Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,548 members, 7,816,334 topics. Date: Friday, 03 May 2024 at 09:41 AM

People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills - Culture (4) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills (10289 Views)

Nigeria Pidgin Proverbs & Their Meanings / ****oyinbo Wey Love Pidgin DIE**** / Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (Reply) (Go Down)

Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by NegroNtns(m): 9:37pm On Jun 20, 2008
I know say urhobo women fine well well.  Back in de days I been go FSAS with some urhobo girls, omo i no lie, na so diem slender, dark and get sharp tongue for mouth.  efrybody dey pursue diem, me mahself e be like urhobo dey mah blood small.  ehn, make u shoot de pishure make man pikin eyeball u nah.   cool

I no lie oo, omo i sense somthing in ya  wink
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by omoovie(f): 10:09pm On Jun 20, 2008
Negro_Ntns:

I know say urhobo women fine well well. Back in de days I been go FSAS with some urhobo girls, omo i no lie, na so diem slender, dark and get sharp tongue for mouth. efrybody dey pursue diem, me mahself e be like urhobo dey mah blood small. ehn, make u shoot de pishure make man pikin eyeball u nah. cool

I no lie oo, omo i sense somthing in ya wink

Ok, I go flash am in 1, 2, 3! FLASH! Sorry! Here today gone tomorrow!
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by NegroNtns(m): 10:17pm On Jun 20, 2008
Omo,

Abeg take am comot make anoder eye no see wetin i see. Wait ehemm, hold on make i think, oh chei mah head don scatter now for wetin i wan say. Omo, make u write me, u get mah email for there. U go dey surprise well well.
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by omoovie(f): 10:34pm On Jun 20, 2008
Negro_Ntns:

Omo,

Abeg take am comot make anoder eye no see wetin i see. Wait ehemm, hold on make i think, oh chei mah head don scatter now for wetin i wan say. Omo, make u write me, u get mah email for there. You go dey surprise well well.

Hahhahahahahahahahahaah! Razzz!  tongue  grin
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Mustay(m): 12:35am On Jun 22, 2008
una two dey MARGINALIZE THIS THREAD O!

CHAT ROOM DEY

ROMANCE SECTION DEY

OFFTOPIC DEY

YIM DEY

MAKE UNA CARRY UNA OPAKS GIST GO DERE! angry angry
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by omoovie(f): 3:37am On Jun 22, 2008
Mustay:

una two dey MARGINALIZE THIS THREAD O!

CHAT ROOM DEY

ROMANCE SECTION DEY

OFFTOPIC DEY

YIM DEY

MAKE UNA CARRY UNA OPAKS GIST GO DERE! angry angry

D romance don end y'hear abeg relax jo! Negro and I know say na just OP toasting we dey conduct 2 mins no pass b4 e begin toast TOH 4 anoda thread! D boy na woman wrappa! So mustay---relax ya own. No worry babe with wandering eye dey wey jus dey crush u laik maddddddd! tongue grin
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Mustay(m): 7:03am On Jun 22, 2008
ehn ehn

That one na good yarns o!
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by NegroNtns(m): 7:12pm On Jun 22, 2008
Omo, I don die oo! Nah so u go just tro'wey me like nothing? No listen to Mustay, hin be mah rival nah :-) I don kuku say make u whisper me for email for sake eyes boku for here. Nah you no gree me o, no be TOH cause am. I no be woman wrappa, I be omoovie wrappa :-) make you do quick quick take put action for ground.

Mustay, omo eyes no dey for de ones wey dey check you out. Her oil lamp dey only shine come mah direction.
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Tetchiness(f): 7:51pm On Jun 22, 2008
well, I sabi pidgin small small sha. grin

Negro et Caucasian, wetin you dey yarn na?

where una wife? I don see her online this morning. Think she dey try to escape you. . . .again! cheesy

I tried wink
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by drrionelli(m): 9:57pm On Jun 22, 2008
<drrionelli is quietly taking copious notes in the Pidgin thread, preparing to ask questions> wink
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by ikamefa(f): 10:01pm On Jun 22, 2008
haaaaaaaaaaa
this thread don gooooooo ohhhhhh
see levels?
shocked shocked shocked
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by omoovie(f): 2:36pm On Jun 23, 2008
ikamefa:

haaaaaaaaaaa
this thread don gooooooo ohhhhhh
see levels?
shocked shocked shocked

Sebi? My girl wey u bin dey? Foh whosai of Jaipur them carry u enter?

Tetchiness:

well, I sabi pidgin small small sha. grin

Negro et Caucasian, wetin you dey yarn na?

where una wife? I don see her online this morning. Think she dey try to escape you. . . .again! cheesy

I tried wink

I don los na hu b caucasian 4 dis sai?

Negro_Ntns:

Omo, I don die oo! Nah so u go just tro'wey me like nothing? No listen to Mustay, hin be mah rival nah :-) I don kuku say make u whisper me for email for sake eyes boku for here. Nah you no gree me o, no be TOH cause am. I no be woman wrappa, I be omoovie wrappa :-) make you do quick quick take put action for ground.

Mustay, omo eyes no dey for de ones wey dey check you out. Her oil lamp dey only shine come mah direction.

I go tro'wey u na. U sef no b loyal omoovie wrappa so I gats to form small! *wink**wink* Y I go whisper u 4 email? U no hear me say na Asians & Latinos dem naim dey trip me nao? Ur toasting nova done b4 u begin anoda 1. As u b laik octopus dey spread ur tentacles into difren difren girls dem me too gats to spread my own tentacles. Which kain action I wan put 4 ground?

As 4 Mustay, truly truly, I no dey d list of babes wey dey eye u sorry. And Negro u dey delusional. tongue grin kiss
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Mustay(m): 3:58pm On Jun 23, 2008
Who dis one dey do yanga for?
grin grin grin grin

shio

Na so all these babes dey do

Them go wan make man dey go interview test like say I be apprentice tongue
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by ikamefa(f): 4:26pm On Jun 23, 2008
omoovie:

Sebi? My girl wey u bin dey? Foh whosai of Jaipur them carry u enter?



na Ashok  nagar  cheesy  na when u go land?  tongue cheesy
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by omoovie(f): 11:33pm On Jun 23, 2008
Mustay:

Who this one dey do yanga for?
grin grin grin grin

shio

Na so all these babes dey do

Them go wan make man dey go interview test like say I be apprentice tongue

You b apprentice o no b only novice! You nova jam! Na correct babe of d highest order naim u wan use back door take toast! Bros, no try me eh! I dey beg u nao mek I no show my dragon side!

ikamefa:

na Ashok  nagar  cheesy  na when u go land?  tongue cheesy

I go land once mai eye dey chuk gamuchi ihn pocket nao! Shuoo! You b gofment? Hajia govamenti, I no bin know!
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by NegroNtns(m): 3:24am On Jun 24, 2008
Omo,

Look how this urhobo princess don vex finish take mouth yab left and right, up and down and wonder why all dis african warriors no fit for am. cool Ehn, urhobo wado, omovie wado, ovieya wado, hahahaha grin. na so princess dey behafe?

Na me get de remedy for ya palava but ya eye dey wey e dey and me mahsef enjoy and like de accompaniment of plenty women but i always get dat special one wey be say nah hin i go settle with. I nefer meet am, i still dey look but as i dey pas go, ya light na hin draw mah eye make me put brake for leg turnabout and put foot for dis floor. cheesy

U dey go look for india and asian and latin, ehn oya, take ya oil lamp go dere nah. Efrytime u miss home whisper me for letter, man pikin dey here. We go eyeball again nah grin mi ni wado grin
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Mustay(m): 9:54am On Jun 24, 2008
omo


where ur frends dem dey?
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by romeo(m): 12:59pm On Jun 24, 2008
ahh ahh wetin de shele for dis side!! I bin dey blow my igbo for dat side since and i no come know say better dey here oooh

I hail una!!
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by omoovie(f): 3:15pm On Jun 24, 2008
Negro_Ntns:

Omo,

Look how this urhobo princess don vex finish take mouth yab left and right, up and down and wonder why all this african warriors no fit for am. cool Ehn, urhobo wado, omovie wado, ovieya wado, hahahaha grin. na so princess dey behafe?

I'm vexing becos u betrayed me nao ehn! Efen @ dat u kno u still love me! wink grin kiss I dey c d rov 4 ya eye boku boku!


Na me get de remedy for ya palava but ya eye dey wey e dey and me mahsef enjoy and like de accompaniment of plenty women but i always get that special one wey be say nah hin i go settle with. I nefer meet am, i still dey look but as i dey pas go, ya light na hin draw mah eye make me put brake for leg turnabout and put foot for this floor. cheesy

Awww, u don tuk d korret tin na, Come here my dahling! kiss kiss kiss


You dey go look for india and asian and latin, ehn oya, take ya oil lamp go dere nah. Efrytime u miss home whisper me for letter, man pikin dey here. We go eyeball again nah grin mi ni wado grin

Which kain backdoor romeo & juliet u wan use me tek do? U dey craze? I b u laik underG jezeebel? I no blame u! I don dey mara naooo! shocked Shiiiiooooooooooorrr!

Mustay:

omo


where your frends them dey?

Which friends dem?
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Mustay(m): 5:32pm On Jun 24, 2008
u no sabi frends.

make person get directory now
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by NegroNtns(m): 1:04am On Jun 25, 2008
Omo,

I laik as u take proper respect recognise for ma sai so, come tell efribody say i be ya romeo but e get as e be nah. de kin toast i dey giff u so, er'body don sabi say fire dey burn for bitwin negro and omo and me i no deny am o.

efrytime i hear ya footstep and see dat light shine, even sef say women dey mah left and right side and we dey miliki nah so i dey take style comot from bitwin come follow till i find u. cheesy

sebi i tell u say i dey search, how rove no go dey mah eye nah? na sake of da rove make me find u grin make u come comot de rove put omoovie enter grin backdoor no dey dis one, efribody know say e get some kin fire wey dey burn bitwin negro and omo. me mahsef don buy kerosene wey i go take dey feed de fire, e no go die and even afta u don become mah juliet, i go kuku go buy oiel to feed de fire.

next time i hear say u dey go india or asia na mah special duty finger i go take poke u for ya eye. na me and you, try me nah, yeye cool
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Mesmerize(f): 1:11am On Jun 25, 2008
Omoolove

haaa!! my sis tetchiness, no be Caucasian o!
for where? shocked

she be Chinese wink
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Mesmerize(f): 1:12am On Jun 25, 2008
@negro
omo, you talk too much jare!
ah ah
na yoruba ni o, na Ingilish nio, na pidgin ni, you still dey write paragraphs!
Jesu, egba mi grin grin
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by luck007(m): 2:19am On Jun 25, 2008
smileybrother thank you oh!! na pigin na bi d topic, but una don turner to another thing. make una fire pigin na dey ask una. i want thicker pigin, wafi pigin lipsrsealed i nor talk pass there ohhh lipsrsealed
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by NegroNtns(m): 3:52am On Jun 25, 2008
lmao mesmerize,

no be mah talk too much oo, na u get wetin oyinbo pipl dey call attention deficit disorder, u no dey fit hold ya mind steady for one thing before hin go begin wander go another thing. Four sentences too much for ya mind to handle nah grin
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Mesmerize(f): 4:01am On Jun 25, 2008
Negro_Ntns:

lmao mesmerize,

no be mah talk too much oo, na u get wetin oyinbo pipl dey call attention deficit disorder, u no dey fit hold ya mind steady for one thing before hin go begin wander go another thing. Four sentences too much for ya mind to handle nah grin
se na me you dey yab like that abi?
see your ponmo head. . hisss
na me get ADD? dnt worry o, we're both in it together. oniranu
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Mustay(m): 1:09pm On Jun 25, 2008
esmy, I dey feel u jo!

Haba, te guy sef wan write novel 4 pidgin

@luck 007

you get problem?

fire first na!
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by joomiegal(f): 3:25pm On Jun 25, 2008
wen una start did thread, i bin tink say una wan add pidgin proverb join am. Oya make we start; if u no know de answer, u fit ask julius agwu or basket mouth make e helep una. make una know say de answer for pidgin no always be the same answer for english. here goes:
1. Birds of de same feather,
na de same mama born dem!

2. A bird in hand,
na to kill and chop!

3. a friend in need, oya make sombody answer na,
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Mustay(m): 3:38pm On Jun 25, 2008
joomie



plenty thread dey like that

Can Somebody Please Teach Me Pidgin?
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by luck007(m): 2:50am On Jun 26, 2008
omo boy!na so we go de dey!! like edede wen nor dey eat food wen peppe dey!!!! very so una go hear say person don write book wit pigin
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Mesmerize(f): 2:58am On Jun 26, 2008
luck007:

omo boy!na so we go de dey!! like edede when nor dey eat food when peppe dey!!!! very so una go hear say person don write book wit pigin
lmao!!
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Mustay(m): 9:34am On Jun 26, 2008
Mesmerize:

lmao!!

wetin that one mean?

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (Reply)

Not Being To Lagos, a 'bush person'? / Origin Of Why Hausas Call Igbos Nyamiri / Do You Have An Accent?

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 50
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.