Hungryboy's Posts
Nairaland Forum › Hungryboy's Profile › Hungryboy's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 79 80 81 82 83 84 85 86 87 (of 119 pages)
Make this women even thank their God say their drunkard husbands never put dem belle, Drunkard were him hunger pass my own, small money were e get na to use buy kai kai, come get pikin join, No be double wahala be dat |
pedrilo:oga i no get cv oh, i be part time labourer, part time gateman, In case you dey find any of the above, am available For now ,Na chop money i dey find, |
Godmother:aunty how i for do nah, Even hausa muslim beggar go recite the Lord's prayer if you promise say u go give am something, Aunty my begging bowel is always open, In case you wan feel charitable |
pedrilo:bros, am happy for you oh, Follow show me love nah, Make hunger no kill your boy, I no wan say make God bless you in advance sef, Cos your blessings just dey start, By the time blessing finish with you, Your name shall become Blessed |
moneybag100:oga Bill Gates don help millions, you never hear of him foundation?, and with the billions were him don give out, him still be world richest man |
MrHighSea:my oga, my hustle no wan pay oh, The way were i look am, if gateman parole no work again, i fit go back my village go do farming oh |
Bros, abeg i get Ph.d for gateman and allied studies, I also get 5yrs experience in grass clearing, gardening, carrying blocks and all other labour jobs, Abeg in case you need my services too, pm me, Make hunger no kill your boy |
moneybag100:i pray so bro, But leave to confuse people like me, were go see your username think say u fit help us with small chop money, Change am to moneyhungry,or money no dey bag |
Oga moneybag, you suppose buy another nah,
Abi money don finish for your bag? |
kehmeh:bros, it shall be well, E be like say we dey travel for the same motor, Infact if you see me sef, na you go pray for me, i wake up everyday, go out, and do some menial jobs to survive, Play play i don learn all the labour jobs for building site from carrying blocks to mixing concrete, to mixing cement for plastering to digging foundation, Blister marks don full my hands sef, I sometimes find the pay funny, but it's enough survival money sha, I'm just working and keeping the faith, E go better for us |
mallamseifaldin:kai mallam, But i am buying hausa man suya, kilishi, onions, tomatoes etc every day, Abi North no follow for your 'resources of Nigeria belong to everybody wherever it is found theory'? |
Aunty it will be a tough decision to make, Don't let one mistake change your life forever, If you are not comfortable with having that baby, Abort it, No let Pastor wife tell you otherwise, It's your life, do what you think is best , No be say tommorrow dia, you go begin blame that pikin say, if no be say you been born am, you for be the next Ngozi okonjo Iweala, Beyonce,Genevieve etc, Don't forget the stigma that is associated with girls were be born one, To see man were go gree marry you go dey like to win lottery oh, But most importantly, think well and hard before you make a decision oh. |
Blastfinito:.my advice for you be say, If you are planning to take his clients with you when you leave his company, Watch your back oh, Make wetin do Stephen no do you, Cos the good Boss might turn to the evil rival in a matter of seconds |
ministeriallist:bros i never see the alert, resend am |
ministeriallist:see am here, 0058509716, na diamond bank oh, Disclaimer: in case the money were you send me no increase tenfold, Abeg no be my fault, Your village people juju don overpower my own |
boboLIL:bros, abeg bone dat talk abeg, The mad man networth na 4billion dollars plus, You were dey sane how much you get?, Trump was just being sarcastic |
See dis ajebutter oh, If you are broke then am Brooklyn, Me were no even get money to buy garri sef talkless of information, But i get secret for you sha, My ancestors been give me one luck juju like dat, With that juju, if you dash me any amount, you go get am back tenfold, Say u dash me 5k now, na 50k you go get, the more amount you dash me, the more your odds of becoming a millionaire increases, If you wan tap from my blessing, pm me |
I dey pity this Emir Sanusi sha,
To wear masquerade attire for 365 days no be beans |
thagift:fresh mumu, can i slap you? |
Khd95:after you collect the Likes finish, Bring am come my shop, I go buy am |
When i hear people say Naija go better, I say keep dreaming The pastor is milking his flock, The politician is stealing from the national pot, The contractor is shortchanging his workers, The businessman is cheating his customers, The strong are oppressing the weak, The employer is treating the employee as a slave, And other vices too numerous to mention, And we the future generation, our eye red pass the present generation own, If i make mistake reach where national cake dey, Dasuki own go be play, Cos, I go carry the cake all come keep for my house, |
[quote author=emamos post=42242301][/quote]oga,
Congratulations
Am happy for you,
But hunger wan kill your boy,
So share the love,
I have an account number and am not afraid to use it oh |
Godditex:bros, no be every roof rain dey touch oh, I hope say you don get this job true true oh, No be to come lie give us make we give you likes and commendations, after you climb bed sleep with empty belle oh?, If na true say you don jam luck so, make i drop my acct details make you follow bless me nah? |
Pastor be like, I retail heaven for a living, Don't question my morals, cos am just the middleman |
Bros, E red for my side pass your own, Shun the entitlement complex, Those thoughts that you deserve to have everything on a platter because you are a graduate, Banish them, Submit your Cv, around a few companies and job websites, Pray that you get lucky some day and get called up, Then look for a few building sites around you, and start carrying blocks for 2k daily pay, there is no dearth of labour jobs, You no need Ph.d to do am, na just common sense. Me sef i get place i wan go pack 200 blocks tommorrow around that una area, if you go like join me , pm me. |
Hunger is a sin, Na him make i tell myself say, If i no fit make money, i no go get pikin be dat, I no wan bring pikin come dis world make him come suffer, To survive as a poor man in this country, no be joke |
saasala:bros, i no dey joke oh, Dash me money if you wan hear the whole gist |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 79 80 81 82 83 84 85 86 87 (of 119 pages)
See the way you turn pastor, bombing him with prayers cos you want him to show you love 