Hungryboy's Posts
Nairaland Forum › Hungryboy's Profile › Hungryboy's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 75 76 77 78 79 80 81 82 83 (of 119 pages)
PoliticalThuG:we already know say, everybody online na millionaire, even those were dia hunger worse pass my own |
Encouraging criminality again, As long as the government is always ready to offer amnesty an a salary to any guy claiming to be a militant or oil bunkerer, It will only encourage more to follow their path. |
Oga, go sleep abeg,
No carry family matter were you never even know how e take start for head |
Back to the matter sha, If una like make una talk say na Paul get talent pass, dance pass, sing pass, But at the end of the day, without Peter, that magic of P square no for hold us, The need each other, It's too late for either of them to go solo |
Na too much chop belleful and money in the bank dey cause all this one, |
.no be wahala be dat, Jude get money to take care of Cynthia and the pikin, If na me put woman belle so, I go think die how i go take do gateman feed the girl and the pikin |
lalasticlala:oga Lala, As e be your day, Show me love nah |
To born into successful family Good oh, Me were born come see say, the most successful guy for my family na okada man, I just talk say as far as i be okada man or try small pass am, I don succeed. |
macino1:morning Monsieur Macino1, Merci for the offer, But can you monetize the package?, Cos na food be my present problemo. |
See as she come resemble refugee for the last picture, |
1miccza:my guy, farm for your farm nah, My hunger and your own no be mate nah, You wan come struggle blessing with me? |
That's what you get, When you choose money over character, Gateman like me, were go dey loyal to you for life, you no go gree give me face, |
bebe2:Aunty,let's not even go there, Na still those same church goers label am witch nah, Some church goers no longer go to their villages due to fear of witch attacks, Churches this days, only preach giving to the church, not your neighbour or those in need |
Chai |
Which kind luck this woman get like dis?, Make she remain small luck for me nah, All dis suffer were i dey suffer for sun, i never fit still afford three square meal, , God, abeg turn your atm come my side nah |
Mr Solomon Arase, Catch the herdsmen, You never catch, You don already dey speculate say dem be foreigners, Oga do your work were dem dey pay you to do, if you no fit do am, just shut up dey collect salary as you dey always do. |
macino1:je parle francais petit petit, I hope say dat small broken french were i speak don do, Make i wire you my account number? |
ceejay80s:my guy na 300 dey make you vex like dis, E mean say, if na 3k dem been scam you, you fit kill pesin oh |
My guy, Girlfriend too cost to maintain, Olosho na fvck and pay, But vaseline na only 50naira dem dey sell am, Tell me which one a broke guy like me will go for? |
Atlantian:oga oh, dis kind money were i dey hear so dey make tears comot for my eye, How una dey take make dis kind money? |
Oga macino1,
Am also in need oh,
Abi you dey only help people were dey speak french? |
Obiagelli:aunty you see road, That's the same thing am advocating for, Scrap this agencies, I was telling someone the same thing, Why do we have a need for NDDC? When it only leads to more corruption, and more workers on government payroll Why not just share the money budgeted for the Nddc for projects , to the Niger delta states? |
bigtt76:aunty, when your wife don become breadwinner of the family overnight, As the husband, you get show increased loyalty and love nah, Make she no dump your broke ass |
Chai, This woman were don hawk bread for years, she no even fit afford 1 room house rent, In just one month were God turn eye look her side, She don become famous, Pesin don dash am flat, And now she is even signing modelling contracts worth millions, Village witches, i knell down beg una, Abeg make una just go holiday for my life for just one month, Una suppose follow pity me nah, Una wan until i carry rope tie for my neck? |
'so na wetin dem carry come frontpage be dis' ? |
This is some funny shi.t, But that's a wrong term for the situation he was in, he is supposed to be shouting, if my dick wills it |
nlfan:aunty mbok, this your story na movie, If it looks like a lie, If it talks like a lie, If it smells like a lie, It is a lie, But in case you are available, Am broke and ready to mingle sha, |
oga Op, abeg in case you wan throw away all the money were you get,
I dey here |
I hope say dem go fit finish that food were i see so for that table oh?, E dey vex me to see people waste food, when i dey here dey find wetin to chop since morning. |
Like play like play,
Dis woman don use gossip take become billionaire,
Chai,
Where people dey carry luck make am for dis life? |
That one no go replace my garri were don dey finish so |
If na me been dey sell that bread dey Pass so when T. Y Bello dey do shooting, She for just tell security to pursue me comot dia, make i no spoil her shots, Why the winch were dey follow me no wan follow go holiday like Olajumoke own go so? |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 75 76 77 78 79 80 81 82 83 (of 119 pages)
BTW the husband don turn nanny shaaa