Beebah321's Posts
Nairaland Forum › Beebah321's Profile › Beebah321's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 13 14 15 16 17 18 (of 18 pages)
Roseodd:Lol ![]() Pray make you see am again, so that you go show am shege ![]() |
Him don go put hand for wetin pass him power ![]() |
Your village people don follow you enter super market ![]() |
See the way the dog keep face sef, u go know say the dog no like the man ![]() |
Nigerians don dey use hypo take wash their eyes. Nice one ![]() |
SpreshMan:Take it easy. ![]() U know say girls of these days dey care more about wetin them dey wear, them no wan wash body well. ![]() Make I keep quiet, before them go con attack me. ![]() |
sultry69:How am I encouraging suicide again? ![]() God dey see the way we dey suffer for this earth. No be our choice to come here. If God give us chance to decide, I sure say nobody go gree come. Everybody go wan stay for heaven. God no go punish us even if we take our life. God know say e no easy for anybody. Take it or leave it. ![]() |
Na wa ooo ![]() |
The problems way dey this country fit make person commit suicide. ![]() Anybody way wan die, make e die ooo. This country sef don tire us. ![]() |
Lol ![]() The daughter sef don reason say Nigeria pass her papa power. Make she better talk to am. ![]() |
Na so. After Nigerians make u win, u go do like say we be strangers. Yeye ![]() |
If Una no wan see shege for 4years, make Una better vote for LP ![]() |
E don cast! Las las..... Na only runz girls go chop breakfast. ![]() |
Make Una better tell am ooo ![]() |
Did he pray for us when we were suffering?? ![]() Their own na to dey steal money. Anything way happen, nothing concern us. |
Every time na APC & PDP. ![]() They should rest and give other parties chance. |
Even if they talk about it, they won't solve it. ![]() |
Na only post na e them go post am, but them no go ever take action. Money dey this country, I still dey wonder why them dey collect loan. Yeye government. |
Broom broooom broooommmm ![]() That man funny ![]() |
That Tinubu wan carry wetin pass Buhari power. If him win now, him go steal money dey fly out to go treat himself. |
JoyousFurnitire:No worry I no go commit suicide. I no fit kill myself because of this yeye country, even politicians no commit suicide as them clearly know say Nigerians dey suffer because of them. People dey do like say them no dey see wetin dey happen. Some people sef go still insult me after them read wetin I write. ![]() Chai! I just tire ![]() |
JoyousFurnitire:thanks Dear ![]() |
Name na name abeg. No matter wetin you write, those girls name way u mention up there go still marry better men. ![]() |
CoronaVirusRelo:You already know ![]() |
CoronaVirusRelo:If you like, talk from now till next year election. Me and you know say tinubu no go win. |
Peter Obi ![]() |
CoronaVirusRelo:Tinubu way don old. Una no dey pity the man?? The man sef no dey pity himself. Nigerians go dey vote for old men, Una no no say as them dey old, na so their brain go con dey weak. APC way show us shege, Una wan stand for hot sun still go vote them again. APC supporters need serious deliverance. |
As I dey like this now ehh, this country problem fit make me commit suicide Why be say everything just hard for this country like say we no get president?? ![]() Make them kuku divide this country into three regions, each side go get their own president because one man no fit hold this country. One man no fit solve all our problems. Nigerian politicians sef no dey take us serious, their own na for them to dey steal money, dey put for their account and their family account. During election, them go con dey promise us nonsense. We Nigerians way be mumu go con vote for them again, we way use our two eyes see say them no do anything last time. Even blind person sef, no go gree vote again. Food just cost like say na inside hell we dey. Poverty everywhere, bad road, unemployment, insecurity, Nigerians just hate one another. Nobody want make their neighbour progress. If your life dey go well, people go try to bring you down, and politicians dey make us suffer, nobody bring them down. Bandits, Fulani herdsmen, bokoharam don kill many Nigerians. Where them dey get those guns, bullets, bombs way them dey use kill our children, our fathers, mothers, uncles, aunties ?? Who dey give them those weapons?? Those demons way no go school, them no dey work sef, their own na to dey kill our loved ones. Who dey teach those fúcking illiterates how to kill our people? Me and you know who dey teach them. Me and you know who dey give them those heavy weapons to do their dirty work. Make Una eyes better open for this upcoming election, no sell your vote because of money. The money way them give you go finish and na me and you go suffer am for 4 years, maybe 8 years sef. Politicians way no dey do anything, but if them wan visit one state, na so their supporters go come stand for under hot sun dey hail them. Them way no care whether your family dey strave for house, them no care whether your children no dey school. During election, na still poor fools go stand under sun dey hear their useless promises. People know say them no go do wetin them promise, but them go foolishly vote am, because of wetin? Because of say Nigerians no get sense. If you like pray to God, dey deceive yourself say God go con save this country. God no go help us, God don already give us brain, na just for us to use am do the right thing na e dey hard us. May God give us everlasting sense. Amin ![]() |
Nigeria dey hot now, u dey talk about women. Abeg go rest. |







