Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,154,755 members, 7,824,164 topics. Date: Saturday, 11 May 2024 at 01:51 AM

AS E DEY Happen(a Pidgin Story) - Literature (5) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / AS E DEY Happen(a Pidgin Story) (31069 Views)

"Nwa Aba Na City" (a Pidgin Story) / As E Dey Happen (pidgin Tory Wey Sweet Wella) / Man Wey Dey Reason (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (16) (Reply) (Go Down)

Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 12:25am On Jul 08, 2014
Lorlaahlozz: And m always ever following a ur stories
i'll update ebiag season 3 today by God's grace with a PC instead of my beloved fone which is now sick grin
I hope you're enjoying ur compulsory holiday.
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 2:26am On Jul 08, 2014
tell?" I tok. "Titi don tell me say na Photoshop office be that before nah. If you no blind you go see the Photoshop wey den write for hin body now."

"See, Chibuzor, Photoshop no be office at all, mey I tok truth now."

"Wetin e be?"

"Na one thing wey den dey use do design," hin tok. "I go show you make I run go bring my laptop. Chiboy, you be correct mugu!"

"Na you be mugu no be me!" I tok as Emeka dey rush comot. "Oya, mey I continue my chat with Titi joor!"

Immediately I don continue my FB chat. Na only one thing wey I sabi for internet be that; two jare(plus Yahoo), yet Segun don issue me certificate say I be qualified Phone Scientist.

"Have you seen the pix, Chidear?" Titi chat me.

"Yeah, babe. I see it!" I text am. "Thank you."

"It's my pleasure darl...have a nice day."
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by bercarray(m): 10:19am On Jul 08, 2014
small tym nw i no say we go get there,even dat sef u no update am finish reach d place wey e be 4 here,maib na me no srbh am well,y u no try bing.com
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 5:07pm On Jul 08, 2014
bercarray: small tym nw i no say we go get there,even dat sef u no update am finish reach d place wey e be 4 here,maib na me no srbh am well,y u no try bing.com

Bing? Lol...
Well...I'm still on yarn me too...
I'll update as soon as possible over there and best readers still gets d award
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by PrinceAdepoju(m): 3:22am On Jul 09, 2014
I don reach where you guys dey, make we dey wait for update together..

Sammy hoe, una well done sir oo

1 Like

Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 3:20pm On Jul 09, 2014
PrinceAdepoju: I don reach where you guys dey, make we dey wait for update together..

Sammy hoe, una well done sir oo

Tank you sir
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by grailer: 5:35pm On Jul 09, 2014
angrywhere this guy go na?

I dont lyk suspence

1 Like

Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 6:28pm On Jul 09, 2014
grailer: angrywhere this guy go na?

I dont lyk suspence
Tinz don't happen in one day...pls try to like suspense cos it's inevitable here wink
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by 01emek(m): 10:22pm On Jul 09, 2014
SammyHoe:

U neva read this thing b4 ni
i never read am oo! I wan make e plenty be4 i start to dey read becos i no like suspense! if you notice i have nt commented in any of your stories except EBIAG..
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Profkomolafe(m): 9:59am On Jul 10, 2014
oga sammy hoe, abeg double up or tripple up, we ah wait ing faaa.
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 3:37pm On Jul 10, 2014
Profkomolafe: oga sammy hoe, abeg double up or tripple up, we ah wait ing faaa.

No vex, na now now I just subscribe...I go update l8er 2day.
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by DONMAYOR19(m): 4:14pm On Jul 10, 2014
SammyHoe:

No vex, na now now I just subscribe...I go update l8er 2day.
do quick o bro, still waitin patiently...we almost there anyway.
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by zeenab(f): 10:26pm On Jul 10, 2014
Waiting patiently. Back to ghostmode
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 10:54pm On Jul 10, 2014
zeenab: Waiting patiently. Back to ghostmode

I'm so so hapi to have u here.

Back to ghostmode
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by zeenab(f): 10:58pm On Jul 10, 2014
SammyHoe:

I'm so so hapi to have u here.

Back to ghostmode
lol where the update na?
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 11:19pm On Jul 10, 2014
zeenab: lol where the update na?
e dey come
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 12:26pm On Jul 11, 2014
Hi sammyhoe,pls continue ur story,and also pls continue hope and the island of greatness back,pls,the story is vry interesting and captivating

1 Like

Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 3:04pm On Jul 11, 2014
MojAyo: Hi sammyhoe,pls continue ur story,and also pls continue hope and the island of greatness back,pls,the story is vry interesting and captivating

Thanks I'll do...but where actually are you on HOPE AND THE ISLAND OF GREATNESS?
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 3:51pm On Jul 11, 2014
SammyHoe:

Thanks I'll do...but where actually are you on HOPE AND THE ISLAND OF GREATNESS?
u knw u didn't finish d season 2 before they wipe off the data,pls I would like u to continue back,Thanks

1 Like

Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 4:37pm On Jul 11, 2014
MojAyo: u knw u didn't finish d season 2 before they wipe off the data,pls I would like u to continue back,Thanks

It's true, but what was ur username initially because I can't remember seeing this username on that thread earlier?
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 7:39pm On Jul 11, 2014
SammyHoe:

It's true, but what was ur username initially because I can't remember seeing this username on that thread earlier?
yeah,I was once a guest reader on ur story
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 12:20pm On Jul 14, 2014
MojAyo: yeah,I was once a guest reader on ur story

And now I can see d face of my guest.
Welcome. wink
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 12:22pm On Jul 14, 2014
http://98.139.21.31/search/srpcache?ei=UTF-8&p=as+e+dey+happen%28+a+pidginn+story6+by+Nl+best+writer%2C+may+2014+sammy+hoe&pvid=wLW5wDk4LjHdtVCLU7VAjQDsMTk2LlPDvGP_r85o&fr=sfp&u=http://cc.bingj.com/cache.aspx?q=as+e+dey+happen(+a+pidginn+story0+by+Nl+best+writer%2c+may+2014+sammy+hoe&d=4659461017317493&mkt=en-US&setlang=en-US&w=QN88hCwqYmdG4Pb2YOmok2jnwDXD66Cj&icp=1&.intl=us&sig=yQAU5eX5bm9RzrpJttwD4A--
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 12:37pm On Jul 14, 2014
SammyHoe:

And now I can see d face of my guest.
Welcome. wink
tanx dear,love ur writing

1 Like

Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 12:40pm On Jul 14, 2014
MojAyo: tanx dear,love ur writing

It's my pleasure...
U can try out other stories I wrote too:

Everybody Is A Genius
Hope And The Island of Greatness
Honeymoon In Prison
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 12:54pm On Jul 14, 2014
SammyHoe:

It's my pleasure...
U can try out other stories I wrote too:

Everybody Is A Genius
Hope And The Island of Greatness
Honeymoon In Prison
the one I love most is hope and d island of greatness(that allegory)and I hope u continue on dat too
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 2:39pm On Jul 14, 2014
MojAyo: the one I love most is hope and d island of greatness(that allegory)and I hope u continue on dat too

Yea, but give me a little more time.
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 2:43pm On Jul 14, 2014
SammyHoe:

Yea, but give me a little more time.
okay
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 1:41am On Jul 15, 2014
[b]Emeka don run waka enter my shop back. Chai! if u see the guy face eeh! E just dey use vex waka come. Which kind palavar kon be this nah? Wetin dey worry Emeka sef? Wetin be hin problem sef? Na hin get the money wey I spend ontop my Titi ni?

"Chibuzor, you be correct mugu!" Emeka tok siddon my side put hin laptop down. "See wetin den dey call photoshop for here!"

I no wan even listen mey I hear wetin hin dey yarn. Na by force? Emeka disturb me so tey I look hin side. Hin run use hin camera snap me kon connect hin phone for the laptop.

"So, where the thing wey you wan show me now?" I ask am. I don dey lose my patience already.

"Get patience smallu nah," Emeka tell me. I soon see myself inside hin laptop.

"Guy, how you take do that?" I dey look am with surprise.

"Simple tekinology," Emeka tok like ibo boy. Na the way wey hin dey take call 'August' na hin dey funny me pass. He go tok say 'Ogosu'. Hin January sef na 'Jenuwari' hin dey call am.

"Eewe!" I shine my eyes dey look the thing. Wetin shock me na one calabash wey I see ontop my head suddenly for that picture. When hin snap me just now, nothing dey ontop my head. How that calabash kon take get there? E kon be like say I wan go do sacrifice take give Ekwensu.

"How come? How you do am?"

"Na Photoshop work be dat," Emeka tok give me. "You never see nathing!" hin tok like those Agbero for Ladipo Oshodi.

The second one wey I see na him make me shock pass. I just see say one woman back me for back like baby. Na only my big head dey show for ontop the wrapper wey the woman take tie me.

"Emeka! You be winch?"

"Na still photoshop, oya make I show you how I take do that one wey police kneedown for civilian."

Emeka begin drag picture up and down. Hin get one picture wey one person dey kneedown. Hin get another picture of one police wey dey collect bribe for express road. Before I know am, he don cut the police uniform comot kon go gum am ontop the guy wey dey knee down body. He do many many other magic wey I no undrlerstand and then the thing don ready.

My mouth don pave way tey tey. Den don sell me wey I no no. I don begin dey bite my lips; my head don scatter.

I no believe say my Titi fit do that kind thing for me. I wan vex text am blast am immediately, but Emeka say mey I no do that.

"We go fit catch am redhanded," Emeka tok. "She go fall enter our trap."

"Hmm!" I sound kon dey look ground like person wey dey hear smell of mess. No be the fact say I lose my money ontop nothing dey vex me, but the fact say my own facebook Titi wey I wan marry fit dey give me that kine big lie lie.

"So, how you kon think say we fit catch Titi redhanded nah?" I ask Emeka.

"Na simple thing Chiboy. Just relax! Pesh!" Emeka dey rub hin chest say make I nor worry.

Chai! My mind don begin shift back go the real Titi now. Soldier go soldier come na hin be this matter wey dey ground o.

Titi chat me, "Hi, Chiboy!"

I no respond.





[/b]

1 Like

Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by JigsawKillah(m): 7:47am On Jul 15, 2014
Good Morning SammyHoe
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 7:52am On Jul 15, 2014
JigsawKillah: Good Morning SammyHoe

Good morning sir...how was your night?
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 8:47am On Jul 15, 2014
story continuation

[b]My facebook Titi don ping me 'hi' like five times wey I no respond. She send me 'Are you there,Chiboy?'

Me wey I don dey rage already. Me nor go fit marry woman wey no dey honest o. My vex don hot so tey if you cook ontop am, e go fit boil water. Chai! See as this girl use my head!

Na Emeka peep inside my phone see say I no answer the messages wey hin dey send since.

"Chiboy! Wetin dey worry your head nah!" Emeka tok. "Sebi I don tell you say make you no worry say we go hayaj am by surprise. If you stop talking to her, we no go fit catch am o.!"

"Wetin you mean?" I ask Emeka.

"Bring the phone jare!" Emeka shout snatch the phone from me. "Iti mpataka!"

I just dey look Emeka. I no kuku sabi wetin hin wan do with my phone. I don taya sef, anything wey hin like mey hin dey do ontop am. Wetin concern me? Wetin I know be say no money go comot my pocket give anybody again.

"Take your phone back," Emeka tok. "I don respond am."

"Why nah?" I shout for hin head. "Why you respond that kind person nah? I don leave am for life! I go go continue with my real world Titi instead of that flirt wey dey inside phone!"

"You too tok Chiboy!" Emeka tok. "Check your phone first!"

I check the phone see wetin I no believe. Emeka don speak with am at length. I begin read their tok tok:

Titilayo Adelanwa: 3:30pm
Hi Chiboy
3:31pm
Chiboy! Chiboy!! Aww!
3:32pm
What happened?
3:32pm
Are you there Chiboy?
3:33pm
What's wrong sweetie?
3:34pm
Please talk to me, I'm getting scared!!!
8minutes ago
Chibooooyyyyy!!!

7 minutes ago
Chibuzor Orizu:You wan call person name die ni?

6 minutes ago
Titilayo Adelanwasadsighs) You scared me! Why aren't you answering my chat since?

6 minutes ago
Chibuzor Orizu: I be dey take my bath ni o. No vex dear.

5 minutes ago
Titilayo Adelanwa: Hey! Come off that dirty pidgin thing Chiboy! I can't understand it.

5 minutes ago
Chibuzor Orizu: lol...

4 minutes ago
Titilayo Adelanwa: You can communicate in that Queen English of yours Chiboy! I love your English.

3 minutes ago
Chibuzor Orizu: hmm...you is fun-making me abi? Ride on...

2 minutes ago
Titilayo Adelanwa: I'm saying the truth Chiboy!

2 minutes ago
Chibuzor Orizu: Okay...you has no problem...your head is there.

1 minutes ago
Titilayo Adelanwa: (frowns) Chiboy, seems you're very fast on the keyboard now. Wow! Your typing skill's becoming awesome!

1 minutes ago
Chibuzor Orizu: A yam laerning... hey, let us leave that talk first. Titi, I love you.

1 minutes ago
Titilayo Adelanwa: Sure, me too...

30 seconds ago
Chibuzor Orizu: Send me your Account Number, I just feel to sending you #50,000 to buy fine fine cloth for yourself. I want come your place soon.

20 seconds ago
Titilayo Adelanwa: Thanks a lot Chiboy!!! Account Number: 012185334, WEMA BANK, no need
sending branch nowadays, they'll forward it to my account straight. I'll be expecting. When are you sending it Chiboy?

Just now
Chibuzor Orizu: "9am, tomorrow!"

Just now
Titilayo Adelanwa: Wow! I'm blushing!!!


"Chai! Which kind message be this nah, Emeka!" I shout for hin head. Where I wan see that kind big money, 50k!"

Emeka look me hiss.

"You no even sabi coding sef."

"Wetin you dey code Emeka?"
I tok.

"You just sidon dey look wetin I go do that girl," Emeka tok.

Na that same day I see person dey use hin java phone dey browse one site wey I never hear before. The boy just dey laugh like say dem dey tickle am for armpit. I ask am, "Biodun, wetin dey make you laugh like this sef?"

"Na tory o! Chai! Omo, see tory," na so the guy tok burst enter laugh again.

"Tory?" I never hear say person fit dey read tory for phone before. Na so I ask the boy, "Which kind tory be that nah mey I see am?"

"Na one pidgin tory o," the boy tok.

"For Facebook?" I ask am quick, wen be say na only Facebook me sabi for phone. Nothing dey sweet me for Yahoo joor.

"Facebook ke? Wetin concern me concern facebook? Mtchew!" Biodun hiss bury hin head inside hin phone dey laugh again.

"Hey! If you wan cre, no be inside my shop you go kon do that one o! Comot for here now now!"

The boy look me begin beg me.

"Oga Chibuzor nah, please nah! Na because of this tory I run comot house o! My mama pursue me comot with turning stick when she tok say mey I carry elubo go kitchen wey be say na inside toilet I go land."

"Chekwe!" I shout hold my head. E dey possible? How come? How person go forget hinsef ontop phone go enter toilet instead of kitchen? Na lie joor.

I begin dey reason with am. E fit be true sha! Like that day wey I dey chat Titi facebook for road wey be say na small e remain make bicycle jam me. Anyway, I just free the guy kon ask am wetin hin dey even check sef.

"Na tory I dey check o," Biodun reply me.

"Tory for where?" I ask am. "You mean say English reading book dey inside there?"

"No Chiboy, na nairaland I dey o," I tok.

"Nairaland? Wetin den dey do for there nah?"

"Den dey read tory noni," the guy tok enter another round of ogbonge laughter. This time I just provoke snatch the phone from ram look wetin hin dey do sef. True true I read small lines kon see say na pidgin story as he tok.

"Oya, help me do am inside my phone mey I dey read sef," I give am. Me too like pidgin that year sha. Sharperly the guy give me the address where I fit go. He tok say www.nairaland.com. I no waste time, I don reach there. Tekinology sha.

Na literature section me enter straight. Wetin concern me concern all the news wey just scatter up and down? As I reach literature section na hin I see Man Wey Dey Reason

Quick I don click am dey read. Chai! the tory long die o! The thing don even enter page 108 before I start dey read am. E go even better for me sha. Mey I just read am direct instead wey I go dey wait mey OP update every now and then.

Before I enter inside the thread sef, I don bypass many many threads when be say readers dey hala Op mey he kon continue hin story, else...

I see thread like Everybody Is A Genius, like that like that sha! Wetin the guy wan yarn for there sef? Which kind yeye tok be that? How everybody wan take be genius for this world. As much as e take concern me, na only me be genius. Any other genius na original fake.

I even see one thread sef. The title too long jare; na only who write am I sabi! Who write am sef, one guy wey hin username be Ericomoto. Mey I try remember that long name sef? Em...em...okay I don remember: [i]LET'S PLAY THIS WORD GAME CALLED LAST MAN STANDING! I run enter the thread vex come outside again.

"Which kind thing the guy dey yarn for inside there sef?" I begin tok to myself. The guy dey tok say hin dey find person wey go comment last. "Why everybody wan even carry last sef? Mtchew!" The name wey I see last for there that time na Sammy Hoe. I shake my head say chai! this guy don carry last last last.

I waka comot there enter my pidgin tory again jare. Na Flow1759 dey reign o!

Emeka kon meet me say wetin I dey do sef.

"Me don get another website o!" I tell am. "This one sweet die!"

"En-hen! Mey I help you feel am too nah!"

"No problem," I tok kon bend my phone say mey hin sef dey enjoy am.

"So, Emeka how far you and Facebook Titi don go nah? Hope say she never kana say you no be Chiboy."

"How hin wan take kana? Impossible!" Emeka tok like person wey get confidence boku! I laff one kind laff wey make my guy shout, "Chibuzor! Wetin be your problem nah?"

"Na Flow wan kill me o!" I dey tok laugh. "The guy too flow abeg!"

Emeka see say I no even get time for ram sef, so tey hin waka comot my shop. Me no even mind am. Mey he carry go with Titi for facebook chat nah, abi I don kuku give am my username and password.
[/b]

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (16) (Reply)

Abubakar Adam Ibrahim Wins The 2016 Nigeria Prize For Literature. / Best Stories I've Read On Nairaland So Far. / Chimamanda Adichie: "Men Holding The Door For Women Troubles Me" (Video)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 77
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.