Politics › Re: Yoruba And Hausa Fight In Mile 12 Lagos (Graphic Photos) by hungryboy(m): 5:12pm On Mar 03, 2016 |
olapluto: I doubt Hausas will make trouble outside their land. Lagos is too far away for them to pick up fights. If they are being pursued, they wont reach Ikire before being caught. I urge Lagos govt and the federal govt to intervene. Oba Akiolu Rilwan, Olowo Eko, Oko Kofoworola, please step in and deal with the culprits. oga oh, This your story come make me remember one film title called, 'i see dead people' |
Crime › Re: IED Manufacturing Factory Discovered In Kumshe Village In Borno (photos) by hungryboy(m): 9:04am On Mar 03, 2016 |
Good job Nigerian Army,
Thunder go fire those boko are rams,
When people dey manafacture wetin go help human kind,
Their own na to manufacture wetin go kill other human beings |
Celebrities › Re: I Didn’t Get Married To Olumide Because Of His Wealth – Dakore Akande by hungryboy(m): 8:53am On Mar 03, 2016 |
Aunty, wetin we sabi been say you no for marry wheelbarrow pusher, You are not a gold digger, but we know say, if dem give you gold, you go collect |
Politics › Re: Senate Moves To Enforce Patronage Of Local Goods by hungryboy(m): 8:34am On Mar 03, 2016 |
I see |
Family › Re: Lady Accuses Married Man Of Impregnating Women With Fake Marriage Proposal by hungryboy(m): 10:13pm On Mar 02, 2016 |
ellechrystal: Lmaooo. Go n pray for urself first for divine direction, before praying for someone else ok. Smh. ok Aunty, but that one no go stop me from to pray for you too |
Crime › Re: Photo Of Yinusa, Ese Oruru's 'Abductor' by hungryboy(m): 10:08pm On Mar 02, 2016 |
. |
Family › Re: Lady Accuses Married Man Of Impregnating Women With Fake Marriage Proposal by hungryboy(m): 10:04pm On Mar 02, 2016 |
ellechrystal: Lmao. Am not searching neither am I 32, hungry man or whatever ur name is, go n get something to eat, u r truely hungry, I think ur brain needs some aunty, mbok, you are lying and i can smell it from my hut here in Calabar, All those guys were don carry you play ball tire , dey always go marry another girl , Aunty you are in my prayers this year, Any man that scores a goal in your net shall surely propose, Say amen |
Family › Re: Lady Accuses Married Man Of Impregnating Women With Fake Marriage Proposal by hungryboy(m): 9:53pm On Mar 02, 2016 |
ellechrystal: I feel ashamed on their behalf. The bleached skin man who can't keep his Johnny down or better still in his house , plus d bleached skin snatcher who is bent on hitting it hard, vrs d bleached skin man's wife who can't spell or write properly to save her life. What in d hell is "ShE IS A SCANNER" shuooo, who she scan,? Ur family? I don't know y some women choose to embed themselves in such situations, I feel for them, its lack of self knowledge and self esteem that leads some ladies into situations like this. I feel disgusted already, Madam bleached skin's wife, hold ur hubby , he is d one u ve an issue with, for breaking his vow, n not d other woman who needs a man. I don finish my own Aunty na so life dey oh, you now were sabi speak better english and no dey bleach still dey single and searching at 32. |
Crime › Re: Man Tries To Bury ‘juju’ At Enugu Market (photo) by hungryboy(m): 3:12pm On Mar 02, 2016 |
I see,
But that one no go stop me from to chop garri dis evening |
Celebrities › Re: Controversial Actress Tonto Dikeh Shares How She Found Her 'mr. Right (hubby) by hungryboy(m): 6:28am On Mar 02, 2016 |
Na so dem go dey always call you Mr right when things dey good,
When dem wan divorce you, na This man dem go dey call you. |
Politics › Re: Bolanle Ambode Donates Conveniences For Children At Ndubuis Park (photos) by hungryboy(m): 6:23am On Mar 02, 2016 |
Things dey happen for dis Naija oh So na children toy house governor get mind comot for government house come commission? |
Travel › Re: Man's Leg Broken After Driver Lost Control Of Car (photos) by hungryboy(m): 6:10am On Mar 02, 2016 |
Chai, See as winch dey take follow pesin oh, Dis man no even dey for road na Mr biggs entrance e dey motor still come jam am break leg,
Like play like play, dat man don become handicap oh
May village witches plans never succeed in our lives |
Politics › Re: 2015 Gov Bid Plunged Me Into Debt – Jimi Agbaje by hungryboy(m): 6:04am On Mar 02, 2016 |
Who send am? |
Politics › Re: Fayose Condemns Buhari’s ‘silence’ On Killings By Herdsmen by hungryboy(m): 6:44pm On Feb 28, 2016 |
To rear cow no mean say, you must become a cow,
The government should ban this nomadic cattle rearers,
If you wish to rear cattle, buy grazing land for it ,
Fulanis are not above the law. |
Celebrities › Re: Nadia Buari Looks Sexy With Her 'man's' Shirt On (photo) by hungryboy(m): 1:37pm On Feb 28, 2016 |
Whether village people like am or not, i must marry fine girl like Nadia Buari. |
Celebrities › Re: Joseph And Adaeze Yobo At "Stalker" Premiere by hungryboy(m): 1:14pm On Feb 28, 2016 |
ellacute45: who give this one official hungry man title holder park well joor Aunty why you come dey vex for me nah? , no be me be your ex boyfriend were break your heart nah, abi na because i resemble am? |
Crime › Re: Robber Set Ablaze For Stealing Plasma TV In Lagos by hungryboy(m): 8:47am On Feb 28, 2016 |
One Mopol name come change to One dead robber |
Celebrities › Re: We Must Celebrate Ayodele Before Olajumoke - OAP Freeze by hungryboy(m): 8:37am On Feb 28, 2016 |
if na so we dey always celebrate Ayodele(s) since, We no for even sabi who Freeze be sef, So Mr Freeze, shut up, cos you are also a beneficiary of our craze for celebrating looks over brains |
Politics › Re: President Buhari Vindicates Barcanista By Abandoning N5k/month Social Benefit by hungryboy(m): 8:27am On Feb 28, 2016 |
Oga Jobless Mr, oh sorry Barcanista, You are always on point, but you dey get time sha,
Abi are you one of the ex militants getting free government money every month? |
Celebrities › Re: Regina Askia Celebrates Daughter, Stephanie As She Turns 24 by hungryboy(m): 8:19am On Feb 28, 2016 |
There are two things that are inevitable today,
One is, this will make frontpage and Two is, i go chop garri and affang soup dis morning |
Family › Re: Malkohi IDP Camp In Yola Welcomes 4 New Babies (photos) by hungryboy(m): 8:15am On Feb 28, 2016 |
Dis one were we dey only see Mama and pikin alone,
who dey put dis women belle for IDP camp nah?,
I hope say no be those soldiers were dey guard the camp oh? |
Politics › Re: Photos: Gov Tambuwal With New Wife by hungryboy(m): 8:12am On Feb 28, 2016 |
This girl should be warned, the same way Tambuwal sideline the other two wives dey bring am into the spotlight now, Na the same way him go sideline am when him marry new wife join am, And e no go too stay were e go happen |
Politics › Re: i Created Over 125,000 Jobs Within 9 Months – El-ruafi by hungryboy(m): 8:06am On Feb 28, 2016 |
caselessogbuagu: sharrap and stop displaying ignorance on public forum.
Since he left abuja as minister, his record is yet to be matched. And not even those that came before him could even boast of what elrufai laid down in the FCT. were dis one comot from, No be your fault sha, I blame the guy were sell you dat igbo were you smoke dis early morning |
Family › Re: Ogun Pastor, Akinsanya Welcome Twins After 18 Years by hungryboy(m): 8:03am On Feb 28, 2016 |
Na wetin make money good be dis, Papa Ejima my neigbour were be gateman like me, As him wife born twins last year add for the 5 children were him been already get, The man run leave him family, till today we still dey find am |
Romance › Re: I Want To Marry But*... by hungryboy(m): 7:57am On Feb 28, 2016 |
Wetin go carry me near marriage,
when i never chop bellefull?, |
Celebrities › Re: Chris Brown Seen With Rita Ora At The Milan Fashion Week Afterparty by hungryboy(m): 7:54am On Feb 28, 2016 |
That one na him cross,
My own cross dey my back |
Politics › Re: i Created Over 125,000 Jobs Within 9 Months – El-ruafi by hungryboy(m): 7:51am On Feb 28, 2016 |
This dwarf don try for Kaduna small sha,
But make him leave to dey mention figures like say him dey talk to small pikin,
How many schools dey Kaduna, were dem go employ over 80,000 cooks? |
Romance › Re: Photos: Woman Goes Down On Her Kneel To Propose To Her Girlfriend by hungryboy(m): 7:45am On Feb 28, 2016 |
I can see why the are getting married to each other,
After all which man go gree put a fair ape and a chimpanzee for him house ? |
Family › Re: Parenting: How Much Can You Sacrifice To Have Your Wife Pregnant by hungryboy(m): 7:40am On Feb 28, 2016 |
No be for naija dis one dey happen, Which naija man go gree make another pesin put him wife belle, him come dey raise the pikin as him own? Naija man go leave him wife, go try him sperm power for different women body first, with luck, e fit work get one girl pregnant |
Celebrities › Re: Joseph And Adaeze Yobo At "Stalker" Premiere by hungryboy(m): 7:33am On Feb 28, 2016 |
funnynation: I swear they look ''bad''.. I mean baddest.. You know say na only for naija people dey answer baddest as good name.. Lil kesh, Davido, wizkid and Olamide all of them na baddest.. . .
Nairaland official comedian who give this one Nairaland Official comedian, Na buy you buy the title, Abi you just dey answer title were you never earn? |
Celebrities › Re: Joseph And Adaeze Yobo At "Stalker" Premiere by hungryboy(m): 7:32am On Feb 28, 2016 |
Who picture don help before?
If nairaland no take care, e go soon become instagram for celibrity pictures only, posted by bloggers |
Celebrities › Re: See How Oge Okoye Almost Exposed Her Vagina by hungryboy(m): 12:45am On Feb 28, 2016 |
Op,
Almost no follow for promo,
Na real exposed we dey find |