Theophorus's Posts
Nairaland Forum › Theophorus's Profile › Theophorus's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 16 17 18 19 20 21 22 23 24 (of 114 pages)
Dey play. Why human being dey reason like this? Elections wen you no for see 25% votes cos you memory loss dey make you balabulaba. Go and rest Sir. |
Wahala!!! |
Admit ooo no admit ooo no mean say him no go collect when him time reach. |
Well, make dem comply with LASG joor. If dem no fit comply make dem go Ogun State or Oyo State. People wen dey ask for Water supply from State Government hope they know the cost? And hope say dem remember say the way PHCN dey do na so Water supply from Water corporation self be? |
Baba never know say dem dey watch am for 4D, very soon dem go enter you. |
Sha, make everybody no forget say January can be a long month if you don't plan for it. |
Well we sabi where this kind research dey go. My simple counsel to anybody is simple "buy only the USD you need". Cos... |
Congratulations ooo. But Abeg wetin be the name of the school? And which one be Dr. Evangelist abi Dr. Minister bayi? |
Shawarmagirl: ![]() Okay ooo. But you wonder why nobody dey rate them? Well, Congratulations to Him and the beneficiaries. |
Dem must to collect. You cannot choose the way of Wickedness and violence and expect not to collect. If you dey support dem, repent ooo before your Cup go full. |
Iamdbull:Come, no let make I stone you ooo. Cos I don't understand why you go dey mention Dapo and Road Construction for same sentence. |
That's True His Excellency is in Lagos. Let me prepare to visit him too so that we can discuss some better packages that will be beneficial for Us both. Quick one, incase you get 3M wen you no need, just DM for my account details so that you can send it to me. Thanks. |
Saner climes. Man inhumanity this fellow Man. The Heart of Man is deeply wicked. Unfortunately that guy may not be guilty of what took him to that correctional facility ooo. Well, na him and him creator remain now. He has to give report of his life to determine the side of Eternity he would be. |
Serious question to seriously ask those people who dey unleash mayhem for that una area ooo. If the locals still dey support them na dem know ooo. FG no fit do anything if una still dey support the miscreants. |
Welcome to Nigeria. Na who get power dey oppress. If you no get baba for background Abeg no go dey drag wetin pass you ooo. |
When we talk say Youths of these days go worst pass their Papa dem, he go be like say we no know wetin we dey talk. Shey you see say Una Guy na low budget Yahoo-Activist? Small money enter hin hand now, he begin dey play different tape because he wan kolobi the money. |
When your Fans expect you to react to everything and attend every function... Very soon your words and visit no go make sense again. |
Hope Betty didn't talk down on her Husband people this time? Cos, anytime me I see her picture or her name na the things wen she talk/post about her Husband people I dey remember. |
We sabi people wen dey manufacture and push fake news to gaslight others. Children raised with Hate-Hatred. |
Who dey lie and gaslight others make he continue, but when matter clear he go realize say na problem he just cause for himself, we sha hope it will not be too late already. The safest region in Nigeria is... |
Lamba. Na who know sabi your Oga way dey reason him media hype. |
Well, Those who don't know Christ are not suppose to celebrate Christmas and Crowd control should be standard Security measures. |
Some people claim say na one FG dey use them destabilize their region but no lele Sha. Since dem fit kidnap lawmaker then soon dey go kidnap Govnor be that. |
Na who go do Giveaway of #3M for me I dey find now. Make FG helep dem save the money for January cos the month dey long small. We don do Christmas already. |
My friend use to call them "Katikati" but I didn't understand until recently. A Landlord is charging 150k for 3 Bedroom, a Caretaker will approach him and say the house is now worth 350k and add 150k for himself and call Total package of 500k (this is a state outside Lagos ooo). Well, the Caretaker people should continue, very soon hand go touch them. |
Put 90s join am. We run these things wella. |
You mean say FG dey neutralize the people wen dem dey sponsor? Well, Ekpa and Him Snr. Brother dey restricted for where dem dey and na to gather all these ones self enter confinement. Pikin wen no wan behave must to collect. Make everybody Sha teach their Children Love if not anything wen their eye see, na dem know ooo. Well Done to NPF and other security operatives. |
Yam and Garden Egg Sauce in the morning. Fried Rice with Chicken + Water for afternoon Dog meat and some Lemonade Drink for Evening. #Who get #3M wen him no need make he DM for my acct details. |
Eeyaaah! Pele ooo. You were waiting for another "Balabulaba" comedy series abi? Rufai you don forget say no be Campaign period we dey again and your doings no go let better people engage you for talks. Well, wait for Una candidate, he go answer all your questions. |
Some people are already in their village and so FP no dey quick full again because no better network for that area. Sha, make dem educate "children of hate" and untrained children make dem no go think say na same Song still dey reign ooo. You type-post anyhow, anything wen your eyes see na you know ooo. |
Abeg who fit link me? Am interested ooo. |
2027 is a goal. We probably may not have any opposition party in 2027. |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 16 17 18 19 20 21 22 23 24 (of 114 pages)