Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,323 members, 7,819,103 topics. Date: Monday, 06 May 2024 at 11:22 AM

The Pidgin English Thread - Forum Games (27) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Forum Games / The Pidgin English Thread (28912 Views)

╚►start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) Part 3 ◄╝ / Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) Part 2 / Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (24) (25) (26) (27) (28) (29) (Reply) (Go Down)

Re: The Pidgin English Thread by mruknaijaboy(m): 4:47am On May 13, 2012
nairaland wetin dey, i no sabi blow pidgin like una sake of say dem born me for jand na im make me no sabi am well, i go try sha, i dey learn am small small from una for dis thread, mak una correct me if una see mistake for my pidgin, how una dey?
Re: The Pidgin English Thread by jamace(m): 7:15am On May 13, 2012
Bros eh, de way una nak the pidgin sef suprice me. You no carry last at all. Any way, make we kukuma dey jolly de go as laif allow us.

Welcome home, mruknaijaboy. grin
Re: The Pidgin English Thread by emofine2(f): 8:03am On May 13, 2012
@talina, Yessoo but for authenticity jus sprinkle it with o...so u can say fine o tongue


@mruknaijaboy, Guy, my own tori mirror ur own sha...fellow jandite welcome smiley


@jamace, Jamace how PH? One day I wan visit that side o

Bros eh, de way una nak the pidgin sef suprice me.

Abi o shocked grin
Re: The Pidgin English Thread by jamace(m): 9:57am On May 13, 2012
emöfine2: @talina, Yessoo but for authenticity jus sprinkle it with o...so u can say fine o tongue


@mruknaijaboy, Guy, my own tori mirror ur own sha...fellow jandite welcome smiley


@jamace, Jamace how PH? One day I wan visit that side o



Abi o shocked grin

Sisita mi, e for good well well to see you land gidigbaaa for gardin citi. There will be plenti jolificashion, plus including isi-ewu and shine-shine bobo for you. Haw you see am?cheesy
Re: The Pidgin English Thread by emofine2(f): 10:19am On May 13, 2012
jamace:

Sisita mi, e for good well well to see you land gidigbaaa for gardin citi. There will be plenti jolificashion, plus including isi-ewu and shine-shine bobo for you. Haw you see am?cheesy


Lwkmd...mek I kuku pack my bags now now grin
Re: The Pidgin English Thread by jamace(m): 1:31pm On May 13, 2012
Sofri sofri pack ya bag so dat you no go forget ya pancake o. cheesy
Re: The Pidgin English Thread by mruknaijaboy(m): 5:59pm On May 13, 2012
@Jamace thanks bros i dey try naw, i go soon reach una level

@emofine2 my fellow jandite thanks oo i salute

wer people dey for dis thread sef? mek una talk so we go yan topic for pidgin

how things dey for una sides?
Re: The Pidgin English Thread by emofine2(f): 4:46am On May 14, 2012
jamace: Sofri sofri pack ya bag so dat you no go forget ya pancake o. cheesy

grin...pankcake ke? abeg I no get time for that yanga...I dey come o cheesy

mruknaijaboy: @emofine2 my fellow jandite thanks oo i salute
how things dey for una sides?

I dey o but sleep jus de evaporate for my bodi...

jus curious....u be wafi?
Re: The Pidgin English Thread by Nobody: 5:41am On May 14, 2012
Googling pidgin english phrases......
Re: The Pidgin English Thread by Nobody: 5:46am On May 14, 2012
emöfine2: @talina, Yessoo but for authenticity jus sprinkle it with o...so u can say fine o tongue


@mruknaijaboy, Guy, my own tori mirror ur own sha...fellow jandite welcome smiley


@jamace, Jamace how PH? One day I wan visit that side o



Abi o shocked grin

thank you oo
Re: The Pidgin English Thread by Roland17(m): 7:02am On May 14, 2012
^^^How you dey?
Re: The Pidgin English Thread by jamace(m): 8:35am On May 14, 2012
Gud money o efribodi. Na me una broda don land gidigbaa again, jus to grit una. Una well don o. grin
Re: The Pidgin English Thread by bernfame(f): 8:44am On May 14, 2012
I no sabi pidgin o...abeg who go teach me?
Re: The Pidgin English Thread by Nobody: 2:31pm On May 14, 2012
Roland17: ^^^How you dey?

I dey fine. Wetin you dey do?
Re: The Pidgin English Thread by jamace(m): 4:33pm On May 14, 2012
[/quote]I dey fine. Wetin you dey do?[/quote]

Haaa shocked. Sista mi, na you dey troway broken like dis? Your level don dey change o. More palm oil to your tongue o.grin
Re: The Pidgin English Thread by jamace(m): 4:36pm On May 14, 2012
bernfame: I no sabi pidgin o...abeg who go teach me?

Dis wan when you talk, don pass my own sabi sef. grin
Re: The Pidgin English Thread by mruknaijaboy(m): 6:01pm On May 14, 2012
emöfine2:


jus curious....u be wafi?

I no be wafi my papa na Kogi my mama na Deltan from Eku, I never dey for any of dem na jand weh i dey from birth, wen kudi dey i go reach dem

wetin mek u tink say i be wafi?

wer dem born u? na jand or naija?
Re: The Pidgin English Thread by emofine2(f): 7:18pm On May 14, 2012
mruknaijaboy: wetin mek u tink say i be wafi?

One thread u create before wey you con enquire of warri pijin english mek I tink say na maybe u be wafi pikin

wer dem born u? na jand or naija?

Na naija dem born me o...and jand na wia dem raise me smiley

talina: thank you oo

Welcome oo grin
Re: The Pidgin English Thread by emofine2(f): 7:28pm On May 14, 2012
talina: I dey fine. Wetin you dey do?

shocked talina u be fast learner...na wa o grin wink
Re: The Pidgin English Thread by mruknaijaboy(m): 8:31pm On May 14, 2012
emöfine2:

One thread u create before wey you con enquire of warri pijin english mek I tink say na maybe u be wafi pikin




ohh i see, yeh I posted one thread weh i dey enquire warri pidgin,na because i hear say dem get deir own pidgin na im mek me wan hear am, I wan hear more wafi slang but e be like say waffi pikin no dey for nairaland or dem dey hide for under rock lol

so how u take learn pidgin sef? u take learn am for naija or u take learn am like me wey i dey watch nollywood and naija comedy?
Re: The Pidgin English Thread by emofine2(f): 9:32pm On May 14, 2012
hehe u kno say even oyinbo wey neva pass Naija before fit pick am...I tek learn am like you lol...pijin simple sha tongue....
Re: The Pidgin English Thread by Caporegime(m): 10:11pm On May 14, 2012
shuo!... tory don wear etibo, i no know say men and ladies of timber and caliber, plywood and sawdust dey NL but as i don focus una so i dey thoway salute make baba God rub una elbow for palm oil and groundnut oil mix togeda, meanwhile wey the Ptown person wey dey hia, me and am surpose cap onside..
Re: The Pidgin English Thread by Nobody: 12:21am On May 15, 2012
emöfine2:

shocked talina u be fast learner...na wa o grin wink

Im trying oo grin
Re: The Pidgin English Thread by mruknaijaboy(m): 1:59am On May 15, 2012
emöfine2: hehe u kno say even oyinbo wey neva pass Naija before fit pick am...I tek learn am like you lol...pijin simple sha tongue....

lol na true oo, i fit speak am but the tin b say my oyinbo accent no dey gree mek i prounounce word betta, i dey pratice am sha, di way i go suprise my mama wen i show am say I sabi speak pidgin pata pata she go salute lol

Caporegime: shuo!... tory don wear etibo, i no know say men and ladies of timber and caliber, plywood and sawdust dey NL but as i don focus una so i dey thoway salute make baba God rub una elbow for palm oil and groundnut oil mix togeda, meanwhile wey the Ptown person wey dey hia, me and am surpose cap onside..

bros we dey oo we dey wait una naija born and bred pikin mek una com dey blow pidgin for we men and ladies of timber and caliber, plywood and sawdust lol

bros wetin be tory don wear etibo i no sabi dat 1, u fit explain am for oyinbo english?
Re: The Pidgin English Thread by emofine2(f): 7:27am On May 15, 2012
lol na true oo, i fit speak am but the tin b say my oyinbo accent no dey gree mek i prounounce word betta

Lol I hear u...I only manage write in am, I no fit speak am at all...my oyinbo accent na obstruction grin embarassed
Re: The Pidgin English Thread by Caporegime(m): 8:50am On May 15, 2012
@mruknaijaboy, i dey believe u scatter, me na confam naija boy dem bake me, come butter me inside naija, wen tori wear etibo or tie wrapper naim be say gist don pas gist eg. 4 example na person yarn me say dis thread dey hia and on how i showcase i see say true true i dey miss no be small. anyway keep it up naija bam bam.
Re: The Pidgin English Thread by Roland17(m): 9:49pm On May 15, 2012
talina:

I dey fine. Wetin you dey do?

I just finish to dey chop, you know say me i be night whale, wetin u do today?
Re: The Pidgin English Thread by Nobody: 11:38pm On May 15, 2012
jamace: I dey fine. Wetin you dey do?

Haaa shocked. Sista mi, na you dey troway broken like dis? Your level don dey change o. More palm oil to your tongue o.grin

Ahh, thank you o. grin ( this ooo thing is really working! hehe!)
Re: The Pidgin English Thread by Nobody: 11:54pm On May 15, 2012
Roland17:

I just finish to dey chop, you know say me i be night whale, wetin u do today?

I also just finish dey chop my night whale. I carry am for head with waka to coast! I do quick or dat one na grammar.Kai! Enta market! grin
Re: The Pidgin English Thread by mruknaijaboy(m): 9:37pm On May 16, 2012
Caporegime: @mruknaijaboy, i dey believe u scatter, me na confam naija boy dem bake me, come butter me inside naija, wen tori wear etibo or tie wrapper naim be say gist don pas gist eg. 4 example na person yarn me say dis thread dey hia and on how i showcase i see say true true i dey miss no be small. anyway keep it up naija bam bam.

thanks bros i sabi am now cheesy
Re: The Pidgin English Thread by emofine2(f): 8:53pm On May 17, 2012
talina:

I also just finish dey chop my night whale. I carry am for head with waka to coast! I do quick or dat one na grammar.Kai! Enta market! grin



laff wan kill me (lol) grin cheesy grin
Re: The Pidgin English Thread by Nobody: 11:49pm On May 17, 2012
emöfine2:

laff wan kill me (lol) grin cheesy grin

Did it make any sense? Im wondering o cheesy

(1) (2) (3) ... (24) (25) (26) (27) (28) (29) (Reply)

╚►When I Meet A 9ralander!◄╝ / Believe Me, This Is Going To Make You Sweat!.the Best Of Puzzles. / Reply Signatures 2

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 57
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.