Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,194,615 members, 7,955,261 topics. Date: Saturday, 21 September 2024 at 08:53 PM

U Spend A Whole 150k On A Babe? - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / U Spend A Whole 150k On A Babe? (2314 Views)

I Just Won A Bet Of 900thousand Naira, ND I Want To Spend 150K On A Female Here. / He Invited Me To Spend A Weekend With His Family / Is It Wrong To Spend A Lot On A Guy? (2) (3) (4)

(1) (2) (Reply) (Go Down)

U Spend A Whole 150k On A Babe? by Nobody: 10:15am On Nov 26, 2011
One of my distant cousin wey we dey close really dey heartbroken as i dey yarn u this tory.From wetin im tell me na one igbo girl break im heart.According to am he meet this babe during one of those night bliss crusade wey Pastor Chris Oyakilome dey always organise.He talk say after dat night of bliss na im dem come start to dey date.He say the babe fine well well and na very good christian and na even member of the believers love world.But he say one problem wey the babe get be say she too like money.Though this my cousin never get Government job yet but then he get one small shop were he dey sell ladies articles and he dey manage this small business well.He say anything the girl ask for money he say he dey always give her without complaining and even sef wen the girl visit am for im shop come carry any of the ladies things wey he dey sell like jeans,pant he go just allow the babe take the thing.But he say upon all wetin he don do for this babe he come catch am dey frolick with one Old Alhaji Salisu for Mr Biggs.He say he come vex den challenge the babe and the babe come deny am and tell the alhaji say my cousin na her one of her brother for village with mental problem.This thing really pain my cousin and na drink he come dey drink from morning till noon to forget about im heartbreak.I come ask am how much he don spend on this babe so far and he tell me say na one hundred and fifty thousand im don spend on the babe and right now im shop business no dey move again and he dey on debt.I just open mouth dey look shocked.A whole 150k on a girl?
haba!
Me sef i jus dey worry over this my cousin make he no go take drastic action ooo shocked
Re: U Spend A Whole 150k On A Babe? by bekay911(f): 10:20am On Nov 26, 2011
Im no buy BLACKBERRY? Na fucck up. Dat ur cuz na mumu im no get swag.
Doz mumulity run in una family
Re: U Spend A Whole 150k On A Babe? by bekay911(f): 10:23am On Nov 26, 2011
Staffkillz tell me say u dey psychiatric hospital n ur cuzin money don finish. Dnt worry straffkillz is coming to pay ur bills n get u out of der. Sit tight no look woman nyansh oooo
Re: U Spend A Whole 150k On A Babe? by Nobody: 10:24am On Nov 26, 2011
[size=14pt] shocked shocked shocked
This your cousin na the real First class Mumu o! Na this kain idi[i]o[/i]ts dem suppose cage, put am for zoo, make other bobos dey learn lesson from am!. . .

150k on babe wey you no go marry? For 2011/2012, na im bobo never get sense? Na this kain maga dey be fool at 40 o! Lefu, do something o! shocked
[/size]
Re: U Spend A Whole 150k On A Babe? by Yorisb: 10:42am On Nov 26, 2011
@Lefulefu

No mind 'em. Abeg tell ur cousin 2 carry on - Givers, they say, never lack. . .

And as 4 im shop business, again tell him not 2 worry - God go provide. U hear?
Re: U Spend A Whole 150k On A Babe? by tellwisdom: 10:51am On Nov 26, 2011
[size=15pt]Nigerian women embarassed embarassed, A beleiver for that matter cry cry [/size]
Re: U Spend A Whole 150k On A Babe? by Mynd44: 1:55pm On Nov 26, 2011
If he can be dumb enough to spend that amount on the girl then he deserves what he gets
Re: U Spend A Whole 150k On A Babe? by ammamat(f): 2:39pm On Nov 26, 2011
So you guys believe this fake story, Men are nt that stupid the days oh, Ask him well or let him tell u the truth @ lefu
Re: U Spend A Whole 150k On A Babe? by Mynd44: 2:52pm On Nov 26, 2011
It might be true ooo. Maga no fit finish for this world
Re: U Spend A Whole 150k On A Babe? by Yorisb: 2:55pm On Nov 26, 2011
ammamat:

So you guys believe this fake story, Men are nt that silly the days oh, Ask him well or let him tell u the truth @ lefu

Talking from experience?
Re: U Spend A Whole 150k On A Babe? by Nobody: 3:04pm On Nov 26, 2011
tellwisdom:

[size=15pt]Nigerian women embarassed embarassed, A beleiver for that matter cry cry [/size]
Eh na those naija girls wey dey attend church na dem even worse pass grin grin
all these christ embassy and winners chapel babes omo when it comes to money dem dey a class of their own grin grin grin
Re: U Spend A Whole 150k On A Babe? by Nobody: 3:08pm On Nov 26, 2011
ammamat:

So you guys believe this fake story, Men are nt that silly the days oh, Ask him well or let him tell u the truth @ lefu
Na u be the fake girl with ur fake yansh and ur fake cray fish legs angry
Re: U Spend A Whole 150k On A Babe? by Nobody: 3:13pm On Nov 26, 2011
Yorisb:

@Lefulefu

No mind 'em. Abeg tell your cousin 2 carry on - Givers, they say, never lack. . .

And as 4 im shop business, again tell him not 2 worry - God go provide. U hear?

Eh u dey talk about givers never lack and my cousin right now get high blood pressure over this babe.If a bobo no gree spend na naija babes go dey refer to the bobo as stingy but now my cousin spend on this babe just because im love her and she jus reward that love by running after one old Alhaji with yellow teeth justy because the alhaji get more money pass my cousin.anyway god dey sha cheesy
Re: U Spend A Whole 150k On A Babe? by Nobody: 3:24pm On Nov 26, 2011
sexkillz make u free the guy small. he no spend all the money at once on the babe but na the total amount of money wey he don spend on the babe for the four months wey dem dey na im total up to 150k.Anyway the bobo do am for love but u know say naija babes dem too greedy grin grin grin
Re: U Spend A Whole 150k On A Babe? by tellwisdom: 3:25pm On Nov 26, 2011
Eh na those naija girls wey dey attend church na dem even worse pass grin grin
all these christ embassy and winners chapel babes omo when it comes to money dem dey a class of their own grin grin grin

Ewoooooooooooo cry cry cry
Re: U Spend A Whole 150k On A Babe? by tellwisdom: 3:26pm On Nov 26, 2011
Na u be the fake girl with your fake yansh and your fake cray fish legs angry

Gbuhehehehe!! grin grin grin
Re: U Spend A Whole 150k On A Babe? by Nobody: 3:40pm On Nov 26, 2011
lefulefu:

sexkillz make u free the guy small. he no spend all the money at once on the babe but na the total amount of money wey he don spend on the babe for the four months wey dem dey na im total up to 150k.Anyway the bobo do am for love but u know say naija babes dem too greedy  grin grin grin

[size=14pt]What love? If you love someone, you should NOT keep an account of how much you spend on them materially. Why would you want to do that?. . . Your cousin, or whoever the dummy is, had an ulterior motive towards her. And he feels hurt that he did not achieve it with her, before she dumped his sorry arse! If he had gotten what he wanted from her, he wont be complaining about the money. He was spending to impress her, and unfortunately a bigger spender came along. . . He's still a qualified & certified mugu for spending such an amount. Smh![/size]
Re: U Spend A Whole 150k On A Babe? by Mynd44: 6:36pm On Nov 26, 2011
I think right now we all agree that the guy and his cousin are both MAGAS
Re: U Spend A Whole 150k On A Babe? by Nobody: 1:27pm On Nov 27, 2011
Dude u should start writing novels. Channel your narrative skills into something better.
Re: U Spend A Whole 150k On A Babe? by Niiade(m): 4:25pm On Nov 27, 2011
Se
sexkillz:

[size=14pt]What love? If you love someone, you should NOT keep an account of how much you spend on them materially. Why would you want to do that?. . . Your cousin, or whoever the dummy is, had an ulterior motive towards her. And he feels hurt that he did not achieve it with her, before she dumped his sorry arse! If he had gotten what he wanted from her, he wont be complaining about the money. He was spending to impress her, and unfortunately a bigger spender came along. . . He's still a qualified & certified mugu for spending such an amount. Smh![/size]
You wicked oh, the dude toast come spend money, you say make him no keep records na from shop most of the thing commot from na haba so record go dey beside him cousin neva tell am the full amount na, I sure say the dude na Igbo man n u sabi say woman na asset jare he must know how much he spend na.
Your cousin funny him say the babe like money him no get money him carry him head enter hole come dey shout for help now.
Well make him pray say the alhaji dey drop for the babe wella make he go ask the girl for small cut from him investment .ː̗̀(̥̊=)))̥̊ː̖́hahahahahaː̗̀(̥̊=D
Re: U Spend A Whole 150k On A Babe? by Mynd44: 4:34pm On Nov 27, 2011
the girl has just proven that if you are dumb, you should be taught a lesson
Re: U Spend A Whole 150k On A Babe? by cynthiafred67(f): 5:01pm On Nov 27, 2011
Come lefulefu abi waitin them dey call u sef, na wah 4 dat your cousin oo him bin dey keep account on waitin him spend on the babe? The babe force am ni? Just 150K na him he dey complain mtcheeew. His heart never break make him sidon there make pant they wear am *smh*
Re: U Spend A Whole 150k On A Babe? by Nobody: 10:03pm On Nov 27, 2011
cynthiafred67:

Come lefulefu abi waitin them dey call u sef, na wah 4 dat your cousin oo him bin dey keep account on waitin him spend on the babe? The babe force am ni? Just 150K na him he dey complain mtcheeew. His heart never break make him sidon there make pant they wear am *smh*
U see wetin i dey talk
na babes like u dey make men spend everything wey dey their wallet until the thing go come lean grin
by the way how much ur bobo spend on that wig wey u wear for head sef grin
Re: U Spend A Whole 150k On A Babe? by Nobody: 10:25pm On Nov 27, 2011
You cousin most really broker than you. 150KNaira less than $1000 in 3 years and both of you are cry whining like some idiotas that you already are. I'm outta here, too many cheap broke asrse nigga's here. I don't wanna get infected.

Btw your story is faker than Kim Kardashian's arse
Re: U Spend A Whole 150k On A Babe? by Nobody: 10:29pm On Nov 27, 2011
REALITY101:

You cousin most really broker than you. 150KNaira less than $1000 in 3 years and both of you are cry whining like some idiotas that you already are. I'm outta here, too many cheap broke asrse nigga's here. I don't wanna get infected.

Btw your story is faker than Kim Kardashian's arse
my guy how the car smuggling business dey do u?
Re: U Spend A Whole 150k On A Babe? by Thelstan(m): 10:36pm On Nov 27, 2011
150k wey go buy Bold 5 (Touch) plus 6 months BIS subscription for the girl in only one day. Pschew na im de guy dey complain. Na small-time mugu self.

The girl no even ask for Louboutin shoes join make the guy kwench last last.
Re: U Spend A Whole 150k On A Babe? by Nobody: 10:38pm On Nov 27, 2011
Bruv shit is paying me real good. I do from California to Mexico now from both tunnels, Rio and boarder. . I call it upgrading limitless. , With that kind of paper don't you think I can have all the hot bbitches in your country to suck my mamba looking pen1s? Including your sisters, cousins and nieces.
Re: U Spend A Whole 150k On A Babe? by cynthiafred67(f): 10:42pm On Nov 27, 2011
lefulefu:

U see wetin i dey talk
na babes like u dey make men spend everything wey dey their wallet until the thing go come lean grin
by the way how much your bobo spend on that wig wey u wear for head sef grin


^^^ lafu lefu I can see u have a thing 4 my heir style. *winkz*
Re: U Spend A Whole 150k On A Babe? by slex(m): 11:17pm On Nov 27, 2011
hahahaha, omo so no be only Yahoo yahoo, mugu de?for road mugu sef dey. hahaha

but seriously, 150 k in 3 years is not so much, how much is brazillian hair plus BB Torch?ohoo. so gut tell you cousin to learn from his mistakes , because a sharp man was once a mugu, not everyone was born sharp
Re: U Spend A Whole 150k On A Babe? by Beync(f): 11:28pm On Nov 27, 2011
Lefu lefu sorry o, so you and all your frenz and causins na wowo una be
every time u dey compain how naija igbo girl take dry your pockect chop all your money leave you, now na your causin.  so una no get fine bobo wey girls they die for dey even give money abe? so na so una wowo reach. sorry no wonder u dey complain. but make i tell you one thing eh, if you and you causins na correct guy wey fine know watsup eh na girls go dey pursue you they beg you make you collect money. see make i tell you once you be wowo like you and you causin, na so una go dey pursue fine girls and na so dem go dey withdraw money from you like atm. see na thru be this, a girl see ugly boy like you wey she no like especially if the boy come dey stalk her, she fit do like say she get interest but she wont suck your mumu commot for her side make she see correct guy wey go tell her waiting she won hear. so my brother i pity you sha becos ego hard before you go find naija girl wey go really love you the way you ugly reach, anyway na that old white woman wey you dey follow na she fit make you feel like say there is something call love but na suffer be that na, becos na granny mate be that, the real chocolate no dey again, sorry u here.

If you need more for waitn babes dey do ugly boy i still dey tongue
Re: U Spend A Whole 150k On A Babe? by tellwisdom: 11:35pm On Nov 27, 2011
benyash, u were suppose to create a thread specially on this,not posting a whole thread as a reply angry angry
Re: U Spend A Whole 150k On A Babe? by Natasha2(f): 11:42pm On Nov 27, 2011
[size=20pt]pheww common #150,000 and you're making noise?  undecided [/size]

(1) (2) (Reply)

Just Look At What Becomes Of Her - Waitng For The Perfect Man!!!!!! / America's Prettiest Prisoners Revealed (from The Website That Lets You Date Them / My Ex-girl Doesn't Want To Let Me Be

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 51
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.