Lawyer's Posts
Nairaland Forum › Lawyer's Profile › Lawyer's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 42 43 44 45 46 47 48 49 50 (of 51 pages)
@oby No worry about my number. Shebi if them wan use my number do yahoo yahoo na me go benefit pass now. No b me the maga go call? E no disturb me. I sabi handle them. When i de serve b4 for ibadan na prosecutor work i de do, so i sabi handle all this kin ppl. No b today. |
@uzzyan Na the same dt and kj wey u sabi. you sef b bad person like me for you to know those places. Thank God we be 2. Shame don de catch me b4! and yes we are spending the midnight mass in st.mary's isolo. The whole bunch on nairaland except pampere i guess@carlosein How u know say dt don run down? Na wah o! u sef don be bad boy before, lol N aonly regular customers na im de know how booze joint sales de do! |
hey pilgrim don call me hin darling finally! God i thank u o! At least i fit marry person wey get visa finally as embassy don show me pepper tire, lolPilgrim ur alright. Just pipe down next year, we all learn everyday and dont make religious learnings be like your engineering maths exams. So na because say the exam hard well well na im u come de vex with us for catholic thread pilgrim? Me think say na C.R.K you de teach for primary school o for u.k! U go sabi book well well o! ![]() |
carlosein na only spanking u wan spank pilgrim? I for like throw banger for im mouth tonight! That girl wahala me tire this 2007 i no go lie. She b one woman keyboard terrorist ![]() @viee , as carlosein yan, i go comot the number na true talk e talk but plz no forget text me, no b call with ur number so i go know waz up! Chei i know even know wetin i go wear again. E bi like say obioma go chop all my money finish today o! Na so so hole i just de see for my trouser and shirt and na night e de take style shine! O boy i de go apo-she! Nothing de happen! Oby u don de sleep, join us for yans now? |
ok, na rich toast e go be. I no too sure say i fit real there quick before the mass start make i see sit siddon for inside church o because its always too freaking crowded and i actually enjoy it from outside sometimes. I have attended almost 10 new year midnight masses there so i know the territory well well. But carlosein and viee try send the text or better still like oby, post it online, I'll call u guys. I already have hers and e b like say na after the mass we go meet, because as i de so, new year don start for me and the booze if delay me small. ![]() So plz post the numbers asap! |
Nice one oby, i don get ur number, at least i no go lost like zombie when i reach there. And if carlosein and viee no send their number quick before nepa take light again for here, na u i go call o oby. And na them go miss the chicken wey i for like buy for everybodi for D.T ( delicious treat) na one joint and booze joint wey de near st. mary's. That time wey i never fall in love with pilgrim, na my second house be that. ![]() AHH Today today, tomorrow no more, today to day. Pilgrim wey u de now and how u go miss this kin reunion. Abi express okada no de u.k ni wey u fit take join us? |
see this my run away wife pilgrim. Na only when i talk say other girls de trip for me na im u come show out of the blues. You wicked o! you No de even give me breathing space. At least i don wash all ur cloth finish now and i don baff the dog, wetin i go do again to let other girls follow me play? If na like so u wan do this new year, i no go marry u again o! Na end of PILAW be that o! ![]() Meanwhile how u de! Its a shame we cant meet too, am sure we would have loved to see the chick that haunted us thru out 2007 on naira, any how sha, have a happy new year in advance and abeg pipe down next year. Your bodi too hot sef, when no b super V de ur bodi! ![]() |
@oby, carolsein and viee How una dey! I dont know why am having the jeepers to meet u guys. I have never done this b4, meet someone on line in real life. Guess am too chicken for that, lol. Anyways saint mary it is and am already in isolo hanging out in my cousin's place so that we can come together this evening. It will b great to meet u guys. P:s how i go take know una sef? abeg this one de give me jamb question o! How una take jam viee and carlosein? Abeg try give me the signal or pass word before i go hug banger boy come think say na una. I no wan start new year with terrorist o! If the information is too confidential, why dont u guys send me a text msg on this number tonight 08077943514 so i'll know when to call u guys or probably meet una. No ask why i say only text msg o! My phone don de kolo since yesterday and e de hard recieve call. Maybe d thing de use me do shakara till new year morning and no want make all those fine sisi de call me this year again. Foolish fone! ![]() Anyways abeg try make me know asp. It will be a great way to end the year with my real friends of 2007 who stood by me through thick and thin despite the distance! Ok too much yans. Make i go iron my shirt and give shoe maker my shoe make e patch am quick quick because from wetin i de see, that oby girl go sabi laugh person well well ![]() |
viee and carlosein, hope say na still saint mary's una go do newyear midnight mass? B'cos i don de pack all my load come play with una for isolo tomorrow night o! Una use style commot me from the chop chop for christmas day, this time, i don purge myself to chop xmas and midnight new year mass chicken together. Make una prepare well well o! Meanwhile shey those kolo boys go still use banger threaten person tommorrow for st. mary's. Me i de fear o! Happy new years day in advance to all catholics world wide especially those in Nairaland and thanks for coming in to my life this year to help me uplift my spiritual life which has been hereto being in a redundant state for many years. One luv ppl! ![]() |
but Eduardo got a red.Sho! which eduardo get red? Abi the time the world de watch arsenal v everton, you de watch vasco de gamma v fluminese for brazil? Our eduardo for arsenal no get red o! but the eduardo wey them de call "the animal" for brazil na im de get red card left right and center and probably don even retire from football sef! Abi na through camera phone you watch your own match? To anyone who cares to listen,ARSERMAL won today luckily, Wenger do complian most time that team played HARD on his team,remember what he(Wenger) said againt SEVILLA Champion League, anyway,YOBO and Host of other uncharacterized EVERTON defenders sold out the match to you,because your OVER-RATED Fabregas and Hleb were no where to be found in both 1st and 2nd Half,, Fabregas needed to be careful as good players doesnt get card at every match ,he gets frustrated easily plus anytime he doesnt play so well,He turns out to be a nuisance Hitting opponents frm behind and hard tackles.God all this grammatical blunders that i can't even understand. Bros abeg next time you wan write epistle, try another language because this one u don write no fit guarantee you say you go pass your English WAEC exam again next year o! P:S: I have just found the best international arsenal fans worldwide forum for arsenal fans only. Check it out www.arsenalmania.com |
Typical mautd: Started the season with a loss and ended the year with a shameful loss. Typical Arsenal: Started the season with a win and ended the year with a bang. Imagine manutd topped the table for only 3 days and the whole world no hear word. 3 days later all of them are hiding in a cave. That's why they say spare the rod and spoil the child. We allow them taste the table topping chart just for 3 days and they thought it was their property. What belongs to caesar belongs to caesar 4 life. On new years day, we would teach manutd how to effectively beat west ham since the only way manutd knows how to win is by scoring doubtful penalties left right and centre Even the penalty sef them no still fit sabi score am!Thank you Eduardo for making 2007 a fantastic year to remember for gunners world wide ![]() Happy new year in advance gunners and may we have a fruitful goal banging and trophy laden season for years to come! |
@stillwater Sorry i dont understand your post. Are you denouncing catholics are trying to shed more light on the positives of catholicism? Please do tell cause we are curious. And if your denouncing catholicism, please postphone it till mid next year because we are all in a positive mood and frankly we have hard enough of the bashings for this year. Abeg let peace reign for once. Whether catholic, muslim, mormons, scientologists, guru maharji whatever, we are all entitled to our freedom of choice of worship and religion. Let sleeping dogs lie and compliments of the season by the way ![]() |
Una funny o! Una wan use laugh kill me, LAWPIL year! ROLF. Na true, love de shak me well well for pilgrim deary You think say e easy to learn the word mariolatory? I tell my father for church one day say why we de follow mariolatory, the man just de look me like say the igbo i smoke don de make me misyan rubbish. He say make i come again and i tell am about sola scriptura, mariolatory and all the bloviates catholicsm de teach us. the man just touch my fore head come de shake head and ask whether i don take my anti-tetanus injection, because e no know where i de get all these opata yans from. E remain small i wan print am from internet show am wetin my babe talk but me sef think am say na lack of the injection na im de do me, na im i fashi that side. I hope pilgrim go teach us new one this new year because i never laugh reach for my laugh until i meet this chick for net. To say she be aluwe no be small thing and i hope we hear more "bloviates, caterwauls and sacrificial ewes next year all in the name of the word of God" ![]() Meanwhile oby, were st.charles de? make we know because all these jedi jedi wey u de promise us de make me wan chop awoof and new year awoof no de run belle o! @viee You ask wey our wife de? She don go work go learn more about st. mariolatory and i de house de wash hin cloth. If she flash me, i go hala you. Make i go back to de wash hin cloth o! because if she catch me de play for internet with catholics, i fit enter yawa o! ![]() Much luv people, keep it coming, am enjoying today, it's a great day to smile and clown around all in the spirit of new year |
people how bodi! How i go talk am merry happy day after boxing day O boy shey harmattan de hammer una d way e de do me so. If my cream no de my side, my bodi for don turn into dirty oyinbo since last week. To laugh na problem before lips turn to tribal marks.Anyways sha, i go show st. mary's 31st and that gyration wen una do carlosein and viee, una go play part 2 o for me! As per my babe pilgrim, una don forget say these new generation chics no de read missal and them own show say man must submit to woman. I like am like that. At least, i fit de wash hin cloth and she go de give me money and the teach me english. Tit for tat. I fit be hin house husband and de help am download links for internet about catholic before she comeback from work and she go de rub my head like puppy say i don try and she go bring gala for me from work. Shey that one no good ni? @pilgrim To my future babe, no vex say i tell the world about our rove, sorry love, i too happy meet you for nairaland and i de dream of you everyday even though i never see your picture before. Na only for dream i de see you and wetin i de see for dream i no fit talk am. Shebi na u.k you de? Ukot ekpene no far from lagos, i fit take okada now reach your house by 31st so we fit still run things before newyear. In fact e de sweet me sing our marriage song for you " my ladi, my suga, my honi, my lova, let me hold you, 4eva, onyo!" abeg help me complete am! Wetin you go like for newyear? egg roll? catholics like egg roll well well. We no get money buy mr biggs but if you chop am, you no go look sweet sensation again for your life and you fit start to de come catholic church from newyear asp ![]() @oby How you de sha! Una de use st. charles make me jealous. Na inside my sitting room na im i watch all the carol we de this world finish. No worry 2008 go better for you and everybody! |
Haaaaaaaaaaaa, these are the most pathetic resolutions i have ever heard. Hope you guys record and print what you have just hoped to accomplish next year so that i will be easier for you to repeat the same old bullocks on the 31st of december 2008, lol. News flash : None of it aint gonna happen, so live with it and get on with your life instead of playing weather forcast man or woman with destiny ![]() |
Rubbish! There is no such thing as a new year resolution. We all hypocritically stand in front of God on new year's day in churches and mosques and deliever our own versions of the new year budget as resolutions which by mid februray we have already forgotten we made such stupid promises to keep. How many of us for donkey years past have made up our minds to stop smoking, fornicating, back bitting, cheat, reconcile with our families, stop drinking, hope to do very well in school, help to improve lives and probably find another fool proof strategy to woo more business clients and increase our potentials psychologially, spiritually, financially and mentally and end up repeating the same old mantra next year as if we didnt say it in 1989, 1996, 2001 and more memorably in 2007. Why is only on the 31st of december we remember when to say those silly resolutions. The women would scream to God and within " oh i want to have that child at last or have another baby boy or give me a better boyfriend or make my marriage work or relationship" and the boys will scream out loud " Oh God let my business boom, let my car finally show this year, let my money show, let the society know i have arrived and a host of a million twaddles and rubbish they hope and wish to accomplish" Well i have got news for all the dreamers and optimists. The cloud is not turning to pink on the 31st of december and the moon will not change to the sun on the first of january. Your nauseating boyfriend will still be around you, your cheating girlfriend will still arouse more boys attention, your sniveling mother inlaw will still harrass you, your pesky granny will not die and still hound you, your shares in the banks will still appreciate and depreciate, danfo and okada riders will still be a menace to the society, nepa will continue to haunt us, the roads will still be death traps, you wont stop smoking until the doctor waves a red flag about your lungs, you wont stop drinking until you pass out in a gutter, you wont stop cheating until your caught red handed and disgraced, you wont make more money until you draw up a business plan that is feasible and realistic and you wont stop going to miracle crusades because you have a fetish for going to such places to pray for get rich quick schemes and inshort, its another day in the life of an ordinary nigerian. So get over it and live your life the way you were living on october 14 and not thinking the sky will fall on october 15. It's just another day. I can remember how i was under the cloud of those that paid much importance to this new year resolution garbage about 20 years ago and i kept on saying i would change and i would do this and that. Each passing year was worse off than the latter and until i realised that it wasnt necessary, things began to happen. Always expect the unexpected and most of the time it favours you when you dont place much importance to it. People would come out here and say you should have the will power, discipline and determination and spiritual help to make your resolutions come true but its all a load of crap. How do you determine within yourself to stop boozing, smoking and fornicating in 365 days and not falther and go back to your old crazy ways that you feel comfortable in? What will power makes you stop cheating, back stabbing, lying and trampling on other people's back to snatch every financial opportunity that comes your way? If your the owner of a petrol station and there is fuel scarcity, what will power prevents you from hiking the prices to make more money? But you will be the first to tell God and yourself on the 31st of dec, no more cheating and stealing! How laughable nigerians can be atimes If your a student tell me you wont attempt to settle any of your exams this semester or year or try and sleep with the favoured lecturer to gain that all desired 2:1 or 2:2 so as to be eligible to work in zenith?Abeg so my new year resolution is to break up with more girls, booze and smoke more, rip more people off financially, climb the backs of other people till i get to the top, take no prisoners and trample on anyone that gets into my way of success, scheme and connive more and finally date the love of my life pilgrim 1 because it just another normal day in my life and in the lives of millions of Nigerians and it's pathetic for you to remotely deny it. Life is too short so play more! ![]() |
@pilgrim You this girl! E don show say you wan marry me. I don leave you de go my own jeje and you still de follow me. For your information i no get money and i no hear english reach you, i neva enter aeroplane b4 and worst still, i be catholic. How we go come do am now? ![]() |
@jackal even if 99% insult you, cant u spare a though for the one % that hasnt insulted you before b4 you insult everyone. At least i havent insulted you b4 so why lump me into your insults with a blanket insult? Take for example I-MAN, i have never replied him before or spoken to him but can you see what he wrote. At least he had more meaniful ways to counter attack my argument which wasnt directed at anyone else in particular. If people begin to insult him, you might come to his defence and say arsenal fans have been insulting him for ages when he actually sets the ball rolling for such hatred. As for my posts, it was aimed at that crappy Arrow adebayor, sorry for the ranting but i had to let it out. I wish he was playing for another team not my amazing gunners. |
@jackal You dont have to insult every arsenal fan that hasnt insulted you before. The phrase " f**K arsenal fans worldwide" is not necessary and uncouth. We may have our footballing differences based on the various teams we support and whenever we win it gives us the bragging rights for the moment but it doesnt mean you should insult us all especially when we have done nothing to you. Anyway my opinions about today. To be frank, i am happy manutd is finally a point above arsenal and that will ease the pressure off arsenal for a while. Trying to sustain that leadership toga has costs us in some games and it will be good to play catch up for a while before hopefully regaining it when it matters the most. It's always difficult to maintain that momentum when you are on top especially when the gap is ridiculously slim. Anything can happen. You could lose a game, draw or lose your best players and it all comes tumbling down. Now that manutd is on top, the onus is for them to retain that leadership spot for the next 19 games and i honestly think it's going to be a topsy turvey newyear between manutd and arsenal each vying for top place and it will boil down to the team that has the character to finally strech that lead to probably 5 points by mid feburary before the real bragging rights start. Manutd should enjoy the moment but it's a bitter sweet moment from what i can see. Tough matches await you and a draw or loss could spell doom for either side. So let's just see how it plays out. As per the game, i have to confess that i didnt see anything wrong in the pattern of play and they tried their best to win. Honestly the person who cost arsenal that 3 vital points is that lump of wood adebayor and i cant fanthom why he is an arsenal player. He is so inconsistent and irrational in his plays. He finds it difficult to beat a man and just perform one moment of magic. I find it extremely insulting when he compared himself to half of both kanu and drogba because those 2 neither have the twit of intelligence that he posseses. Apart from inzaghi, i cant remember a player who plays himself offside so may times in a game unintelligently hereby frustrating the works of other players but at least inzaghi delievers most of the time compared to that tart adebayor. The clarion cry of his supporters that he is a hard worker holds no water to me because a hard worker that gets no end product is a dumb slave. His so called 10 goals in 19 games is laughable because he has played almost all the premiership games for 90 minutes plus and despite him playing for a team that isnt so selfish and would do anything to supply that glorious ball for him, makes me wonder how such a tart can be so stupidly lackadastical in front of goal. Take for example tonight. An old hag like sol campbell kept him quiet for 90 minutes Anyway, it's not his fault. I blame it on van persie who is made of glass because i cant fanthom how a van persie would play in that position for 19 games and wont be scoring at least 15 goals by now including some magical goals to talk about for weeks. Rvp plays only 9 games for arsenal, 4 games for 90 minutes and 5 games as a sub and scores 7 goals. He scored 12 goals last season and missed a vital 3 months away because of injury and still yet adebayor who played almost the whole season couldnt catch up with an absent van persie. It just so sad and i predict another disasterous outing for arsenal against everton on saturday if this twit is allowed to play 90 minutes without bendtner or rvp beside him to carry him along. Boy it's going to be a long newyear with this twit as an albatross on gunners neck. I cant even remotely imagine anyone tagging adebayor as their favourite player even for a local under ojuelegba bridge football competiton. P:s Rosicky was amazing tonight and from the arsenal point of view was definately the man of the match ![]() |
@carlosein Thanks my guy! hopefully all will be well and i feel envious that i couldnt join the gang but i'll try my possible best to hook up with you guys and maybe it's the inspiration i need for the forth coming year. Happy boxing day to y'all by the way. |
@carlosein and viee Sorry i couldnt be there. Had a terrible and horrid week and a very uninventful christmas, that's why i havent been on nairaland for a while. Hopefully we see during the new year vigil mass. Once again sorry. Hope you enjoyed yours though! |
Finally, my prayers have been answered. I have been praying for this fixture for a very long time and now my UEFA has granted my wishes. ARSENAL V A.C MILAN. A very tasty matchup and i can confidently say arsenal are gonna destroy the so called legendary Milan. 4 weeks ago ancellotti made a comment about arsenal not quite being capable of doing well in the champions league and predicts they wont go far. Unfortunately for him, little did he know that arsenal were going to be paired with milan this early so i guess he is already quaking in his boots. My young guns are going to outrun these old cargos and despite the brillance of kaka and seedorf, i dont see them being able to withstand the fast pace of arsenal. These kids are going to run them rag-tag and i dont think milan has ever played a team that will make them chase the ball forever. Arsenal are not man utd and will not be scared of them. On the contrary, arsenal plays better when the opposition is bigger and they love to demistyify that myth of being "unbeatable". We did it aginst inter milan, Juve and real madrid and it's time for milan to graciously bow out to a more superior fire power. These kids have nothing to lose if milan beats them and milan has everything to lose if arsenal thumps them, so the ball is in arsenals favour. As long as the super 5 plays namely hleb, cesc, gallas, falmini and Rvp, i am more than confident that arsenal will tear milan apart. Milan's present form is an indication of how age is taking it's toll on milan and definately, youth will prevail at this rate. Nobody loves to chase rats around the house and that's what milan will do all night when they meet. God helps them theo walcott wont be fit that day, it would be double whammy for gattuso and maldini ![]() |
Just for the record, am posting relevant sections of the companies and allied matters ( CAMA) act to nullify iyabo's claims Section 292 (1) cama: " Every company shall keep at it's registered office, register of its directors and secretaries Section 292 (2) cama : " The register shall contain the following particulars with respect to each director, that is to say HIS PRESENT FORENAME AND SURNAME, ANY FORMER FORENAME AND SURNAME, his usual residential address, his nationality, his business occupation, if any, particulars of any other directorship held by him and the DATE OF BIRTH Now if iyabo used an alias name to register the company and act as a director of the company, is it not in violation of section 292 (2) cama? Because obvious the name is fake, address is fake and date of birth is fake. So therefore, she is not a director of that company because she has contravened this section. Section 82 cama : If anyperson falsely and decietfully impersonates any member of the company and thereby obtains or endeavours to obtain any benefit due to such member, he shall be guilty of an offence and liable on conviction to imprisonment for a term not more than 7 years or a fine. If iyabo has registered the company under another name which is fake and not existing and she is actually obtaining or endeavouring to obtain a benefit from the company which she isnt a member, isnt she in violation of section 82? Bottom line, she is not a director of the company and if she is not, it remains only 1 person since she said the company was formed by only 2 of them and a company can only be formed by a minimum of 2 directors. So therefore, the company doesnt even exist under the law |
Carlosein, Pamperme, Laywer, Ebos may God not allow us take our money buy stubborn ram wey go dey fight usMy gift 2 you viee na that stubborn ram emeka 09. Na fresh one so handle with care! ![]() |
@ emeka 09 J.J.C to naira land. Welcome o! Your first post in nairaland is to misyan about catholicism. If you like, join the bandwagon of anti-catholics and be prepared to recieve the same silent treatment your "seniors" in the struggle have been given. If you change your mind, accept a heartly welcome to nairaland ![]() |
@jackal Your criticisms of eduardo is totally unfair. This is a guy that's just trying to adapt to the pace and style of arsenal and your saying he's crap because he hasnt scored a single premiership goal. This is a guy that contributed immensely to England's downfall in the euro 2008 qualifiers. He has scored approximately 5 goals in the carling cup competition and has 2 goals to his credit in the champions league. Despite his limited appearances and wrong positional play on the left mostly in the premiership games he has either started or come in as a sub, he has put in all his efforts to become a team player and adapt to the style of the game and so far so good he has been doing his best. Even arsene wenger agreed that it takes a new player at least 6 months to adapt to the style of arsenal's pattern and the best way to lift his spirits and learn to adapt is throught these lesser competitions such as the F.A cup and carling cup. We all know he's a sharp shooter and fox in the box when given the opportunity and a player that has signed for 4 years only means he'll get better. Even the great henry did not score his first goal for arsenal until after 8 games despite him playing all 90 minutes of same. Same thing for Rvp and it took a while for adebayor to adapt to the fast english pace. Werent manu fans worried about tevez lack of goal scoring opportunites until he scored his first goal against chelsea and you ended up killing malu to celebrate it? Arsenal is now a team and it's not how long but how well and Eduardo fits perfectly to that adage . P.S: Eduardo wasnt bought to replace henry but to add to the attacking options because the pattern has changed. You talk of players lightening up the premiership such as torres and tevez. We all know about the prowress of torres before he came to liverpool that's why he was the hottest bride of all clubs who desperately wanted his services. You can't compare torres and eduardo now because they play 2 different styles and are from 2 different cultures of football. The tevez your talking about wasnt exactly raining the balls of fire when he was with west ham and the anderson your talking about shouldnt even be mentioned. We all saw how RVP and Fabregas missed from 2 yards against Petr Cech.but we all saw how he scored from 3 yards against cech although it was disqualified due to rosicky's offside so he still scored and he has 5 premiership goals goals in 7 matches out of a possible 14 as a supporting striker so whose really having a laugh ![]() |
@cgift God don catch you today. Your hatred for catholics knows no bound. Ivee wrote a scathering remark about Benny Hill. Immediately you termed her and accused her of being catholic and only catholics can write such things. To refreshen your memory, i'll post your exact statement: I know you are a catholic and would not understand most of these thingsAlso in case you missed what ivee said, i''ll follow it up for you: I am not a catholic and I do speak in tongues. I am penticostal and also an intercessorShey your mind don come down now? And anytime people complain that your an anti catholic basher, you'll be the first to throw tantrums and accusations against catholics. Instead of giving your own objective comment to the above post, your insinuating catholicism into it for no just cause. Anyway may God give all of us the eyes and ears to see and hear his word and help us differentiate whose real and whose not! |
The Blue Devil's in the building, Run for cover https://static.arsenal-mania.com/forum/images/avatars/9238390454764249806bce.jpg My thoughts on that self-servicer ASSley cole or should i say Ca$hley cole ![]() https://newsimg.bbc.co.uk/media/images/42336000/jpg/_42336759_ab.jpg For the love of money from the bank of Russia and signed by the central bank Governor of Russia Peter Kenyon 20 pounds cheap skate. He's the ugliest queen i have ever seen! https://newsimg.bbc.co.uk/media/images/42336000/jpg/_42336767_ab2.jpg Who said arsenal can't pay cashley's rent. All he would have done was ask and we would have sprayed him with all the pounds he wanted ![]() https://img.dailymail.co.uk/i/pix/2007/12_03/ColeFabragasL_468x468.jpg Talk about a fabulous cesc Kicking Ass- ley Cole's Ass This picture is priceless ![]() [img]http://bp2.blogger.com/_fzb2E6Wnm_k/RcJ2GFI20WI/AAAAAAAAAFs/NvrX5Fil0YY/s320/0,,2007050736[/img] The moral of the story here is cash goes before a Fall ![]() |
@cgift I know you are a catholic and would not understand most of these things. But never condemn what you don't understand in its entirety because you might find yourself in the same thing later in life by then which you would have had fuller understandingThis statement is really funny. You have been taking pot shots at catholics since time immemorial and all of a sudden, someone exposes the hypocricy of a pastor that isnt catholic and you just make few comments about it. Am sure if it was about catholicism, you could have re-written the whole library of congress to show how terrible catholicism is. You write boldly to defend benny hinn never condemn what you don't understand in its entirety because you might find yourself in the same thing later in life by then which you would have had fuller understandingWhat does it mean? A vague show of support of that charlatan? All of a sudden "we shouldnt condemn him because we dont understand its entirety? But you understand the vatican beyond the sphere of life! But i guess it's alright with you as long as it's not the vatican or pope or mary we are talking about here. You guys know how to blow hot when the ball is not in your corner but any veiled reference to your kind or any slight or mundane criticism of anything pentecoastal, you try to shield and dodge the question by claiming that they are fake pastors amongst us, but when it's catholicism, oh o! You can rave and rant all year long about it. What is good for the goose is also good for the gander. If you can write an epistle condemning one doctrine, it shouldnt be hard for you to snipe out one man unless it simply goes to show how biased and partial you are in picking on other people and their doctrines . Am not going to behave like you by posting links to his dubiousness or professing how pretensious he is by writing a forum on it for donkey years to come and boring everyone's head off but i just wanted you to know that your extremely biased in the way you analyse things as long as it's not pentecosatal in nature, you happy to sit on the fence! |
Jeez, the jinx is finally over! 3 years of ramblings from chelsea fans that arsenal hasnt beaten them in a while and finally, the best goal keeper in the world ends up making the costliest mistake to allow a disgruntled former chelsea player nick in that all important goal. To be frank, despite the mistake from cech, this match has made me regard him as truely the best in the world. The saves he made were just out of this world and more especially the double save from Rvp and fabregas in the spate of 3 seconds is something to appreciate even though am no chelsea fan . Also chelsea fans have to agree that sheva is almost a finished product. Apart from that free kick, he was virtually useless and was in toure's pocket all night. It's a pathetic end to a once glorious career. Meanwhile good to see Mikel finally take a shot at goal. He really suprised me that he packs a canon in his boots and that shot really scared me. For Nigeria, that's a positive sign but this chap is ridiculously rough and jocular in his defending and was lucky not to be sent off. I was totally suprised at lampard's invincibility in the whole match. He looked out of place and neither contributed to chelsea's attack. I swear i thought he was going to take that last minute freekick and i was already sweating because he has a knack of scoring those freekicks either through a silly deflection or low drive but once again thanks to old man Shevy, we were spared the impending threat. Joe cole also did not make those rivetting runs, dribbles and passes that makes him chelsea's most dangerous player behind Drogba. Sagna uncharacteristicly subdued him and i was shocked because i know he offers the greatest threat when he's on point. But thank God he wasnt tuned in. Finally Swp really impressed me because he was chelsea's liveliest player and was the most probable player to score and that sitter he missed will probably hunt him for a very long time. Well sorry chelsea, we all have our good days and bad but today chelsea was horrible and they ought to have lost this game by 3 clear goals. P:s How come anytime john terry plays arsenal, an arsenal player must put a foot up his arse and send him out of action for at least 2 weeks? ![]() [b]Almunia 9: Absolutely amazing today and shut up a lot of his critics. Between him and cech i can't readily pick out the man of the match. Top notch performance Sagna 8 : Pocketted the 2 coles tonight and defended well. Only snag was that his passings were a little off and ended up providing some scary moments in the arsenal defence Toure 7: At least he has shrug off last week's pathetic display and looked fresher and defended well but was still out of place atimes and still made those unecessary long balls. Needs to improve on those frekicks. They are becoming more laughable these days. Gallas 8 : Captain Fantastic and finally closed the chapter on the chelsea transfer sagna by shutting up the chelsea board and scoring that decisive goal that he promised to score against chelsea whenever they meet ![]() Gallas 1 ashley cole 0 ![]() Clichy 8: Am extremely suprised at clichy's defending today. He took Swp to the cleaners by not even giving him a whimper of hope to actually dribble him except using the crossing route. Maybe the prescence of Ashely cole gave him the reason to play extra better and it worked. Eboue 6: Was threatening in the first half and became less effective in the second half. Naturally he should get a 5 for his display but gets an extra point for the classic foul on terry. ![]() Hleb & Fabregas 6: match rusty and fear of going back under the surgeons knife made them play cautiously but their prescence nevertheless scared the shit out of chelsea who were praying for the duo to miss the match. Great to have them both back and i know next week will see the best of them again. Also loved cesc taking a shot at ashely cole at the end ![]() Flamini : 8 tireless worker. Did a lot to help snuff out the misplaced passes of cesc and defended more deeply to help out the back 4. A stellar performance from him tonight. Rosicky 7: A major improvement from lack week's disasterous outing and was involved in the tick of things and was easily our best midfielder tonight. Also helped out clichy alot to neutralize Swp and should have gotten an assist to his credit for Rvp's goal if not for the offside. Thumbs up Adebayor 6 : Really wasnt that into the game especially when he was playing as a lone striker. Although he nodded the ball down better today for his other team mates to pick up the pieces and didnt get offside as much as he is known for and i thought he had a very very good goal disallowed. But still raw and unpredictable which can be extremely frustrating. Rvp 8: Immediate impact and showed he meant business. He sparked up our attack when it seemed to be dying down and devoid of ideas and had agoal disallowed. We all saw his desire to score and he did well. Great to have him back. Looks hungrier than ever Bendtner 7: Spent 3 minutes and gave the pass of a life time to cesc to score which the latter failed to put away. This boy has a great future with arsenal and Adebayor has to watch out Gilberto 5: These are worrying times for gilberto and something fast has to happen. He's getting slower and making silly tackles around dangerous places. His passings are off and it's really sad. He really needs our prayers to do better this winter season because in the absence of toure, he might cover for toure and if he brings this kind of form to the defence, we might lose some very vital matches before toure comes back from the ACN. Wenger 10 : For playing mind games with the press and chelsea fans about the availability of flamini, hleb and cesc which invariably disrupted their preparations on how to paly arsenal and who was going to play and who wasnt. As for that Cunt cA$hely cole, i hope he enjoyed the welcome party arsenal fans waited for 2 years to throw for him [/b] P.S Manchester United fans should feel really worried that this season, they have just topped the tables briefly for only 2 hours in 2 occassions, lol guess this makes them practically 2nd best ![]() |
Funny enough, i just stumbled unto this thread today and laughed my head off. I was right pilgrim. You don't know how to make a single sentence without resorting to insults. It's the same old tired and overused argument, catholicism is this, pope is that, mary is blah blah blah and i was almost sleeping off on my chair because i know i have read this lines over a million times so there was nothing new there g to do with religion. It's just you. This is how you operate 1. You read something you don't like 2. If offends your sensibilities and you draw up your insult plan 3. You attack the person, his intelligence and his beliefs 4. You walk away. Job done! 5. Wait for the next poster who doesnt concur with you In fact i'll bring each one to out so as to make you understand how insultive you have been of recent: I really do not have to repeat myself - as most of your usual[b] bloviates [/b] have been answered already in my response to lawyer Please tell me: did you come out of a beer parlour before constructing your statements? I'm just curious. And as to your confused statements above: do you realize how clownish you get sometimes when you allow inordinate passion becloud your sense of judgement? I'm really sorry for you guys. . . low thinking has done your wits in! Self-confessed idolaters have always been "proud" of two things: "Brutal" is not the word - I am merciless against DECEPTION!! Rubbish! Butterflies do not "jump", and not at any time have I pretended a position of know-it-all! Your caterwauls here are simply an indication of your fears - Catholics are known to turn the WORD of God into something other than what God revealed - and that is why I have refused many times to be detracted into making this a denominational issue! If you have anything to contribute, open your Bible and let's see where Catholics stand - that has been my simple message! Many thanks for your blind observation - that is how legal practitioners mislead many people into their doom! But this caterwauls do not score average on the IQ scale.Those quoted words, summarizes who you are pilgrim. You should give your self a pat on the back as the queen of spewing ascerbic words all in the name of defending God's word. They were written with your own hands and i can safely say that this is the gospel of Pilgrim's "Word of God" and as bad as you potray catholics and muslims alike everyday 24/7, from what i can read, i don't think you offer a veritable alternative for us to choose your "Word of God". No person who prophecises to be attached to the word of God can be this venominous in their choice of words all in the name of God. If this is what your word of God preaches, then it is just as bad as everyother one that you have so brutally condemned. Even if someone hurt you with a foul statement, must you go the whole hog to reply an epistle with words that offend the holy spirit by justifying your beliefs? I said it before that this shows how the real you would be in person. Quick to anger and slow to forgiveness. It's just a total reversal of what the Lord really is. Anyway i dont really have to take you seriously anymore since everytime you convert, your only sign of remorse is to " regret your actions and admit your stubborness and quickly jump the bandwagon to another religion and continue from where you stopped. I can't wait for the day you would turn your back on your "word of God" philosophy and rip to shreds the bible or more specifically your bible. It's your gift and talent and your extremely good at it and as you rightly put it Good for you, if that's the reason for your existence.P:S: If your going to reply and furnish us with more insults and accusations that we readily expect from you, abeg try and change the use of the words bloviates and caterwauls. I believe those words are way past their expiry date in terms of their usage by you. |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 42 43 44 45 46 47 48 49 50 (of 51 pages)
and yes we are spending the midnight mass in st.mary's isolo. The whole bunch on nairaland except pampere i guess
