Theophorus's Posts
Nairaland Forum › Theophorus's Profile › Theophorus's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 21 22 23 24 25 26 27 28 29 (of 114 pages)
descarado:Check my Bio on my profile, it will help confirm your statement. Thank You. |
Ebenezer2021:Thank You and God Bless You. |
Ihibehe Effiong Abeg continue ehn but Sha reason the source of wetin you talk ooo. If na Hatred, na you know wetin you go dabble enter ooo. Well Done. |
CosmeticChemist:Okay ooo, make dem release Criminal so that his boys will stop killing themselves shey? Just negodu. |
Chai, may we never born m*m* ooo. Amen! How you go carry Boyfriend face paste for your Chest? Abeg, make the brother soak the Cane inside Pepper water and give the girl 99 lashes of that Horse wipe. |
Magnus Ozeigbe Abeg Rest. Wetin be your own? He chaotic Abeg he dey higi-haga no concern you. Just dey your DEY amke you let Monday run hin things the way hin understand. Obaseki don run hin own, make una leave Monday to do hin own. Ordinary inauguration na hin una don carry for head dey do publications abi Social media brouhaha self. Abeg, make opposition Rest for now, no be to dey Bulaba-Balablu, make una learn from Akpata. |
Welcome to the Real world. Abeg, be Happy joor and enjoy the moment. Those beautiful blessings, Abeg enjoy their "wahala" joor. |
If you think say most people wen dey claim say dem go school and say dem no be illiterate, if you think say na True dem dey talk Abeg just look up make you reason all the comments. People wen no know the importance of Huge Fx reserve. toprealman: |
Go Church you no gree, Study your Bible you no gree, Give your Life to Jesus Christ you no gree. Con men wen dey disguise go sell Painted Spoon and Sugar for you because you lack knowledge. Ogbeni no go dey follow Herbalist think say na Pastor ooo, shine your EYE. |
Make we fry potatoes? Abeg, make una leave USA make dem face their own matter. Abeg make we face our own matter for Nigeria. |
Okay ooo. Sha, make we scrap NNPCL or make we Remove Refinery Maintenance from their Budget and make dem sack all Refinery staff, make NNPCL come dey do karakata of Petrol till when we go Scrap dem finally. |
Congratulations to her. Abeg which Movie she act for Nigeria before this one? and who be the Iya ah? She na the one wen Barb gorimapa abi which of them? NB: I dey available to act role of President for movies Sha, atleast from there I go begin strategies how to do President of NG. |
Jostoman:Before nko? See ehn, if PBAT give me Ministerial appointment I go reason am ooo. |
Seriously, so this woman self go gree work with PBAT. Well, na PO remain to be given Ministerial appointment, from there he go mobilize ElluPe71 votes for PBAT2027. |
Okay. Make I Waka pass as this one no concern me. |
Before nko? Na who she expect make dem send? Abeg, if you no fit go message, Abeg get House girl for them or make you automate everything for house for them. |
Things dey happen. Oluwa Remember Me too. Congratulations to the New appointees. #This Government Must Favour Me. |
Dem give you work to do, you go dey sit down for office, you sabi say na work dem say make you come do. Well, congratulations to them Atleast "former minister of" have been added to their name. #This Government Must Favour Me. |
Dem no know say dem fit comot their hand from the cooky-jar. Some of them get Children for Foreign Universities wen dem dey use Nigeria Fund their lifestyle. While some dey use Nigeria fund their wayward lifestyle. Well, day don break, make dem use water wash their eyes cos matter don reach their side ooo, if na corrupt money dem dey chop before, na now dem go now say no Champion forever. |
Any level wen you dey for this Life ehn, Just dey Humble cos no Winner forever, everything na about time. So use your time well by investing in the Lives God has place around You. #See how David hand dey person neck like say na him boy. ![]() |
Just like EndSars people, if you no be Theif wetin go make you dey reason Police wahala? You see that Oyo, Edo and Ondo ehn... Na Yahoo Obasek and Makind and Ayedati dem be na why dem dey run be that. |
PBAT till 2031? Well, arrangements don dey arrange for Baba second term. |
Baba dey find MONOPOLY with High billing. He still wan add to the problem of Nigerians. You Cement na him cost pass and you don dey do same for PMS already. Nothing wen FG never do for you but you still wan collect everybody Bread. |
Well done Mr. Sanwo-Olu. Itesiwaju Eko. We wish this kind of Development can be replicated all over the SouthWest. |
Imagine, the wahala wen untrained children don cause naw. Hmmm! May we Never be Unfortunate in Life. |
Abeg make everybody go their house. May we sha, never be Unfortunate in Life. Amen! |
Which Church dem for Arrest them? Una just carry random people dey use am drive traffic? Laslas, na person wen no Read hin Bible loose guard. |
May You never be a Mumu. You got delivered from who was using You as Cumming tool and got someone who value you but still use your hand throway the Gold. |
I know say GSM must dey dere. Baba sabi use Media hype and control but wait make he handover first, na that time you go know WhatsUp. |
When Flood happens in other Regions they Blame the Government but if it happens in their Backyard they Blame Nature. If na dem dey Government dey go defend their brother but if na another person na so so Insult and Complain. #This Government Must Favour Me. |
If you dey among people wen dey critics LASG but come do fem for RSG then na Hypocrite you be. Inside Rivers and Lagos which one dey more expensive to live in? |
This Life ehn, Just do well and prepare for your eternity cos you fit be Next. |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 21 22 23 24 25 26 27 28 29 (of 114 pages)