Teejayphillip's Posts
Nairaland Forum › Teejayphillip's Profile › Teejayphillip's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 (of 33 pages)
When others dey lament baba God picked ur own call dat moment ....Nor worry,everything go soon go back to factory reset. Keep counting ur blessings
|
No b lie.... Those pigs called ‘white’ always think they are god.... And the problem is d way we worship dem too.... The one wey try nonsense with me in my former place of work chop better slap. Since dat day em brain reset straight up. If u don’t stand up to your RIGHT atimes,they throw rubbish @ u. Say no to RACISM and xenophobia |
Insightful ![]() |
|
EFCC go dey okay las las. Wetin concern traditional rulers with unah work? All dis high service syndrome don become part and parcel of us... Nah Oni of Ife wan follow unah dey arrest people?
|
Chasing Okorocha upandown should be part of his 100days achievement ![]()
|
Even our president is cloned and all em cabinets b scam as well ![]() Nothing in dis country amaze me anymore. But posters those creatures nah demo dem dey do oo... Just try enter dat cage and confirm if they are or not. Nah dat time I go believe u. Just pull ur hand through the cage, body go tell u Howfar later ![]()
|
Oya over to the boys wey saabi. Dem go begin pick client from there now ![]() Awon soapy gangs |
Smh for suegbe wey call emsef MI.... So e get mouth to apologise after spilling rubbish outta his mouth. The one wey weak me pass nah dat one of Tuface. Instead of facing the message nah Husppuppy e dey follow throw yarns. Time go reach nah unah go dey listen to unah music... So far Ebenezer Obey,Sunny Ade, Orlando Owor, Fela, Lucky dude album still dey,I don’t give a bleep bout ur music. If our leaders are being truthful to themselves we won’t be in dis mess. MAY GOD HEAL OUR LAND
|
Baba don vex oo ....Our politicians and sack be like bread and butter
|
Useless people.... No b wetin dem suppose do b dat? Africans with their animal mentality |
Everybody is frustrated. Dis issue of SARS should have been things of the past. Nothing is ever working in Naija. Yet all dis our outdated leaders go to other countries and they all see how things are being done... You can’t travel abroad and go with your entourage blowing sirens upandown and come back here start forming LORD OF THE RING. Police can’t protect but Rob you. Soldier can’t kill Boko Haram, but are fast in punishing unarmed citizens. Lastman will fold hands watching the agberos do whatever they like,but citizen wey beat traffic light will be dealt with. How long will dis menace continue? We go dey okay las las oo
|
Priest Oya go gbe igba ope (go do thanksgiving) .On the day of thanksgiving make sure you gbe body e, give dem shaku mixed with meg walk. U nor no Wetin God do for you ? U escape death.
|
Those ones wey don belle full already..... God help our leaders to make the rightful decisions. Our trial and error too much.... We know the people who are competent,but religion and tribal matter won’t allow us do the right thing. Itis well
|
Chai! Las las dem finally get Rochas family oo. Kai!
|
If God no call you, pls and pls don’t call yourself .Here’s the gory situation of most African men all in the name to extort people of their stipends. No b by force to call yourself if God no call you. Look for another hustle .God wey call you,go don give you enough strength and power to fight strange unforeseen issues. But you sleep after taking 5bottles of burukutu u come dream say u dey host revival . Baba u go suffer for earth go continue the remaining one for HELL May his soul rest in peace
|
Uniquely abi? Pls Mr President do u patronise our medical centres whenever u fall sick or does any of ur family member do same? D same answer to all questions every now and then,on how we can collectively assist ourselves while y’all travel elsewhere to get ur stuff done. May God heal our land. Dis country heat too much jaare. Our presido just dey yarn yen yen yen dey go
|
Naija matter tire me jaare..... Medicine after death. So Police aren’t aware dat since there’s a crisis affecting other people staying outside naija dat it’s going to spring issue in our own dear country? So apart from crisis like dis our policemen are jobless? Itis well with our dear NATION. So nah why unah no fit dey use Rubber bullet to scare people away, unah own nah to dey shoot upandown killing innocent souls. We shall get to the root of dis matter in some years to come
|
Yen yen yen! U better carry ur bag and baggage’s go meet AKA for southy or else nah to dey knock dat ur head wey no wan correct. Every short man I know dey get sense but ur own is way too shallow ![]()
|
Sanwo Olu just take Ambode glory.... Ambode too dull sha
|
When she go dey run her mouth like tap water ....Btw,one of the brave women I know,even though nah appointment she dey look for
|
Dunno what to write or type on dis issue. God bless u Makinde..... Here are the change we are clamouring for. My utmost respect also goes to the governor of Kwara state,dat dude is a genius. Even as papa no go skool,his effort/policy on agriculture is superb I wish all dis our old skool/archaic Governors can learn something tangible from dis people. Not like dat mumu imo governor.
|
You are a HERO..... God bless for dis bravery heart.... U sure deserve an accolade
|
Have we heard from our President yet? The answer is No! The time is near whereby angry citizens will start storming houses of our leaders,maybe then they’ll all take us serious. We still look like a joke to dem. The day of doom on dem is near.... We will see where they’ll all run to. |
The same man we accuse of dictatorship,cruel and wicked is the same man unah dey hype praise on today.... We are just bunch of ungrateful citizens..... Someday some of us will also write something good abt Buhari.... All I know is dat we get 2 mouths
|
And dis yeye news enter Front page....Smh And our Moderator conveniently push dis to front page! Issoraite Wetin concern us with person wey pass ball give perusi? Will dat solve the crisis we found ourself in? Lazy readers and lazy posters. Let’s grow up
|
Gbese re oo! All dis kwe kwe people calling themselves celeb. I wonder the morals and values they’ve got. Almost all of dem living above their means just to show how perfect their imperfections are. May almighty God heals all broken homes |
If nah our National wealth dem take build their house,may God wrath visit dem... Someday all dis politicians go run leave their house for safety.... We are getting to that point whereby frustration will take place and we will put an end to all dis barbaric looters.... Dem just start
|
Wake me up when dem enter RING ![]()
|