ClassCaptain's Posts
Nairaland Forum › ClassCaptain's Profile › ClassCaptain's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 68 69 70 71 72 73 74 75 76 (of 100 pages)
Dominique becomes Idiyat.. na play I dey oo |
hefelove:lol |
I fine pass am |
Signs of the End time |
lol |
End Time Racists and it was DAT same fat Idiot .men from all races rejected the other day on Facebook. ![]()
|
adesewa4uyahoo:why |
Episode 11 As he took his bath.i tried to access the house better. Apparently.his Sister had clean and arranged the whole house before she left..She bin don mop floor sef..Dem never even tile d Floor .And i sure say dem no fit near say dem wan tile bathroom at all ?? Where this guy con dey see all dese Pictures he day take for different tiled bathrooms ?? Na today i go know.Tho i never Even settle down and i get things i gats do tomorrow.a little adventure today no mean anything jor..Afterall i fit rest for evening and midnight if i don come back .. Soon he was Out of bedroom in his boxers .. " No vex jare boo.Na my mama Cream i go use rub body ,make i check her room . " Na him mama cream hin dey use.If to say him dey bleaching cream d mama dey use nko ?? " Ok naw ".. " He wore a Faded polo shirt and white jeans with a Gucci palm which nobody need tell me before i know say na Fake. .As dem write Gucci for front.Na Nike dem put for d side. Gucci nike palms ?? my guy still con balance hin mama necklace for neck. ' Is that not a Ladies necklace ' I questioned " Lol Boo u get wahala.Nobody go know naa.same thing... He used the palm oil from d spag to clean his palm and hung d one hand brown bag on his neck. " Lets Go " Ok..i stood up and adjusted my shirt " U don off the Nepa switch " i asked. " Guy u don smoke b4 u reach here ooo...U no hear when i tell u say Nepa don cut light.. " haa,i don forget abeg no vex " i said smiling.. " Na so hin go dey do gentle gentle, make we go jare.. . |
Episode 10 i got the inspiration at our shop" " ehn " there was this time .one of this customers at our shop approached me about how to do my sister parol... " ehnn " Ehnn ...he sha dey talk " your sister is a diva..o fine.. Baby diva " baby diva ni sister e yen .. ..i want her to be my Baby Diva " hmnn.....What a weird way of getting inspiration for A song !!!. " So the line stuck in my head... And u know since when i bin don day talk sey i go drop song..Na that period i bin day serious about am.. Na so we shall talk ,i help am do the stuff and we settled.. Hin dey part of d people wey Even contribute for d first track.we go reach hin side today too. But na hin first talk dat " Baby diva " . " so u do your sister parol 4 am " " yes naw..my sister sef dey enjoy am naw because the man dey help her 4 her hairdressing salon.. ' Lol ..shebi na marriage " marriage for where ..person wey don get fiancee..! Abeg free that side...." So as i was saying..i got d line from there and developed d rest... " Hmmn nice one .freestyle d one wey u wan do naw " no oo.wait make we reach studio first,no rush naw.hehehe.i sabi say u don dey anticipate.. ![]() Soon he went to take his bath.. |
End time Sacking |
shona2487: ![]() |
End time Nunu |
lasisi69:nigga u cray..End Time laughter !!! |
End time Album launch |
End time Kidnap |
End time innocence |
end time lover boy |
I need a phone |
End time Pageant |
Episode 9 But rather than make my guy reason all these troubles and be more focused in life con find hin true talent wey God give am,The wealth and affleunce wey all dis palongo artistes dey show just dey Shark my guy , dey make am think say he be genius 4 Music, A field wey he no sabi shishi about, I pity this bros sha !!. As this guy poor for 1Q.,na so he poor for music .Con poorest patapata for Cooking.Whether na Spag i dey chop or Na half cooked spag palmoil peppersoup stew. I sha know that i ate one of the worst spags of my life that day...... And na this same guy go dey form chef online....Oga oooo. " How d Spag be ![]() " Ha .u such a good cook,your wife go enjoy u gan " People dey talk am say i sabi cook " Ehn " You know see as i garnish am with salt and pepper " You are good " i said trying as much as possible to suppress my emotions.. " If i no do music,.the next thing na to turn chef " Lol.. Ehn....Mgoat ... ...how did u write that your last song sef He swallowed the Spag in his mouth and picked the one that fell on d concrete floor.back directly into his buccal cavity.The palm oil just dey shine for under hin lips. " Baby Diva " He asked " Yes " ... " Hmmnn ... |
Episode 8 " See u,the money for jamb sef i add am join, why u think say i dey bin dey house dis year again"" " Hahaha...u bad ooo """ " Yes am doing this because i know i will make it in d music industry ,all these things are just neccesary sacrifice wey person gats do.. " hmmn " Wizkid had to drop out,9ice had to drop out..So i now am fully going into music,why i go con go school knowing fully well sey.with d pace i dey go,and my immense talent. i fit no pass 200 level before i blow,i go con drop out .. " Hmmn ,True talk" " i wise gan .I get sense Naw.. I don think everything together... So he better make i focus on d music,instead make i go waste time for school .Abi wetin u think ?? " Na so Jare boss. baba.. " Na me..haaa..spag " He runs to quickly check the food. Being the only boy in the family with one elder sister.Viviangist1 and two younger sisters.LadyF and Introvert., He remains d man of the house since hin papa.Midolian Left to marry another woman ,MrsPhyno and abandoned them and their mama to cater for themselves. |
Episode 7 " shey bi na your 5th track be this guy " " yes ooo..This one na hit jam. " U sabi say your first four tracks wey me i hear own.dem no " eh i sabi..i sick small when i be write that track " Ehnn..shebi u no sha sick now sha....( laughter) " How your babes ow ?? " which babe " Akube said suprised. " haa all this babes " lol..all of dem no serious jare..na money dem dey find " lol..Buh i think say dem day fall for celeb ni " Oga park well abeg..If dem Come close say u be celeb.wetin u go use maintain dem.....no be money " Lol.. All dose money.cash .wey u dey show nko " Guy man,na publicity naa..as i no get manager, i gats manage myself.... " Lol " Akube haa.... Abeg heat day oo..i said as i bin dey use cloth fan myself. " Haa no vex,dem don cut our light, my mama no gree pay bills after 3 months " Ehn .i sha see say light dey outside too..una no get gen " Noo ...Na The Gen i sell, use gather money for my second track... ' U sell your mama Gen ?? I said amazed |
Episode 6 Boo boo" you dey fresh ooo " Ma Bros na God"..When u con enter yesterday naa ?? " I went to settle some things. Ni ! Oya naw.Badht guy " Ehnn.... How d package wey u con do naa ?? " We thank God ooo .. The thing dey,we pray Make result good . " Boo boo,the Professor.. scholar.... " Bro na u na,doro mega superstar " Na me be dat ...talent different from talent ... " Yes ooo.baba mi.lol..Na your name everywhere for twitter, Facebook. nairaland ' Haa, u even land for better time, i dey even go studio today sef ..Na d wahala i go dey sort yesterday jare.. " ehnn.. " Na your bag be that ?? " yes...haha wetin dis girl slippers dey do for here.. " Who be that ..... " my sister.. i hope say she no....He said checking load of books laid against the wall.. " God save this girl..Always searching my property. " Hehe .Girls ow we go do dem......but akube.your mama don talk say make u no comot early now Na mama Akube u dey send "" " Lol " " Make i go find Spag cook,make we chop before we go "..I no fit dey chop yam this early momo.. " Ok naa..but bro how far with your admission"runs naw ?? " We still dey push am oo. This was his 3rd year at home without admission.. i don finish my secondary school and na my final year me dey so.. .. Despite the fact shey akube senior me with like 3 years,only those close to him know say he never get admi not to talk of ssion. ... |
wristbangle...he be like say u and tosyne2much dey call una selves before una create thread abi .u are always Ftc on each others thread ![]() |
End Time Ladies |
am sorry for the late update . Bin busy ..will endeavour to update as soon as i work out some urgent issues.. |
Kingsley1000:Bin following andyblaze Story...THE humour is certified FRESH .... ...HE is GOOD.. |
Beautiful family |
Hmmn |
lol |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 68 69 70 71 72 73 74 75 76 (of 100 pages)


