Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,194,258 members, 7,953,975 topics. Date: Friday, 20 September 2024 at 10:10 AM |
Nairaland Forum / Entertainment / Forum Games / The Pidgin English Thread (30051 Views)
╚►start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) Part 3 ◄╝ / Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) Part 2 / Start The Sentence With The Last Word (pidgin Version) (2) (3) (4)
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (29) (Reply) (Go Down)
The Pidgin English Thread by edoyad(m): 9:21am On Mar 11, 2009 |
This na pidgin english thread. This thread na for we people wey don tire for oyibo talk talk. If you no fit speak pidgin na your torror. 2 Likes |
Re: The Pidgin English Thread by Amigoz(f): 10:51am On Mar 11, 2009 |
I no fit |
Re: The Pidgin English Thread by edoyad(m): 12:20pm On Mar 11, 2009 |
If you fit then nor enter here again.NO OYIBO FOR THIS PLACE OH!! I NO GO WARN AGAIN. |
Re: The Pidgin English Thread by wunmilyn(f): 12:40pm On Mar 11, 2009 |
sey u think say we no go skool? wey we o con dey speak pidgin english. me too i no fit. |
Re: The Pidgin English Thread by edoyad(m): 1:13pm On Mar 11, 2009 |
Omoge this nor be matter of skool or who nor go. E mean say as my palle nor get money to pay for english skool for me na him be say i nor fit de nairaland abi ? |
Re: The Pidgin English Thread by Amigoz(f): 1:14pm On Mar 11, 2009 |
na u talk am o |
Re: The Pidgin English Thread by edoyad(m): 1:23pm On Mar 11, 2009 |
This Amigoz think say she na ladyDragon ba ? I just dey see her name everywhere i go. Fire pass fire o. |
Re: The Pidgin English Thread by wunmilyn(f): 1:26pm On Mar 11, 2009 |
ehn ehn sey na my friend u dey talk to if i catch u, u go no say ur fire small near my friend fire. |
Re: The Pidgin English Thread by Amigoz(f): 1:27pm On Mar 11, 2009 |
thx u jere ore!! no mind am o, e wan use style make we dey yarn dis pidgin, we go soon melt am down |
Re: The Pidgin English Thread by edoyad(m): 1:34pm On Mar 11, 2009 |
Chaii!! I don die o o o. . . . Shey na me unu de talk to like so ? I nor blame una,if then join una name together e go spell WOMANGOES. Oya , alele. Make una find una way from my dormot. |
Re: The Pidgin English Thread by Amigoz(f): 1:40pm On Mar 11, 2009 |
y u no just confess say u wan yarn ur abinibi language we 4 bring more peeps to ur thread as pe u no like women - "womangoes" i go go bring mencome |
Re: The Pidgin English Thread by ulanda(f): 1:43pm On Mar 11, 2009 |
i no de understand u shah. |
Re: The Pidgin English Thread by wunmilyn(f): 1:50pm On Mar 11, 2009 |
who u dey talk to? |
Re: The Pidgin English Thread by Amigoz(f): 1:51pm On Mar 11, 2009 |
i no no, help me ask am, i think say she fall sideways land on d thread sef |
Re: The Pidgin English Thread by wunmilyn(f): 1:55pm On Mar 11, 2009 |
leave ham, na amebo tithle she won get. |
Re: The Pidgin English Thread by edoyad(m): 2:01pm On Mar 11, 2009 |
Heh Heh . . . (IDLL-I DE Laff Well Well) shey dis una crase wey una don catch no de travol thru internet ? because if i catch this kind thing wey una get, i go jump inside river kaduna this evening. |
Re: The Pidgin English Thread by wunmilyn(f): 2:22pm On Mar 11, 2009 |
u beta throw urself inside any river wey u see cos if me and my friend catch u ehn unn u go know say kaki no bi leather |
Re: The Pidgin English Thread by Amigoz(f): 2:29pm On Mar 11, 2009 |
na wound e go wound ore , e fink sey we be jonny just dey waka like am, im dey look wella 4 twinny wahala |
Re: The Pidgin English Thread by edoyad(m): 2:51pm On Mar 12, 2009 |
Yes . Correct place. Where all my neighbours de now ? I DON COME OH . |
Re: The Pidgin English Thread by Amigoz(f): 3:19pm On Mar 12, 2009 |
Una wellucom wich 1 una bring 2dy? |
Re: The Pidgin English Thread by edoyad(m): 3:51pm On Mar 12, 2009 |
AH !! So una neva hear the tori. |
Re: The Pidgin English Thread by Amigoz(f): 4:23pm On Mar 12, 2009 |
yarn me d koko, but hold on o, u dan enroll 4 d english class? |
Re: The Pidgin English Thread by edoyad(m): 4:31pm On Mar 12, 2009 |
My sista. No be need to go enroll for english class, na you and your twin need to see psychiatrist. I for refer una to one man for ilorin but him don retire for wereh business |
Re: The Pidgin English Thread by Amigoz(f): 9:53pm On Mar 12, 2009 |
Una dey talk about d one wey cure u |
Re: The Pidgin English Thread by tytylayor: 11:25am On Mar 13, 2009 |
wetin una dey talk about? |
Re: The Pidgin English Thread by Tonyet1(m): 1:06pm On Mar 13, 2009 |
help me ask dem for here o my sista |
Re: The Pidgin English Thread by romsky: 1:50pm On Mar 13, 2009 |
i bin tink say dem dey tish person pidgin language self |
Re: The Pidgin English Thread by tytylayor: 2:24pm On Mar 13, 2009 |
dem tell me say na u dem dey wait make u come start lecture nw |
Re: The Pidgin English Thread by romsky: 2:30pm On Mar 13, 2009 |
na bigina class dis ones blong to, if dem dey my class i go flog dem tire |
Re: The Pidgin English Thread by edoyad(m): 8:08pm On Mar 13, 2009 |
romade: tytylayor: tonye-t: Ehe. Na who be all this bongafish them ? Na Where those evil twins wey suppose de guard this dormot against this awuf people go sef ? Una tink say to enter here na free ba ? Oya , before i count. . . . |
Re: The Pidgin English Thread by Bbeee: 8:14pm On Mar 13, 2009 |
wetin de para 4 hia? |
Re: The Pidgin English Thread by edoyad(m): 10:18pm On Mar 13, 2009 |
na wish kind name be BiBi again ? |
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (29) (Reply)
Can You Spot The 6 Hidden Words From This Picture? / ╚►When I Meet A 9ralander!◄╝ / How Many Of These Characters Can You Name
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 16 |