Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,193,960 members, 7,952,866 topics. Date: Thursday, 19 September 2024 at 06:10 AM

AS E DEY Happen(a Pidgin Story) - Literature (6) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / AS E DEY Happen(a Pidgin Story) (31930 Views)

"Nwa Aba Na City" (a Pidgin Story) / As E Dey Happen (pidgin Tory Wey Sweet Wella) / Man Wey Dey Reason (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (16) (Reply) (Go Down)

Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 8:48am On Jul 15, 2014
[b]I spend plenty time for the pidgin tory kon say mey I enter another one. This time, the thread wey dey ontop patapata na that LET'S PLAY THIS WORD GAME CALLED LAST MAN STANDING

Mey I even enter there see the thing wey den dey do jare. As I reach there na hin I see wetin the guy dey tok. He tok say den dey find person wey go comment last. But your comment must begin with the last word wey previous person tok.

"Na me go comment last for sure," I smile for my 'title block' mind. Na so I kon begin find where I go post message. When I no see am, I vex drop the phone. When Biodun come back my shop na hin I ask am, "How I go fit comment nah?"

"E dey there nah!" Biodun tell me.

"I no see am," I show am.

"Ah! Oga, na like guest you take enter o. You never register?"

"Which one be guest again?" I confuse.

"Na so you go appear if you no register account for nairaland, oga Chiboy," he clear me.

"So how I go register nah?" I ask. Biodun show me how. "Hmm...Biodun, you too gbaski!"

'Na u o!" the guy wine me small.

Quick, quick, I don do the needful. E no hard me before I open account for Nairaland. Na wetin dey my mind that time be the way wey Titi take dupe me, so I use 'Magawealthy14' open my account. The last comment wey dey the thread tok say 'Today Is Friday!'

Quick, my head don run boot wetin I go tok wey go make me be the last man wey go stand. Oya now, I write Friday na dat wey get many xanxxanxnanx

I relax dey wait for who go fit try that kind jagajaga word wey I write. Na me be champion. Na me be last man standing. Quick I don go back flow dey read hin pidgin tory. But before I enter oga Flow tory sef, my finger don go do mistake click one kind long sermon like that wey one boy write; the boy name na Seun.

I don read am small before I no say no be Man Wey Dey Reason I dey o. This one na[i] HOW TO PLACE AD ON TARGETED AREA[/i] I think say that Seun guy wan dupe Nairaland ni, so therefore I run click report, so mey I report the guy for Nairaland say make den be careful o, say I guy called Seun don open thread to take dey siphon people money enter corner o. Abi nah, I nor fit see truth mey I no talk nah.

Emeka come back tell me say mey I get ready to spend more money o.

"Wetin again?" I provoke. "One chi-chi no dey come out this pocket again!"

"Chibuzor nah! Just mey you spend the last money mey we take catch dat facebook girl as e dey hot, you kon dey show yourself abi?"

"This one no be matter of showing any sef, Emeka. Me no just get chi-chi to waste again. Period!" I vex.

Emeka no fit deceive me again. No be now wey my eyes don dey open enter inside internet world. Na ignorance wan kill me die before. No be here again, Chiboy don wise, olote, mey una carry waka enter corner.

Since last month November, na soso Chiboy Maga this, Maga that I dey here up and down street and I no who scatter that yarn, na Segun for sure. Now sense don boku my head, make nobody no think say hin go fit use my head again o.

I enter my dear literature thread again say mey I check that LAST MAN STANDING THING sef. Na like page two hundred and forty something that thing dey that time sef. Na one girl dey rain that time, her name na Babe2sure. She just dey all over the thread that time.

Wetin surprise me be say the 'xanxxanxnanx' wey I post that time no be the last word standing again. Den don dust am pass. How manage! I shock. Mey I look person wey comot me for position. Na one kind Damex333 name I see there o. Which kind thing? I run read wetin the guy post.

Xanxxanxnanx is not an English word, so let's waka pass

The thing pain me enter bone. The guy don push me comot for last guy standing kon still disgrace me. Walai I go revenge. Na ontop revenge mission I dey wey make me quote am dey vex for am. Instead make people begin console me na sosos abusw den dey open like bullet ontop my body:

Guy you blind
Didn't you read the rule?
Magawealthy14...smh for you
Na your name dey follow you...maga
Illiterate on thread
Waste of space
No blame the guy nah

Na the last quote wey den quote me catch my attention. At least one person don take side with me. Quick quick I don click 'like' for ontop hin comment.

"You get sense!" I tok for my mind kon refresh see say the guy never finish wetin hin wan tok:

No blame the guy nah. I know am personally, na garri hin don dey drink since last two weeks. Like seriously, people no dey read rule? Mtcheeeeeewwww! angry

"What?!" I shout. I don provoke pass elastic limit. Quick I don unlike am kon vex click 'report'. E be like say den don use that report do me sef.

I opt comot for nairaland patapata. Me no go come here again for life. Imagine how guys just serious ontop my matter dey run their mouths anyhow.

[/b]

1 Like

Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 8:49am On Jul 15, 2014
bercarray, I see you...how far nah?
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by DONMAYOR19(m): 9:26am On Jul 15, 2014
Still pipping...and waiting anxiously

1 Like

Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by bercarray(m): 10:00am On Jul 15, 2014
SammyHoe: bercarray, I see you...how far nah?
i still humbly follow oga sammy sir,*bows head 4 respect*but while i wait 4 updates i still dey read everybdy is a genius

1 Like

Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by harrinhurla(f): 8:24pm On Jul 16, 2014
Following kiss
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by JigsawKillah(m): 11:02pm On Jul 16, 2014
Are we there yet


SAW

1 Like

Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 1:47pm On Jul 17, 2014
JigsawKillah: Are we there yet


SAW

Not yet...it's like many posts are missing... I'll summarize it up jare undecided
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by dammygoody(m): 2:01pm On Jul 17, 2014
SammyHoe:


Not yet...it's like many posts are missing... I'll summarize it up jare undecided
exactly prof..

1 Like

Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 7:05am On Jul 18, 2014
[b]Emeka kon meet me again concerning that mata.

"Guy, you just dey make yanga eh," Emeka tok.

"Wetin I do you nah?"

"Me don play with that Titi head wella."

"Continue," I tok. "My hand no dey there again.

"Chiboy, why you dey fall my hand nah? The girl don dey ask for that 50k since two days ago, buh me just dey scope am."

"Na you sabi," I tok. "Nna mheen, me no dey for this and that again, you hear? The one wey all of una don cheat me don do."

Emeka just siddon kule ontop the mata. Hin no just wan give me allowance mey I take breath.

"Okay nah, tell me Wetin you want," I ask am at last.

Emeka clear throat kon sight wella tok say "Chiboy, e for good mey we teach that girl lesson nah. Mey we catch am give godogodo."

"Hmm, na true," I tok. "But wetin kon be the problem nah? Ride on, I free you."

"But we go need small money take do am."

"Wetin?" I look Emeka like say hin be boss me be actor.

"Na 3k we go need o, Chiboy and we go fit catch that girl collect big money from am."

"How? Wetin you wan use 3k do?"

Emeka don sabi say I don dey fall small small. No blame me, na my weak point be that. I too dey believe people too much. Na wetin make me go give one care taker money for one shop be that wey be say na fake. That time, when I wan kon pack enter the shop, I see say somebody don pack enter. Na soso fight we take settle am that year. In short na police kon quench the matter. Na after that time I kon rent the shop wey I dey now.

"Answer me nah? I say wetin we wan use 3k do?"

"You dey sleep?" Emeka tok. "You no here say we wan use am buy bulk sms?"

I don confuse again. Which one be bulk sms again now.

"Bulk sms abi wetin you call am Emeka? Shay na dat kine thing wey den send give me that year say I don win for the lacasera promo?"

Emeka laugh. Anytime wey I tok that lacasera thing, na so Emeka go dey shine hin teeth.

That year eeh, na #2,000 recharge card waka comot my hand because say I wan collect #500,000 wey den tok say I win. Chai! 419 boku for naija o.

"Bulk sms no be that kind thing joor. That one na because MTN go give people plenty free text messages na hin make dat kine thing boku that year," Emeka tok. "Me sef dupe many magas that time too nah! I make my cool money!"

I just dey look Emeka with vex. Na matter of thief wey wan catch thief now. So, Emeka sef dey inside that kine thing.

E be like say Emeka don see reaction inside my eyes na hin make am tok say, "But me don repent now sha!"

"Repent ke? You wey you still wan dupe me last week for that photo matter before I run enter Titi hand."

"Mey we forget that one, Chiboy," Emeka use calm voice change the tok. "So, as I dey yearn you, bulk sms na one package wey be say u fit use am send message make the thing enter person phone with any name wey you want."

"Azzz in!"

"Az in dat kind alert wey Intercontinental bank, abi wetin be there name now, dey send give you anytime wey you go withdraw for inside their account abi if money enter."

"So, wetin we go kon use am do to take catch Titi now?"

"You no grab? We go use am send Titi message say #50,000 don enter her Wema bank account nah! We go put Wema like say na dem send am."

I begin reason sense with Emeka. That kine thing go make sense die, buh me never still know how we wan take catch am o.

"So, how we wan kon take catch am now?" I ask.

"Simple!" Emeka tok. "We go just send the message like that kon catch am when hin wan withdraw am."

One problem kon show face inside our plan sha. Emeka tok say hin go need know Titi name gangan as she no put her name for the account number wey she send inside my facebook chat.

"Na Titilayo Adelanwa nah," I tok. "You no see am for facebook?"

"You dey believe that name?" Emeka tell me. "E fit even shock you say that girl fit be boy sef!"

I open my mouth. Emeka don confuse me again o. I begin reason with am sha.

"Yes! Yes!" I shout. "The account number wey she give me when I send 4k give am for subscription that time na one Olagoke Adeyemo I see inside."

"En-hen. Na guy name be that nah!" Emeka tok.

"Buh she tell me say no be her account number be that dat time sha," I tok.

"Bring am mey we correlate," Emeka tell me. I rush find the teller wey I take pay Titi that time. The account number na the same thing o!

"What?!" I shout. "So, Titi real name na Olagoke Adeyemo! Na wah for waya road o!"

"I tell you!" Emeka tok. "I tell you say this your Titi na original fake! Now we go catch am, just give me the 3k mey I take buy the bulksms."

I dey doubt say the bulk sms wey hin dey tok no suppose reach that amount. Now I don dey wise small small say mey I no dey rush things. People don show me nah, so na wiseness thing now.

"See, na #1,500 I get o," I clear am.

"E no fit reach anyway Chibuzor!" Emeka dey do strong head.

"Okay then, bye bye," I tok immediately. Me no dey for chere cambia.

Emeka just dey find way to take collect 3k. E tok say mey I call hin friend ask am say hin go tell me say na how much den dey sell am be that.

"E no concern me o," I just dey stubborn so tey Emeka tok say mey I bring the #1,500 first.

"You go balance me o," he tok.

"No problem now," I tok. "First go buy am come."

Me don dey wise now, abi wetin una think? If to say na before before, me go don pay am in full. Make Emeka no go put mind say I go give am chichi later, because me no get any chichi to give am again.
[/b]

1 Like

Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by DONMAYOR19(m): 11:55am On Jul 18, 2014
This one is almost close too...we getting there.
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 12:24pm On Jul 18, 2014
DONMAYOR19: This one is almost close too...we getting there.

Yeah!!!
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by edogho(m): 6:38pm On Jul 18, 2014
e be lyk say d tori don dey happen as e dey happen.
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 8:02pm On Jul 18, 2014
E remain small make tory begin dey happen as e dey hot!!!
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by JigsawKillah(m): 9:29pm On Jul 18, 2014
SammyHoe: E remain small make tory begin dey happen as e dey hot!!!

i cant wait sir.....keep up the good work
greetings sir


SAW
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by bercarray(m): 9:40pm On Jul 18, 2014
still on fire gettn close to d boiln point

1 Like

Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by DONMAYOR19(m): 8:31am On Jul 19, 2014
Sammy try meet up nah, ah ah...u starving us here o
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Heymus(m): 1:00pm On Jul 20, 2014
Big ups! to the op!, great job! 've been reading from the beginning now am here. I've been silent though.

1 Like

Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 1:16pm On Jul 20, 2014
Heymus: Big ups! to the op!, great job! 've been reading from the beginning now am here. I've been silent though.

Good...tanx for commenting

1 Like

Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by DONMAYOR19(m): 4:20pm On Jul 20, 2014
Sammy what's happening nah, no update for here again?
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 6:41am On Jul 21, 2014
dedicated to DONMAYOR19, DAMMYGOODY, HARRINHURLA, HEYMUS, MojAyo, Edogho and all other EBIAG FAMILY MEMBERS.

[b]
Me no sabi how I carry enter Nairaland again sef, something wey I don tok bye bye for before before. I run enter that LAST MAN STANDING thread wey dey literature section. E shock me when I see say the thing don get one page pass where I dey before.

I jejely look wetin dey. Many of them still dey ontop my matter sef. One person tok say Magawealthy no get sense na...like hin name na so hin be Another person tok say Where is that Maga?

Then another person kon quote am say Maga is paying me tomorrow! Hurray!

The thing catch my interest so tey I run check who post am. I shock when I see say na one name, GokeYemco419. Quick quick I don run correlate am. Abi na that my Titi Facebook be this, Olagoke Adeyemo.

"Okay, me wan dey sure. I run quote am kon tok say, "Hurray! Hurray! Hurray! How much hin wan pay you?"

GokeYemco419: You want to share the money with me?"

Magawealthy14: Me wan help you flex the money na

GokeYemco419: Na you help me do the job?

I dey try make I just know whether na me be the maga wey this guy dey tok about but hin no wan come straight. I go continue dey ask am question whether e fit do mistake fall enter my hands.

Magawealthy14: Job na hin you wan kon job person here abi? How much your maga wan pay you tomorrow?

GokeYemco419: Tomorrow na #50,000 go rush enter my account o. *But na ear you take hear am o...one kobo no go reach you, guy*

[i]Magawealthy14: O my God! That your maga na real maga o; you mean say hin go vomit that kine plenty money give you.


GokeYemco419: You no sabi how much I pretend na hin cause am. I use power of woman for ram--Titilayo Adelanwa, hian...LWKMD.

So na Facebook Titi I just finish chat with now for Nairaland. I smile. So true true na boy be this Titi. Na 'm' den even write for front of GokeYemco419 name, meaning say him br boy. Okay nah, no problem. Small small hin don dey fall be that nah. I go tell Emeka.

Emeka soon waka enter my shop dey sweat like goat wey dey inside son since morning. Den say goat dey sweat na hin hair no let us see am.

"Emeka, how far the parole nah?" I ask am sharpaly.

"Guy, I don get the bulk sms o. I add money ontop buy am sef."

I know say na lie Emeka dey lie. Me wey I don go do research about bulk sms. Den say that #1,500 go even fit buy 1000 units of bulk sms sef, na hin this guy wan kon dey use my brain for here.

"Shut up Emeka! Do mey you send that message give Titi Facebook tomorrow kon allow me flex the remaining Nine hundred and ninety something SMS wey go remain jare!"

Emeka open mouth dey look me. He wonder say how I take know say na like that he dey be.

"For your mind," hin tok kon use style change topic sharp sharp. "Em...Chiboy, na one problem go kon show face for all our plans o."

"Wetin again? No tok money again o, because I no go give you shishi."

"Shut up!" Emeka shun me. "The thing be say if Olagoke no see the Wema Bank alert for hin e-mail follow the one wey we wan send enter hin phone, our trap fit no catch am o. Hin go suspect say na trick we wan trick am. You know say na sharp guy hin be nah."

"So wetin you need now?"

"If to say I fit get hin e-mail address, e for make brain die. I for just open one email address call am WemabankNigeria@ gmail.com. I pray make hin no even reason go the gmail wey I wan use sef. If not hin no go believe the scam o."

I don dey confuse. E just be like say na grammar Emeka dey tok for my ears sef. Na yahoo me sabi, and na the one wey Segun don open for me since 2011 na hin I still dey use. Me just dey hear gmail for the first time sef.

"Wetin you need gan gan?" I ask sharply. Me no dey for slow motion again joor.

"I need Goke email address," hin tell me. Where I wan get that one? I no even get idea. And if we ask am for Facebook, the girl, abi na guy sef, fit begin kana small small.

My mind flash back GokeYemco419. I run yarn the tory give Emeka. When hin hear am, hin jump wan use mistake put hin neck for fan wey dey number five for my ceiling. E remain small, Emeka head for dey roll for ground like ball, American football.

"Wetin make you jump like that nah?" I shout. "I pity your life, Emeka." I run remember one guy wey jump like that for one advertisement wey dey inside my phone. Hin rob bank successfully, escape enter house. Na so hin unzip the bag see million for inside, jump enter fan mouth. The remaining story na hell hin go go tok am. Hin head scatter for ground like egg wey break!

Emeka tell me reason why hin jump like that. He tok say person fit get another person email address from nairaland. I shock, because me no know say Emeka know abkut Nairaland at all at all.

I just dey observe. Sharply, Emeka don log in to nairaland with hin own account kon go search for GokeYemco419. He click hin name and hin profile come out sharply. Emeka click 'Send E-mail Message to This Member'.

Emeka clap once and tok say Titi e-mail go soon show face.

"How you take know?" I ask am. "You be winch?"

"You mugun nah! You no sabi say you fit get person email from nairaland?"

Me dey wonder how Emeka take sabi dat kine thing, wen be say na JJC e be for nairaland. I ask am wen hin join nairaland.

"Since 2005," Emeka tok. I shock.

"Na lie," I no believe. "Why you no kon tok say u dey Nairaland that time wey I dey tok to you about the site?"

"Den don ban me for life na hin cause am, because I dupe people. Buh sha, I no wan open another account, na why. If not, I go don open am dey dupe them go, but me don change sha."

"Hmm!" I just release breeze comot my nose.

"Kon teach me how you dey do am nah?" I tok. Emeka laff roll comot seat. I just dey there dey look am.

"Chiboy, na talent o. If you no get am come from birth, you no go fit sabi am o."

"I no fit learn am?"

"E no go fit be like am o," Emeka tok. "If e no be panadol, e no fit be panadol."

"Emeka, just dey teach me nah. I go dey pay you salary."

"You no fit pay my money, Chiboy."

"Tok your price first nah."

"You fit pay 50k per month?" Emeka tok. Hin eyes show say hin dey serious. "I get plenty people wey I don teach this kine business wey den don even do freedom from my hand sef."

"Emeka! How nah? You nor even dey sabi you real real abi? I be your guy from day one, you don forget?"

"I know, but na real matter I don clear you so. Pay my money. I go change you comot for mugun but you for mogul."

I just dey look Emeka with one kine eyes. Abi na lie hin dey tok? How hin go dey teach people 419 tutorial dey collect money? Okay, why hin shop never big pass as e dey? Why be say na beke business hin dey do, ordinary rice and beans business? Yet this Emeka of a thing dey owe me close to 20k for some bags of rice and beans wey hin never still pay sef.

"Emeka, if true true you dey teach person 419 dey collect money, how e kon be say you never still get motor? U no get house wey you build, na 'face me I woze you' house you still dey live.

Emeka laff.

"You no sabi nathing," he tok. "Wait until next year mey I carry you go my hometown show you the kine structure wey I don lay down there. Na roofing level I dey already. You siddon there, you hear?"

"Why you nor fit build the house for Lagos nah? I no believe you."

"Kai! True, true Chiboy, you be bastard Ndigbo. How you dey yarn that kine rubbish nah? Mey I build my house for Lagos, tufiakwa? You no remember biafra war? E go shock you wen den go tell everyone mey e dey go back hin papa land. Me go just jejelly waka go inside my mansion for my town while you go kon beg me mey I accomodate you. True true, you don ever see igbo guys dey build house for Lagos when den get their hometown for East?"

[/b]


Attention: A competition is on right
now: GO AND VOTE FOR THE WRITER
WHO YOU FELT HAS UPDATED MOST
THIS MONTH, JULY. COULD BE ANY
WRITER(not necessarily myself, but I'm
eligible too anyway )
Follow this link: http://
www.nairaland.com/1804027/free-
n5000-writer-here-every

3 Likes

Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 7:09am On Jul 21, 2014
[b]As next day reach, me and Emeka don enter motor go Ajegunle where Olagoke bank branch dey. We first go one cafe way no far from the bank so we go fimt send the email and bulk sms. Emeka say mey we no use phone send the email.

That Emeka clever die. Hin send the bulk SMS enter Gone phone the same time as hin send the email too. Emeka kon use one sense:

Dear Olagoke, a credit transaction occured on your account at 10am, December 20, 2013....
Pls note, due to network problem, you can only withdraw your cash in your bank branch either through your ATM Card or over the counter for the next 24-hours. Thank you for banking with us.


Emeka tap me say mey we dey hurry go the bank one time. Quick quick we don dey rush go there.

Every young guy wey we dey see dey enter bank na hin we dey suspect. When we reach bank, Emeka tok say mey I enter bank say hin go dey the ATM machine area dey watch. Na both of us kuku get phone for hand. Hin tok say mey I call am if I don enter bank. Hin too go dey call am for that side. If hin phone ring like this, work don do be that.

"Mey I stay outside nah, Emeka. You go inside," I first tok, but Emeka no agree, so I begin get ready mey I go inside.

Emeka dey ATM place dey wait am. One small queue kon go dey for front of that glass door sha. Why nah? Make this thing no spoil our show nah?

E soon reach my turn. As I enter the door so wey the door close round me, I turn my neck look the door wey be exit door kon see one guy inside. I call Titi Facebook inside the door wey I dey kon see say the guy wey dey next door dey look inside hin phone.

"What?!" I shock. "So that guy na Olagoke Adeyemo. I turn sharply inside the door wey don open for me mey I enter bank. Chai! the door no fit open mey I go out again. Na only inside I fit enter. I run enter inside sharply kon go stay for exit door.

E be like say that Olagoke turn hin face see me as I dey enter that time. I run call Emeka say the guy just comot bank now now.
"Emeka, I see Olagoke nah. The guy wear one yellow shirt with jeans. Hin just comot inside bank now."

"Sho o!" Emeka shock. "E no fit escape. Mey I call am first."

E no reach one minute when I comot go outside. I see Emeka wey dey look about like say hin dey find 50kobo coins wey roll comot hin leaking pocket.

"Emeka! How far nah? I see the guy now now nah!"

"I no see am o!" Emeka tok. "I call am hin number no go."

Quick, we don distribute ourself go right and left. We must not allow this guy escape. To me, e be like say na escape hin escape so. Abi which kine jax hin use sef?

My facebook alert me. Na my FB Titi:

Chibuzor, you think you're smart, abi? Sometimes Yoruba guys are smarter, fool!

I find Emeka show am the message.

"Chineke!" Emeka shout hold hin head.

Another message enter:

I have gone too far. You can't catch me, you and your friend. I saw you when you were both coming together. By then I was queuing inside the bank exit door. Thanks to your pix on facebook which makes me recognise you on time.

"Chai! Odere bird don escape be that," I tok.

"E no possible," Emeka tok.

"This one don por!" I tok. How we wan take do am now? The guy don go nah.

Emeka begin bite hin lip dey calculate.

"Mey we enter streets first," Emeka tok at last. "You pass their, me go pass here."

Emeka enter one dirty street, me sef enter another dirty one. Roforofo and stubborn water just full everywhere because of rain wey fall overnight.

One motor even splash dirty water for the white cloth wey I wear. I call Emeka after ten minutes. Hin tok say hin never see Olagoke.

As I dey waka up and down for under the hot sun, Goke message enter. Hin dey make jest of me:

Ten of una no fit catch me, Emeka. I don tey for this business, no be today."

Chai! E pain me enter bone.

I dey ontop my bed dey sleep now, sure you guys dey inside hot sun dey find me up and down, mumu dem."

As I hear that thing, my moral go down. I don use sweat stain my cloth sef. Na going home things be the issue now.

I begin call Emeka buh hin number no wan go again. The #500 wey remain that time for my hand I remember say I give Emeka say mey hin use am buy cafe ticket to take browse. Hin never give me the #350 balance and na hin we wan take enter motor back. How we go do am now?

I call Emeka so tey my battery begin low. The guy phone no just dey go again. My common sense tell me say mey I dey waka go bank whether hin go fit come back there mey hin kon find me.

Emeka dey complain say hin battery dey low when we dey browse for cafe that time, so hin battery fit don flat. I trek twenty minutes go the bank again, but me no see Emeka when I reach there.

I begin dey wait am whether hin fit come back. I no get choice since when be say I no get chichi with me and I no fit trek nah! No be trekkable thing at all.

Now I don spend like 1hour 30minutes from the time wey I see Olagoke that time.

Kai! I don suffer. Na mey I kon dey beg molue conductors up and down now whether den fit carry me free. I go dey hang for door mouth dey do like thug so den go fit think say I be one of them.

I remember that year wey I be kondo. If Agbero boys pull you comot bus, your driver leave you go, you go kon dey hang for any other bus wey you see dey tell dem you be kondo like dem so den go fit carry you go front small till you go hook up with your bus again.

Omo iko sha. That guy eeh, hin don leave me run many times. I remember when LASTMA wan hayaj our bus. Me go dey call people for wrong place say mey den kon enter na so LASTMA sight us begin dey pursue us come. Omo iko just put fire for bus dey speed go. I run mey I fit catch the bus but my hand no reach am till LASTMA catch me. They beat me like drum.

As I say mey I dey waka comot the bank dey go bus stop na hin message enter again:

[i] Chibulolo the smart maga, now I am jejelistically leaving the bank premise. I am at the gate now. How? Sure I no comot bank that time. I enter back sharply as I sight your guy wey dey wait me for outside--saw you leaving the bank and I was like--oh, lucky me."

As Olagoke dey look down still dey press hin phone for gate wey me sef dey, na inside my hands hin enter straight.

Immediately na hin one ogbonge upper cut hit me for jaw. I shout leave the guy. Immediately, hin don begin run.

I follow am dey shout thief! thief! thief!

The guy no even waste time at all. Hin don enter inside one compound before anybody go fit do anything. E don miss kpatakpata.

"Wey am?" people just they ask up and down, but Olagoke don disappear already. Na that time Emeka kon dey waka come.

Emeka don mess up big time joor. Where hin dey when I need am pass? Hin just dey waka come like person wey den don starve for many days.

Emeka eye red wen I see am.

"Wetin do you, Emeka?" I ask am. Hin left eye don red well well. My own jaw sef don swell up like boil.

"I go catch wrong guy," Emeka whisper like person wey wan faint. "The guy sef wear Yellow
top kon wear blue jeans as you describe am nah!"

"Ah! hin kon sama you slap for face abi?"

"This one pass slap, Chiboy. E pass slap abeg."

"Wetin he do you nah?"

"I no even know sef," Emeka dey yawn. "Na backhand the guy take sampaper my face; the ring wey hin wear just land for inside my eyes straight. Hin beat me silly, carry me throway ground wella before I get opportunity take escape."

"You mean am?" I tok, then Emeka see my jaw.

"Chiboy! Wetin be this?" he begin point my face.

"Na Goke o," I confessed.

"You see am?"

"I catch am sef."

"Wetin kon happen?" Emeka dey look me with one kine funny eyes.

"The guy give me hooking for jaw na so hin take escape o!" I tok.

Emeka vex as I tok that thing.

"Chibuzor, why you let the guy escape nah?"

"You wan blame me abi? Why you no dey here that time mey you help me? Na immediately wey I grab am hin give me that upper cut. I never even prepare for ram."

"You be loser joor!" Emeka shout ontop my head.

"You nko? Wetin you be? Winner?" I give am straight. Me wey I don dey provoke since.

"Give me my money wey dey with you mey I dey go, Emeka," I stretch my hand for hin front.

"You deaf?" Emeka hala dey shine face. "You no hear say person beat me? He don collect all the money nah!"

"E no concern me!" I begin row for hin head. "Na trek you wan mey I trek reach home?"

Emeka look me shock.

"En-hen, you sure say you no get any money for hand again?"

"Chingbain wey small pass I no get. Emeka, no they yarn that kine yarn for here at all. Give me my money mey I dey go."

That day, we nearly blame ourselves. As we reach bus-stop say mey we even enter any bus wey we see dey beg kondo, na hin one kine heavy rain begin pour again.

Chai! I no fit forget that kine day for my life. If no be Omo Iko bus wey pass road luckily for us, we for just tanda gidigba there.

Olagoke Adeyemo don even send me many messages wey I never look. I no say e no fit pass make hin dey make jest of person.

The thing pain us enter bone so tey we no fit tell anybody wetin do us for jaw and eye.

Na so my attention shift comot from FB Titi back to the Titi wey I know for real life.

Now I see say I don tey for that seat dey think about wetin don happen pass. Na one usher even kon tap me come back to real life when hin see say e don tey when I don shake my body last.

Now I check my wristwatch see say I don spend like 2 hours dey think of wetin don happen for the past.

As I look front ontop pulpit mey I hear wetin den still dey yarn, na Titi I see wey dey waka go upstage.

She first sing one praise and worship song. E be like say she wan kon share testimony of wetin God don do for ram since beginning of year.

I say mey I listen hear whether she go mention how she take maga me give am 3k that time. Abi who provide that money give am sef?

As she begin dey share her testimony, I begin listen wella. I nor even know whether she sabi say I come her church that day sef. She for see me if to say I stand up that time wey den say make newcomers stand up. Na surprise attack I wan give the girl. I don make up my mind say I go approach am again propose new year marriage give am immediately we enter 2014.

Titi sing finish enter her testimony. Na the last aspect of hin testimony shock me pass wheb she say:

"And lastly but not the least. I have found him. The bone of my bone. The flesh of my flesh. The sugar in my tea. The one I can lean on..."

Omo, kon see as clap wan tear person ear comot, yet she no stop those kine yarn. Me sef get hope whether she fit just mention my name sef.

"...my future partner...my heart...my love...His name is...OLAGOKE ADEYEMO!"

E just be like say person dey use stick drum my eardrum. I open mouth gasp for breeze.

"Chineke!!" I shout hold my head.
[/b]

2 Likes

Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 7:15am On Jul 21, 2014
Now AS E DEY HAPPEN IS UP TO DATE...
EXPECT FRESH MEAL ANY MOMENT FROM NOW.

Calling all AEDHA fans, 3Dimension, Zeenab, Akinkudin, Talk2riel, Omortolah, etc.

Beware, UPDATE COULD BE HERE ANYTIME!!!
CONGRATS! WE MADE IT HERE EVENTUALLY!!! grin

1 Like

Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by 3Dimension: 7:32am On Jul 21, 2014
Wow! One word for u?

Exceptional!!
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by JigsawKillah(m): 7:37am On Jul 21, 2014
If person head no comot ma no wetin cos am
olagoke wetin? If na me na butcher tins oo
d pastor go tire for life


SAW
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by JigsawKillah(m): 7:38am On Jul 21, 2014
Kaymania
here is AEDH


SAW
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by talk2riel: 7:50am On Jul 21, 2014
Calamity chibuzor
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 8:09am On Jul 21, 2014
hmmm thank God the story is up2date. am in oh
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by DONMAYOR19(m): 4:13pm On Jul 21, 2014
Yes Sammy, we made it at last, I don tell those Deinde, momoh and co to free u, this lunch alone don do me...now make I spread my mat for here, because the nxt food eh, go too sweEt o.... grin
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Nobody: 4:23pm On Jul 21, 2014
DONMAYOR19: Yes Sammy, we made it at last, I don tell those Deinde, momoh and co to free u, this lunch alone don do me...now make I spread my mat for here, because the nxt food eh, go too sweEt o.... grin

No kerosene, a beg somebody there mey e go buy kerosene come o. I wan cook.
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by JigsawKillah(m): 4:43pm On Jul 21, 2014
Yawns.........




SAW
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by Kaymania(m): 4:59pm On Jul 21, 2014
JigsawKillah: Kaymania
here is AEDH


SAW
thanks
Re: AS E DEY Happen(a Pidgin Story) by DONMAYOR19(m): 5:12pm On Jul 21, 2014
SammyHoe:

No kerosene, a beg somebody there mey e go buy kerosene come o. I wan cook.
use fire wood jare, after all fire wood is faster compare to kerosene.

1 Like 1 Share

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (16) (Reply)

Dealing With Plagiarism Of Nairaland Stories By Rogue Sites / A Bolt From The Blue (18+) / Horror In Two Sentences..

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 132
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.