Semid4lyfe's Posts
Nairaland Forum › Semid4lyfe's Profile › Semid4lyfe's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 378 379 380 381 382 383 384 385 386 (of 406 pages)
@ Maedan Eeeya - I dey feel for u on top dat ur ipod wey dem steal Becos for music that stuff na the real deal Anyhow sha, make ur spirit no dampen Becos when 1 door close, anoda one go open Sleep don dey catch me, so goodnite Wish u sweet dreams and make u sleep tight. |
Most definitely Modenine! That guy is heads n shoulders above the rest. Even una M.I doesn't come close. |
Yeah rite! |
@ just2nice I'm back online for good. Holla at me on my 0806 no. |
@ Maedan & Mailmalc See as una dey do like Tom and Jerry Well, its all good as long as the play dey merry Here is a typical response to my bolded and italicized post above Na real wa for u o Wetin u want make person like me talk so? As na only 3 days of no light dey make u vex Guy-no think am, comot for house, enter club go flex Although their inefficiency na of the greatest height PHCN just dey show and flex dem tiny might When dem ready, dem go bring back the light Me no get dem time- na joint I dey enter every nite At least I go beer up and shack myself tight And forget all my sadness, pain and sorrow I no dey think too much of naija's tommorrow Becos many things for dis country no just follow See-no carry naija problem for your head Becos solution no dey in sight & e heavy pass lead If u think am too much, e go weigh u down And na so so frown u go dey frown Becos naija problem na basket case So cheer up and put smile for your face But meanwhile me go soon be foreigner As I go soon emigrate and go settle for Ghana But make we just continue to dey fast and pray Becos I know se one day, and I say one day Baba God go deliver us comot from dis our egypt Like em do for the Isrealites for the Holy Script. |
Dis thread come dry all of a sudden Abi dis pidgin rhyme 'thingy’ don become burden? Abi all man don run out of rhyme? Or shey na becos of lack of time ? Becos e be like se all man don abandon this thread Go hussle and work for dem daily bread Well, no lele – me go dey hol’ am down Until everyone return from town Make una just bring back some goodie Or else me go dey very moody. |
Hmm---------------- I just dey waka pass |
Sorry se I dey digress But this post na the measure of my distress As life for naija na nothing but stress Therefore, e be like se I go break una laws And steer this our love ship off course But please, make una no vex give me ban As na only my church mind me wan yarn [b]Why person dey struggle to live when person dey live to die? If I talk se dis country never tire me, I go dey lie Sometimes, e go be like se make I breakdown and cry Becos government for naija na big failure as dem no dey try For three days now, I never see light for my house ![]() Infact person just dey prowl around for darkness like mouse ![]() Well, like most Nigerians I don adapt and now I fit see for dark ![]() For 2009, pipe-borne water and other social amenities still dey lack With all these things, how hillary no go paint us black? Well, all dis things no dey new as e don tey wey our yansh dey back As things dey go so , shey we go fit achieve vision 2020? Becos things to do before then still dey plenty - plenty Before, na Niger Delta militants for south south dey wreak havoc But now, na Boko Haram self-styled talibans for north dey run amok Which time all dis kain religious and ethnic crisis go stop? Becos naija be like overblown balloon wey go soon go POP! Infact e dey surprise many se we still dey and never break up. [/b] |
maedan:Hmmm--U get better vision and foresight As your reply dey very impressive and tight Dis your post don give me good insight Into the kain person wey u be For dis life nothin wey man pikin no go see Becos people get different beliefs and mind Many babes, na chop and clean mouth dem dey find Those kain babes dey act and play funny As their kain love na koni-koni When money dey, dem go call person honey But when pocket dry, u go turn to monkey Those kain babes na serious nuisance In short, make person pray for Baba God guidance Make e no go fall into dem net Otherwise em go get serious regret Remember, one word dey enuff for the wise So make una take to dis my timely advice. |
I'm surprised Rita actually thought she could win with her obvious shortcomings. Truth is, if there was a thorough screening process and auditioning, She wouldn't have made it into the koko mansion. IMO, Bolanle deserved to win although I found my self rooting for Rita out of sympathy. I guess all Rita fans and supporters were suffering from the 'underdog syndrome'. |
Without meaning to disrespect to the ladies--------------- Love na one kain complex emotion Some dey talk sey na romantic illusion While others dey call am sexual infatuation. To find true love for naija no be beans Becos most babes dey find men with means Some babes go milk man pikin dry Then dem go tell you goodbye So make all man shine em eye Otherwise em go experience betrayal Becos no be all babes be wife material |
Hmmmmm--------So many newbies in da house, but its all good sha. Abegiii, make una pass me the mic jare. Na my turn to flow. Ok---here goes-----Mic check 1, 2, Finally, finally me don pitch my tent And dis my babe na pure heaven sent As she no cost me one single cent She fine pass Leonardo da vinci's Mona Lisa Even Venus de Milo no fit compare to her She dey make my heartbeat go hyper Even sef, my body dey shake and shiver To talk sef, I go dey stammer and stutter I for die if she no give me entry visa Her name na victoria And I jam am for my area Dem born am for Nigeria But her pale' na Liberian And her male' na Nigerian Therefore me dey call her Niberian (Mix of Nigeria/Liberia) She get shape like hour glass In short, the lass na top class Her voice be like that of nightingale Even for manners sef, she no dey fail To top am, she come get good sense of humour And na everyday,me dey love her more With am, I no dey experience loneliness Dis my babe na epitome of beauty & loveliness For her,I no mind to spend all my money Just for her to dey call me honey Becos she too Behind, posh and creme In short, she be the stuff of my dream Don't worry,I go give all of una dial When we wan waka down the aisle. |
I just say make I show face And touch down for dis our pidgin base I happy se una keep the thread for road But me don get plenty work load So I no go fit dey too consistent But I go still dey everly represent Dey drop rhymes from time to time After all pesin no dey pay a dime |
I happy se una don end the travail And common sense and peace don prevail Na so e suppose to be so this thread go sweet like honey Thank una 4 taking to my advice We no suppose dey hate like cat and mice Instead,we suppose dey live in happiness and bliss And dey share plenty hugs and kiss |
There is definitely no basis for comparing both novelist. I don't think both authors can write outside their comfort zones. When it comes to espionage thrillers, Frederick Forsyth is head and shoulders above R. Ludlum, J.Archer, Tom Clancy, Sidney Sheldon and any other person who has written in that genre. When it comes to the law and courtroom thrillers, John Grisham is the best I've read. |
@ Dragnet Thanks for the swift reply. As a typical Nigerian, I like awoof die so I won't miss that your F.O.C offer. I guess we'll iron out the other issues on YIM, right? |
@ Dragnet My N73 joystick has become 'somewhat' stiff and this has made navigating the phone a bit difficult. Any do it urself remedy? Or do I have to change the joystick? |
Shoo! For this computer age, people still dey read hardcopy novels? I've got about 50 e-novels of the best authors ranging from danielle steele, robert ludlum, frederick forsyth, john grisham,Jeffrey Archer, dan brown, sidney sheldon, judith McNaught, jackie collins etc on my lapy, so its being long I read a hardcopy novel. The only thing is everytime I switch on my lapy with the 'supposed intention' of reading one of my novels, I end up watching a film instead. I'm afraid my reading habit has gone down over the years. Hmmm, I just finished re-reading The 11th Commandment by Jeffrey Archer though. Its my favourite J.Archer and I first read it around '99. I've just started on another espionage novel - Icon by Frederick Forsyth. So far, so good. |
Na wa o. Us wey no go school , God go help us. |
@ Dwayne Sorry, but do I know u? |
@ Maedan Baba God, na em know best So em will, make we no contest Everything get em time and season And I know se everything na for a reason Remember se ashes to ashes and dust to dust And one day all of us go dey buried under the earth's crust So make we all live life and leave positive impact So our legacy go dey strong and intact Me, I go try contain my sadness and pain Becos I know se all em life work no dey in vain |
Kai! Una no sabi read? I thought the guy categorically stated fbt not shared lasts longer! Anyhow sha, glo is very fbt conscious, so I don't expect this to last whether shared or not. |
Nice! I'll be back to drop sumtin'. |
Maedan, u don commot the words from my mouth So I no go fit talk much or shouth E be like se na me em death pain pass Becos for music, Mj dey em own class I be man 'n' e don tey wey I cry But walahi, em death commot tears from my eye Who go come be the next king of pop? Becos all musicians of today be like flop Baba God, I know se na final be ur say But abeg, u fit bring back Mj? Na so I don dey pray Every morning of every day Since I hear se em don pass away. |
Wow! Nice poem. It encapsulates my online life in brief. Most of my buddies on YIM are peeps I met on Nairaland and other fora. We chat online and even call each other on phone but truth is, we ain't seen each other before or even know what we look like. |
Guys, xplore 1.33 is out. Here is the link http://www.fzdownloads.com/attachments/14/8/1/1246960090-frendz4m.com-Lonely.Cat.Games.X-Plore.v1.33.S60v3.S60v5.SymbianOS9.x.Unsigned.Full-Symbian.zip It isn't different from the 1.32 IMO. |
aieromon:Aaah ! Cheer up. E no bad reach like that. If your redeployment runs no click and u eventually have to serve out the service year in Katsina, Just find an educated Hausa chick and "open office on top of her head" if u know what I mean. The educated chicks or hausa undergraduates are usually from rich families with good connections , and dem dey love we southerners die. If u play your game right, u no go touch your "allowee" through out the service year Disclaimer ; But if u go Bleep, ol boy ----O ma sha e ni bulala (yoruba) and u go jina like suya . For that one, my hand no dey o ![]() |
@ Toyosi20 E don tey wey person see ur face I don dey think se u don quit dis race But u come show with ur usual grace . Becos u be like commodity wey scarce I bin think se u don go planet mars But e be like se u dey prepare for ur birthday celebration That one be se, for here na maximum jubilation Me I be jolly good fella And I like to dey shak and chop wella So make u prepare enuff food Becos all ur guys for dis hood Go fall in big time and participate For dis birthday wey u wan celebrate. Happy Birthday, Gal. |
@ Just2nice Which kain books u get for dis your mobile e book collection? Abeg, u get janet and john? I know se e neva too late for me to go school. Abi wetin u think? |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 378 379 380 381 382 383 384 385 386 (of 406 pages)



