (10) (11) (12) (13) (14) ... (40) (Reply) (Go Down)

Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 8:18pm On Jun 06, 2009
RuuDie:

grin

No need for me to repeat
I no go even try say I wan even compete,
Becuz I know say my own go be defeat,
you and roty na stew and meat. . . .
no matter how e be ma mind no jus reesh,
me i be student na una dey teesh
roty na shark me i be crayfish,
if i tranga too mush d end na inside dish,
as per the love matter me still dey wish,
to find that babe wey go complete me finish. . . .


RuuDie:

Madam maedan me soji say u na correct,
no need to vote na u i go elect,
something dey worry my brain,
and i sure sey u get d melecine 4 d pain,
abeg neva hiss,
me know say u no be pastor chris,
i know sey u can fit helep me,
na who wear shoe know as e dey be,
i don culee arrange d wahala list,
but b4 i give u d gist,
i dey feel sey make i first collect oga roty allowance?
becuz i dey fear 4 im annoyance,
abi make i begin download,
dis matter wey don carry me enter road. . . . .


grin
ur rhymes dey make me go ha ha ha
me i no want my roty wahala cheesy
if na any oda thing i know I go fit assist
but if na to overtake d show, make u no persist grin
shark & crayfish get plenty difference
make u take the others as point of reference
i no go mention any of their name
but dem all back down even b4 dem finish d game
in any case, u come bring some fresh air
to the cobweb wey for gather for this naija rhyme fair wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 4:36pm On Jun 07, 2009
Baba God no go gree we see kasala,
not even small kwanta,
we life dem go sweet pass asala,
all na we prayer,
oya follow me shout halleluyah,
maedan abeg no laff dis no be okpata,
dis thing do me sotey i tire,
my mind tell me sey u fit end dis waka,
dats why i come table d matter,
abegi make u helep for dis my wahala,
if na to pay with with rice and cassava,
i fit try small becuz me i be common farmer,
and i no too get naira,
oga roty me i no be toaster
or small boy casanova,
or d man wey call imsef mr lova lova,
i no get liver to put asunder,
better wey people jackee tey'lee to discover. . . . .

Maedan abeg jus maintain
and hear d matter wey dey worry my brain
Na dis love matter again,
d way d thing dey pain,
e be like dem baff me hot water rain,
na one edu wey jus dey carry me train,
i no jus no know how to explain,
in fact, she don carry my heart waka like aeroplane,
wen i hear her voice d happy no fit jus contain,
d sweetness pass sugar cane,
instead to lose her my make my market no gain
my small money make agbero obtain,
if ee'ke like make dem detain,
for her love i fit climb mountain,
shuo, warri river sef na fountain,
for where she dey, no long thing like plantain,
i fit waka from abule-egba to costain,
all for her to dey sustain. . . . . .

dis wan pass shoot bird,
d chic'alla don finish scatter my head,
wetin dey hol me now na jus needle and thread,
evryday na im my eye dey red,
for night na so so cry for bed,
sumtym e be like i jus dey dead,
walahi i don dey too frustrated,
shey becuz i be aje kpa'ko born and bred,
or i no get house or even simple shed,
abi na becuz i no fit buy butter and bread,
she dey call me nerd,
i don write luv letter "a" to zed,
so she go dey reminded,
how mush she dey needed,
abi make i run enter market square naked?

wetin i fit do make she blend,
make she jus look me small and send,
i no even mind to go join MEND,
if na to borrow people plenty wey go lend,
i no sey her toasters plenty and i no fine reash to contend,
d kain place she dey enter i no fit attend,
but nothing wey she do dey make me offend,
if any pesin try her i go gree'dai to defend,
make sure sey ti'ti lai'lai on no man she go depend,
d luv wey me get so no be jus pretend,
as day dey go d more my heart dey bend,
dis my sick na only she get the power to amend,
e don reash five years and na make we jus be friend,
how she no dey see sey my for luv her no go ever end!?
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 8:46pm On Jun 07, 2009
the following in bold na my favorite lines
from this ur post wey pass love letter 4 valentine . . .


[b]maedan abeg no laff dis no be okpata,
dis thing do me sotey i tire,

if na to pay with with rice and cassava,
i fit try small becuz me i be common farmer,

. . . or small boy casanova,
or d man wey call imsef mr lova lova,
i no get liver to put asunder,
better wey people jackee tey'lee to discover. . . . .

e be like dem baff me hot water rain,
na one edu wey jus dey carry me train,

in fact, she don carry my heart waka like aeroplane,
wen i hear her voice d happy no fit jus contain,
d sweetness pass sugar cane,
instead to lose her my make my market no gain
my small money make agbero obtain,
if ee'ke like make dem detain,
for her love i fit climb mountain,
shuo, warri river sef na fountain,
for where she dey, no long thing like plantain,
i fit waka from abule-egba to costain,
all for her to dey sustain. . . . . .

d chic'alla don finish scatter my head,
wetin dey hol me now na jus needle and thread, grin grin

i don write luv letter "a" to zed,
so she go dey reminded,
how mush she dey needed,
abi make i run enter market square naked? shocked cheesy

i no even mind to go join MEND,
if na to borrow people plenty wey go lend,
i no sey her toasters plenty and i no fine reash to contend,
d kain place she dey enter i no fit attend,
but nothing wey she do dey make me offend,
if any pesin try her i go gree'dai to defend,

as day dey go d more my heart dey bend,
dis my sick na only she get the power to amend,
e don reash five years and na make we jus be friend,
how she no dey see sey my for luv her no go ever end!?
[/b]

@ RuuDie
dis ur post long almost reach like chronicle
but I see say u be guy wey get good principle
as u take d time explain ur situation
i come see say no be ordinary infatuation

fost of all, make i raise elbow to respect and commend
this paragon of womanhood wey dey make ur head bend grin
i wish to say she fit read this your post
u no go need me again to help u to toast
be that as it may, i no get much to say cheesy
inside love mata, third party no fit play
d only thing be say i go dey helep u to dey pray
make u win d love of dis ur dreamgirl b4 e too tey. wink
no be until ur hair don turn full grey
by then, e go too late for u to have ur way!! grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 12:29pm On Jun 08, 2009
RuuDie:

Baba God no go gree we see kasala,
not even small kwanta,
we life dem go sweet pass asala,
all na we prayer,
oya follow me shout halleluyah,
maedan abeg no laff dis no be okpata,
dis thing do me sotey i tire,
my mind tell me sey u fit end dis waka,
dats why i come table d matter,
abegi make u helep for dis my wahala,
if na to pay with with rice and cassava,
i fit try small becuz me i be common farmer,
and i no too get naira,
oga roty me i no be toaster
or small boy casanova,
or d man wey call imsef mr lova lova,
i no get liver to put asunder,
better wey people jackee tey'lee to discover. . . . .

Maedan abeg jus maintain
and hear d matter wey dey worry my brain
Na dis love matter again,
d way d thing dey pain,
e be like dem baff me hot water rain,
na one edu wey jus dey carry me train,
i no jus no know how to explain,
in fact, she don carry my heart waka like aeroplane,
wen i hear her voice d happy no fit jus contain,
d sweetness pass sugar cane,
instead to lose her my make my market no gain
my small money make agbero obtain,
if ee'ke like make dem detain,
for her love i fit climb mountain,
shuo, warri river sef na fountain,
for where she dey, no long thing like plantain,
i fit waka from abule-egba to costain,
all for her to dey sustain. . . . . .

dis wan pass shoot bird,
d chic'alla don finish scatter my head,
wetin dey hol me now na jus needle and thread,
evryday na im my eye dey red,
for night na so so cry for bed,
sumtym e be like i jus dey dead,
walahi i don dey too frustrated,
shey becuz i be aje kpa'ko born and bred,
or i no get house or even simple shed,
abi na becuz i no fit buy butter and bread,
she dey call me nerd,
i don write luv letter "a" to zed,
so she go dey reminded,
how mush she dey needed,
abi make i run enter market square naked?

wetin i fit do make she blend,
make she jus look me small and send,
i no even mind to go join MEND,
if na to borrow people plenty wey go lend,
i no sey her toasters plenty and i no fine reash to contend,
d kain place she dey enter i no fit attend,
but nothing wey she do dey make me offend,
if any pesin try her i go gree'dai to defend,
make sure sey ti'ti lai'lai on no man she go depend,
d luv wey me get so no be jus pretend,
as day dey go d more my heart dey bend,
dis my sick na only she get the power to amend,
e don reash five years and na make we jus be friend,
how she no dey see sey my for luv her no go ever end!?

I go talk loud say I no be a sharkfish,
And make you know yourself as crayfish.
All men dey equal before Baba for yonder,
And go respect d other come rain or thunder.
I dey feel your pain for the girl you love,
But you go dey real even if you live for cave!
Five years dey enough for you to read her like a book,
By now you go decide if to go on or to let her off your hook.
But coolu temper as no waman worth dying for except na your wife!
Anyday anytime anywhere, for Maedan I dey ready to lay down my life!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 12:32pm On Jun 08, 2009
@@@@@@@@@@RuuDie@@@@@@@@@@

I go talk loud say I no be a sharkfish,
And make you know see yourself as crayfish.
All men dey equal before Baba for yonder,
And go respect d other come rain or thunder.
I dey feel your pain for the girl you love,
But you go dey real even if you live for cave!
Five years dey enough for you to read her like a book,
By now you go decide if to go on or to let her off your hook.
But coolu temper as no waman worth dying for except na your wife!
Anyday anytime anywhere, for Maedan I dey ready to lay down my life
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 6:23pm On Jun 08, 2009
dis no be play becuz we no dey stage,
d luv i get 4 u omo dem no fit guage,
from small pikin to old age,
e no matter say we no be d same language,
u dey sweet my bodi pass orange,
babi if to sey u be maths u 4 good pass average,
i no be book but u don turn my page,
babi boo d way u hook me like i dey inside cage,
i no be van damme but 4 u i go chop liver find courage
pepper no rest but anyhow, anyhow i go arrange,
even if na ko'le work i go pack garbage,
if dat wan no reash i go clear drainage,
even go join alaye 4 garage,
as a lagos boy i go way manage,
i fit kpai if we no disengage,
me no sabi dance but on dat day i go rock fuji-cabbage,
becuz na only u i wan spend my life with 4 marriage,
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 6:49am On Jun 09, 2009
@ rotylovy wink kiss

i hapi say u come quick-quick to my defence
as a good e-hubby with prudence and patience kiss grin
make we take this RuuDie case as our own pet project
e no easy to send love make the receiver come reject
u feel im pain, that one na good of you
and we go devise sometin for him to do
to take him mind from this heart matter
make d girl no make him head come scatter grin grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 7:03am On Jun 09, 2009
as for you, RuuDie
make u no get too moody cheesy
with these ur good wordings, u go get d victory
over this your love of 5-year history grin
woman like sweet-talk pass food & money
keep up ur rhymes wey dey flow like honey wink
finally finally, we go package dem to ur babi-boo
u go see say she go gree b4 u fit say "yahoo!!!" grin wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 2:29pm On Jun 09, 2009
Nothing go ever scatter him head,
Soon he go mature and take the lead.
Now he dey take words dey plant the seed
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:52pm On Jun 10, 2009
my deary i hope say he no go run comot
just as we dey give am our full support cheesy
im talk dey sweet, almost like my roty own grin
e fit make girl head swell like rubber blown-blown
we must to always give people our full encouragement
make the thread continue to dey flow with pidgin wonderment wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 10:33pm On Jun 12, 2009
shue'eppes, una tink sey me i don surrender,
bobz, me be rugged defender,
omo me i be all weather,
i too mush to jus be ta'shere pretender,
if u still dey ponder
use one eye sheck una calendar,
u go see sey na only jus 1 week or under,
dis na becuz i jus leave naija delta yonder,
clear from tom-pollo and JTF thunder,
and return to eko d land of wonder. . . . .
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 9:59pm On Jun 13, 2009
i for sey make i shout halleluya
as e be like i be d only playa,
but how e go be wen u go shop of mai-suya,
no egg dey fry for fire,
or u go d joint of enuf man'ya,
and all ur men dem don ka'ya
no be my praya,
sey make una now come tire,
becuz d way una don make dis thread waya,
e no jus set make una retire!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:15pm On Jun 13, 2009
no be say we don retire
we just dey wait d new messiah grin
we go deliver d thread from shadow
and make am blossom like green meadow
maybe we go need a brand new couple
wey their love still dey fresh and supple
make them take over wetin roty start
as me and him don do "till death do us part" cheesy
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 10:33pm On Jun 13, 2009
Madam maedan, i see sey u dey online,
na whish time u sign?
hope u dey very fine,
how d weekend 4 ur line,
abi rain turn ur area to riverine?
omo i jus twist like twine,
e dey do me like sey i dey quarantine,
since morning things jus dey 1 kain,
from police palaver to no food for dine,
iron come burn my shirt wey be calvin klein,
i no fit club again becuz e don pass nine,
and i no fit dribble my people becuz i no be argentine
for inside my house i no go fit to drink wine,
or find party people wey i go follow grine'
as e come be sey i no get babe of mine,
my today no jus resemble valentine. . . .
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 10:50pm On Jun 13, 2009
e fit be say na true u talk,
but i no see how e go work,
cuz dis una fruit real sweet to pluck,
with time i no sey people go flock,
and dis we thread go rock,
but still yet, make we no gawk,
we fit carry dis we market hawk,
with enough luck,
we fit hail am like pork,
even put am on export for dock,
cuz e too cool like ice block,
i no sey some people go mock,
some go even dey yarn okp'ats like f@@k,
but if we firm up put mind inside sock,
hol' we side tight like tummy tuck,
and refuse to siddon look like duck,
we fit gather mush pass even sellers of stock. . . . . . . . .

grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 2:36am On Jun 14, 2009
smiley cheesy grin

u funny well well, i go must to confess
d way u dey flow make me dey impress'
i no fit believe say u no get am for chick
when plenty dey for each tom, harry & nick grin
some even get ten from which dem dey pick
u need am for boost, make ur love life dey tick wink
as you get time to dey rhyme for this our thread
e go take off your mind from say u no get no bread cheesy
money no be d main, e no be our master
to worship am b say u dey find disaster
as u say make we tighten up like say we do surgery
we go dey stay real, we no go do forgery
d thing wey go save us na our originality
and pple go dey trip for our sweet personality wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 10:24am On Jun 14, 2009
Maedan u too mush,
even 4 midninth sef u no jus rush,
u jus cul'ee polish ur rhymes with brush,
ngwa nu 4 u, 1 bottle of crush,
i hope sey u dey go shursh,
e necessary 4 sush,
make all bad belle dem flush,
so we dem no go fit tosh,
or even near who'sai we reash. . . .
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 8:26pm On Jun 15, 2009
@ RuuDie

sorry say i no quick reply
my work & nairaland no gree comply cheesy
but no how, no how, i go still dey try
to dey hail u back by and by wink
thank u for all ur commendation
i no wan get big-head reputation
but my bottle of crush i go siddon enjoy
and all my good rhymes, i go still dey employ grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 10:18pm On Jun 15, 2009
Wifey Maedan you be expert for good advice,
I support make things for RuuDie dey very nice.
True love dey scracth person head as him get rice,
But I sure RuuDie go soon melt her heart like ice!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 12:44am On Jun 16, 2009
true talk, rotylovy cheesy
d guy dey rock am like bonjovi grin
i dey sure, he must to win d lady
so long as he stay cool & no act shady wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 7:59pm On Jun 16, 2009
Walahi,I dey gbadun dis una steeze
I dey feel am pass cool hawaian breeze
I don waka the thread from 'hay' to 'zed'
And e be like se ruudie heart heavy like lead
Make u no worry as ur matter don end
As me be origo luff dokitor,barrister and solicitor
Infact ,I be Queens counsel for luff matter
Only tin be se e go cost u no be small
My office dey 10th floor for city mall 
But u sef, u no dey try
E fit be se ur heavy words dey make her cry
As u don break her heart instead of winning it with ur nuclear luff missiles
So she still dey pick up d pieces
No worry,she just dey do yanga
as she go soon fall 4 u yakata
And una go come marry 'n' live happily ever after
Baba God don show me d big picture
But to actualize am, u go need take my ogbonge luff mixture
So hurry come see me b4 e too late
Cos I dey close office by eight
As I no wan make una case be like that of Leonardo and Kate
Otherwise e go be matter wey market women dey discuss 4 racecourse
And small time e go be matter of national discourse
Me just wan helep u as I be ordained luff 'cementor'
and pencil in the hands of the Almighty Creator.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 3:22am On Jun 17, 2009
@ semid4lyfe

dis one wey u be jack of all trade
ur own 419 dey d higher grade grin
how u go be dokita, barrister, solicitor
u go soon say u be ordained pastor
but u try say u wan helep ur fellow man
to make d love of him life understan'
say im love dey true pass dem own for Titanic
u rhyme well well, but make ur head no dey gigantic! wink cheesy
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 8:42am On Jun 17, 2009
@ Rotimi, Maedan, Ruudie and all the 'Ogbonge' Pidgin Rhymers

No be na wa
Na real wa!
Cos I dey trip for all of una effortless pidgin rhyme
To talk truth, e hard me like se I dey dance pantomime
This my post come be like song wey I dey mime
I know se I no dey make sense
But at least una go feel my essence
So make una no too vex
Because me na jewman for dis kain pidgin flex.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 6:46pm On Jun 17, 2009
@ semid4lyfe

for this our show, no one be novice
everyone na star for this pidgin province cheesy
in your big way, u don contribute
now the news of this thread, make u distribute wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 7:29pm On Jun 17, 2009
Gbosa, Gbosa. . . . no be Eedris Abdulkareem,
no begin look like na film,
na RuuDie and im All-star team,
and we dey carry d Surulere dream,
o' sha mo' na we be creme de la creme,
our pocket too fat to trim,
omo boy brain too much to scheme,
our light no fit ever dim,
while u dey struggle with fence we don scale d beam,
u still dey read, no time we don skim,
papers we dey carry for ream,
no dulling ahead full steam!

grin grin grin grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 8:40pm On Jun 17, 2009
@ RuuDie

up you, thank God for the change of mood
i think say ur heartache go dey make u brood
but e be like say u don leave d game for good
make u continue to stick for dis our neighborhood cheesy
u go see say u go like us pass even ur favorite food tongue
even tho' them go say we be pako like wood
we go still dey shine, we no go ever dey misunderstood wink cool
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 12:43am On Jun 18, 2009
I no dey see vision like Paul Adefarasin
But I don sense se somethin wan happen
On top dis luff thread of rotimy and maedan
Wey ruudie come dey maintain
And me dey try sustain.
Mba o, to bed I no dey retire
Cos My brain dey on fire
and like pirelli, I no dey tire
So I go still dey flow
On top dis pidgin rhyme show
wey be like film trick to my elder bro
But dey fascinate my younger sister so
Sotey she come shout, 'Please give me some mo'
And she talk se I go soon blow
but I come tell am se all na for play and no be for dough
Maedan words come give me strength, vitality and courage
Like se I drink Milo chocolatey beverage
As her yarns make me dey encourage
As she don confirm se I dey on track
Cos my rhymes no dey wack
But rite now e be like sleep don dey nack
As my well of rhymes don get crack
No le le, I still dey come back
For dis my absence, make my rating no drop
Like that white wanna be king of pop
For this pidgin thread, I don already show my class
So me know se I go pass
Even if the rest fail en masse
becos me don chop trainin' from the best of d best
And I don pass the test 
to join de creme de la creme
On top dis thread of strictly 9ja pidgin rhyme .
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 8:12am On Jun 18, 2009
@ semid4lyfe

u don already fulfil my prediction
say dis thread go come be ur addiction
so tey ur brain dey hot, u no fit sleep
u come dey sprout rhymes wey deep
me i always dey here to strengthen and energize
my fellow pidgin-rhymers wey no dey compromise
from the first post to the last, the quality never fall
in fact, the latest converts dey make me stand tall cheesy
to RuuDie and Semid4lyfe, una get my respect
una do pass wetin i don eva expect
no be say i be the pidgin madam; i just dey try
but una skills dey make me say, "my oh my---" grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 10:17am On Jun 18, 2009
Me don bookmark dis thread
Cos e dey sweet me pass agege bread
To enter, some Nairalanders dey dread
Abi dem no get 9ja pidgin cred?
E come be like se I dey on coke
Cos 4 3 days now, I just dey voke
Like se I don get Kolomental craze
And I come dey 4 daze
Like that plantation boy, faze
But no kain, dis pidgin gbedu I go rock together
With Ruudie, my big brother   
And Maedan, my pidgin rhyme mother
In the absence of Rotimy my broken english father
Not forgetting the others
And even the 'magas'
Wey in their own small way don contribute
For dis big oyinbo grammar antidote
Wey we dey distribute
On dis pidgin rhyme mission
In the literature subsection
For nairaland Cyberstation
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 11:22am On Jun 18, 2009
@ semid4lyfe

u dey pretend since say u be rhyming junior
but now u wan know am pass ur senior cheesy
see as u dey improve day by day
abi u just dey take us play
be lyk say u be pidgin maestro
come here dey form newbie aggro
no probs, we go put d crown for ya head
as u don enter where others dey fear to tread grin
but our mission remain to always spread d love
and to dey waka tight like hand inside glove wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 1:56pm On Jun 18, 2009
@ Maedan

Gbosa!No fear, no be gunshot
Na my head dey threaten to explode
E remain small make e implode
On top dis ur ogbonge praise
Cos na my spirit u don raise
No be me, na by em grace
Me no be pidgin rhyme maestro
I just dey kolo like se here na world of kentro
U know se I be fast learner
And like dat gongo aso crooner
For dis land, me dey always steal the show
With my cool original pidgin flow
Even when artists from obodo oyinbo dey present
Cos dem no dey represent
Kai! e be like se muscle pull don catch me 4 mouth
There4, I no fit shouth
But west, east, North or South
I go still dey strut my stuff
And make u no think se I dey bluff
Becos me na man of action
Wey get quick and fast reaction
To every pidgin rhyme situation
based on our cyber interaction
But I go still dey waka 4 ur back
Becos u no be quack
As long as u give me hope
Se u go teach me d rope.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 2:29pm On Jun 18, 2009
@ semid4lyfe

no be only teach u d rope
i go buy you "The Audacity of Hope"
make you stop to dey play "innocenty"
when na u get rhyming skills plenty
even tho' na rotimy start am
and na me try maintain am--- wink
i know say, out there we get posters of courage
wey get d talent to make us to dey turn d page!

(1) (2) (3) ... (8) (9) (10) (11) (12) (13) (14) ... (40) (Reply)

Oyeku:story Of Lust,injustice, Destiny And Human Wickedness, 18+ / Nephilim / Wole Soyinka: Things You Never Knew About Him

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 100
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.