Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,154,739 members, 7,824,127 topics. Date: Friday, 10 May 2024 at 11:45 PM

After God Fear Women - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / After God Fear Women (1224 Views)

After God Fear Woman / After God Fear Ph Girls (pictures Added) / After Devil, Fear Women . (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

After God Fear Women by Iceking1(m): 10:55pm On Apr 01, 2015
AFTER GOD, FEAR WOMAN Na base on my experience as a marriage
counsellor and inspiration from personal
encounter with pipo nai I take write this
book wey I title




"Devil Dey Fear Woman"



Just go through the first 10 issues wey
make chapter one of the book.



1. Carol and Felicia na two best friends
wey dey husband house. When Carol get
one kain issue with her hussy, her hussy
cum tell her to park. Felicia and her hussy
try to settle the matter but carol husband
say e need space now. Felicia cum tell her husband say make carol cum stay with
dem for the meantime befor she go settle
with her husband. Only one week nai
Carol stay the house befor she begin doke
Felicia husband. Befor Felicia know wetin
dey sup, her husband don drive her from house as e continue dey doke her friend
as new wife.



2. When Lucy born finish, her younger
sister cum follow her mama come do
ormugor. Na the two months wey dem
stay nai Lucy younger sister for get belle
for Lucy husband. Being say dem come
from one kain funny tribe for Nigeria, their family say make Lucy husband
kukuma pay Lucy younger sister bride
price make e marry her join e wife. Befor
dem even start to hold family meeting,
Lucy younger sister don poison Lucy die.




3. Benson carry babe wey e wan marry go
show e papa. Befor dem do the marriage,
the babe don dey straff Benson papa.
Dem continue their doking till the babe
get belle. When she wan born, pikin nor
gree come out. Doctors say both mama and pikin go kpuff if dem do operation.
Na for native nai dem for tell the babe to
confess becos the pikin for belle say e dey
vex. Na so the babe take talk how she
take start to dey service both papa and
son.




4. Clara husband travel yankee for two
years course. Befor e come back, Clara
don get belle for e driver. She try to do
abortion but the thing back fire. Na when
her husband come back nai her bleeding
start. She feel say the abortion through. She dey unconscious for hospital wey the
husband rush her go when the doctor for
tell am say na complication from the
abortion wey she do nai dey worry her.
When God cum wake her up, her hussy
threaten to kill her befor she gree confess say na driver dey shine her congo when
the hussy nor dey.




5. When small Yinka dey sick anyhow, nai
her papa cum carry am go hospital make
doctor check her. Na from genotype test
the doctor for tell papa Yinka say Yinka
na AS. The papa na AA. E wife na AA. So
how come? Na so e eye dey red when e dey ask mama
Yinka. Na last last she for confess say na
her ex nai give her penalty befor her
wedding. That free kick score goal. So,
Yinka nor be papa Yinka pikin.




6. Every evening, Eguonor go tell her
husband say she dey go all night prayers
for one house fellowship. News cum fly
enter her husband ear say she dey go
meet one guy wey dey massage her
steady. Na when the hussy trace her one day nai e discover say she dey true true
dey doke on top o her pregnancy.




7. Mr Joseph and e wife and senior son of
7 years dey house one evening when one
chief wey norva born come meet Mr
Joseph say na e pikin e cum collect. E wife
nor fit talk again when the chief dey
shout say e go carry them go court to show dem say na him she born the pikin
for. When Mr Joseph dey date Helen, she
dey doke chief join. She get belle but
chief tell her to remove am she nor gree
cos she dey fear abortion.
Na so she hang the belle for Joseph. Na becos of say she get belle nai make
Joseph rush marry her.




8. Benji decide to marry Chioma when
Chioma lie for am say she get belle. Na so
so wayo she dey play Benji for the 5 years
wey dem don marry now say she miss
period whereas nothing dey happen.
Na when she and her childhood friend get quarrel nai the friend use am take curse
her say na the aborted baby wey she use
mortar and pestle take pound for native
doctor shrine nai dey worry her wey make
her norva fit born so.




9. Utienyin and e wife dey owe landlord
10 months rent. Make the landlord for nor
drive dem, the wife cum go seduce the
landlord without her husband knowing.
Befor you know what, na steady doking.
Dem doam sotay the landlord wife cum know she cum go tell Utienyin. Utienyin
cum say make e wife park. But landlord
cum say make Utienyin park. As Utienyin
dey park, the wife remain for the
compound as landlord babe.




10. James with e babe go club. Where
James for dey find e babe make dem dey
go house, e sight her for one Range Rover.
She sidon for front dey wave James as she
dey use straw dey sulk star.



My pipo, from number one to ten, e get
wetin one woman go do again wey big
pass any of dem?



We dey construction company wey one
guy waka pass me. Wetin e write for e
helmet nai inspire me to write this book.
He write



"After God, fear women"


When I ask am why e write that kind
thing. This na wetin e tell me. "My brother, when God dey question
Adam why e eat from the tree wey e tell
am not to eat from.
Adam say,




"Baba, nor be the woman wey you give
me nai say make I eat am? Lwkmd.



Why Adam nor fear God but e cum fear
Eve?




Mind you, the second chapter of my book
"DEVIL DEY FEAR WOMAN" go come
tomorrow. Watch out!
Re: After God Fear Women by falconey(m): 10:56pm On Apr 01, 2015
NOTED!!!
Re: After God Fear Women by Nobody: 10:57pm On Apr 01, 2015
When you offend a woman, just pray she does not hold it against you!
Re: After God Fear Women by wenger2(m): 10:59pm On Apr 01, 2015
cool
Re: After God Fear Women by Iceking1(m): 11:00pm On Apr 01, 2015
rubey:
When you offend a woman, just pray she does not hold it against you!


Gbam!!! , u jst nailed it
Re: After God Fear Women by Hawlahscho(m): 11:05pm On Apr 01, 2015
rubey:
When you offend a woman, just pray she does not hold it against you!


Let me quickly change My signature. cool
Re: After God Fear Women by Iceking1(m): 11:07pm On Apr 01, 2015
Hawlahscho:



Let me quickly change My signature. cool


lol
Re: After God Fear Women by Hawlahscho(m): 11:11pm On Apr 01, 2015
Re: After God Fear Women by floma07(m): 11:44pm On Apr 01, 2015
Oh boi no be small tin ooo
Re: After God Fear Women by Nobody: 11:51pm On Apr 01, 2015
Re: After God Fear Women by jashar(f): 8:27am On Apr 02, 2015
*sighs*
And the OP never gave credit to the male actors.
The one who betrayed his wife
The one who lacked self control
The one who betrayed his son
... Et al.

*sighs*
2 sides to a story, several perspectives to it.
Re: After God Fear Women by ivyT(f): 9:51am On Apr 02, 2015
na Long tory b dis,fear every one_cos no one is to b trusted
Re: After God Fear Women by Iceking1(m): 9:59am On Apr 02, 2015
floma07:
Oh boi no be small tin ooo


i dey tell u
Re: After God Fear Women by englishmart(m): 10:11am On Apr 02, 2015
sometimes I fear women more than the gods

(1) (Reply)

How Long Is Too Long To Say Yes? / What's The Worst Thing Your Boyfriend Or Girlfriend Has Ever Done / He Need Advice On A Girl He Met On Social Media (facebook).

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 27
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.