Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,029 members, 7,818,036 topics. Date: Sunday, 05 May 2024 at 05:45 AM

Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... - Literature (16) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... (75415 Views)

The Gang {edo Kings} (a breaking crime thriller story) / Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi / Drug, Sex, Friendship, (a Bad Story?) (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (13) (14) (15) (16) (17) (18) (19) ... (26) (Reply) (Go Down)

Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Therock5555(m): 7:42pm On Oct 30, 2021
gstelly:
Therock5555 am hungry come and feed me o


check back around 10:30 pm



I dey type one obonge update now....

1 Like

Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Therock5555(m): 7:43pm On Oct 30, 2021
TPound:


We dey expect update, e go dey quote whole page...
It's just like you expecting credit alert and Domino's pizza texts you offering amazing deals on fried bread and burnt tomato sauce...
Abeg ooo.. post more updates


hahahahahaha omor I pity who go banter with you. you get words for mouth die...

1 Like 1 Share

Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by TPound(m): 9:30pm On Oct 30, 2021
Therock5555:



hahahahahaha omor I pity who go banter with you. you get words for mouth die...

Taink yhu...


Oya, back to the update...
Abi make koboko find vacancy for ya back?
grin
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Therock5555(m): 10:39pm On Oct 30, 2021
abeg make una no vex for any errors o, na double eyes I use type this update

make una enjoy

1 Like

Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Therock5555(m): 10:40pm On Oct 30, 2021
~~~FIFTY~THREE~~~
You see for this life eh, no be say we no fit stay with one woman oh, but girls too choke and as e be say girls this days no dey send if you get babe or not (by the way them too dey get guys na), who dey gree say them dey relationship this days, everybody is always single and searching until you're married.



Where the problem go come dey na when one girl go come dey gum body you like say na chewing gum she be. Na wetin Collins come dey pass through for Becky hand be that.


I no know if Becky install gps tracker for Collins yansh cause anytime wey Collins come house from school, Becky go just turn up like vulture, even Collins sef dey shock.


E get day wey one of him babe follow am come back from school to come do weekend for house with am.

As I sight them that day, I ask Collins how he wan do with Becky, the bros tell me say make I no worry, say that one na small matter.

As him leave the babe for house with me, him run go Becky house, go drop lamba about how him get journey that weekend so he wan come see her before he goes.


For him mind, everywhere stew for am. E shock am as Becky show house that evening in the guise of coming to give me food, I tell her say I dey hungry ni?


Luckily for Collins, him no dey house that moment, so when Becky come meet the other girl, she no reason anything, she think say na my babe, the other girl sef think say Becky na my babe, naso them siddon dey gist till Becky left.


I text Collins say, if him no want make world war 3 happen that night, make him remain for where him dey, till further notice.


~~~~~~
Now, due to Collins being an artist, I got to meet lots of local artist that comes to visit Collins for various reasons.

During that period, I got to dive Into the local music scene and knew one or two things that happen amongst artist.

See eh, no be all artist get talent o, some no even Sabi wetin be their calling sef, all they know is that they want to be musicians.

Okay answer this question, what would you call someone that has voice like frog(I no dey shade anybody o), the person no Sabi write songs, the only thing wey dey person get na part payment for studio sections.


Hahahahahaha.


Now that's where Collins come in. All they have to do is to reach Collins, give am half the money for the studio sections and automatically, Collins would produce a song and teach you, una go go studio together, producer go drop beat, before you know, music don drop.


E dey always funny me eh because I go just dey house, Collins go come back say him don drop mad jam with him homeboys and girls(if any).

Him go play the song for me, the song fit dey okay at first but then I go just hear one voice enter from nowhere come distabilize the whole jamz.

If I ask am why him allow that werey voice for him song, him go yarn me say the person follow contribute money for studio sections so them gats put am.

Una see Sapa eh, if say enough money dey, him for go sing alone. But as Sapa dey slap people, you fit see 8 of them go sing one single, and every one of them go get verse.


Trust me, na only for Collins jamz I dey hear two different chorus and 5 solos with 2 bridges and two interlude. One song go come be like mixtape, e fit reach 9 minutes....



Hahahahahahaha.



The one wey dey shock me pass na the female artists. Let's forget talent here, I no know whether na curse abi pussy power but even the female artists wan use their toto blow I stead of talent, abi na because the two names start with letter 'T'.....



You go see babe come house, come tell Collins say she wan sing with am but she no get song or money to go studio.


Collins go carry her enter room go test her voice, I go just siddon for parlour dey hear sonorous voices.
The funny part go be say Collins go come tell her say him no get enough money for studio sections so they gats run collabo with another guy.

Like play like joke, the babe go gree o, naso him go call one sharp guy fellow artist wey get money, that one go come collect him share of the voice training tutorial...

Naso the babe don turn artist o, them go carry her go studio, go give her solo verse to take. Naso the werey babe go come comot talk tomorrow say she na musician, even dey play her song for gullible folks.


The one wey dey shock me pass be say them dey use Collins room as hotel lodge AKA rehearsal studio and most times na tag team match dey happen.

You go see one artist bring another apsiring artist, the aspiring artist go bring her friend as back up, this back up no be cover for her Incase anything happens o, this back up na supporting cast cause some of them feel that their pussy no go dey enough to get a recording contract, so them go wager their friend toto join.



"Guy show me the way na, no be only una go dey enjoy Everytime." I asked Collins one day.



"Guy that one na small thing na, since you no wan be musician, you go become artiste manager."



"Wetin come be the job of artist manager?" I asked.





"Na title jare, nothing dey there. You go just explain to the girl say you go dey find show for her to perform and in return you go dey nack her back to back."





"Ehhhhhhh, is that so? So how I wan get the babe wey I go manage?"




"That one no be problem, one of my guy dey bring one new artist wey wan feature me, I go link una up. Just make sure say you go get liver talk to her."




"Baba between me and you who chase woman pass? That one na small matter for me nah." I assured him.



But then no be by assurance alone, if not chioma for don dey Davido house by now. Na reality dey ground


I dey inside my room when someone knocked at the front door. Collins got the door and ushered them in.

It was a guy and girl, I rush go my door go peep make I sight their face.

As I sight them, my heart cut for eleven places.

Asin the babe is huge..... Na wetin we dey call better tom boy. She even get muscles pass, I come dey wonder if na macho man she be abi woman, if no be say she manage get small breast, me for conclude say that one na hermaphrodite.

I come dey wonder how I wan take dey lash this one, abi na she go lash me sef. The babe even barb afro punk like me, please who suppose manage who? I no for mind ask her to manage my life join cause if she na my bouncer, them no born anybody well to near me.


But then again, the babe get one of the most nicest bass voice I ever heard, she na Gangstar rapper, infact na she dey feature guys to sing chorus for her.


For my mind I just dey curse Collins as I hid back for room, I dey pray say make him forget call me.

As I dey pray Nai the werey begin shout my name say make I come meet him new artiste. Atleast this one get money Sha so no be free toto she come drop for boys.


I Waka go meet the babe, I be wan just greet them and then run leave house but Collins beat me to it.


"Ehen Baby ***, meet Peter, na very good manager. Him go find shows for you tire." Collins introduced us, babe give me hand shake, she even dey shake like man sef, I just weak.



"Nice meeting you sir..."


Her talk just dey pass one side of my ears dey enter another side cause my interest don nose dive like airplane.


"Guy e get show wey we dey go this evening, so get prepared." The other guy informed me.

I look Collins, him just dey smile wildly, na that moment I know say the yeye boy no get plan to make things easy for me.

Infact him sure say I no go ever see that babe bra talk more of pant, infact where I wan start from, when I dey reach the babe for neck and na tom boy join, I fit swear with my two balls say the babe na lesbian and na she go be the man for the relationship sef.


Anyway we set time wey we dey go the show. As them Waka, I make sure say I insult Collins life sotey him begin shout back to sender....

When na him be the sender .... That boy need strong beatings. And I promise am say I go deck am one of this days or so I thought.




Me wey no too like night parties or shows, I was forced to turn up dressing corporate as per manager without salary. The salary sef wey I suppose get na one chance I come enter.

Collins made sure to avoid me cause my face no nice at all.

As the show went on, I couldn't bear it anymore, I just comot outside go find where them dey sell cigarettes.


I went to the back of the show venue and lit a cigarette. As I just dey do one drag, naso person shout my tribal name....



"Uduak when did you started smoking?" A female voice yelled behind me.


The way I shock eh, cause the location wey I dey, almost everybody calls me Peter, na only few people know my native name.

Reason be say, most people dey bite their tongue to pronounce my name so I simply tell them Peter and move on.

If you hear person wey call my name, na either family member or person wey I dey exclusively close with. And the person wey call me no sound like my family members voice but then the voice has been etched in my subconsciousness that I could tell who owns that voice even if na from sleep the person call me.


Wetin shock me be say I no expect to see that person for that place at that time.

Naso I comot the stick for mouth, I look am begin calculate whether to throw it away or continue smoking, but then I know say them no born me well to continue smoking, naso I painfully trowey am away and turn to see the female walking behind me.


True to God the shawty was still as radiant as ever. It took me plenty energy not to rush and embrace her.


"Hello Anna. It's been awhile." I said grinning.


"Haba Uduak, when did you started smoking? I'm disappointed."




"Eh, uh, ehh... No reason am. What are you doing here?" I asked.



Anna looked at me, shook her head and wipe a tear of her face before turning back in. I stood watching her as she walked away. I couldn't rush her or say a word, I just felt frozen and sad.



Now before you get confused. If you're a fan of the Preacher's son series. You'll know Anna.


Anna was my first Love. The only babe wey still get my mumu button till I die. It's been years since we last met, so I was super shock that she would recognize me in the night even by just seeing my back. Isn't that amazing.

E fit be say she don see me for inside hall and been dey find me tey tey cause the thing shock me die.

My body just weak, naso my hand begin shake. I jejely comot another cigar put for mouth.

As I dey light am, drag am once, I hear voice again.



"Jesus Uduak, are you this addicted to smoking? I thought you'll even feel remorseful when I caught you, you even light another one again."

Anna voice broke me again. Why the hell does she keep turning up when I wan smoke, them swear for her.


Quickly I comot the cigar trowey again as she walked towards me.


"Uduak, I'm really disappointed. I don't know you like this when we were dating."


"Babe it's been more than 8 years, lots of things have changed." I argued.


She bursted into tears again.

"I thought when I rebuked you the first time, you'll take correction, when I went in, I told my friends that I met you and they encouraged me to come back and talk to you as per you don learn your lessons, only to find you still smoking again. What changed you, tell me, what changed you. I'm really disappointed."

I stood with my head bow like a drunkard, I no know whether to begin apologize or shut up, but then as I dey scan my mind for better line to use calm her down she just shake head begin run go road, stop bike, come climb dey house.


I open mouth, close am back as I dey watch wetin dey sup. As I watch the bike go far with no hope of coming back.


I jejely comot another cigar put for mouth.....





Ask around, I get coconut head, I no dey hear word.........

26 Likes 2 Shares

Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Therock5555(m): 10:41pm On Oct 30, 2021
TPound:

Taink yhu...

Oya, back to the update... Abi make koboko find vacancy for ya back? grin

I don drop am as e dey hot....

no para again biko, hahahaha

1 Like

Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Therock5555(m): 10:43pm On Oct 30, 2021
omor see as viewers plenty, una sure say I never enter FP?



abi naso I get fans reach...


BTW why I never make FP yet, I don pass half of the story ooo, make this mods remember me na...


una goodnight Sha.....

2 Likes

Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by WAACUT(m): 11:10pm On Oct 30, 2021
Nice one bro
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by bennyflipy(m): 12:12am On Oct 31, 2021
My niqqar
But wait all these things wei dey sup na for your home town abi nasarawa (keffi)??
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Therock5555(m): 12:51am On Oct 31, 2021
bennyflipy:
My niqqar
But wait all these things wei dey sup na for your home town abi nasarawa (keffi)??


if I answer this question, I don cast my location na....
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by gstelly: 6:22pm On Oct 31, 2021
Therock5555 u rock although I am still hungry
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by bennyflipy(m): 11:09pm On Oct 31, 2021
Therock5555:



if I answer this question, I don cast my location na....
Lolz, somewhere in .........
From my starting line
You suppose know where I sabi that line and I know your location too
You rock grin
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Therock5555(m): 1:44pm On Nov 01, 2021
bennyflipy:
Lolz, somewhere in ......... From my starting line You suppose know where I sabi that line and I know your location too You rock grin

you know the state wey I dey, no be my exact location you know na, hahahahaha

1 Like

Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Cls55: 7:34pm On Nov 01, 2021
I dey wait for una oh
I don dey loose weight
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by dalexz: 7:45pm On Nov 01, 2021
One love bro nice 1
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Whyzaid(f): 8:31pm On Nov 01, 2021
Brother Peter, we are waiting oo
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Carterj007(m): 3:52pm On Nov 02, 2021
Therock5555, abeg come give us update.
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Nobody: 4:39pm On Nov 02, 2021
[font=Lucida Sans Unicode][/font]
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Kawo9ze(m): 8:45pm On Nov 02, 2021
Therock5555 update pls o!
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Therock5555(m): 10:09pm On Nov 02, 2021
guys make una no vex....

area transformer don blow....

hopefully tomorrow updates go drop.….

I greet una once again...

6 Likes

Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Nobody: 5:43am On Nov 03, 2021
Therock5555:
guys make una no vex....


area transformer don blow....


hopefully tomorrow updates go drop.….


I greet una once again...

Ok sir
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by ghettochild(m): 3:34pm On Nov 03, 2021
One of these days I go dash u small change.
I dey gbadun your story jare
E dey totori me
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Kawo9ze(m): 10:00pm On Nov 03, 2021
Therock5555:
guys make una no vex....


area transformer don blow....


hopefully tomorrow updates go drop.….


I greet una once again...
Oga pls na Una yesterday be today o, Oya drop something for us to chill body
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Kawo9ze(m): 10:04pm On Nov 03, 2021
Udauk, I understand you bringing new character somehow old fella's into picture but where Stephanie or your family and what abt that hausa girl selling masa n others!
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Tissyjay(f): 12:09pm On Nov 04, 2021
=Therock5555
guys make una no vex....


area transformer don blow....


hopefully tomorrow updates go drop.….


I greet una once again...


Olumo rock when exactly is your own tomorrow. Patiently waiting sha
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Therock5555(m): 10:44pm On Nov 04, 2021
Cls55:
I dey wait for una oh
I don dey loose weight


Loose no more weight sir, I don show....

1 Like

Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Therock5555(m): 10:45pm On Nov 04, 2021
igobuybenz:


Ok sir

Turn up bruh .. small update don show...

dalexz:
One love bro nice 1


Thanks man...

1 Like

Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Therock5555(m): 10:46pm On Nov 04, 2021
Carterj007:
Therock5555, abeg come give us update.


I don show sir...
Whyzaid:
Brother Peter, we are waiting oo

Mama, no vex ko.... Make una manage with me....

1 Like

Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Therock5555(m): 10:47pm On Nov 04, 2021
Kawo9ze:
Therock5555 update pls o!


I don show small sir...

1 Like

Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Therock5555(m): 10:47pm On Nov 04, 2021
ghettochild:
One of these days I go dash u small change.
I dey gbadun your story jare
E dey totori me


Oga make the day do come soon oooh, I need am Wella..,.


Hailings mehn...

2 Likes

Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Therock5555(m): 10:48pm On Nov 04, 2021
Tissyjay:
=Therock5555
guys make una no vex....


area transformer don blow....


hopefully tomorrow updates go drop.….


I greet una once again...


Olumo rock when exactly is your own tomorrow. Patiently waiting sha



This chookings enter Sha... Oya manage the small update...

1 Like

Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Therock5555(m): 10:50pm On Nov 04, 2021
Kawo9ze:
Udauk, I understand you bringing new character somehow old fella's into picture but where Stephanie or your family and what abt that hausa girl selling masa n others!


Yeah as for Stephanie, I'll speak about her soon, her matter never finish yet...


My family, I be wan talk about them but I wan respect some kind of privacy, them go still feature for the story Sha...


As for that Hausa girl selling Masa, I face my front o, no be me go lose hand because of toto....


Hope I don quench your taste small...

2 Likes

(1) (2) (3) ... (13) (14) (15) (16) (17) (18) (19) ... (26) (Reply)

Magic Doctor: CEO Lady's Humble Husband [A Story] / <<<The Tri-Paternal Son>>> / "Wole Soyinka And I On Our Way Back To Nigeria" - Prince Adeyinka Success Says

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 91
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.