₦airaland Forum

Welcome, Guest: Register • Login • With Google • Trending • Recent • New

Stats: 3,344,826 members, 8,513,873 topics. Date: Thursday, 05 November 2026 at 04:55 PM

Toggle theme

Semid4lyfe's Posts

Nairaland Forum › Semid4lyfe's Profile › Semid4lyfe's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 379 380 381 382 383 384 385 386 387 (of 406 pages)

Phones › Re: Only D Best 4 Ur S60v3 by semid4lyfe(m): 3:05pm On Jul 06, 2009
@ Hayprof

Na lie u talk o. Smartmovie is far better than coreplayer. Smartmovie has an inbuilt loader that enables u to view and play ur videos directly while wit coreplayer u gas go manually to the location of video, select and play it.
Smartmovie player has screen display for controls like volume increase, ff, rewind etc
The only thin coreplayer has over smartmovie is the higher volume and the fact that it plays more video formats IMO
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 2:13am On Jul 06, 2009
Na wa o!
Dem say my yarns dey too philosophical
Some even talk se my flows dey metaphorical
Small time dem go talk se I dey political
And e no go surprise me if dem say my style dey dramatical
Well, like KSA go talk - na dem get dem mouth, so let dem say
After all, all way na way as long as e lead to better day
For dis thread, me no dey follow anybody compete
Sometimes e go be like se all the rhymes for my head don delete
But somehow somehow, my brain go come replete
So I go come drop pidgin rhymes wey dey fresh
Come dey flow like se I be spirit 'n' no be blood and flesh
Well, make I no praise my self too much
Becos, yesterday- when I bin dey church
Pastor talk se 'pride dey always come before person fall'
But that one no mean se I no go dey waka tall
Becos me I know se to rhyme for pidgin no be yam
If una doubt me, make una try am
And una go see se I dey talk true
Some people no even get any clue
Se dis thin dey involve plenty brain cracking
And e come dey emotionally and mentally tasking
Well, make I no yarn una too much story
Except to tell una se, I go still dey flow- so no worry
But make una remember se na Baba God get the glory.
Phones › Re: Only D Best 4 Ur S60v3 by semid4lyfe(m): 6:40pm On Jul 05, 2009
@ aieromon

Thanks, but I've already gotten the keygen and generated my key so my smartmovie 4.10 is fully working now.

All those precracked versions of smartmovie 4.10 stop working on my phone after some time.

Thanks sha.
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 12:27am On Jul 05, 2009
Still in the spirit of love -- but this time a higher love.


Baba God, na becos of u we still dey
So to u, we go everly dey pray
We all never read bible from genesis reach revelation
But we know se na u be the road to salvation
For our lives, we don succumb to many temptation
But u still give us ur heavenly redemption
Bombard us with divine promotion
And come bless us beyond all expectation
Gbege too plenty for dis life
But u lift us above all the strife
Our blessings we no fit count
Becos second by second dem still dey mount
Na ur love be the ultimate
Becos e carry big big weight
And e no get expiry date
Na only u fit turn water to wine
So people go fit drink and dine
In short Baba God, ur ways too fine
Therefore, na em we all go dey preach
With dis our small pidgin missionary outreach
Phones › Re: Phone Section Chat Room by semid4lyfe(m): 2:18pm On Jul 04, 2009
@ Aieromon

Long time! U still dey for this your clowning mood? Welldone o !
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 6:33pm On Jul 03, 2009
Wey toyosi wey cause all this storm
Now wey e don happen, she don dey keep mum
Well, all na experience for person to learn from
Me, I know se true love no dey give person stress
And no be matter wey person dey discuss for press
So e fit be se Ruudie and toyosi dey romance for backstage
Come dey form "I no do" for this our frontage
Becos I know se my guy ruudie no be tout
And e no dey shack beer talkless of stout
I go give am the benefit of the doubt.
Me just dey yarn my church mind
And no be everytime truth dey dey kind
So make nobody carry vex
Come meet for where I dey flex.


Dis thread don surpass my expectation
From day one e no experience stagnation
Becos all man for here na pidgin rhyme sensation.
I throway salute to all those wey hold am down
Before me come join dem dey flow for this town
Rotimy, maedan, just2nice and all the rest
Wey proudly carry dis pidgin thin for dem chest
So tey dem imprint "proudly pidgin" for dem vest.
One Million gbosas no dey enuff
Becos all off una be pidgin rhyme buff
To all of una, I commot my hat in salute
Becos this thread still dey and never go kaput
Technology Market › Re: Very Clean Nokia N95 For Sale For 25k by semid4lyfe(m): 2:31pm On Jul 03, 2009
Hmmm

Just for the avoidance of doubt - semid or semid4lyfe is a different person from semidaraeb.

I've got two user names on this forum --- That is semid and semid4lyfe.

Semidaraeb is my elder bro though.
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 1:28pm On Jul 03, 2009
All my people 4 here, I dey hail
For dis life we go be head and no be tail
And we go continue dey drop pidgin rhymes wey no go fail.

I just se make I drop one or two line
For dis thread wey celebrities dey wine and dine
Wey dey explosive pass land mine
So here goes --


@ Ruudie

On this thread u dey consistent
And for love matter u dey persistent
Ur pidgin rhymes dey shine like sun rays
If dis na exam, o boy u go get straight A's
Ur love poems dey carry big big weight
So God forbid, u no go wait too much for ur love mate
Make u just continue to live ur life by faith
Becos u don near the appointed date
If I get sista, walahi I for give u marry
Becos na big big weight ur love poems dey carry
I know se u be man of integrity
Wey no dey compromise on quality
And like me, u no dey tolerate mediocrity
So any body wey u marry jam better luck
Becos u go love am die and give her plenty buck
Leave toyosi make she continue to dey form
Besides u know se 4 babes that na the norm
U go soon meet babe wey fine pass her
Wey go make ur heartbeat and blood pressure go hyper
So make u just chill dey play cool
Becos very soon na miss world u go dey pull
But 1st make u reduce ur poem wey long like essay
Becos all man don hear wetin u get to say
Make u just keep all dem scrubs at bay
Becos dem go sink u fast like clay
And u go come dey broke like mc hammer
That one be se u go come go village go do farmer
So make u just take to my advice
Dey play am gentle and cool like ice
And Baba God go bless u with the ultimate price.
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 8:40pm On Jul 02, 2009
@ Ruudie

To ur prayer, I say a big amen
Na as u talk am Baba God go make am happen
Infact, for my life I no go see commotion
Kasala and gbege no go be my portion
And for everywhere, I go dey get divine promotion



@/For all

For here, I go dey keep am real
Becos this pidgin rhyme don become my meal
Even though I no be soothsayer
I know se all we pidgin rhymers go prosper
As this thread don be literature section topper
Small time we go come become big stars
with the best and state of the art luxury cars
We go come dey take luxury space cruise to planet mars
In short, we go shame all the doubters
And even the rumour mongers
All these na my  prayer
For all the pidgin rhyme player
Wey dey contribute for this thread
Wey other nairalanders dey dread.
Technology Market › Re: Very Clean Nokia N95 For Sale For 25k by semid4lyfe(m): 5:17pm On Jul 02, 2009
@ Poster

U sure se the phone no get K leg? grin cheesy

Make I pay u 20K--CASH and CARRY.

What say u?
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 1:46pm On Jul 02, 2009
@ Toyosi20

Your in depth love analysis dey make me trip
Becos e dey very very deep
But make I ask u-u get any man for keep?
Abi u still dey wait for "Mr Perfect" to sweep you off your feet?
If na so, na only for dream una go meet.

Make I yarn u sey ruudie na good and truthfull lover
No mind Altavista wey talk se em be cassanova
Becos the truth be se em and ruudie get beef
Ruudie love go last forever n e no go dey brief
And with am u no go ever experience grief
U dey there dey ask who Maedan dey love
Well make I tell u se na the guy wey she dey call rotiluv grin cheesy
If u no attend dem wedding" O girl u miss
Infact right now dem dey enjoy marital bliss
And dem don dey share enuff french Kiss cheesy grin
So make u take ruudie love into consideration
Becos em love for u don pass addiction.
Phones › Re: GSM Network Issues And Problems (Zain, Etisalat, Glo, MTN) by semid4lyfe(m): 11:37pm On Jul 01, 2009
@ Hayprof

I dey see your under G moves o. U sef don turn to F.B.T militant abi ? Well done o. Make u accept the offer of amnesty and hand over your Nokia 5800 and your sony ericsson phone complete with all the F.B.T
Phones › Re: GSM Network Issues And Problems (Zain, Etisalat, Glo, MTN) by semid4lyfe(m): 8:39pm On Jul 01, 2009
Tolu, U still dey? I bin think se all those Osama bin laden militants for Minna don Kidnap you. Anyhow sha, How body?
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 8:31am On Jul 01, 2009
Wow! For dis pidgin arena, we don get plenty star
Na correct be dis guy wey dey bear altavista
See as em just set ruudie for the path wey dey right
Me don see se em future for dis game dey bright
I just hope se em go stick around more
Becos em fit join hand and helep us bring pidgin english to the fore
Em talk na inspiration and big big motivation
And em come get better foresight and vision
E be like se this thread go need em touch
Altavista, nna man- u too much
So make I welcome u officially to this thread
Wey be the den of dem pidgin rhyme head.
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 6:31pm On Jun 30, 2009
Toyosi, ruudie no like as u dey play hard to get
Becos u don trap am 4 ur love net
These days na so fret em dey fret
Becos em love 4 u, u no reciprocrate
I know se u go ask, 'why semid4lyfe dey play ruudie's advocate
The fact be se na 4 em health I dey concerned
But more importantly na with u ruudie dey enamored
Toyosi, make u no listen to Maedan
Cos na so she dey form until the rotimy thing happen
Make u no let ruudie love fly
becos true love dey hard to come by
I know se eventually u go gree
And to celebrate am ruudie go carry u comot 4 shopping spree
Ruudie tell me se na u or nothing
So please make u no put am on a long thing.
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 5:12pm On Jun 30, 2009
@ TOYOSI20

E be like u don cast ur love spell
Cos 4 some days now ruudie no dey well
For love matter, u dey dribble pass jayjay
Becos all this while u neva tell ur toaster ur say
If na NO, make u quick tell am so em go find em way
Abi u no know se ur silence dey give am hope?
E come be like se ur love dey hook am pass dope
Cos I no fit imagine how grown man like ruudie no go fit sleep
Unless and only if em love for u dey pure and trully deep
I know se fine babe like u dey get many proposition
But make u please take em own into consideration
Unless u wan give am the wrong impression
Se love na nothing but romantic illusion.
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 9:33am On Jun 30, 2009
Ruudie! Ruudie!
The one and only lover boy for dis hood
I see se u still dey 4 romantic mood
E be like se u be career love applicant
Otherwise,how u take know se Toyosi heart still dey vacant
But u know se soup wey sweet, na money kill am
That one be se to catch fine babe like toyosi no be yam
I dey admire ur gallant efforts to find true love
Becos person wey get am dey at peace like dove
So make u no slack and let push turn to shove
Becos by that time e fit don be too late
U no gree come see me the 'Love doctor', so I don leave u to ur fate
Make u just know sey no be to write love poetry
Cos for where she dey, Toyosi just dey laugh dey make u mockery
For her mind, she dey talk- na love letter I go chop
That one be se from ur pocket somethin must to drop
Toyosi na biggs girl wey sabi wetin dey like jennifer
So make I tell u se ur road still dey far far
No be se I dey try pour san san for ur garri
I just dey tell u se na only by divine miracle u and toyo go fit marry
For dis my talk, make ur spirit no dampen
As me just dey yarn u wetin dey and how e go happen
This ur love hunt go be serious misadventure
Unless and only if u gree to take my love mixture


Guys, Dont take this personal. I'm just tryin' my best to lace together some rhymes.
Damn! Its so difficult.
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 6:24pm On Jun 29, 2009
Maedan,Thank u-- ur words dey too nice
Infact u don make my spirit rise
With these ur words of encouragement
So I no go shout or vent
For dis our pidgin rhyme tent
Instead I go dey keep am real
Dey drop pidgin rhymes wey dey ideal
To promote tolerance and love
So dis thread go come progress and evolve
In peace and harmony
And not rancour and disunity.
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 11:56am On Jun 29, 2009
Maedan, no mind me jare
I just dey carry dey go like dare
Make TOYOSI20 know se I know dey voke
As na joke me dey joke
As u dey see me so, I dey very gentle
And I no dey involve my self for battle
So make she no get the wrong impression
Se I dey use tactics of force and intimidation
Cos my last post no be confrontation
Becos as u dey see me so, I dey on a peaceful pidgin rhyming mission
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 8:59am On Jun 29, 2009
Duplicate post deleted.
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 8:58am On Jun 29, 2009
@ TOYOSI20

Mba o, I no dey 4 toastin mission
Me just dey express my admiration
For maedan and her exceptional pidgin skill
Cos she dey on top her game like danielle Steele
And that 1 alone dey worthy to praise
Her rhyming skills be like sun rays
Cos e dey shine road for the rest of us
Her delivery come dey on track like BRT bus
And her lines dey captivate like suspense novel wey get plenty twists and flip
So tell me why I no go trip?
Anybody wey hate, make e go jump inside well
Otherwise em go end up 4 cell 
Instead make u dey appreciate
U dey there dey playa hate
Anyhow sha, u don talk ur own
But to me, e be like se u dey clown
No take this my post serious
Cos me no dey vicious
So no think se I dey draw battle swords
Becos me just dey play around with words.
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 1:00am On Jun 29, 2009
Maedan, For dis thread u strong kakaraka like concrete wall
Infact u still dey waka tall
I dey surprised se u never fall
Cos u don dey drop pidgin rhymes since day one
And ur delivery never wan
By the way, I be ur greatest fan
How u dey take do am?
Cos me know se no be yam
Those wey start with u don fall yakata
As all of dem don scamper and scatter
But u, u still dey go strong
Sometimes u dey post rhymes all nite long
Anyhow sha, more grease to ur elbow
And make ur brain no dey hollow
Cos na ur steps me go dey follow.
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 9:52pm On Jun 28, 2009
Wetin man pikin wan talk
As all man don waka d walk
For here, all man na star
Cos our rhymes sweet like nectar
For me, this thin don become addiction
E come be like virus infection
Wey doctor? Abeg, I need medication
Becos my pidgin rhyming skills too sick
Me no be ajebo and I no be geek
So come rain, come sunshine
Na on top dis thread, I go dey wine and dine
Otherwise make una call me swine.
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 8:38am On Jun 28, 2009
@ Just2nice

For dis ur debut, u no dissapoint
Cos ur pidgin rhymes dey on point
As e don become ur vocation
U no need to write examination
Cos u don get automatic promotion
Me go soon send u letter of commendation
But make u go prepare 4 ur induction
Into the pidgin rhyme hall of fame
Cos u don live up to ur name
For dis our broken english game.


Eeeya
So Baba God don call M.Jay
Aaah, O ma se
Anyway,na bros Gode know best
So em will, make we no contest
But to talk true, I go miss Wacko jacko die
And that one no be lie
Nobody fit be like am
Cos to be M.j no be yam
Who go come be the next king of pop?
As all dem other musicians na flop
Anyhow, dis 1 na my small pidgin rhyme of remembrance
Filled with admiration and reverence
For M.J, as em soul don go eternal silence.
Literature › Re: Naija Love Rhymes For Valentine by semid4lyfe(m): 7:07pm On Jun 27, 2009
Una dey always display correct attitude
And as such una dey stand out in the multitude
Una too sabi rhyme
E be like se una dey for una prime
Well, that one no be crime
Me just wan yarn se I don come back from my absence
So dis thread go feel my presence
Dat one be se here go sweet like song by evanescence
Cos my pidgin rhymes too dey make sense
Anyhow sha, how una weekend?
Cos me dey enjoy for my end
In short I dey party dey gyrate
I just say make I take small time partake
For dis pidgin rhyme thread wey sweet pass party cake
So make una no vex 4 dis my senseless yarn
Cos to post pidgin rhyme on top phone no be yam.
Phones › Re: To Mrs Info And Dragnet.pls Help Me love-vendor My Phone by semid4lyfe(m): 5:39am On Jun 27, 2009
Markenny:
hey guys, i forget a lot of things about mobile apps.
i need some softwears and application for  my phone ooo
i dont even kwn the sit to download from anymore

MOBILE PHONE PROFILE
sonyericsson.,.
model:w580i , ,
       
screen shot
games
dictoriay
mobile fonts
bike and table tennis
football
and other more mobile fun
Have you been walking with your eyes closed all these years in the phone section? cheesy grin
Phones › Re: GSM Network Issues And Problems (Zain, Etisalat, Glo, MTN) by semid4lyfe(m): 6:30pm On Jun 26, 2009
Hmmmmmm

No Comment. I just dey waka pass grin
Phones › Re: Only D Best 4 Ur S60v3 by semid4lyfe(m): 4:08pm On Jun 25, 2009
@ Grizzy

Could u shed more light on how to activate the lyrics on TTpod player?
Music/Radio › Re: Are All Rappers Beginning To Sound Like M.i by semid4lyfe(m): 9:58am On Jun 25, 2009
@ rockyfela

Your anonymity in cyberspace is not a license for u to insult people . I stated my opinion without resulting to insults. Couldn't u possibly do the same?

It seems all u M.I groupies can't live with the fact that not everybody is feeling M.I that much.

Like I said when I feel like dancing, I'll rather slot in a Naeto C cd and when I'm in a pensive and thoughtfull mood, I'll listen to Modenine.

The fact is one Modenine track  packs more multies, metaphors, punchlines and wordplays than an album of M.I

Modenine is the most intelligent rapper in Nigeria.
TV/Movies › Re: Jenifa the. blockbuster by semid4lyfe(m): 6:53am On Jun 25, 2009
@ Stellacool

Read what u posted and tells me if it makes sense.

I wonder who gave u access to the internet sef.

Aaaah, o ma se o! Owo ti jo no. Money don miss road.

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 379 380 381 382 383 384 385 386 387 (of 406 pages)