Theophorus's Posts
Nairaland Forum › Theophorus's Profile › Theophorus's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 20 21 22 23 24 25 26 27 28 (of 114 pages)
Mayflowa:#2,000,000.00 |
This Life just get as he be, make God help Us not to misuse opportunities ooo. Sha, who get like 2Millions wen him no need make he DM for my account details, as I need money. |
Make una stay one lane joor. If una like to be Igbo, then make una join dem for their 5 States no be to dey Rivers dey claim Igbo. |
But I think say na FG dey use the guy play Ping-Pong for SE before. But rate wen everybody dey deny this guy no be here ooo. |
No lele, from the tribe we know say the guy dey innocent cos him people way dey pure. |
Chai! You mean say the New York of the SE still dey do open shitting? |
Make she face from make we see her eyes joor. Which one be this face back when una snap so? Abeg, make una paste her face ooo. |
You think say na our leaders be the problem ba? Well, if you gather thief na Thief go still lead them except say by luck one of them get good mind. |
This one dey everywhere naw. No be Lagos only ooo, Dem hail you, you give them 500 another person 1k before you know wetin surp money don complete 20k, so boys go behappy. |
That one self, he good but Sha remember say you no get root again be that ooo. And somebody wen dey reason like me go avoid you because this one show say you no ever fit keep to any deal abi agreement. Congratulations Sha, name yourself anything wen you like. Maybe you fit adopt 'Gbana'. |
Biochemist, Pharmacist, Genetic engineers and maybe Doctors show have a brief on this. But sha, most importantly na make God no let make we sick abi na take ill self. May we Enjoy Good Health all the Days of Our Life. Amen! |
This should discourage those people in search of quick money at the expense of the sanity of others. But sha, people wen their motor be Get Rich Quick or Die, no go still hear word. |
Would He listen? Well, the sycophants around him will cheer him on so as to make some money from the waste. Same reason some people are urging the current Governor of that Premier state to contest for President. Both of them will waste some of their money and will act as spoiler for their party colleagues and work for... |
See who Sim dey drag? He get why dem give Dat guy Mr. Project. Instead make Sim carry on from where the guy stop, he go dey listen to those Hatred infested people. Obaseki own don done now, he don gentle. |
That polarize is the main deal, make everybody go answer him papa name, na the main deal be that. |
You suppose understand say everybody get their clients. Jackson gat to feed his clients with necessary Conspiracies to keep them occupied. If you doubt me, Reason am Why people go believe say na Jubril el Sudan be their President abi how people go believe say their President na FBI Agent? |
Chai! Abeg who be Psychologist for here make he help me decode that Don Jazzy Body language. Walai! This VDM and him crew na same-same dey be. See as Don J dey reason una and still una no sabi say una don... Well, who get #100M wen he no need make he DM, so I go send my Aza. Thanks in advance. |
Abeg life is not hard make everybody do wetin dem think say he right. Even if na me, I go appoint people wen I fit work with and wen I trust. |
Be safe out there. Make our food no dey where hard. |
Well, her time don pass make she go relax, Na Odunaiya turn now. Life na Turn by Turn. |
Letting emotions of Love lead instead of common sen** |
Monday just dey restyle Edo things comot for how Obaseki arrange am. Okpebolo go soon organize am him own way. Another quick reminder say No Champion forever. Well, this Government must to Favour Me. |
Make Fubara continue him runs naw, abi wetin be this talk again? When Fubara dey do anyhow dem dey hail am, now Him opponent Don dey get upper hand dem begin dey call CJN. Abeg, make Fubara do him thing joor, na him be the CSO of Rivers so make he do hin thing but Wisdom suppose help am learn from Edo but that lesson don dey useless naw. |
At this rate, I doubt if anyone can save PDP. |
MEGAWATCH:Hope you are going home for Christmas? Abi you will still celebrate Christmas and New Year outside your beautiful region and not live in your mansion atleast for 2 weeks? Congratulations to the folks from the East. |
Abeg make you shift una building or make Aple shift their cable abi make Otti help una shift one of the above or make una both kip kwayet for the matter. Atleast na family matter so nothing concern PBAT abi PHCN. |
NSK4U:He pain you Chai! so tey you quickly use the "Skull-Miner" cliche. Ndo, Iberiberism na your way, so I understand. |
Good. Baba go site am for him home state sharperly. Well, na 4 days dem dey take work for that area. |
Nwoba Chika Ndo ooo. Hope you remember how your brother dey spend money during Burial ceremonies? Abeg leave Nwifuru to spend money to welcome Firstlady. |
Joshkid:My Aza is not for Public. ![]() |
If na you get pikin you go see am for hin body and behavior, all this DNA brouhaha Abeg make una bring the Money make we used Native Eyes take reason the matter. Just send 100k to my Aza make we run am. DM for details ![]() |
Well Baba should be used to crowd shouting Rankadede, if he fall for this na him know ooo. If him come out for 2027 again base on this hype na hin know ooo. |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 20 21 22 23 24 25 26 27 28 (of 114 pages)
so tey you quickly use the "Skull-Miner" cliche.
No need for DM, paste your details here. Let’s run it ASAP
