Lovinam's Posts
Nairaland Forum › Lovinam's Profile › Lovinam's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 33 34 35 36 37 38 39 40 41 (of 45 pages)
Just Negodi!! Your mum borrowed to see you thru school and all you get to say is "I'm will only pay the principle" you are selfish o! God forbid that your mum will have HBP over this loan. You are supposed to borrow and pay off your mums debt. |
ToyosiR I talk am. I just de feel u this afternoon!! Una don see say notin de labour. E de sweet eh! |
She is not serious one bit. She should keep staying with the guy till they poison her out of the house. A man that calls his girlfrinds in your presence, abeg which other sign she wan see to know her marriage is over or is she waiting for a parting gift like HIV? Na wa o |
Hahahahahahah. E. Be like e don. The u begin read this thread. EwO!! Good girl gone bad!! Onegai: |
No worry sis you are not missing anything if u are like me. When he show after delivery una go continue wia una stop. Lol!! Byvan no be u and lyndaroyce and donatee spoil all d mama wey de this thread eh!! U are a denial it now abi? beedam: |
Wetin?? Na for air u take load!! No mind me. Errrrrr for some people e sweet pass sugar but for some e de disguting. beedam: |
Maram!! Your turn never reach?? Abeg go kpekus everyday jare. Lol. That's true sef mamas wey don reach 38 weeks make una de submit everyday so babyu go quick come #truetalk ToyosiR: |
Byvan na u be senior kpekuser o! Beedam sef be like master for d tin. Abeg all u virgin wey never born, abeg make una try to de submit o. We know its not easy but una sabi say body no be wood too. Oya byvan teach dem. |
Hahahahahahahahahahah. I don laff fall for bed. Kai! itstpia111:Make I exhibit small ignorance. Which wan be attachment parenting bikonu!! |
goosebumps:Ewe! Na so e do me o. Nne just lie don submit juo. Its not about u now cos u no go feel like cha cha. Just kpekus for oga sake eh |
Hahahahaha LMAO! I don see who cray pass me wen I preg. Beedam dis ur testimony na correct. Shebi na u sef get metallic taste for mouth. Abeg enjoy ur cornflakes de go jare. I can't wait for you to born. Your birth story go sweet well well. @byvan glad to see you back. E don remain lyndaroyce |
My poraro baby relax all na play for me o. She needs to understand say e get people wey razz pass am. Nobody de fear am cha cha. Na just accomodating we de do am. Abeg no call donatee o. Na correct angel be that, she go pepper me. Lol I can't wait to jam for another thread. Make I respect this thread. Peace out. beedam: |
Which idea have you being exchanging? All I see is rantings all over the thread over issues that could have been handled via email or pm. You are just a cantankerous person. CHANGE!!! Busybody2: |
Busybody2 you talk too much for a lady. Pls know when to draw d line. I wonder what you will teach your kids o!! It haf do.... Zip it or open another thread and rant there. Hian |
It true. When you are rich you can afford to pay peopl to do things for you ie maids, drivers! Dry cleaner, nanny etc. It gives you time to stay relaxed and enjoy all your life. Imagine d life of a typical struggling woman. Wake up 5:30am, make breakfast and lunch for d kids to take to school, 6am bath kids and get them ready for school, 6:45am off to drop them, then off to her small shop in a corner street. 3pm school run.. Get home cook, wash uniform, cook dinner. Oga comes back 7pm gets served dinner fastfoward 11pm he wants action. Tell me how the woman will even remember to relax to orgasm. Na so so curse e go de curse d man sef |
Thread ke? Implnon dat needle fear me small o. Na fear hold me since o. I will go soon byvan: |
I sent u a mail. If I don't hear from you today..... Moving on babysheju2: |
Choi. radiance26: |
beedam:. Too bad they didn't pick it up. It would have made a lot of difference. I was deeply hurt sha but its ok o. Na the guy I de pity for d thread cos he de read all the nansense dem de write there. Thank God u are doing ok. Well done! Make una try organise prayer for this end na. Na byvan be our coordinator during our time. It was split in two Christian prayer and muslim prayer. E go good o. |
byvan:Hahahahahahaha. Nne eh no mind me o. I neva nack am o. Which one u do na? I never get time to go dia o. Meanwhile had d greatest fear 2weeks ago, I just de pray de sama tongues o. How I wan tell dat tory. I don tell oga make e hang booth o abi go get shelter if he wan do sontin. U sabi say I never see AF since I born. E be like na after christmas I go do am cos I no say action no go too de dis period maka umu azim etogo o. I no wan make persin begin look me funny eye. So na to comport till skool start. Lmao. E de sweet me... |
beedam:Hahahahaha. I wan run small sha before una go infect me with 9 months condition. Loll. Babe your head de dia, u be correct lady. I bin see ur post for d other thread. It is well. I no wan talk too much cos I vex small for d crew as per why dem no adopt that baby case. E don pass sha. How borri de do you na? Hope everything de fall in place. Chifreke I de salute you! I just de wonder wia all of una disappear to eh? Beckytunde! Donatee my very person. Nkemella. Dbeautyjas! Wia una de? Beeevan/ byvan I de sight u. Lyndaroyce!! Hola |
Sayoberry glad to know u are doing ok. Abeg sofry sofry! E be like all d old mamas don run commot for this place. Newbies make una de encourage one another and try hard to respond to every question. One love! |
babysheju2:How old are your kids? How are you? |
That's the point. When you have people shouting all over the net that money is being wasted. Pls tell me who will be motivated to give again? Some things are best handled privately. I believe there is no baby on this thread. I pray people will over look the back and forth going on here and give more to this cause. Sometimes we just need to zip even when you think u have the solution. Its just for things to move along smoothly. colossus2: |
The way the c word(cancer) is thrown all over the thread is very insensitive. I'm sure the patient reads this thread. The docs on this post should know better. Pls find ways to communicate privately and just give simple updates here. |
Sayoberry! My sis nothing I decree nothing will happen to ur babies in Jesus Name. Stay calm and keep declaring words in faith. Declare all you want to see happen. We will be praying for you. You will carry to term in Jesus Name. New virgins in the house. Don't you all think its wise to organize prayers. We used to do it a lot. Pregnancy is not something you joke with, just cruise along as the day comes u take. No! The enemy is roaring and looking for who to devour. Set a date for prayers. Be wise my young ones. We did it, it worked for us and we had a lot of great testimonies. Supernatural birth etc. (The tsunami wiped almost all our posts). I will keep remembering you all in prayers. God bless you and your babies |
Nothing its part of the package. I guess its d way baby is lying down. Go see her doc, pls don't give her any drug not recommended by d doc sammieone: |
Hian! All new virgin mothers in this place. Shebi na no de look face abi? I never hear hailings for old mamas like we o! Shebi cos we no gee new mamas work to do abi? Park well sharp sharp. Lmao Chifreke I de hail o! Beevan e be like " fortification" don happen for that side. Hehehhe gist me na |
forlahkhe:God will strengthen u. Fear not, ma healing be ver fast |
beeevan:Imakwa d nos of children I get? Ewo! That prayer is not for me. Meanwhile body de do me one kind. Lmao |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 33 34 35 36 37 38 39 40 41 (of 45 pages)



