Hungryboy's Posts
Nairaland Forum › Hungryboy's Profile › Hungryboy's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 78 79 80 81 82 83 84 85 86 (of 119 pages)
When will this attacks by abokki na ram stop?, |
CEtoO:aunty God is not fair oh, Me were don suffer pass Frank Edwards still dey pack blocks for building site, E be like God blessing na Baba ijebu, very few winners and millions of losers |
That one na your cross, Carry am alone |
Mologi:you were get, My account number dey my signature, an alert from you will go a long way |
This my Akwa ibom people sha, This is a very big problem that the government has to look into in that state, You go see poor man get plenty children,when things over hard with am, him go begin blame those children for him woes, use your dick according to your net worth to avoid situations like this, dem no gree, If i be governor na 50yrs jail term i go dash dat boy papa. |
. |
My oga,
Come complete this story abeg,
whether i go get solution here follow solve my own small wee wee problem, |
Cholls:oga stop that play oh, You think say na only people were dey IDPs were dia condition worse pass? You no sabi say many of us were dey internet never chop food since morning? |
.i go beg am say make him dash me small chop money, To add to that, i'll ask him if he will be able to finish the 1billion food budgeted for in his 2016 budget, If his answer is no, I'll tell him to avoid the food going to waste, He should designate me Chopper Of The Federal Republic (COFR), and send all excess government food to my table for onward chopping |
And why should we believe you without proof Alhaji?, Even giving us your banking details won't do cos you might be using proxies to hide your wealth or you have a safe room where you keep your money at home. |
All this young women were dey go marry their grandpapa mate because of money sef, I fit bet say no be the ejection pain am, Na the motor, store, land and money were dem collect from am were dey pain am so |
The guy get mind sha
Even though truth be say, all men shall die, I no go see death dey waka on him own, i go challenge am |
Na countdown to frontpage we dey so, Lalasticala no dey waste time to run this kind topics go frontpage, I no even know again whether nairaland dey compete with Linda ikeji for celeb gossip , But that one no go give me chop sha, so make i shut up |
That's your decision to make Op, Do what you think is proper, not what i or any other person thinks, Don't live your life based on the expectations of others, To add to that in case you get any money were you no wan use again, abeg borrow me, my account number dey my signature |
Mr Op, Creating a topic that you got a job from a post on nairaland, there are two things involved, it's either you are saying the truth or lying to get likes and congratulations, If you are saying the truth you are safe, but if you are lying for likes, there are two things involved, it's either you are just another troll or hungry just like me, If you are a troll, you are safe, but if hungry, there are two things involved, Its either you get garri for house or nothing dey house, if you get garri for house you are safe, but if nothing dey house there are two things involved, it's either you get where to borrow or you are on your own, if you get where to borrow you are safe, but if you are on your own there is only one thing involved, Hunger go kill you |
To add to that, in case you wan help the hungry, my account number dey my signature, Also if you need a lover, i'm single, hungry and broke, Since you are the one with the money, i'll let you be the 'man' in our relationship |
tribalwest:Madam, abeg manage that work so, Business is not all that is cut out to be, Many an employee have left their jobs and invested their savings into a business that didn't even return their capital, didn't make enough to survive on, got scammed etc, I'm not discouraging you though, you can start a little business, put someone trusted in charge, and still do your job, Another thing, never make the mistake of putting all your savings into a business venture, put in at least half of your savings or less in case of any eventuality |
omojesu202:if na so you dey always deliver 25k a day and 100k a month, you for be millionaire now na, Wetin you for need loan of 200k for, Abi, is scammer thy name? |
MadeOfBlaq:haba bros, Believe and ye shall receive, I still believe too that you will also support my ministry, Nothing is too small, |
MadeOfBlaq:bros, i don already get vision about that your garage, I saw a G wagon, Porshe Cayenne, Bently, and a Maybach, And i also saw your account balance, I no wan mention am here, make e-kidnappers no target you, Bros abeg make i follow tap into that your blessing, Na only chop money i dey find, The account number dey my signature |
Caringguy:were people dey get millions buy Lexus for this same country were i no fit chop three square meal?, Bros, abeg how una dey do am, I don pack blocks for building site since the time i dey 12yrs i never fit afford bicycle, Bros make i leave sob stories first, I hear say your name na caring guy, Abeg in case you wan share the love, my account number dey my signature, To help hungry boy na blessing, Before the end of this year, Lexus too toy na Range Rover you go dey drive |
Hmmm...
I no fit talk |
We know this game, It's called Operation mockingbird 2.0, Use the western press to tarnish Putin and Russia's image, Bring whatever little vice that is going on in Russia to your frontpages, The next step could have been Opposition Protests, an Invasion and regime change, but that game won't work with a nuclear armed and alert Russia, It worked in Libya, It worked in Iraq, It almost worked in Syria if not for Putin, And that's the reason for all this bad press. |
Almost 38million for just concrete and block works for one building?, Money were don build two story building sef finish put furniture inside, Abi na national stadium dem wan build? All dis one were dem dey do, In case dem wan follow share the money like Dasuki, my account number is always available oh |
sunshine1974:oga no be joke i dey, Na hunger bring me come here so, In case you wan put something for my begging bowel, check my signature, But even if you no put, God go still give you wetin you dey find |
If there is one thing i have realised, It's that, you have be a dictator if you really want to change things, Though i may sip garri to sleep for now, But i still believe that it's too early to start blaming it on Buhari, I'll only start criticising him, After am still sipping this same garri in 2yrs time |
sunshine1974:oga, Send me small chop money, in case i see fine AA Girls i go collect their contacts send give you |
All this our universities sef dey funny me, So the need more funds to build a prototype of a refinery that can refine just one barrel of crude oil, a day, While my guy Egberipapa were be illiterate, dey refine like 100 barrels of crude oil a day for creek, without government funding, The only thing government dey give am na pipeline to break siphon the crude oil |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 78 79 80 81 82 83 84 85 86 (of 119 pages)
Madam hawfa?