Nduchucks's Posts
Nairaland Forum › Nduchucks's Profile › Nduchucks's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 300 301 302 303 304 305 306 307 308 (of 315 pages)
e be like say our biafrans don start to complain instead of being grateful, again. federal government don award contract to upgrade enugu airport, but dat one no do them. dem want make dem license de airport as international airport. nevermind whether e make economic sense or not! even for overseas, like usa where most of the biafrans wey dey complain dey reside, big states like oklahoma and new mexico no get international airports. if you wan travel to china from usa, for example, na from only a handful of states wey you fit get direct flight; most of the flights go first carry you go a hub airport, wey be de real international airports, before you begin go china. de 4 international airports wey dey nigeria are gravely underutilized sef. even if we build 8 more international airports, which airlines go patronize dem? na real disgrace however, for someone going to enugu from london to fly into lagos and then have to travel to enugu by road. na dis disgrace of a problem wey de current federal project go solve. but intead of our biafran internet warriors to show appreciation, na ungratefulness dem dey show. one dede1, while complaining, even call enugu, nigeria, cesspit, out of anger. make una think rationally for once. |
Pro Anti:by your logic, proanti = eziachi; beaf=sapeleguy; kosovo=richyblack; yar'adua = goodluck ebele jonathan. abeg make i borrow beaf emoticon: www.nairaland.com/attachments/180447_ROTFLMAO_gif3d0c775232c7f27cf80592785b9635b6 |
Beaf:beaf beaf, you can't eat your cake and have it at the same time. which is it? you believe goodluck when him say nobody dey pressure am to resign or you tink say goodluck lie (using your words to calm the heated polity)? no be trick question, which do you believe? you no fit put de word "persuade" for quotation, come tell us say dat give you the OK to take position on one hand and then take another position on de other. small time you go need 5 hands and a leg to take all de posible positions. |
Beaf:e be like say, una no understand how senate dey work for naija at all. de real hero here na ndoma-egba. de motion wey ndoma-egba tried to pass for force de senate to debate de health of de president - with far reaching implications. david mark quickly maneuvered to quench de motion since dat kind debate go almost eliminate david mark's secret wish to take over from yar'adua. |
Beaf:goodluck announce to de whole world say nobody dey pressure am to resign. na him be say, de news of de alledged persuasion dey false. why people like you distrust goodluck enough to believe say goodluck dey lie about dis issue. if you believe goodluck, make you ignore my comment, but if you no believe goodluck, why you tink say de man tell that bold face lie? if na lie wey him tell, wettin dat tell you about the integrity of de man? @sapeleguy, e be like say you no know the history of "federal character", a constitutional provision. additionally, i no tink say you know de history behind this unconstitutional power sharing arrangement wey all political parties agreed to. i go advise you make you go do small research, unless, your stance na to put wool over our eyes, by pretending to be ignorant. we know better. |
Today for Abuja: Mallam go buy dollar: N151.50 Mallam go sell you dollar: N152.50 |
naijaking1:@naijaking, onye kuziri gi hausa? i hope you know say, many of our ceo friends dey try to fight to maintain status quo as well. SapeleGuy:e be like say, you, ibb, and i, agree on one ting. de federal character nonsense needs to be scrapped. we need competent people wey go govern us with high integrity and competence, no be all these thieving leaders wey don dey rule us for de past 40-50 years. de ting be say, these incompetent leaders come from just about every region in de country. as far as i dey concerned, whether person wey go move the country forward come from east, west, south, or north, it does not not matter. |
Beaf:no be for my mouth you go find out where i dey for the past few days. even if i rush go saudi arabia, i no go tell you. ![]() Beaf:na ya people start de rumours. you sabi say, una no sabi politically strategize, as long as person come from una side, una go want make de person be president. e no matter whether substance dey for de person character or not. give me de logical reason why you tink say ebele go make a great president. de man na mumu even by the most liberal standard. Beaf:de problem wey dey with ya suggestion be say, it is impractical. e go mess up de 4 year term wey constitution call for. impractical in the sense that, i no tink say any nigerian dey alive wey go voluntarily resign from office when 2 years still remain for him term. no be yar'adua dey there for sick bed without resigning? if any person resign after 6 years as you suggest, i promise you say, at de end of de day, you go find out say na from niger republic de person come from. |
kosovo:kosovo, i no go debate de issue, but e be like say, "Political Man" means male, whichever way you look at it. i no tink say you need anyone to second de suggestion, when it is clearly sensible. But na ya prerogative, process it as you see fit. The idea of the thread is itself a good one. una do well. |
I'm afraid that most of the posters on this thread grossly underestimate the desire of the beneficiaries of the status quo, to maintain this status quo. many of una wey dey romanticize de idea of goodluck to suddenly become a cowboy, when everybody know say de man was shell shocked when dem give am VP position, despite de fact say efcc was pursuing his wife for theft, go dey disappointed. if una tink say de king makers for north dey suicidal or stupid make una think again. should de office of de president become vacant, de only ting wey go happen na smooth transition wey go make goodluck president. goodluck go come hand pick him own VP as required by de constitution (ehr, with de consent of de powers dat be). goodluck go be lameduck president because him go announce say, for de sake of peace and harmony, him no go run for de office come 2011. 2 years dey very short and after goodluck, another northerner like yaguda or kaduna current governor go rule naija for another 8 years. dis one be de most likely scenario. |
make I make a couple of observations. first of all, una for title dis thread "Nairaland Political Person of The Year" so dat nobody go accuse una of male chauvinism. una sabi say women dey make positive contributions for here as well. de title don already eliminate women - i guess una dey learn properly from iwuruwuru. secondly, una never hear of federal charater? all of una dey vote like say na over seas una dey, why all of una votes na for southerners or implied southerners? small time una go say na southerner go replace umaru next week. de last sentence na joke so make una no attack.ngwuanu me i go cast my votes: (1)Jakumo - because de time wey i set am up for vigorous attack, him disarm me with his way with words, him be dan iska. (2)dede1 - dis one na intellectual wey no dey shy from abusing ya papa and mama, when him vex. apart from his biafran stance, i fit share burukutu with am. (3)citizenY - dis nominee dey quite intelligent to say de least, on top of dat, him help me to include federal character for my list. |
love am or make you hate am, IBB na de only ex-head of state wey dey make any sense in recent days. dat man dey exhibit wisdom attimes with sagacity and perspicacity, wey dey quite interesting, to say de least. methinks IBB don already see say yar'adua no go complete his term, and him know say, northern leaders go pressure goodluck to resign, in de name of ogbange federal character. na because of this IBB sensibility wey him take call for de elimination of de federal character thingy. indeed, while i get my reservations about de man, i completely agree say, de federal character ting need to be eliminated. my prediction be say, if de president office becomes vacant, goodluck go rule nigeria until yar'adua term expire. after dat, another northerner go rule for 8 more years. de Yoruba people go support northerners since OBJ been use him own 8 years. yawa no go gas because even prominent igbo leaders go support de scenario. peace go reign for naija, come what may. ![]() de only people wey go vex, be our eminent armchair warriors and seccessionists, wey dey strategize for war, from de comfort of their living rooms in diaspora. people like dede1, eziachi, onlytruth, and possibly our resident MEND warrior who is based in the deep creeks of diaspora. i no go mention de mend warrior name, because him dey for good behavior lately. it suffices to say him name dey almost synonymous with nama. ![]() |
SapeleGuy:Sapeleguy, given the make-up of the executive council, I do not believe such a resolution is forthcoming. If Goodluck becomes president, under the these possible circumstances, the constitution also gives him the power to handpick the VP with national assembly consent, to serve out the remainder of Yar'Adua's presidency. Goodluck is sitting pretty! Truth be told, Yar'dua needs to resign and take care of his health, we only have one life to live. 2011 will be full of drama. |
nex:The above statement is not quite accurate. Here's what the constitution states: The Vice-President shall hold the office of President if the office of President becomes vacant by reason of death or resignation, impeachment, permanent incapacity or the removal of the President from office for any other reason in accordance with section 143 of this Constitution Fresh elections will be held only where the office of the president becomes vacant during a period when the office of Vice-President is also vacant. This could occur if the office of the president becomes vacant and the vice-president resigns . The President of the Senate shall hold the office of President for a period of not more than three months, during which there shall be an election of a new President, who shall hold office for the unexpired term of office of the last holder of the office. The constitution also states: Whenever the President transmits to the President of the Senate and the Speaker of the House of Representatives a written declaration that he is proceeding on vacation or that he is otherwise unable to discharge the functions of his office, until he transmits to them a written declaration to the contrary such functions shall be discharged by the Vice-President as Acting President. If we assume that such transmission was promulgated, then Mr Goodluck is a lucky man indeed. na wa for wayas |
methinks pdp need to find another flagbearer for 2011. yar'adua no need dis kind stress when him get chronic illness like dis. i wish say dem go tell us de real illness wey yar'adua get, de country deserves to know. may Allah grant him good health. |
Nchara:dat federal character ting, dey do more harm than good, because in many cases no be de best man for de job wey de ting dey produce. na because of dis federal character ting wey dem dey prep soludo for presidency (2015), meaning more qualified governors (for example, fashola wey everybody dey praise), and others, no go get chance to become president for 2015, as long as dem no change de federal character nonsense. ibb has a great point, but i tink say other branches of government fit pass law or change constitution to bring those tings about, regardless of who be de president. i no tink say anybody go create state police for naija. dat, in of itself go create security risk. before you know it, seccessionists go begin arm themselves under the guise say na for equipping state police. |
oyb:well said. |
Today for Abuja: Mallam go buy dollar: N152 Mallam go sell you dollar: N153 |
SapeleGuy:sapeleguy; i no sure say you get any positive expectation from the federal government regarding this topic. na dem fit effectively deal with issues of this magnitude. i no blame you for de low expectations, na condition cause am. ndo o. @citizenY, nobody fit disagree with ya statements, they are grounded in facts. |
SapeleGuy:ya statement would have been more beautiful if to say you start am like dis: Ultimately, the Nigerian masses need to rise up and demand justice from their rulers |
@sapeleguy, i no sure say "deportation" address the root cause of the problem; bad leadership. |
de almanjiris of de north and de common people of niger delta area are the most marginalized nigerians. de plight of these people is shameful and a disgrace to all nigerians. when i talk of common people of niger delta, no be people like beaf wey don escape the poverty of de area, i dey talk o. i talk for another thread say nigeria problem na problem of bad leadership. this thread once again support my stance. how all de minerals wey dey for north remain inside ground without mining, while de masses for north dey wallow inside poverty and almanjiris full ground? how de whole niger delta go remain in a pathetic state when most of the onshore oil dey come from dat area? how come, we no fit manufacture needle, when ajaokuta dey there? de answer, my friend lies in bad leadership. these bad leaders come from north, west, east , and south. every state dey get money on a monthly basis from federal government. de truth be say, most of the governors and other government officials dey loot de money. de earlier wey we recognize de real problem, de earlier we go find solutions. one tind dey certain, the tribal undertone wey i dey detect for inside many of the post for dis thread no go help the cause at all. some of my posts about marginalization of almanjiris and the people of niger delta area dey for here: https://www.nairaland.com/nigeria/topic-338360.96.html#msg4854317 https://www.nairaland.com/nigeria/topic-325012.352.html#msg4647192 https://www.nairaland.com/nigeria/topic-332857.0.html#msg4670594 |
udezue:brainless people resort to name calling when they run out of points. this is typical of you people. dan tselewa! |
udezue:udezue, i don tell una de context wey i take provide the proverb, go read de pertinent post again and you go see say de proverb only apply to de person wey dey ask me for answer wey him no go get. de only ting wey de person go get na my request for hausa lyrics. shikena! i no know why paranoid biafrans dey all worked up about de proverb. na one person wey i dey address but e be like say paranoia no let several unfortunate casualties of war rest. @onlytruth, if you refer to me as slowpoke, then you must refer to ya superior ojukwu, soludo, and the rest of ya leaders as imbeciles because their views about one nigeria and biafra dey closer to mine than yours. olodo. @dede1, bla bla bla be my response to de first part of your last post. as far as the phrase "nyamiri yamutu yakari, nyamiri yakari yamutu, nyamiri ta munu ta banza" dey concerned, nothing for dat phrase mean raping of igbo women or any other people. de phrase wey you post be like typical war song wey talk say make enemies die finish. nothing unusual there, that is why it is a war song! if you fit provide de lyrics of de so-called radio kaduna theme song wey mention raping of igbo women, i go tender unreserved public apology. dat apology no dey forthcoming because i know say the said reference no exist. na lies wey una post for here. |
bilymuse:They are all "criminals" indeed, yet being unconvicted, possess the constitutional right to contest. Truth be told, 99% of you people are criminals by your implied definition. @citizenY, Spot on. |
Beaf:abeg go and re-read my post. make sure you pay attention to where i said "make we assume say na oil dey keep nigeria together". abi you be lawyer wey dey try call white woman pink, or brown woman black? biko, my challenge to your statement about carting off stuff is still very much valid. |
Beaf:you dey mention akinrinade wey get zero influence and power, in terms of causing Nigeria's disintegration. make we assume say na oil dey keep nigeria together: how many years you tink say e go take before de oil finish, mind you dem still dey discover oil reservers as we speak? 30years, 40, 50years? so you see if oil be the glue, as you claim, then disintegration no go happen for at least 50years. if massive oil reserves are discovered in the north, however, all bets may be off. na dat time wey disintegration go fit happen with less resistance from the north. trust me, ND people no want dat kind intergration because biafrans go come take over ND territories. dem don tell us over and over say ND na part of biafra and ND nairalanders dey fear to challenge the biafrans wey make those pronouncements. dan daudus. |
Beaf:Thanks for the clarification. i know say you get sense small. That Nigeria will break up is the least of my worries. dat one no concern me at all. you see, de powers wey dey keep de country together dey too powerful and i never see any scenario wey go fit wrestle dat power away easily. certainly, de mumus wey dey for diaspora dey shout biafra, no fit do am because their own leaders including ojukwu and others, are squarely against a breakup. de breakup of nigeria exists in de figment of imagination of some nigerians, and that's it. in addition to the powers that be wey dey hold nigeria together, external forces, china, usa, india and others go make sure say status quo no change too dramatically. US marines go invade nigeria for oil before any break up - that one worry me pass nigeria breaking up because of some internal problem. and, by the way, those pictures na Abuja pictures. |
see ya question, its is very funny: What do you mean by superior point, the emoticon ![]() i go give you a break because you don make me laugh small. go read my statement again, you go see say, i talk say i no tink say you dumb. stop trying to be deceive people, i dey here to keep una straight. de ting wey you suggest about carting away stuff no fit work, and you know it. |
Beaf:I get a soft spot and a vested interest for ND, so you no fit blame me. some "biafrans' sef don accuse me of de same ting. if you disagree with any ting wey i post, make you tell me ya disagreement make we iron am out. no need to dey use phrases like bullshit when you no get superior point. ya statement: should the nation split, the ND should be allowed to cart off stuff to recoup what it can as recompense for 50+ years of thankless suffering.dis statement dey laughable, improbable, and highly unrealistic, and you know it! so na wettin be ya real reason for making such a statement? |
Beaf:beaf, e be like say you designed your naive statement above to incite trouble. you are either dumb or just trying to excuse your thieving leaders as usual. i no tink say you dumb, but i believe say ya excuse no hold water. MOST of the leaders wey we get for nigeria at de moment are bad leaders wey be thieves, and the list include our governors for south south region. Beaf:de only response wey dey appropriate for dis ya statement, be ya very own favorite emoticon www.nairaland.com/attachments/180447_ROTFLMAO_gif3d0c775232c7f27cf80592785b9635b6 |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 300 301 302 303 304 305 306 307 308 (of 315 pages)

de last sentence na joke so make una no attack.
.