₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,330,417 members, 8,445,405 topics. Date: Wednesday, 15 July 2026 at 12:31 AM

Toggle theme

Kaxmytex's Posts

Nairaland ForumKaxmytex's ProfileKaxmytex's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 (of 92 pages)

CelebritiesRe: See How Little Girl, Success Adegor Has Grown 5 Years After Going Viral (Video) by Kaxmytex(m): 9:39am On Jun 18, 2024
How time flies
EducationRe: Sanwo-olu Announces ₦10 Million Reward For Lasu’s Best-graduating Student by Kaxmytex(m): 3:05pm On Jun 06, 2024
RepoMan007:
So unfair.
Someone studying accounting and another studying engineering cant be weighted on sam scale. Do it faculty by faculty.
What's this?
Una go just open mouth waaa
PoliticsRe: Wike Reveals Reason Behind Naming FCT Road After Wole Soyinka by Kaxmytex(m):
Well deserved recognition..

Talk of prof wey fit handle Chihuahuas even at old age, that's wole Soyinka...
Because sey a man air his opinion no mean sey u go use 600naira 2.5gb dey abuse am...
That man go talk one thing today, next 3 decade, e go still dey ring, unlike u wey go use ur 600naira 2.5gb talk one thing, and e don expire before that data... nobody knows you, u go just dey online dey constitute nuisance all because ur opinion no align with other people's opinion, u better think about life..
RomanceRe: As A Married Woman, I'm Tired Of Sleeping With Different Men by Kaxmytex(m): 6:54pm On Jun 01, 2024
U don go igbara, u don go igboro, u come dey suggest open marriage for ur so called husband, still come dey spew thrash sey u love him..
wetin be diz?
PoliticsRe: New National Anthem Is National Self-Debasement By Farooq A. Kperogi by Kaxmytex(m): 6:14pm On Jun 01, 2024
If u ask ur so called compatriots to arise, who the heck are ur foes??


65years ago, a woman came up with the line, though tribe and tongue may differ, in brotherhood we stand, una sure sey she never see 100years ahead.
FoodRe: Man Counters Those Who Say "Yoruba No Get Soup" (VIDEO) by Kaxmytex(m): 6:41pm On May 29, 2024
As a Yoruba guy, fear sef dey grip me with some soup wey I don chop....

Yoruba soup are highly medicinal, no be one kind soup u fit just decide in a blink of an eye sey u wan go make because u just cook ur rice, u go don make up ur mind like a week to that time, dey prep ur sef how u go take run am...na once in a while soup, they are not made to be a common soup or usuals...
Questions like, hope u are on leave at work, do u have plenty of water to drink and bathe, how many people wan chop am,etc has to be put in place before making some Yoruba soup.. u go fear nah...anything you are taking in has to have a positive effect on ur body, na their mantra be dat....
U fit chop soup for 5min, make u open mouth for 10min, dat one too dey...

Yorubas get plenty soup, they are not just common or usuals u will find in a restaurant..
They can make a soup out of any leaf... do u even know that some leaf dey wey be sey Dem no fit pluck Dem at anytime, u gats first check the time before touching those leaves, they believe plucking it at the wrong time, u are going home with a sleeping leaves with zero potency.....lolzzz
Soup dey o, na u no go far....
TV/MoviesRe: Phyna Cries Out To Nigerians To Help Her Recover 1BTC Promised Her By BBNaija by Kaxmytex(m): 9:44am On May 24, 2024
1BTC is close to 100meter now...
O loud gan....


For now, just dey tap
u hear, fine girl....
No cry, wipe ur tears, just keep tapping..

Fulfilling 100m promise now go hard o....
PoliticsRe: Atiku Will Keep On Contesting For President "As Long As He Is Alive & Healthy" by Kaxmytex(m): 9:44am On May 23, 2024
I think we all agreed that we are voting tinubu again so that the Stoopid Nigerians wey vote him can feel the shege dey voted once more...
Please, distinction gats dey between us and bat o, bat can't fulfil is promises, we promise diz guyz shege, abeg make we fulfil am....
FoodRe: This OR 100K Cash? Choose Wisely by Kaxmytex(m): 11:12am On May 16, 2024
Foodstuff, then I go sell am....
RomanceRe: My Relationship Of 7 Years Is Going Down. I Need Help!!! by Kaxmytex(m): 4:46am On May 15, 2024
Funny girls ..

I am sure the guy wey dey bombard her with text knows about you...

She felt she is getting older to settle down, if u are sexting other girls, u fit dump her, where she wan come start from...
She needed an option, her NYSC guy fits in....

One thing about diz ladies, they are only loyal to their feelings, 4get sey na ship of 7yrs, she doesn't care, if she's feeling another person, just free ur mind from her....
U don't have to block her, delete her contact, if she calls, don't pick and drop the call, if she text, don't reply, if she comes back begging, don't even think am sey u wan accept am back, don't stalk her on SM, unfollow and unfriend on all SM, don't block her, na she go do the blocking by herself....

Don't enter another ship in haste, e no dey end well...
Work on urself
Build urself
Get ur mind of her.
Don't wish her any negativity in ur mind.
Wish her well

Na sporty she play, life na risk...
PoliticsRe: NLC: If Peter Obi Adopts IMF Policies As President, We Will Disown Him by Kaxmytex(m): 2:48pm On May 14, 2024
Wahala, if obi had been the president, by now everywhere fit don burst o
Music/RadioRe: Ayra Starr - Bad Vibes Ft. Seyi Vibez (Official Music Video) by Kaxmytex(m): 9:44pm On May 12, 2024
Song hitting my screen one more time...

Nice jam

Zero cap
TV/MoviesRe: #AMVCA10: Genoveva Umeh Wins The Best Supporting Actress (Picture) by Kaxmytex(m): 9:00pm On May 11, 2024
It pays to put so much thought and hardwork in whatever you do..
A black beauty incorporated with massive brain, congratulations ma'am..

Well deserved
TV/MoviesRe: #AMVCA10: Layi Wasabi Wins The Best Digital Content Creator (Picture) by Kaxmytex(m): 8:27pm On May 11, 2024
One of the few content creators wey get something upstairs...

No be by objectifying and sexualizing the BBL people, if u still wan ply that route, continue..
E no dey pas 1-2years,

Congrat to layi wasabi, e go school and school pas through am, e dey reflect for hin content..
Every content was a hit back to back.

Congratulations once again THE LAW
RomanceRe: Man Asks Girlfriend And Daughter To Leave His House After A DNA Test (video) by Kaxmytex(m): 2:56pm On May 11, 2024
As it should be, emotions are for sissy's...

If at a point in time u cheated on ur man and u think e go dey hidden for life, like u are taking it to ur grave.... dey dere dey whine devil, that guy no dey disappoint, u just dey postpone ur pain....
The moment u consent to another man make hin spread ur legs like divider wey dey mathematical set, u've violated the so called person u called ur man, u've disrespected him big time, just find a way and tell him make the relationship or marriage end for there, doing that will give u the utmost peace of mind...
After una don dey separate ways, u fit come decide sey u wan become one of his call girls or u learn to have a self worth wey go help u stay respectful in ur next ship if u ain't too old...Ur choice....

Shoutout to all the newly wedded barnies wey still dey cut eye for another man outside, we are rooting for y'all, please.... just cheat on the idiaat wey put ring for ur finger, u can do it, no big deal in it....
RomanceRe: Chimpanzee Kisses And Touches A Lady's Boobs As She Smiles (photo) by Kaxmytex(m): 6:04pm On May 06, 2024
handling bwess ain't a big deal but handling bwess with braids, damn! that's some real gangster shii....the chimp na OG



Werey, I know sey u go scroll up to look at the picture again....
Christianity EtcRe: When Your Dating Partner Is Disturbing You For Marriage by Kaxmytex(m): 5:28am On May 06, 2024
LadyRosa:
Mtchew!
So as I no marry am, you think say na because him no get moneyhuh

Una can mumu for this NL Walayi! grin grin
So the one wey marry me, give me children no be man that one be?! cheesy

Make una try dey comot una sense from una rectum to reason well.
Typical 9ja Lady, she don shapaly result to insult

Who said anything about u not marrying him because he doesn't have any money...
Lolzz, I only said condition, many circumstances fit be the condition..
I don't want to believe ur godmother told u to leave him because of the circumstances u stated above coz you are smart and if u are to have a godmother, it's definitely going to be a smarter one..
Big respect to the man wey marry and give u children, na real man hin be but how u wan make hin process am if he gets to know that u still gathering information on the man ur godmother told u not to marry
Christianity EtcRe: When Your Dating Partner Is Disturbing You For Marriage by Kaxmytex(m): 9:14pm On May 05, 2024
LadyRosa:
I still have feelings for WHO?!WTF!!!
I didn't care to read the remaining of your writeup after that sentence. Love kor! Blokus ni! cheesy
The self-deception is real... cheesy

Make I clear ur first lie, u read everything finish...
Feelings no dey there and u have the information that he is still single,... like WTF!!!
Only God knows other information u had about him... cheesy

I just dey imagine the guy dey in good condition, the union prep. between u guyz going on smoothly, no godmother wey talk anything, but the guy godfather tok sey make hin halt the preparation, and the guy had to settle down and marry another lady ...

E sure me, the guy go don run mad by now...
Christianity EtcRe: When Your Dating Partner Is Disturbing You For Marriage by Kaxmytex(m): 8:01pm On May 05, 2024
LadyRosa:
I'm married with kids.

And no, even if I wasn't married she is not still an ekwenzu. The guy sef isn't married till now.
U are dating a guy, ur godmother scatter the relationship, u ended up marring another person, u don born 3 and u still have the information that the guy ur godmother stopped u from marrying is still single till date....

Wowwww...
I just pray u don't end up hating that godmother for life coz it's obvious u still have feelings for that guy, u are stalking him to know the kind of girl she dey with wether she's better than you.
If the guy condition had been better, I'm sure ur godmother no get mind to shook mouth ontop r'ship wey she no know how e take start.
Now the guy condition still the same after u don born 3, ur godmother deserve some flowers for halting the union..
I pray God elevate that guy sha, he has been through a lot enough...
Christianity EtcRe: A Christian That Commits Suicide, Will He Go To Hellfire? by Kaxmytex(m): 11:22am On May 05, 2024
No, they don't die...

They reincarnate to another country they last dreamt off when they were alive...

Every life has a time to be spent aloted to it, u can't end what u don't start.
PoliticsRe: How Voters Voted For Presidents By Region And State In Nigeria- Statisense by Kaxmytex(m): 3:25pm On May 04, 2024
Lolzzz,OBJ was a menance.... dude was practically rigging with reckless abandon

As Nigeria be today, any state wey give 90% to one candidate, something fishy don xup....
RomanceRe: Nigerian Lady Face Swells After 6years Relationship Ended by Kaxmytex(m): 1:50pm On May 02, 2024
Just Imagine ur friend knowing u are dating 2guyz at once, and she feels this guy wey u dey treat like diz no deserve am coz he is very nice to you and even ur friends... but to u, it's a game, if plan A no work, plan B go work out
As u no value am, what's bad in it if she helps u value am...

All she just need to do is burst ur double dating game to this mr nice guy....

We have seen diz scenarios like thousands of time...

If foul play no dey on ur path, I see no reason why the guy will ditch u for ur friend considering the number of years u both have been together..

Love is pain, stick to one person, even if the person eventually leaves which will definitely be painful, he only left for another person wey go wipe that tears and stay for life, if u feel u are a gamer, Dem reach like 5 for ur hand, na u go hear am laslas, no be curse, na universal law
FamilyRe: My Husband No Dey Knack Me Well- Cheating Wife's Confession To Her Pastor(Video) by Kaxmytex(m):
Wahala....

If ur husband no knack u the way u want, the best thing to do is call him and tell him point blank that u ain't satisfied, na ur other half be dat. as a guy, that ur woman come reason u sey u no satisfy am no mean sey she's loose or she was promiscuous at a point in time..
U both need to come together and find solutions to it, e fit be hormonal imbalance, two good heads are better than one, u both have to come together and fix whatever causes the problem, cheating will only create more problems

And if hin come dey knack u d way u like, try dey tell am, no show am, tell am with ur mouth sey u feel the knack, thank you...
PoliticsRe: Crackdown On ‘Yahoo’ Boys: We Have Recorded 500 Convictions - EFCC by Kaxmytex(m):
A yahoo guy stayed eyes open all through the night bombing as they always call it, 1 doll bill, e no collect, he was then lost in deep thought, and he was like "omo! this thing don hard o, e be like sey I go leave am o" he bombed till daybreak, e no see anything. The time wey everybody dey wake up, na that time sleep carry am go Dreamland, for hin dream, hin come see sey client send am huge amount of money, happiness wan kill am, he woke up and said to himself, hope still dey, I just need to have patience, everywhere go still soft.
He picked up his phone and he continue bombing grin grin, some couple of minute pas, he feels he needed a break, he decides to surf the net to check the latest news and happenings in Nigeria, yeah! he was on nairaland and he clicked on efcc record of convicting 500 people, he scrolled down to read some comments, lo and behold, he saw this one, yeah! The one you are particularly looking at right now, why are u smiling, bro... I am talking to u o...
Lemme first congratulate you, even If efcc reach 2million people, Dem no fit catch u, the reason is not far fetched bro, it's just that, one naira or dollar or pounds or euro or Kuwait dinar will never come out of yahoo for u again, I no curse u, it is what it is.. u don collect for that end before, it's game over now.
All u just have to do now is, find ONE tech skill, and take ur time to learn it, 3years after, come and thank me...
Note: When choosing the tech skill, make sure nobody is telling u which one to chose and make sure it is just only ONE you are focusing on...
Looking forward to see ur mention in year 2027
Thank you very much
CrimeRe: Edo Housewife Hacked To Death By Father, Son While Separating A Fight by Kaxmytex(m): 6:29am On May 01, 2024
Nothing xup in fighting but using cutlass, knife, bottles,etc, that's an act of cowardice..
EducationRe: Graduate Applies To Teach Secondary School Students In Niger State For Free by Kaxmytex(m): 6:21am On May 01, 2024
Student no go deny extra lessons nah....


Simple tactics
EducationRe: Outcome Of 2024 Utme Results, Who Is To Be Blamed? Parents, Teacher Or Students? by Kaxmytex(m): 11:10am On Apr 30, 2024
No need to blame anybody

The number of student wey make am pas the 200 mark should be admitted automatically...
The rest should go and pick beans
CelebritiesRe: Wizkid Mocks Davido With His Viral 'I Am On My Knees' Video by Kaxmytex(m): 8:59am On Apr 29, 2024
huh
CrimeRe: Police Arrest Suspect Who Claimed To Have Seen Charms In Car Of Boy Killed (Vid) by Kaxmytex(m): 9:38pm On Apr 24, 2024
Ijapa meta
Christianity EtcRe: A Place In Kenya Where They Pay To See A Mermaid (video) by Kaxmytex(m): 9:36pm On Apr 22, 2024
Oluwole manmade...


Abeg no ask me how I know o..
EducationRe: UNN Lecturer, Professor Mfonobong David Udoudom Caught Pants Down In GS Building by Kaxmytex(m): 9:33pm On Apr 22, 2024
Lecturing Job no easy...

Ordinary tutorial, na grace of God dey cover us...

But why go for married woman, na rubbish nah ...
Na pesin wey no get level dey run shii with married pple
PhonesRe: The Itel A70 Vs Redmi A3: Which Is Better? by Kaxmytex(m): 11:33am On Apr 17, 2024
Ladies and gentlemen, this post was made using "itel A70 AWESOME" with an extendable 8gb ram, 64gb rom, having an advance octa-core processor and 5000mAh battery with type-C charging port..
So far so good, the phone Is 5 day old in my hand and I haven't experienced any form of overheating which is common among other itel models, charging is super fast, the display on the 6.6" screen is pretty cool.
Price wey I buy am is 78,500, e suppose don less now coz naira don dey fight back ..

1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 (of 92 pages)