Hungryboy's Posts
Nairaland Forum › Hungryboy's Profile › Hungryboy's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 72 73 74 75 76 77 78 79 80 (of 119 pages)
You never get money, you get mind go put woman belle come dey blame your inability of taking care of her for your stealing, Mr Kingsley, you are a first class fool, But our churches too no dey try, make una dey try use this offerings and tithes follow help una poor members nah, |
Gifting an Suv to a woman who already has more than one and enough to afford more, Me were dey waka for Leg here dem no come dash Motor |
Na only for Lagos abi na nationwide? |
This guy dey vex oh, which one you just dey write finite,infinite anyhow?, Your Infinity Suv loss? |
So na so dis two Sans come take enter sand sand? |
Why i go help you type amen,
If you win, na me you go chop the money with? |
To serve Nigeria is not by force, Our unity is only written in the National anthem, In real life na Manchester Disunited we be. |
Our Calabar police too corrupt abeg, If the AIG dey serious about fighting corrupt officers, He should arrest all those corporals and sergeants driving cars that their monthly salary in 10yrs cannot afford |
Deejacy2:i dey wait until the price reduce to 15k before i call you |
Good development |
tony4u035:if you go send me flight ticket, i go come |
aventura:if you dey near me, bottle for land for your head oh, we are talking about a 13yr old girl, even if she was not hypnotised, what does a 13yr old girl know about love? If 25yr old man carry play near my 13yr old sister, i go break am head first, then we go settle for police station later |
R.i.p |
Happy birthday,
Were the party dey hold, i hope say rice and stew go dey dia oh? |
I see, But why Genevieve come dey pose like 17yr old? Abeg make una remind that woman her age oh, Ibu belle sef don big now pass pregnant woman own, To get money no mean say you must dey drink beer anyhow oh. |
Guy no do me vex oh, Wetin fell in love mean?, Ab.oki were deceive 13yr old carry am go dey bleep for their village, even get mind come convert am to Islam, you come here come dey yarn okpata, If you get 13yr old girl for una house, you for understand why dis story dey vex pesin |
Adasun:na the same thing were my friend were no fit even afford bicycle been talk |
funkyibodude:he is complaining of a 50k reduction in his salary, while other workers are taking home 18k salary every month, If i was the president, i'll slash salaries of every government worker earning more than 200k, and use it to upgrade the minimum wage to at least 30k. |
Ekakamba:ato uke? |
Ekakamba:da ikpa, ndionghoke Ekakamba oh, Etekamba kpod ke ndiongho. |
Na dis kind people were my village people for Akwa Ibom dey call craduad |
Airforce1:na the same reason were you read my comment you no understand, be the reason were you still be C grade musician till now |
Abeg leave grammar for Grammaticas, Your family background and what you are exposed to defines your dreams, While Rich man pikin dey think of how to become doctor, lawyer , pilot, Poor man pikin dey reason say as far as him no poor as him Papa when him grow up, him don try be dat, When you dey for house were your father no fit afford bicycle, if you him son come succeed buy Motorcycle, you go think say you don over try |
Chai,
Why to kill fellow human being dey easy some people like dis nah? |
Lalasticlala to create thread e no make frontpage, mean say dem don sack am for work. Na sure frontpage thread be dis. |
Now, this is tragic,
May their souls R.i.p, |
Ohanaeze is a disgrace, No matter as hunger dey hold me, i no fit visit the killer of my brother house, go beg am chop, No matter which side you are on the Biafra issue, if you are sane, i don't think that you will support the extra judicial killing of unarmed Ipob protesters, Innocent igbos were killed, and instead of the group that claims to represent the interest of igbos, voicing out to the government to compensate the families of the deceased, and jail the soldiers responsible, the are going cap in hand to Aso rock. This guys are pathetic |
ibibiofirstlady:aunty, mbok yak nkid picture mfo, yak nse whether you merit the title |
This dwarf just dey enact laws anyhow,
Leave bible and koran matter, focus on developing your state,
By developing, i no mean, to dey give primary school children lunch oh. |
ibibiofirstlady:Mma, mbok na who dash you Ibibiofirstlady title? |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 72 73 74 75 76 77 78 79 80 (of 119 pages)
