₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,330,945 members, 8,447,848 topics. Date: Sunday, 19 July 2026 at 07:19 AM

Toggle theme

RuuDie's Posts

Nairaland ForumRuuDie's ProfileRuuDie's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 196 197 198 199 200 201 202 203 204 (of 295 pages)

LiteratureRe: Short, Witty Quotes! by RuuDie(m): 7:31pm On Jul 04, 2009
"Man is incomplete until he is married. Then he's finished."

grin grin
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: The 2009 Summer Football Transfer Thread(Bayern £22m Robben, Inter £13m Sneijdr) by RuuDie(m): 7:22pm On Jul 04, 2009
I wonder if anyone has taken note of the debts Valencia is alleged to be owing - if 2 na UTD dem write 4 there now, people 4 don dey run around dey crow like cock wey dem don sever im head grin
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 7:15pm On Jul 04, 2009
dis wan wey TOYO even mention my name,
i no jus dey d same,
e sweet me sotey i almost lame,
as if pesin don dash me fame,
make e no be like dey claim,
i fit print dis ur post put 4 frame,
na true i dey trip and no be game. . . .

TOYO u sey last drip,
my own even start 4rm d tip,
dat na small, u get me inside ur grip,
if u ask me to jump, i go skip,
tell me 2 tumble, i go flip,
even 4 river naija dis my head, i go dip,
now ehn, i be like baby wey dem tie bip,
dis na jus make u get idea how deep. . . . .

Maedan & Semid4lyfe, una don try una best,
thank una well well, una jus leave d rest,
i take TOYO challenge as correct test,
as i dey unload every wey dey my chest,
e be like wen man dey invest,
sometime na loss instead of interest,
if she no gree, no be contest,
i go jejeli put on my vest,
and begin dey waka face west,
maybe no be 4 me, so i go jus return to my nest!
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Manchester United Fan Thread: Champions Of England! by RuuDie(m): 6:19pm On Jul 04, 2009
Its confirmed - Owen is a UTD player; 2yr deal. . . . . . .

Just the type of buy i wanted, even lower in profile than a Hunteelaar. . . . . . .
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 11:42pm On Jul 02, 2009
@ toyosi20 - u dey ask wether luv dey fair huh

sometimes e dey be like love no dey fair,
e dey resemble say im no dey show care,
but dis wan depend 4 where u stand,
and how u take show ya hand,
truely atimes e no jus make sense,
but dat wan no mean say make we build wall of defense,
d more pesin think am 4 im head,
d more d answer dey far like A to Zed,
betta love go shack u like mo'et,
and wen im touch u, instanta na im u go become poet,
me i sabi many husband and wife wey dey very happy,
and no be becuz dem still dey wear nappy,
wen dem begin 2 relate, nobody been ring bell,
how dem still dey till now, even dem no fit 2 tell,
no be by d fine-ness of dem face,
but by d almighty grace.
na true sey pesin no fit talk wen love dey right,
dat na becuz wen e show, e no dey flash NEPA light,
everything we do 4 dis life na big risk,
shey dat wan mean sey make we come dey cover bodi like disk!?
nothing wey spoil, wey dem no dey fix,
so dia 4, e dey wrong make pesin tanda and refuse 2 mix,
becuz pesin fit come da'ba'ru my heart,
no go stop me from making relationship start,
some kain time e fit be say na jus luck,
but shey i go come close up like padlock!?
people many wey be original fake,
dat no suppose make us finish mash brake,
how many dem go be!?
inside 12, how many bad egg Jesus see!?
of course, we go see somethin' wey go pain,
but why we get bleach if not 2 comot stain,
nobody dey dis world wey no need love,
from anywhere yonder, under or above,
by right, na wetin all man and woman deserve,
e no be like somethin wey dem dey specially reserve,
as long as me i dey live,
dis be wetin i believe,
i no be expert, i no fit tell wen love na correct,
but i dey sure sey no be by how u select,
my own be say,
make we dey wise and no dey over think sotey,
wen we finally jam dat wan wey suppose be we own,
we go loss d pesin sake of sey we bone!
i neva see any man or woman wey be island,
even if im be JJC from thailand,
LiteratureRe: Short, Witty Quotes! by RuuDie(m): 11:00pm On Jul 02, 2009
Marriage is an institution in which a man loses his bachelor's degree and the woman gets her master's.
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Manchester United Fan Thread: Champions Of England! by RuuDie(m): 8:46pm On Jul 02, 2009
nateevs:
Just learning that ManU are in talks with Micheal Owen. . . . Yes you read it right . . Micheal Owen.
Absolutely perfect. . . . . . i hope this is true and UTD are really tryna sign him!
I'm cool with just about anybody that we don't have to break the banks for!!
SportsRe: Your Team Of 11 From The Confederations Cup by RuuDie(m): 8:35pm On Jul 02, 2009
Dr Kitaun:
wey Kaka for ur list ?
Na only Kaka play football 4 Confed Cup huh
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: The 2009 Summer Football Transfer Thread(Bayern £22m Robben, Inter £13m Sneijdr) by RuuDie(m): 8:31pm On Jul 02, 2009
Reports in Spain say that Lyon want to sign Real Madrid striker Ruud Van Nistelrooy to replace Karim Benzema, who is going the other way.

Not bad for RVN
LiteratureRe: Short, Witty Quotes! by RuuDie(m): 8:24pm On Jul 02, 2009
"True love comes quietly; without banners or flashing lights. If you hear bells, get your ear checked." - Erich Segal
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: The 2009 Summer Football Transfer Thread(Bayern £22m Robben, Inter £13m Sneijdr) by RuuDie(m): 8:13pm On Jul 02, 2009
BREAKING NEWS!
Chelsea are reported to have signed goalkeeper Ross Turnbull from Middlesbrough on a free transfer - 4yr deal. He will be back up to Petr Cech.
SportsRe: Your Team Of 11 From The Confederations Cup by RuuDie(m): 8:05pm On Jul 02, 2009
Dr Kitaun:
et tu Ruudie ? shocked
wetin happen huh
SportsRe: ~Wimbledon 2009~ by RuuDie(m): 7:59pm On Jul 02, 2009
An all-Williams final. . . . . . . . Venus pls whoop Serena's big behind! grin
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 7:56pm On Jul 02, 2009
@semid4lyfe,

thank u as u help hold my side,
ur blessing go dey wide,
lucky no go see u hide,
happy no go jus lef u slide,
lai lai u no go fall like pesin wey 2 get pride,
inside ur heart love sef go come abide,
in fact e go sweep u like bar beach high tide,
no yeye pesin go come dey take u 4 ride,
Papa God go give u betta bride. . . . . . . .
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 7:40am On Jul 02, 2009
maedan i feel u, no need 4 we 2 dey spectacular,
or begin make people shiver like dracula,
we fit no even need curricula,
no need 2 begin over-crack we medulla,
halla, sing sotey voice crack like tetuila,
no be hia a.k go hol' man 4 parti-kola,
dis na we fine art & na we own circular,
d way we dey use speak our own mind like 'toryteller,
and d only how we 'tory go waka tee'lee like ebola,
if we do am proper, we message go tey pass metusellah. . . . . . .
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Manchester United Fan Thread: Champions Of England! by RuuDie(m): 7:27am On Jul 02, 2009
Obviously Hunteelaar isn't the best striking option out there for UTD; but the minimum requirement is a decent player. . . . any slightly above-average player - maybe not in the league of spectacular or fantastic but just good enough to fit in and deliver.

Why go for such a player huh Simple - there's little or no pressure on him to perform. . . . . he can settle down and play to the best of his abilities and improve; unlike big-money, high-profile buys that will always have a big chip on their shoulders trying to prove that they were worth all the hype and the huge price tag!
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Manchester United Fan Thread: Champions Of England! by RuuDie(m): 7:18am On Jul 02, 2009
@ Biina,

just liken Kaka to ZInedine Zidane and CR7 to David Beckham. . . . . . . . He is the center of attraction anywhere - forget football, the man is now a global brand name! The bernabeu will be filled to the rafters when CR7 is being unveiled.
Madrid do not mnd this kind of media hype or attention as long as its profitable; UTD do - SAF always tries to keep the focus on football and nothing else.

In the case of Benzema, even you have noted that he is not worth the #35m price tag - what more is there to say!? There's no way in the world SAF would even consider splashing that amount for him.

Personally, IMHO. . . . . . . UTD do not need any big-name player - give us Huntelaar, Anelka or even worse Bendtner and see what we make of it!
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 11:07pm On Jul 01, 2009
@ maedan,

no need make we fight,
shebi we all dey write,
as we no get we own website,
dis don be like our daily rite,
here we dey use our mind and hand to throwey light,
even use our words to give blind people sight,
try make people see morning for inside night,
me i no come here to test might,
abi e don turn to issue of wrong and right!?
shebi d topic here na love & na make people unite,
come together and dey tight,
dis be my own widow's mite
my own small way to make people life bright.
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Manchester United Fan Thread: Champions Of England! by RuuDie(m): 10:43pm On Jul 01, 2009
Am not even so particular about how many goals he scores or can score but in the long run how consistent is he huh what kind of influence can he wield in a game huh does he have the presence, the stature to command attention as a threat when he's out on the field of play huh

For instance, from the perspective of Ligue 1, compare a Benzema to Gourcoff --- who's more highly rated huh
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Cristalz, Mukina2, Bludiva And Tubabie by RuuDie(m): 10:20pm On Jul 01, 2009
[quote author=~Sauron~ link=topic=290818.msg4118020#msg4118020 date=1246451317]Mukina2------Highest goal scorer in Sierra Leone/Gambia. Still waiting to join Arsenal Ladies but Wenger is stingy.[/quote]Muki's story

this 1 played football for the SPLA female football team before the civil war began in Freetown, then they were in amateur division 1 and were known as the Bomber Queens FC of Kwakale.
When the war began, they were drafted, as back-up, into the main millitant wing of the SPLA - so be careful around her, she also does shooting and Javelin.

Well, as per how she fell in love with the Arsenal; she used to have a crush on this Sene-gambian football star called Jawara who played for the Scorpions and looks a bit like the Toure brothers.
Well, when EPL football started becoming popular and was being shown on Tv everywhere, she started seeing a player that looked like the loff of her life in one club popularly called "the gunners."
Since it was Kolo that first came into the limelight, she took to Arsenal because of him. Now she is also going bonkers about Yaya becuz he looks more like Jawara than kolo; but unfortunately/forunately whichever the case may be her eyes are now open to the world of attractive footie players and she is now so into Arsenal becuz of other fine-boy players like The Prof, Song, Gallas, Silvestre, Eboue, Sagna, Eduardo, Diaby, Arshavin etc. so she cannot migrate to Barca (Yaya's club) - but she still supports them whenever it is possible.
LiteratureRe: Most Uninteresting Book You Have Read. by RuuDie(m): 9:49pm On Jul 01, 2009
WildOne:
I have to go with Tom Clancy. Whoever put it in his head to make a career as a writer certainly did humanity a disservice.
you've got a point here. . . . . . . the man can write some crazy volumes filled with so much millitary lingo and techno mumbo-jumbo that can make ur Bsc look like u'd been wasting time and money!
1 Like
European Football (EPL, UEFA, La Liga)Re: Manchester United Fan Thread: Champions Of England! by RuuDie(m): 9:43pm On Jul 01, 2009
Benzema's got some ability no doubt - but this fella is just being over-rated at the moment. I'm glad UTD didn't get him; not at that price anyway!
SportsRe: ~Wimbledon 2009~ by RuuDie(m): 9:40pm On Jul 01, 2009
Dr Kitaun:
upstage Fed ?

and u mean that as a joke innit ?

Basketmouth must be ur protege grin grin
neva rule out the possibility of an upset. . . . . . . but isn't that what d brits would love most to see !?
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 9:37pm On Jul 01, 2009
i 4 say make i begin cry,
but tears don finish 4 my eye,
e be like sey d well don dry,
d thing don pass me to lie,
i been wan find way 2 hang and jus kpai,
but when i think am, i ask myself why!?
no be sey u no try,
dis na fact wey i no go fit ever deny,
shey becuz of me, make ur body come fry!?
abi make u grow wings begin fly!?

i no blame u sey u no fit wait,
in fact, i dey lucky sey u even show me faith,
believe me die sotey u open gate,
treat me like i be king or head of state,
baby u no go dey wrong if 4 me u get hate,
becuz u do ur best 4 us 2 fit relate,
siddon 1 on 1 like paddy and communicate,
d problems we get na me dey always create,
atimes sef i no go yarn, i go jus relocate,
i lie, cheat, steal, forge even duplicate,
dey feel like bad guy dey always try manipulate,
upon sey u no be my mate,
na u still make sure sey we date,
u do betta to set table and arrange plate,
but na me get blame becuz i dey always dey late.

baby i no sey i no even get right to say i dey feel blue,
after all i don make u go thru
as we dey now so, na beg i go dey if u say u wan sue,
shame go kpai me if i no come out talk true,
d debt wen i owe u, i no fit ever finish pay d due,
God bless d very day u enter my view,
and 4 all u do 4 me, i jus have to say thank you,
babes plenty 4 naija but ur kind dey very few,
u enter my life and make am sweet like fresh fish stew,
1 hand u pursue all d smell smell comot with morning dew,
as u dey waka go, i wish u betta 4 d line wey u wan start new,
i pray dat d next bobo no go be like me a jew,
wey no go lef u alone dey waka with boys sake of say na crew,
pesin wey go give all wey i no fit ever do!
SportsRe: Your Team Of 11 From The Confederations Cup by RuuDie(m): 9:27pm On Jul 01, 2009
01. Howard [USA]
02. Masilela [RSA]
03. Demerit [USA]
04. Lucio [BRA]
05. D. Alves [BRA]
06. Xavi [ESP]
07. Bradley [USA]
08. Donovan [USA]
09. Shawky [EGY]
10. Villa [ESP]
11. Altidore [USA]
LiteratureRe: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 8:32pm On Jul 01, 2009
e dey me like i neva luv b4
like sey breeze dey blow pass me go,
rain no dey fit fall touch my body again,
and no matter how sun hot, e no dey reach my head. . . . . .

e dey me like i neva luv b4
like sey i been neva take eye see,
as if dis foot dem jus remain 4 1 place,
and my hand dem dey hang here like wood. . . . . . . .

e dey me like i neva luv b4
like sey my mind no fit think anything again,
dis heart wan jus stop dey pump blood,
and NEPA don kukuma off light 4 inside my brain. . . . . . . . .

e dey me like i neva luv b4
like sey anoda day don come pass 2 sharply,
me wey no dey send 4 yesterday, today or even tomorrow,
now 4eva no go even dey long enuf!
SportsRe: ~Wimbledon 2009~ by RuuDie(m): 8:29pm On Jul 01, 2009
Just heard a run-down of Haas' injury history - this dude is probably the all-time most injured tennis player!

Hope that shoulder injury doesn't recur when he's just on the verge of upstaging Fed!
SportsRe: ~Wimbledon 2009~ by RuuDie(m): 8:09pm On Jul 01, 2009
Pheeew. . . . . a real marathon match!

So surprised Roddick came back to win it - Hewitt was ahead all along, albeit a slim lead.

Hope we get some good games in d s/f - particularly interested in what T. Haas will offer against Federer; since he beat Djoko, he must have something - hope he puts up a good fight in the semis!
LiteratureRe: Most Uninteresting Book You Have Read. by RuuDie(m): 8:06pm On Jul 01, 2009
Probably Notes of a Scandal

never could make out what it was all about still can't!
SportsRe: ~Wimbledon 2009~ by RuuDie(m): 7:54pm On Jul 01, 2009
Astonishing rallies. . . . . but none of these fellas appear very eager to attack the net - they're playing too deep from the baseline.
SportsRe: ~Wimbledon 2009~ by RuuDie(m): 7:38pm On Jul 01, 2009
I swear Hewitt mean dis 1 oh. . . . . d guy don jus vex - he's playing out of his skin in this game.

Won't be surprised if this ranks as one of the top performances in his career!
SportsRe: ~Wimbledon 2009~ by RuuDie(m): 7:36pm On Jul 01, 2009
omo na real battle be dis oh. . . . . last set and dis 2 guys jus do real gbege on top d fourth game. Roddick finally win d titanic battle.
2-2 in the 5th

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 196 197 198 199 200 201 202 203 204 (of 295 pages)