Hungryboy's Posts
Nairaland Forum › Hungryboy's Profile › Hungryboy's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 70 71 72 73 74 75 76 77 78 (of 119 pages)
Aunty, i sympathise with you,
But i no get money to give you,
May someone with the means, meet you at this point of your need, |
Seun:maybe the Op took igbo were pass him mental capacity |
INTROVERT:she don come back again, Wetin you bring for us? Abi na only 4G network you bring come back? |
halfricanadian:na tribalism dey cause am nah, Anything she go post now for instagram, E- telepaths full ground were go interprete am . |
Guy, change for your sake oh, Now were something never do you, your moniker na Painfullife, By the time police catch you as you dey bleep fellow guy, na Prisonlife or wastelife e go turn to |
In Wenger we Rust,
Sack that man or else, he will soon change our team name to IsaleAm |
400billionman:Oga, i hope say you are not making this comment from a face me i face you like me oh? |
cruzita:Aunty, who talk am, where am, make i break am bottle for head |
Dem P-square, don help Jude make millions for himself, The best thing for him as a senior brother now is to move on to other businesses and let the twins do their thing, if him don chop the millions finish, make him come join me dey pack blocks, We go dey get work well well, since people go like make P-square dem senior brother pack their blocks for them. |
Holes too dey dis your story, No be say, you carry money, were your parents send give you, go try to double am for nairabet,come lose all the money, come form story were you go tell them, so that dem go pity you, send you another money oh? |
asokoromadam:this one just land oyinbo on tourist visa, come here dey form made in America, Madam, who tell you say all Nigerians dey in support of many bad things were dey happen here so? Abi, na now oyinbo release you from jail? |
Airforce1:like the Russians always say, If it looks like a lie, if it talks like a lie, if it acts like a lie, it is a lie |
The way dis women dey always waste money on make-up, hair extensions, and clothes dey vex me, |
HungerBAD:quiet side ke, It just that the major national newspapers and other medias, are not really active in Calabar, Infact presently, there is a war going on between a village in Abi L.g.a in Cross River, with a neighbouring village in Ebonyi state, 5 people were killed on Sunday, but no major national newspaper reported it |
Like play, like play, the definition of what is newsworthy don change, If na dis kind thing been dey always make the news for our Parents time, dem no for dey start Generator to listen to 9:0 clock news |
Dem never still answer the question were we want, Did three different men drive her Corrolla before the Ooni bought it? |
cocaineaddict:as God don bless your hustle so, follow Dash me chop money nah, me sef i be food addict |
Abeg make una interprete the video give us, were dey use etisalat free mb dey browse nah abeg? |
dainformant:oga, you sabi whether for inside house na Fuji house of commotion? |
raf2angel:where dis ram comot from? |
Wetin dis Pastor dey feel like sef?, Because you chop nairabet one time no mean say you don become expert gambler oh, If na so you get anointing, why you never kill all boko are rams, rescue the chibok girls come house? |
1)NIGHT BUKA- selling garri and soup, rice or fried yam, plantain,potatoes and fish in the evenings 2)NIGHT CABBIE- Driving taxi in the evenings after work 3)NIGHT ASHAWO- e dey self explanatory nah,just find one roadside were dey always dey busy stand, one money miss road go come talk price carry you go hotel go cure konji |
Nice one Oga Joshua, But make him also know say, many of us were dey Naija, hungry pass those were dem deport from Libya, abi na because dem show dem for tv, make am thing say na dia condition worse pass? |
Ifeconwaba:. |
I can't begin to imagine, what the Mother of the abducted girl is going through, The child you carried for 9 months, being abducted, converted and probably married off to one Hausa man at the moment, Don't be suprised to discover that she will be a few months pregnant, if she is eventually given back to her parents. |
Adaure4ever:it's called love jihad in India. |
I fear human beings pass lion sef |
If una like make una rant against am, or make some of una support am, at the end of the day, your comment here, will not change anything, |
I no even get wetin to talk, I just love to see how stupid i have become, If you think say, you get sense, like this post for no reason |
The Russians are right, Obama's presidency has been a disaster to the world, At least George Bush didn't mince words and called his, war on terror and sanctioned the invasion of Afghanistan and Iraq, Obama, the pretender, called his huminatarian interventions, and bloody trail stretches from Libya, Syria to even Ukraine. Obama's presidency didn't make racism go away or helped the African American population or Africa in anyway, He only served the interests of those who placed him there |
Give me the money, make i keep for you, when you see the phone were you wan buy, you come collect am, I dey Marian street in case you wan do as i talk so, just pm me |
Protesting because the present government after getting their votes is not carrying them along?, Aunty Tinubu, leave all this big english,make una just talk say, dem no settle una financially or wetin dem been give dey below una expectations, But this Tinubu daughter get mind to join this market women protest sha, Pesin were him father dey control Lagos treasury and money dey flow for their family like sand sand, abi na because her greed no get end like her Papa own? |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 70 71 72 73 74 75 76 77 78 (of 119 pages)
Only aunty lola dey chop blame d oda two wives nko?
who say money no good