Theophorus's Posts
Nairaland Forum › Theophorus's Profile › Theophorus's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 22 23 24 25 26 27 28 29 30 (of 114 pages)
Beverlyjean:How Old are you and the people who liked and share your comment? If they refuse to do that Road you think it is the FG it would affect abi? Well, it shows the level of your reasoning. |
Good, una do well but make una remember say na una money dem go use build another one wen go fine pass the one wen una burn. |
He get places wen if you no get money, no just bother say you wan buy land for there cos na waste. And e get area wen if your account Balance no be hundred of millions no just bother say you wan buy land cos na still waste. Maybe one day we go enact that Mortgage thing wen Oyinbo dey do Sha so that the "Poor can breath". |
Eeyah Well Done Mr. Fubara. Never begin cry cos matter still dey come. |
Una mean say APC get una Phone numbers? Una mean say dem know all of una wen be witness? Una mean say una state no get CSO again? Una mean say una CSO of Governor no fit do anything? Abeg make una stop this whining joor. |
Just compare the before and after picture and there you have your Answer. What God has made plain, you should never make crooked. |
Why do we dislike Nigeria so much. Where did OP get that Pix of Train track in current Lagos? |
Okay, the final pieces are beginning to set in place. End of an Era. End of an Emperor Beginning of another Era. May the New Era bring Blessings and Peace to the people of Edo state. NB: Prepare because one day you self go kpai and na throne of Judgment be that ooo, so Abeg Prepare ooo. Make Peace with thy creator. #Maranatha. |
Make Husbands dey Help their Wife Fold-Rub and Suck the Breast always. Salute to those women who took the Bold step and survived. May we all always be in Sound Health. |
This Regime abi Government Go Favour Me and My Family. Amen! |
Some people go dey claim Witch hunt but still na still. All the Best to everyone. |
Anything for the Money Bag. Oya, World Bank come and give your clients free money Atleast make dem cash out. |
Dey Dere dey reason say na Politicians be Nigeria problem. Shebi you see naw say ordinary estate chairman dey zuzzu. Civil servants na another cubicle of things. Abeg, na only God go fit deliver this nation from Corruption. |
Dangote wen dey use Nigerians play Ping-Pong but Hatred for PBAT has blinded the citizens. Cement na him dey first increase Price and everything wen hin dey sell but no wahala Sha everyday for the... One day for the... |
Dem dey Drum for you and You dey Dance hmmm watch ooo because once gbege happen na only you go remain ooo. |
Continue, since na una be Court wen give ruling make una continue. Person wen like Vawulence make he prepare to collect Vawulences. |
Eeyah! Na naw your eye clear abi? When dey among those wen dey share the "National Cake" you no know abi? Abeg, shift joor. For you Info, the Children of this age learn from una, dey just dey wait to continue from where una stop ni. Na only Miracle go fit save this Nation. Na why Voting and Protest no get any effect be that. As some dey protest, other go backyard go dey Collect Money. |
DaddyCoool:Well, let me stop explaining Poverty na Wealthy Ievel I dey Enter now. |
Dey gave Saraki Otoge things because of things like this and unfortunately this current guys are doing worst than Saraki naw. You think your Friend is better than those in Aso Rock abi? My brother if you no take heed to yourself, you go do Worstest. |
Badassniggga:Well, thunder wen go Strike Me, must definitely be a Thunder of Blessings. Well, I stopped voting in 2011 because I realize Voting will never solve Nigeria's Problemses. But you see this Fuel things ehn, just reason Dollar-Naira rate and you will get the problem with it prices (bear in mind that Nigerians are always looking for way to shortchange the system. Finally, Our Leaders are a reflection of Us and the System is a reflection of the People. #Peace |
Zeal0000007 Are you sure that Pregnancy is 3Months or More? I will encourage you check your time line with her and be sure that you're the real Father of that Baby. Someone who really Love you cannot be doing like that and asking if she is... But sha I pray make your Hustle Pay so that you can Prepare adequately for the Baby's arrival but Abeg, check your Timeline with Her and do scan to calculate say you be the legit Father ooo. Cos this wen una never enter Marriage wen she don dey Bulaba so ehn. |
Poverty is NEVER genetic. How Rich was Baba Obj's Dad? How Rich was Adenuga's Grand Dad? How Rich was Innocent Chukwuma's Grandfather? Where is Odumegwu Ojukwu's Sons? Where is MKO Abiola's Son? Where are the Abacha's that it was claimed once said "Even if all their properties in Nigeria is seized they can never be as POOR as Dangote"? Remember for the Abacha's to refer to Dangote as Poor, it means their Wealth then was... |
So, Bobo no gree for Baby Oil na why dem no give am Grammy be that. ![]() |
Firstly, THIS GOVERNMENT MUST FAVOUR ME. Okay, back to the matter of Fuel Price increase, Abeg anybody wen dey pray make Naira dey depreciate make he no complain about Price of Fuel ooo cos na Global product and na Global Price he dey work with. Una say T-Pain dey pay himself Subsidy and Baba don comot am finally, so no Subsidy for am again. Una dey pray make PBAT fail so una go fit tell other say ntoor we tell una say our Candidate better pass but una forget say if shit hit ceiling na everybody go collect. Sha, THIS GOVERNMENT MUST FAVOUR ME. AMEN! |
Quick questions: 1. Who be the leader of each of the Protests? 2. Wetin be their clear demands? If you can answer this questions without balabuling then you will realize where the problem came from and learn. If Voting fail una; Go to court fail una; Protest still fail una Abeg make una find another strategy. #THIS GOVERNMENT MUST FAVOUR ME. |
Make we sha thank God say no be those Florida kinda of things dey sup for Nigeria. NiMet wen just dey disguise, we sabi dem just like their NNPCL colleague. |
May God deliver Us from enemies within and enemies without. Check that matter na people wen no like the man run am. I have never been to Unical before but I can tell you for Free; That lecturer na one of those people wen want make he good for everybody but some people with Bad mind no like things like that so dem kukuma victimize the Man. Check well, the man no dey Collect Bribe and na Good Man wen dey help people. |
Yes ooo. This Government Must Favour Me for Sure. Amen! |
3 out of the 4 suspects are less than 25. 2 out of the 3 that are less than 25 are Ex-convicts. They also have Libya Dinar with them. Hmmm, my counsel is "Train up a Child in the way He should Go..." My Prayer; "Lord please deliver Us from every form of Evil". |
Aaaah! Who raised this kind of Wicked Women? Who raised people with this kind of Devilish mind? Aaah!... This one na real issue ooo. Make dem no release that kind woman ooo. |
Na who go sponsor Me to be President of NG I dey reason naw. Congratulations Monday, na your time so flex. Mr. Obaseki just dey corner dey reason hin life, Kai How are the "mighty" fallen? |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 22 23 24 25 26 27 28 29 30 (of 114 pages)
