Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,506 members, 7,816,208 topics. Date: Friday, 03 May 2024 at 07:43 AM

People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills - Culture (2) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills (10287 Views)

Nigeria Pidgin Proverbs & Their Meanings / ****oyinbo Wey Love Pidgin DIE**** / Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (Reply) (Go Down)

Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by replenish(f): 4:04pm On Apr 02, 2008
how all of una dey. she una de jolly jolly as me sef dey jolly.
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by ikamefa(f): 1:50am On Apr 03, 2008
' grin " cheesy i don laff commot teeth sef for d i s yard! cheesy

see as opata full ground! grin

pipol wey dey arrange pomushele(girl) grin and pipol wey dey arrange pous " grin grin' abi na soup?

make me sef carry jolly ,carry ma yansh comot sef!

all of una i dey hail oh ! grin cheesy grin cheesy cheesy grin

@ thread starter u do well sef! grin
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by akins4(m): 2:31am On Apr 03, 2008
everybodi, kei kene mmenu(weytin dey hapen), hope say una dey miliki(for) your side?, nna ehn how i wish

say everybody wey fit enter ibudoyibo(yankee) with me make una come enjoy weytin dey for bigbrothers,

though i be yoruba boy but at least i fit talk sumtins for ibo wey go make everybodi jigijigi(shake),

make una dey sempe(cool),

nna bia(i dey com),
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Zandra1(f): 5:07pm On Apr 03, 2008
I guess some people are speaking the 'real' pidgin and, I dont get some of the stuff they said cry.
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by gilgee(m): 9:18pm On Apr 03, 2008
I salute una ooo. Make I go pack my squad come jokes section, we need to cause katakata for here.
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by crisp: 12:12pm On May 19, 2008
Una don tire to post? Why everybodi just dissappear like say ojuju dey come this forum. Na wah for una o
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Nobody: 12:25pm On May 19, 2008
seee me hiaaaaaaaaaaaaaa ooooooo,gorund no too level na hm make me never vomit myself enter hiaaaaaaaa,how far my people?hope say d go dey go well well wink
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by darfur(m): 10:01pm On May 19, 2008
o'boy, e be like say pidgin differentiate into assents and dialects grin

some peeps pidgin na kasala grin
to decode de yarns na real full time job grin grin
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by smile4kenn(m): 11:22am On May 20, 2008
@darfur

I feel your yarns,

the thing about pigin be say, make e just sound like pigin, then e go make sense
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by drrionelli(m): 1:05am On May 31, 2008
Since I've been here at nairaland.com, I've tried to familiarize myself with Pidgin. Several fine people whom I've encountered here have been helpful to me in that regard. To those persons I am, and shall remain, grateful.

However, allow me to address this to everybody. I would like to learn Pidgin, so that I may more readily understand some of the postings made here (and for a possible trip to Nigeria, as well).

Is there a good method of learning it? Do I have to simply struggle through reading it and trying to approximate its pronunciations?

What do you suggest?
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by ikamefa(f): 1:10am On May 31, 2008
@ drrionelli

try learning Hawaiian pidgin English , that is the closest thing to Nigerian pidgin English, i think you will be better able to understand 9 j a pidgin then cheesy
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by replenish(f): 1:25pm On May 31, 2008
I hail una oh.
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by drrionelli(m): 8:31pm On Jun 02, 2008
Ah, the ever-charming ikamefa!   grin   Certainly you know that it is you to whom I refer as one of the people who have graciously and generously assisted me in my quest to learn Pidgin (the ever-chilly iice is one of the others!).   

Is the language pronounced in a phonetic way, i.e., is it largely pronounced the way it would seem to be in proper English?

Example Is "sabi" pronounced sah-bee
                 Is "una" pronounced ooo-nah or yoo-na?
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by ikamefa(f): 12:58am On Jun 04, 2008
drrionelli:

Ah, the ever-charming ikamefa! grin Certainly you know that it is you to whom I refer as one of the people who have graciously and generously assisted me in my quest to learn Pidgin (the ever-chilly iice is one of the others!).

Is the language pronounced in a phonetic way, i.e., is it largely pronounced the way it would seem to be in proper English?

Example: Is "sabi" pronounced sah-bee?
Is "una" pronounced ooo-nah or yoo-na?

embarassed

as to the second part of your question : erhmmmmmmmm i nor sabi oh " grin "

for real though! i grew up listening to and then being able to speak pidgin, never went to schoo to learn it ( like any other 9 j a child)
so that pronounciation thingy up there " i nor sabi" grin cheesy
like i once told yah get a good book on pidgin english wink or prolly some other folks in here can help you clarify that dear! grin
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by omoovie(f): 9:27pm On Jun 06, 2008
WHOOOOWHHHEEE! I LOVE THIS!! Yayyy! I love rapping pidgin! Wetin dey? Which kain yannings una want I get pidgin slangs wey go tumble tower of pisa once no shakement!
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by omoovie(f): 9:31pm On Jun 06, 2008
Shuuu! Ikamefa e be lai say da oyibo bros wan tek style dey toast u oh! Kai! Kai! Kai! Rovu wirrout Rangwayge! Abeg make una carry una transcontinental toasting go another side u hear? As me ah no dey get toasting you too must not get toasting! angry I go spoil una under-G runs! Eeehhhn bodi dey pepper me! Oya! 1, 2! Carry go! "The ever charming Ikamefa, " Eeeeuuuuuwww rovu nwantintin! LOL.  wink


Amsky, Area don land! Wey levels make I brutooth all de peeps wey dey Nairaland! I fit scatta & dismantle bomb with my Waffi pidgin!

Naija until we kpeme (delete/revert/kpai/die)!
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by ikamefa(f): 9:26pm On Jun 10, 2008
shuo@ omoovie

why bodi dey pepper you na? you for cool-down grab one oyinbo bros too na!, mean while carry yah wahala go front small!

makaginni! cheesy
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Ikomi(m): 10:02pm On Jun 10, 2008
ikamefa:


shuo@ omoovie

why bodi dey pepper you na? you for cool-down grab one oyinbo bros too na!, mean while carry yah wahala go front small!

makaginni! cheesy

Make una see Ika oooohhhh, where u go since? Long time no see. If u nooo tell me where u go since u go see gbege. angry
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by omoovie(f): 3:44pm On Jun 11, 2008
ikamefa:


shuo@ omoovie

why bodi dey pepper you na? you for cool-down grab one oyinbo bros too na!, mean while carry yah wahala go front small!

makaginni! cheesy

No-oh! I no go go front lai lai! I go turn maiguard shine torchlight for una eye! All deez shidrenses of now-a-days! I for grab one but all de ones wey dey where I dey no too carry_____se you get?  shocked wink grin LOL! Like sai na da one man wan chop! LOL. E don run? Wey e dey make una continue una underGizee!


Ikomi:

Make una see Ika oooohhhh, where u go since? Long time no see. If u nooo tell me where u go since u go see gbege. angry

Ikomi na ur wife abi na ur sista? LOL I be amebo no vex! Je jeje!
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by ikamefa(f): 7:50pm On Jun 11, 2008
Ikomi:

Make una see Ika oooohhhh, where u go since? Long time no see. If u nooo tell me where u go since u go see gbege. angry

ikomi i sabi you? grin grin nor be only gbege! kwapata nko? cheesy yeye!

omoovie:


Ikomi na your wife abi na your sista? LOL I be amebo no vex! Je jeje!

wetin kwonsain you ohhhhhhhh! grin grin grin
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Uche2nna(m): 7:52pm On Jun 11, 2008
**** subscribing*****
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by omoovie(f): 8:38pm On Jun 11, 2008
ikamefa:

ikomi i sabi you? grin grin nor be only gbege! kwapata nko? cheesy yeye!

wetin kwonsain you ohhhhhhhh! grin grin grin

Pssshhhhewwww! What kwonshains me kwonshains u and kwonshains the whole population of Nairaland se u get? Eh-hen! Wey this yor awol toaster e don select comot, mek e kom back naaa! I dey wan see as onye ocha peeps dey perform their own "1, 2, collect d kokolet" so e go be my own practice round wey them dey toast me! Oya I don wear glass wey d bobo mek I begin take notes!

Today's Lesson:

drrrrrr*Inosabiagain*(a wandering onyeocha) vs. Ikamefa (a home-grown kokolet)
conduct a series of experiment wey fit or fitn't end fo insai shursh!

Watch kiafully to c if drrrrrr*abegwareva* manages to catch this elusive babe or if na porto porto she go rub 4 in face!


scribbling furiously!
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by ikamefa(f): 8:45pm On Jun 11, 2008
omoovie:

Pssshhhhewwww! What kwonshains me kwonshains u and kwonshains the whole population of Nairaland se u get? Eh-hen! Where is your awol toaster he should come back naaa! I dey wan see as onye ocha peeps dey perform their own 1, 2, collect d kokolet so e go be my own practice round wey them dey toast me! Oya I don wear glass wey de man mek I begin take notes!

Today's Lesson:

drrrrrr*Inosabiagain*(a wandering onyeocha) vs. Ikamefa (a home-grown kokolet)
conduct a series of experiment wey fit or fitn't end fo insai shursh!

Watch carefully to see if drrrrrr*abegwateva* manages to catch this elusive babe or if na porto porto she go rub 4 in face!


scribbling furiously!



omoovie carry yah wahala go front ohhhhhhhhh!! see as persin carry head shook for another persin bixnix, i sey go find yah own onye ocha na! " grin "
i look like lab experiment to you cheesy hah! nairaland we hail thee ! cheesy
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by omoovie(f): 8:49pm On Jun 11, 2008
I no need onye ocha when I get gamuchi-gamuchi-gam-gam! D gamuchi-gamuchi do me! LOL. Speaking of which I c say u sef dey gamuchi ihn land, how di place be sef? My gamuchi say e want mek we travel go dia. If man watch dia film e dey be me laik say them dey quite similar to our own peeps. Na so abi no be so? Tru talk oh, I wan kno before I carry myself enta palava or cause kasala 4 pesin.


Come to think of am, wetin dis drrrr*chai!Chineke!* guy appearance be sef? Una don torchlight am b4?
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by ikamefa(f): 8:20pm On Jun 12, 2008
LOL @ gamuchi! gamuchi ! gam ! gam! "  grin "

oh you dey yarn about my desi numberi-land?  cheesy,tell your gamuchi make hin bring you come!  tongue of course they are similar to our own peeps  grin

tourchlight who? , what? tonguegrin "
i no sabi wetin you been dey yarn oh! cheesy , maybe if you talk am for sanskrit or tamil i go hear you wella "  grin "
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by omoovie(f): 10:18pm On Jun 12, 2008
ikamefa:

LOL @ gamuchi! gamuchi ! gam ! gam! "  grin "

oh you dey yarn about my desi numberi-land?  cheesy,tell your gamuchi make hin bring you come!  tongue of course they are similar to our own peeps  grin

tourchlight who? , what? tonguegrin "
i no sabi wetin you been dey yarn oh! cheesy , maybe if you talk am for sanskrit or tamil i go hear you wella "  grin "

O-oooh! Ojoro! No b lie! Make I yan kpata 4 sanskrit or tamil! No b only sanskrit! Chicken scratch nko? My bobo been b Tamil oh, lol. Even though d bobo don b past tense we still dey go ihn gamuchi land. This na one relationship wey I comot amicably and I dey very proud of how I conduct myself! Area! We no dey carry last! Me and ihn go stay good friends 4 a long while. Ihn na correct guy so man no go vex. NEways me dear, "torchlight" = see/meet. I bin think say u fit dey follow my waffi/baffi yannings. If d tin too hard, I get levels oh. I fit shift am to gear 1.  tongue LOL.
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by ikamefa(f): 4:46am On Jun 14, 2008
omoovie:

O-oooh! Ojoro! No b lie! Make I yan kpata 4 sanskrit or tamil! No b only sanskrit! Chicken scratch nko? My bobo been b Tamil oh, lol. Even though d bobo don b past tense we still dey go ihn gamuchi land. This na one relationship wey I comot amicably and I dey very proud of how I conduct myself! Area! We no dey carry last! Me and ihn go stay good friends 4 a long while. Ihn na correct guy so man no go vex. NEways me dear, "torchlight" = see/meet. I bin think say u fit dey follow my waffi/baffi yannings. If d tin too hard, I get levels oh. I fit shift am to gear 1. tongue LOL.

" grin " kwamputu! putu ! putu pam ! cheesy

dem tell you sey i nor sabi sey to torchlight na to don see the persin before? chinekeee! see as this waffi persin just take style twist my yarns and de tin wey i been dey talk sef ! tongue( i dey takee style run cheesy you dey take style pull me back)
back to the torchlight thing sef! i don ask you sooooo teyyy! ,grow hunch back sef grin if i don torchlight dis onye-ocha before nko? cheesy wetin kwosain you?
i neffa see pesrin wey hin nose long dis yah level sef!

so your ex gamuchi wan carry you come jaipur! grin, tongue tongue, so wetin your current gamuchi go dey do? cheesy siddon dey look una? tongue grin grin
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by debosky(m): 4:47am On Jun 14, 2008
siddon dia make pant dey wear you. grin

Ika6 come back on YIM jo tongue
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Nobody: 4:59am On Jun 14, 2008
ikamefa:

" grin " kwamputu! putu ! putu pam ! cheesy

them tell you sey i nor sabi sey to torchlight na to don see the persin before? chinekeee! see as this waffi persin just take style twist my yarns and de tin wey i been dey talk sef ! tongue( i dey takee style run cheesy you dey take style pull me back)
back to the torchlight thing sef! i don ask you sooooo teyyy! ,grow hunch back sef grin if i don torchlight this onye-ocha before nko? cheesy wetin kwosain you?
i neffa see pesrin wey hin nose long this yah level sef!

so your ex gamuchi wan carry you come jaipur! grin, tongue tongue, so wetin your current gamuchi go dey do? cheesy siddon dey look una? tongue grin grin

This one na conc. broken. Wetin you just yan here? I'm confused. tongue cheesy
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by ikamefa(f): 5:01am On Jun 14, 2008
debosky:

siddon dia make pant dey wear you. grin

Ika6 come back on YIM jo tongue

wink

stillwater:

This one na conc. broken. Wetin you just yan here? I'm confused. tongue cheesy

me sef don gauge! " cheesy " i nor sabi ask me tomorrow by 12pm ! cheesy cheesy
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by drrionelli(m): 4:08pm On Jun 15, 2008
Please keep this thread going.  I think I'm actually learning a bit!   grin

(albeit very slowly)
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by omoovie(f): 5:32pm On Jun 15, 2008
drrionelli:

Please keep this thread going.  I think I'm actually learning a bit!   grin

(albeit very slowly)

My question drrionelli because I have seen your posts before and when this question has been posted to you u have either played the clever dodger, deflected by feigning you are being unduly attacked or posted an answer that isn't concrete.

Here are the questions:
Why do you want to learn pidgin? For what purpose? Are you married to a Nigerian? Are you friends with one? WHAT IS UR PURPOSE FOR WANTING TO LEARN PIDGIN? Most of the other non-Nigerians that are on this site are either married to one, have dated a few or are good friends with one. You have all these questions on our language and culture. That's all well and good. I'm flattered that an oyibo person wants to learn about us. I have only 1 question that I really need the answer to, why do you want to learn pidgin?

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (Reply)

Not Being To Lagos, a 'bush person'? / Origin Of Why Hausas Call Igbos Nyamiri / Do You Have An Accent?

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 57
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.