₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,331,287 members, 8,449,576 topics. Date: Wednesday, 22 July 2026 at 03:27 AM

Toggle theme

Rayblast's Posts

Nairaland ForumRayblast's ProfileRayblast's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 20 21 22 23 24 25 (of 25 pages)

PoliticsRe: Jonathan To Campaign In Borno Today by rayblast(m): 7:28am On Jan 24, 2015
Oga Jona,shebi na now morning dey break abi wey old woman dey cry for make up?
PoliticsRe: "Buhari Executed My Father But I Will Still Vote For Him" - Lawal Ojuolape's Son by rayblast(m): 5:38am On Jan 15, 2015
SAI BUHARI come FE BUHARI 14!!!! Sai ka yi ko ba posta!!! pdp we r tired , change is what we nid . Talking about health Yar a dua would hav been d best president eva produced here in 9ja. Abeg if na people wit health problem go dey pity us make dem dey rule cos we are suffering . How can a normal president give license to a group of individual to import arms into the country . See as armed robbers dey blow bank doors na knockout dem dey use ? Jonathan we came out and voted for u in our numbers not minding da weather and stress.What did we get from u and ur cabal? Anyway wen i hear people saying there was a massive crowd(ur pdp presidential campaign) oga Jonathan no be everybody we cum there go vote for u o . Alot of people came for different reasons. I even get person wey say as light no dey joor and i no get where to go make i go see Wetin dis pdp people dey do . U see u don get (-1) from that one o
SportsRe: Okocha Deserved To Have Won CAF Awards-Issa Hayatou by rayblast(m): 2:28pm On Jan 11, 2015
Idiot did u give him? Even d one he was close to wining how u do am?I jus pray u leave so we can hav a true feel of african football again. ewu nama
PoliticsRe: President Jonathan Did Not Squander Nigeria’s Reserves – Finance Ministry by rayblast(m): 6:55am On Jan 08, 2015
9ja!!!If na mi dem accuse of squandering Wetin una expect make my wife Rose talk na?So am nt surprised even as we stil dey for season of surprise!!!
SportsRe: OMG!! Photos Of A Football Pitch Built On Top Of A Shopping Mall In China by rayblast(m): 7:42pm On Jan 06, 2015
To watch match for dis kind football pitch ehn spectators must hav to watch from inside of an helicopter, aeroplane, parachute or beta stil become a witch or wizard.For mi d match ticket for to enter dis stadium is d most expenive in d whole wide world.For people wey no fit afford helicopter go village go collect winch so dat u can watch live and direct.Al d Players, ref, linesmen,match commisionals and al d people wey go dey run ontop d field must get one parachute and 2xtra life!!!
PoliticsRe: What Do Gej Fans Think Of The No Bomb Blast On Christmas And Boxing Day by rayblast(m): 8:28pm On Dec 26, 2014
Op nice Observation.Buh d fact remains dat Jesus christ is Lord.Abi u tink say al d conventions,conference and retreat wey people go na moi moi dem go sell for there?People dey pray o and our God is a living God him dey hear prayer.No be say dem no wan do am buh God took control of their heart, actions and thought!!!
PoliticsRe: Tinubu Not Copying Fayose With Any Stomach Infrastructure Programme by rayblast(m): 3:52am On Dec 24, 2014
Abeg o.What is dis stomach infastructure i hear about?Jus one meal for a year?abi people wey dey for Ekiti wan argue wit mi?4small cups of peak milk tin and agric chicken of 5weeks?I can not fit eat dat kind chicken. chicken wey him suppose still keep maybe make him share am for valentine e cum dey give am out nw and d most annoying tin is dat people excahnge punches jus to get dis tins.Naija ina za mu je ? Naija nibo ni an lo ? Naija which way ? Abeg d igbos make una finish am for mi . I rest my case!!!
PoliticsRe: A Dollar Is Equal To 194 Naira? by rayblast(m): 7:58pm On Dec 20, 2014
babs ask ur broda Jonathan.Where him dey drives us go cos mi i don tire for dis kind journey
PoliticsRe: Cry Out ! ' Pls Pray For Me ', President Begs Nigerians by rayblast(m): 2:10pm On Dec 20, 2014
pray 4 u ? Na dis same u no allow naija qualify for nations cup.dem sack Keshi u re-in state am.Oga Jona abeg go sidon make greed no kill u o.i been vote for u.u enta turn mi to mumu.u enter finish i adopt ur Niger Delta style with ur hat for head.U know how much dem dey sew one Niger Delta cloth?u don disappoint mi.Mi wey dey change hat like say na boxers i don throway da hat cos nobody sef wan dress like u again.D only prayer wey i fit pray for u be say make God spare ur life Shikenan buh say make u continue?Mba,aha, rara o.God forbid!!!
PoliticsRe: The Reason For Southeast To Vote Buhari by rayblast(m): 1:39pm On Dec 20, 2014
nzeobi:
Buhari is yet to impress me with his speeches, he is too emotional just like he cried and instigated violence in 2011
He doesn't know nigeria very well, he also doesn't know politics and he lacks the needed ideas that can transform nigeria.
d ideas wey oga jona use wey 1dollar=194naira?Abeg we nid change.No b speech we want na positive change(action). no b apc,i no b pdp.I don t belong to any political party.I am a Nigerian
PoliticsRe: Female Suicide Bombers Attack Maiduguri Market Again by rayblast(m): 1:23pm On Dec 01, 2014
Pls wat is d state of health of d female civilian JTF?Did we lose her again?cos dis report seems nt to be complete
PoliticsRe: Urinating In Public Should Be marked Out As A Crime In Nigeria by rayblast(m): 5:08am On Nov 30, 2014
If dat one go be offence den dem must legalise to dey piss for inside car.banana dey spoil una talk say na ripe e dey ripe!!9ja dey blow una still dey do piss effizy.make we no pack ourself enter public toilet o make una remember say na where people gather plenty na there boko boys dey trow bomb.if na only mi stand dem no fit throw bomb dem go do d cost of makin one bomb
PoliticsRe: 3 Gunmen Killed In Kano Mosque by rayblast(m): 4:59am On Nov 30, 2014
d one wen we don dey interrogate since nko ? Where d tin don lead us ? Da release of Ogwuche(nyanya bomblast suspect) is da begining of jungle justice!!!
SportsRe: Eagles Player Blames Onazi For Afcon Failure by rayblast(m): 3:50pm On Nov 29, 2014
which kind mumu eagle player b dis?infact u dey craze to remind mi of una again.When Onazi no play to instruction why u no cover up for am abi no be team work be football?Very soon una go talk say na my mama no make una qualify becos she no sidon for front of television watch how una disgrace una sef for Akwa Ibom stadium.
PoliticsRe: Stop Killing Boko Haram Members – Buhari Tells FG by rayblast(m): 2:37pm On Nov 29, 2014
Ogbeni Buhari e b like say den no carry hot water hold ur mouth wen u dey Small.Are u actually da one behind diS Boko Haram menance?If yes make dem catch u roast ur blocus for mi make i carry am drink garri
SportsRe: Sunday Oliseh Blamed Stephen Keshi For Super Eagles Failure To Qualify For 2015 by rayblast(m): 3:03pm On Nov 28, 2014
who be Nff where Keshi dey ? Who go dare sack am wen him backbone wey be gudluck stil be president?Flush gudluck out and see if Keshi will nt be sacked dat some second i refuse to use minute cos d way everytin dey go i dey manage buh dis football wey oga Jonah go put him hand so i tire.President wey dey call our super eagles,golden eaglet Wetin him sabi about hin country futbal?NOTHING!!!pls notin concern mi concern politics o buh pls leave our football alone for da betterment of we wey say na d only tin wey dey give us Joy for dis country b dat
SportsRe: Sacking Me Won't Solve The Problem -keshi by rayblast(m): 4:03pm On Nov 23, 2014
we must sack u Keshi we nid change
EducationRe: Urgent!!! Interprete This Grammer In Politics by rayblast(m): 8:08pm On Nov 21, 2014
femicyrus:
I mean in simple terms so as to understand
Kai Kai Kai Wetin dis man talk be say our president na agbero.Daris God o cos dis grammar dat u r spark ehn!!!
SportsRe: Stampede Alert Ahead Of Nigeria South Africa Clash by rayblast(m): 3:53pm On Nov 19, 2014
Naija ehn!!!for Ait dis morning dem been talk say dem stop ticket sales since day before yesterday.Common fuel queue sef na trouble to manage nt to talk of football fans.Abeg if we no go fit dey manage dis crowd make only d players family and wives/galfriends cum dey watch dem.I don tire for dis stampede wahala.Person no dey build stadium na him Akpabio build stadium?
PoliticsRe: REVEALED!How FG Officials Turn B/Haram Ceasefire Plan into Multibillionaire Scam by rayblast(m): 3:39pm On Nov 19, 2014
Na dis same GEJ bus i go sidon again for anoda 4years?Mbanu!!!Syria here i cum
CrimeRe: Video Many Came Out To Welcome Boko Haram In The North by rayblast(m): 7:04am On Nov 19, 2014
Imposicant!!!!!My questions plenty.Where BH get dis kind Weapon?Na wen Shekau ressurect?If na from our military BH guys get al dis weapon abeg make our govt no waste billions to buy any weapon.D same weapon wey our military go run leave for battle field?BH boys are getting well equipped by da day.See as BH guys dey flex govt armoured tank!!!Which way Naija!!
SportsRe: Johnathan Trains With Eagles Ahead Bafana Clash by rayblast(m): 12:52pm On Nov 18, 2014
Abeg make him train well o cos we go nid replacement for Enyeama.Ejide and Agbim should go back to da Creek
TravelRe: 10 Unbelievable Photos Of Lagos You Will Mistake For London by rayblast(m): 9:31am On Nov 09, 2014
klem93:
Lagos good sha for pictures taken from the sky
gbam!!ur head too correct
PoliticsRe: Total Blackout In Ekiti And Ondo (9 Days And Counting) by rayblast(m): 6:25pm On Nov 08, 2014
Bobbystanley:
No the Problem is from GEJ.

Useless APC e-rats.
All these bush Yoruba people that left their villages and all of a sudden become Lagosians won't go home and fix their problems.
my broda u see Wetin u don cause for urself?U no go insult yoruba person make dem tell u say wait make i go house go bring ur reply.As u dey bring am na so dem go give u back
PoliticsRe: Total Blackout In Ekiti And Ondo (9 Days And Counting) by rayblast(m): 6:21pm On Nov 08, 2014
teemanbastos:
d tin dy spoil my runz lyk mad... D probz na 4rm osogbo
Hmmm osogbo ke ?
SportsRe: 2 Feared Dead, 20 Injured In Stampede At Akwa Ibom New Stadium by rayblast(m): 9:28pm On Nov 07, 2014
okpismart:
Source: http://.com.ng/index.php/national-news/item/1128-2-dead-20-injured-in-stampede-at-akwa-ibom-new-stadium
See mi see local wahala o!!!Stampede kwa?and una dey dorobuchi for inside stadium?if na like dis fans for akwa ibom go dey rush enter stadium dey kill dem sef make everybOdy wey must cum watch match dey bring chair from him house
SportsRe: Nigeria Vs Ghana by 6:30PM. Your Prediction? by rayblast(m): 12:12pm On Nov 07, 2014
Dacronym:
Ive missed quite a no. Of them and may most likely not be able to watch dis one. Ive missed quite a no. Of them and may most likely not be able to watch dis one. ;-(
u dey stammer?
SportsRe: Ike Uche Happy For His Recall(see His Tweet) by rayblast(m): 12:43pm On Nov 01, 2014
where will Mr keshi play u dis tym?

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 20 21 22 23 24 25 (of 25 pages)