₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,327,125 members, 8,429,455 topics. Date: Thursday, 18 June 2026 at 10:16 PM

Toggle theme

FILEBE's Posts

Nairaland ForumFILEBE's ProfileFILEBE's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 96 97 98 99 100 101 102 103 104 (of 120 pages)

SportsRe: Nigeria Vs Mexico: FIFA U-17 Semi Final 4 - 2 Full Time! by FILEBE(m): 2:03am On Nov 06, 2015
goldiam:
This guys are heartless I am in love with the u17 team ;DThis guys are heartless I am in love with the u17 team
me nko? I follow for u17. Be inlove with me too jor
SportsRe: Nigeria Vs Mexico: FIFA U-17 Semi Final 4 - 2 Full Time! by FILEBE(m): 1:58am On Nov 06, 2015
Tonto be like ALIGATOR wey get skin defect. God forgive me o.
Abeg wen we go meet Mali?
SportsRe: Nigeria Vs Mexico: FIFA U-17 Semi Final 4 - 2 Full Time! by FILEBE(m): 1:55am On Nov 06, 2015
Nice one! I understand una no wan score much like una dey do. God no like aseju.
SportsRe: Nigeria Vs Mexico: FIFA U-17 Semi Final 4 - 2 Full Time! by FILEBE(m): 1:52am On Nov 06, 2015
Wetin make that guy sit down for ground like same needle dey him yanch? Come on! Stand up! Na una get match
SportsRe: Nigeria Vs Mexico: FIFA U-17 Semi Final 4 - 2 Full Time! by FILEBE(m): 1:51am On Nov 06, 2015
Guys relax na! Una go score more. But sha no go do the one wey go make USA break ties with Mexicans o. Abeg
SportsRe: Nigeria Vs Mexico: FIFA U-17 Semi Final 4 - 2 Full Time! by FILEBE(m): 1:47am On Nov 06, 2015
Guys relax! Each of una go score one by one! Won ma pe yin ko ti tan yi
SportsRe: Nigeria Vs Mexico: FIFA U-17 Semi Final 4 - 2 Full Time! by FILEBE(m): 1:45am On Nov 06, 2015
Refeeree! Wetin happen na? Why u dey rush my boys na? I think say you wan go flog am ni sef.
SportsRe: Nigeria Vs Mexico: FIFA U-17 Semi Final 4 - 2 Full Time! by FILEBE(m): 1:42am On Nov 06, 2015
Goaal! Ha! Iya won! Their pappa! Who say we no go win o! Thunder! Thunder fire thier papa!
SportsRe: Nigeria Vs Mexico: FIFA U-17 Semi Final 4 - 2 Full Time! by FILEBE(m): 1:42am On Nov 06, 2015
Goaal! Ha! Iya won! Their pappa! Who say we no go win o! Thunder! Thunder fire thier papa!
SportsRe: Nigeria Vs Mexico: FIFA U-17 Semi Final 4 - 2 Full Time! by FILEBE(m): 1:40am On Nov 06, 2015
Penarity! OPE O!
SportsRe: Nigeria Vs Mexico: FIFA U-17 Semi Final 4 - 2 Full Time! by FILEBE(m): 1:37am On Nov 06, 2015
But wait o. Is their anything against wearing our native attire as a football coach ni? Must we wear blip and suit come look like King kong inside am.
I no talk say Amunike look like King kong o
SportsRe: Nigeria Vs Mexico: FIFA U-17 Semi Final 4 - 2 Full Time! by FILEBE(m): 1:34am On Nov 06, 2015
Until dem break the guy leg b4 you change. Make the guy mama catch you. This one wey dem bring, Madueke. Na Allison pickin?
SportsRe: Nigeria Vs Mexico: FIFA U-17 Semi Final 4 - 2 Full Time! by FILEBE(m): 1:31am On Nov 06, 2015
Oga Amunike. No too go depend Lucozade boost o. E nor dey work for 24hrs o. Change players na,
SportsRe: Nigeria Vs Mexico: FIFA U-17 Semi Final 4 - 2 Full Time! by FILEBE(m): 1:28am On Nov 06, 2015
This Mexican coach never reach substitle limit ni? Na the whole teenager for Mexico e wan put for pitch ni?
SportsRe: Nigeria Vs Mexico: FIFA U-17 Semi Final 4 - 2 Full Time! by FILEBE(m): 1:26am On Nov 06, 2015
Ehn ehn! Their papa! Goaaaal! We nor be una mate!
SportsRe: Nigeria Vs Mexico: FIFA U-17 Semi Final 4 - 2 Full Time! by FILEBE(m): 1:24am On Nov 06, 2015
Goridoe:
'em matter don tire me bro.. na only them go Cambridge... tcheew.. simple sentence 'the boys are good'
you know say i fit blame am for the goal wey Mexico score? The guy use grammer comot me from concentration.
SportsRe: Nigeria Vs Mexico: FIFA U-17 Semi Final 4 - 2 Full Time! by FILEBE(m): 1:21am On Nov 06, 2015
Oga commentator! Shey u wan dey mock us now ni? No go think say stone no fit reach where you dey o..!
SportsRe: Nigeria Vs Mexico: FIFA U-17 Semi Final 4 - 2 Full Time! by FILEBE(m): 1:20am On Nov 06, 2015
Hey! Una pack una sef for cörner like sardine wey dem don odemn, watch as the idiot carry ball pass una body. Una take sleeping tablet?
SportsRe: Nigeria Vs Mexico: FIFA U-17 Semi Final 4 - 2 Full Time! by FILEBE(m): 1:14am On Nov 06, 2015
Clevite:
These Eaglets have really shown character! The sign of a team with a good character is when they are down they keep on the mental balance and keep the ball, controlling the game and pressuring the opponents. In no time, a team with that attitude almost always come back from behind and take the lead. That's exactly what the Eaglets have displayed so far in this match.
*yimu* Oyinbo ti poju. Knack wetin we go understand. Na we we dey here. Na go do like Chuks wey go dey speak grammer for viewing centre, "cover your left flank! You guys should retreat! " . Na beg the guy beg to enter watch 2nd half.
SportsRe: Nigeria Vs Mexico: FIFA U-17 Semi Final 4 - 2 Full Time! by FILEBE(m): 1:08am On Nov 06, 2015
Dear Ref! Kaju! Gboju! Commot eye! You no fit Kaju make that boy score the offside goal ni?
We go enta pitch knack u something now.
SportsRe: Nigeria Vs Mexico: FIFA U-17 Semi Final 4 - 2 Full Time! by FILEBE(m): 1:05am On Nov 06, 2015
Shey our keeper na MfN member? E fit be keeper wey get part time job as prayer warrior sha.
SportsRe: Nigeria Vs Mexico: FIFA U-17 Semi Final 4 - 2 Full Time! by FILEBE(m): 1:01am On Nov 06, 2015
The way wey dem use Tonto Dike for this ebola advert dey wan make me vex go catch ebola. God forbid sha. I mean.... See how steewpid and irresponsible the tatoo she carry for neck like american flag. The neck be like Dinosaur specie.
SportsRe: Nigeria Vs Mexico: FIFA U-17 Semi Final 4 - 2 Full Time! by FILEBE(m): 12:56am On Nov 06, 2015
If dem show that indomie advert again ehn.... Wich kain mumu advert be that? Agbayas dey dream of indomie. Maybe na why supa eagles no dey perform well for bed.
Sorry, pitch.
SportsRe: Nigeria Vs Mexico: FIFA U-17 Semi Final 4 - 2 Full Time! by FILEBE(m): 12:49am On Nov 06, 2015
Na wa o. NAIRALANDERS dey update pass wall street o! Kilode. Na dey browse untop mtn mast ni? We dey see goal before comentator sef!
SportsRe: Nigeria Vs Mexico: FIFA U-17 Semi Final 4 - 2 Full Time! by FILEBE(m): 12:45am On Nov 06, 2015
Their papa! Goooaaaal again!
SportsRe: Nigeria Vs Mexico: FIFA U-17 Semi Final 4 - 2 Full Time! by FILEBE(m): 12:44am On Nov 06, 2015
Osihimen dey knack him papa mate for waist ni sha.
SportsRe: Nigeria Vs Mexico: FIFA U-17 Semi Final 4 - 2 Full Time! by FILEBE(m): 12:37am On Nov 06, 2015
Their papa! Goaaaaal!
SportsRe: Nigeria Vs Mexico: FIFA U-17 Semi Final 4 - 2 Full Time! by FILEBE(m): 12:34am On Nov 06, 2015
The mexicans too dey bee. Dem be Oya. See as we dey give them koshi. Person go soon tear ligament now.
SportsRe: Nigeria Vs Mexico: FIFA U-17 Semi Final 4 - 2 Full Time! by FILEBE(m): 12:30am On Nov 06, 2015
FILEBE:
This Jersy get as e be jor. E nor fine . E be like bag of garri design.
na Tom tom design the jersy?
SportsRe: Nigeria Vs Mexico: FIFA U-17 Semi Final 4 - 2 Full Time! by FILEBE(m): 12:27am On Nov 06, 2015
This Jersy get as e be jor. E nor fine . E be like bag of garri design.
Jokes EtcRe: Checkout The Most Hilarious Adverts Ever Put Out....lol! by FILEBE(m): 5:57pm On Nov 02, 2015
koligs:
A senior friend asked me to wait 4 him in an eatery in Oshogbo. So I ordered for sumtin of ₦250(sometin a gentleman lyk me can afford)..100 amala,50 naira meat,20 pure water and 30 naira for madam keep d change.

After Eating succesfully d Voluminous meal and waiting ,i noticed a rich man in agbada
. About 50secs later, a man went to dis richman & told him he lost his wife & need money...Immediately, d richman gave him a millon naira cheque out of pity.(wow! I was shocked).
Another man went in crying dat he lost his father & needed money 4 burial, this good rich man gave him a millon naira cheque too (ehn? Kini mo gbo? I CANT BE LEFT OUT)
. I was cooking in my mind, d type of pitiful lie I'll also tell 2 rececive my own 1 million...I summoned courage and went to d richman's front.
I told him I lost my grandfather & I need money (I was crying,sheddingcrocodile tears...).whileI was expecting this man to open his brief case & give me a cheque too, suddenly I heard a noise

















"CUT!!! CUT!!! CUT!!! MR MAN, YOU CAN'T INTERUPT OUR FILM JUST LIKE THAT"
Now that is funny!
PoliticsRe: Ben Murray-Bruce Takes A Shot At Buhari by FILEBE(m): 10:01pm On Nov 01, 2015
Will we just attack the person and not the party? Apc this , Pdp that. We all know both of them are not saints. We are giving these party too much attentions jare. Once they produce a candidate we should forget about the party and focus on the candidate. We are making these pary look stronger than they are. I hope someone understands what i'm saying.

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 96 97 98 99 100 101 102 103 104 (of 120 pages)