Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,195,067 members, 7,956,982 topics. Date: Tuesday, 24 September 2024 at 01:15 AM

AS E DEY Happen(a Pidgin Story) - Literature (8) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / AS E DEY Happen(a Pidgin Story) (31953 Views)

"Nwa Aba Na City" (a Pidgin Story) / As E Dey Happen (pidgin Tory Wey Sweet Wella) / Man Wey Dey Reason (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (5) (6) (7) (8) (9) (10) (11) ... (16) (Reply) (Go Down)

Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by bercarray(m): 10:42am On Jul 27, 2014
edogho: buy am na. and my joypad too. e charging port just spoil for d second time. u go buy?
how many phones i wan use 2geda,abeg jare,anyway i go chill till u start updatn
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by VigorousV(f): 1:50pm On Jul 28, 2014
Back nd beta...hws d family?

1 Like

Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by bercarray(m): 6:07pm On Jul 28, 2014
VigorousV: Back nd beta...hws d family?
erm....erm...we are fine,wen av u gon to b4?
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 7:14pm On Jul 28, 2014
VigorousV: Back nd beta...hws d family?
Welcome!!!
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Lorlaahlozz: 12:37am On Jul 29, 2014
Re we there
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by edogho(m): 12:41pm On Jul 29, 2014
tandagidigbarism as prof sammy talk no dey for dictionary o. no do mistake speak am anywhere o. If e don end let us know now. d next time i come online na tru mi lappy. so expect me for our site.
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 4:41am On Jul 30, 2014
edogho: tandagidigbarism as prof sammy talk no dey for dictionary o. no do mistake speak am anywhere o. If e don end let us know now. d next time i come online na tru mi lappy. so expect me for our site.

e neva end o. na my phone cause am. i go continue am here when i get a good one later.
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by eneLight3(f): 9:09am On Jul 30, 2014
haba I wan die for suspense.. where the continuation nau embarassedhaba I wan die for suspense.. where the continuation nau
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by stormybucci(m): 2:41pm On Aug 02, 2014
sammyhoe i haf dey here again ooo, waiting 4 update nd if nah 4 our website u upload am, let me know ooo

1 Like

Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 4:38pm On Aug 02, 2014
stormybucci: sammyhoe i haf dey here again ooo, waiting 4 update nd if nah 4 our website u upload am, let me know ooo

Okay no qualm...but have you read it all here?
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 4:47pm On Aug 02, 2014
Visit http://www.ebiag.com/cstory.php?post=post60&ptop=SammyHoe&ini=0 after 8pm daily and let's talk about how we spent the day wink
It should keep the ebiagites in oneness. Meanwhile, I would keep posting my stuffs on Nairaland till further notice.
Thanks to all EBIAGITES!!!
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by stormybucci(m): 6:32pm On Aug 02, 2014
SammyHoe:

Okay no qualm...but have you read it all here?
i started reading it immediately u gave me d link nd am through with it... make dat titi no fall chiboy hand ooo
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 11:50pm On Aug 02, 2014
stormybucci: i started reading it immediately u gave me d link nd am through with it... make dat titi no fall chiboy hand ooo

Now AS E DEY HAPPEN PART TWO IS HERE!!!

GHEN GHEN!! GHEN GHEN!!
grin grin
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 12:36am On Aug 03, 2014
~~~~AS E DEY HAPPEN (PART TWO)~~~~~~~

Dedicated to LORLAAHLOZZ and all ebiagites who takes the pain to start their own stories last month/this month. Pls if you are an ebiagites who haven't written a story, pls do because you can do it. WE ARE ABLE!!!

Also DEDICATED to LARRYSUN, the man who won the 100-word flash fiction organized by Kenewriter.

Dedicated to all AEDHA dwellers.

[color=#770077][b]

PART TWO: CHAPTER ONE

I rub my eyes like say stone don enter ram. The thing nor fit see clearly again o. Abi no be Titi dey front so? How manage? How Titi go dey share that kind testimony for new year day? Over my dead body! I tok kon snap my fingers.

My body just dey shake like person wey just stop dey sniff cocaine. Abi na Parkinson disease I develop suddenly? Person wey I love wan kon go marry person wey I hate. Kasala go burst today.

Pastor begin do new year prayer:

"Yes, we are in the new year 2014. Can someone give a loud shout to the lord!!?"

Titi begin scatter ground with her loud shout kon dey raise her hands like say she wan touch ceiling. Me just open one eyes down like Nokia torchlight phone wey no fit off again.

Bomb scatter church suddenly. Guy, the thing too too sound joor. Nobody fit even think say Boko Haram don enter Lagos. Kon see race. Titi don evaporate sharperly.

"Come back! Come back we have not collected our offering!" Pastor begin shout loud, but church Don scatter already. "It is just mere banger! Banger! please come back to pay your offerings. Offering time..."

Na only pastor dey for that one o. This one wey we don dey here tay tay say Boko Haram wan bomb places for January 1. Na that banger sound remind people of that thing wey kon put fear for everybody mind. The roof of church don even catch fire sef. Na some ushers run go fetch fire extinguisher take off am. Nobody show face say Na him throw the banger enter church.

Stampede don happen for entrance as people dey rush comot for church. Yet, Titi no even dey where I fit see am. Chai! Yoloba girls too dey fear mheen!!!

Who kon throw those heavy banger enter church nah? This one wey be say no other church for that street open church crossover programme, person kon still get the gut dey frighten people wey risk their life come out for midnight for the crossover service.

If no be Titi way I find come church, me for dey my house dey rest sef. Now na bad news I kon use my ears hear. Anyway, things never spoil at all at all. That wedding no go hold Na Hin be the thing. Na me must marry Titi, no matter what.

One mind tell me say mey I go meet pastor for front tell am wetin happen, but the second mind tell me say make I get patient small.

I begin waka go my house fold my hands together like person wey don bedwet. I see where den dey roast suya Na so I branch. Na #100 dey hand, but e go fit reach me chop small suya Na. I join the suya queue like 'oya'.

The mallam sharp die, just like Hin knife. I remember those years wey mallam dey deal with the Lagosians home and away. Den go kill yourba for north kon kill dem for their backyard(Agege)again. Na OPC bring abrupt end to that kine thing o.

Sharply, the 'aboki' don run butcher the meat roll am inside newspaper for me kon sama pepper and onion on top for me. Na garri me dey like use suya chop o, but this time around me go just eat am like that because me no wan use garri start new year, else, person no go get money take eat real food throughout the year. Na dat kine believe grandma slice my head put.

As one chunk of suya enter my mouth like this, my heart vibrate like say my Tecno phone dey right inside my ribs dey vibrate. Na my conscience grip me so.

"Wetin happen?" I ask myself. Na my brain function like mouth reply me say, "You just chop your offering money."

"Chi mo! For new year? Kai! I don enter ram."[/b]

2 Likes

Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Lorlaahlozz: 12:45am On Aug 03, 2014
Lmao cheesy


I have miss this story gidi gaan oogrin

1 Like

Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 12:54am On Aug 03, 2014
Lorlaahlozz: Lmao cheesy


I have miss this story gidi gaan oogrin

Now it is back!!!
I saw your new story, you're really trying, but pls don't make it too informal, you don't know you might be publishing it soon.

Replace all your 'd' with the; your 'nd' with and...etc.
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Lorlaahlozz: 12:56am On Aug 03, 2014
SammyHoe:

Now it is back!!!
I saw your new story, you're really trying, but pls don't make it too informal, you don't know you might be publishing it soon.

Replace all your 'd' with the; your 'nd' with and...etc.
ohh..tanx
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 1:16am On Aug 03, 2014
Lorlaahlozz: ohh..tanx

No tanx my 1drfl sis.
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by tbmas(m): 1:34am On Aug 03, 2014
Cool story bro
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by maputohq: 6:11am On Aug 03, 2014
Cool...Following.
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 6:34am On Aug 03, 2014
What's up, no die yet
eneLight3: haba I wan die for suspense.. where the continuation nau embarassedhaba I wan die for suspense.. where the continuation nau
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by 3Dimension: 7:21am On Aug 03, 2014
I don. Miss this story like mofedaku
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by LarrySun(m): 8:11am On Aug 03, 2014
This is very nice. Thanks for the dedication.

I've never read any of your stories before but I'm following this one and 'We Are Able' loyally. I hope to be intrigued.
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 1:10pm On Aug 03, 2014
Happy Sunday to you all wink
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by dammygoody(m): 1:33pm On Aug 03, 2014
SammyHoe: Happy Sunday to you all wink
happy Sunday prof...
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by stormybucci(m): 2:40pm On Aug 03, 2014
happy sunday aedahites!!!!
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by DONMAYOR19(m): 10:41pm On Aug 03, 2014
Imagine me dey for ebiag website dey wait for update, why una dey here dey chop leave me, no be so, na ojoro una dey do now o...sammy me na story reader, not story teller grin. Just kidding thou.
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Holluwaphlexy(m): 11:15pm On Aug 03, 2014
*clearz Throat*>uhnu~uhn< Oga Sammy Abeg Continue As I Dey Sip My Alomo Bitterz Dey Go Vv
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by PrinceAdepoju(m): 11:18pm On Aug 03, 2014
E be like say I don catch up with una grin

Wait ooo, so na Titi name Goke go use for facebook.
The guy bad ooo...

Anyways, me dey enjoy you jare, Sammy.
you be confirm guy!! cheesy
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by bercarray(m): 11:22pm On Aug 03, 2014
tank God o,i op say we no get any delay again
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 2:15am On Aug 04, 2014
[b]January 1, 2014
7am-9pm

The food way I cook for new year nor even sweet for my mouth at all. If I know I for allow that girl help me cook the food; that girl way wan make sure say she get me by all means. If to say I invite her to cook for me, she nor go think twice before she go gree but Titi go dey do yanga if to say na her.

I receive some text message way dey wish me happy new year. Now na another year we dey so, yet the person way I wan marry I never sabi am. Maybe make I begin do sharp guy joor. Emeka don invite me say make I follow am go club many times but I go dey tell am say I no like that kine thing. Maybe I fit see one babe for club, who know. E be like say this night na me and Emeka go gather go that club house.

Emeka hold me kon shake me like Tecno phone way dey vibrate.

"Yes! Now you sef don dey think like big man! I like your decision, Emeka. No P, I go carry you go tonight. I go spend on you so tey..."

"Eh, eh, eh...I no send you message o Nneemeka. Wetin I dey find go there na housewife, nothing else."

"Wife?" Emeka laugh. "Wife for club?"

"Yes na!" I tok kon give Emeka one close look. "You think say good girls no go dey there abi?"

"Well. Me no tok say dem no fit dey o. But wait o, you no dey run that Titi rons again?"

"Forgot that one joor, she don get owner jare."

"How you take sabi?" Emeka ask me with strong face.

"She share testimony for church today. She tok say na Olagoke Adeyemo be her Mister Right. Me don give up jare."

"Olagoke? That 419?"

"Yes o, na him."

"Come, Wetin you kon dey yarn here? Make we treat that guy fvck up nah!"

"How we go do am?" I ask Emeka. Emeka whisper inside my ears. I laugh. E go good like that jare.

Me and Emeka meet for junction around that kine 8pm. Me don Behind wella. I go make sure say I see person woo tonight wella.

The DJ just dey start when we reach the club. The music just dey rock like wetin happen. People begin step to dance floor. Me sef join them like say I don tey for clubbing too. Na second time way I go taste bear be that.

That DJ sabi mic songs abeg. I just dey feel am well. One babe roll come my side. We begin dance together. She tall kon dey pretty. She discover say I no fit dance so she begin help me. Me just count myself lucky say I don see fresh fish. Suddenly, she begin roll comot for my side just the way wey she take roll come before. I roll follow am. She don face another guy sha.

I look myself. Wetin wrong nah. I no bad for handsomeness and appearance na. I raise my face make I see who be that guy way wan hijack Sandra, the girl wey dey dance with me. Our two faces meet each other. Na Olagoke Adeyemo!!!

Now I kon sabi wetin den dey call interlude for film. I just shock so tey I no fit do anything. Hin too halt Hin dance kon dey stare for my face. The space of time wey both of us no talk go fit do three advertisements come back.

"Titilayo Adelanwa," I tok point finger for hin face. "You are under arrest!"
[/b]

1 Like

Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by 3Dimension: 7:45am On Aug 04, 2014
"You are under arrest!!!""

#epic

(1) (2) (3) ... (5) (6) (7) (8) (9) (10) (11) ... (16) (Reply)

My School Love / Dealing With Plagiarism Of Nairaland Stories By Rogue Sites / A Bolt From The Blue (18+)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 47
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.