Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,158 members, 7,815,033 topics. Date: Thursday, 02 May 2024 at 05:42 AM

Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... - Literature (5) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... (75336 Views)

The Gang {edo Kings} (a breaking crime thriller story) / Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi / Drug, Sex, Friendship, (a Bad Story?) (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (26) (Reply) (Go Down)

Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Therock5555(m): 5:23pm On Sep 03, 2021
rafikii:
Following with all my back bone, some nights should print and laminate episode 20 then paste it on their wall so they can read it every morning and follow suit..


wetin dey there wey you wan laminate sef, hahaha
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Therock5555(m): 8:16am On Sep 06, 2021
so update wey I drop since Friday, no single comment, hahahahaha.

issokay....

1 Like

Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Ismaxx: 10:17am On Sep 06, 2021
Nice one bro...na real G you be
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Obisteve42: 12:56pm On Sep 06, 2021
Baba, na now I just dey read your update. You may junglist specialist.e na learner for where you dey. Just dey teach dey go....
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Konphido(m): 5:09pm On Sep 06, 2021
Oga Rock, we dae your back oh,
Fire on
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by lanreabbey(m): 6:26pm On Sep 06, 2021
Rocky, we dey here o
No use dat one punish us na cry
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Carterj007(m): 11:47am On Sep 08, 2021
Boss, how far na? Abeg give us update.
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Carterj007(m): 12:03pm On Sep 10, 2021
@therock5555, hope all is well? We never see update oo.
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by lanreabbey(m): 2:53pm On Sep 10, 2021
Uduak dey punish all of una,, sheybe Dem no fit comment abi
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by WAACUT(m): 7:22pm On Sep 10, 2021
Comments are trooping in
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Therock5555(m): 10:18pm On Sep 10, 2021
haaaa, so una Sabi comment like this, see as my belly dey sweet me....



oya na, I'll resume tomorrow....

2 Likes 1 Share

Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by bennyflipy(m): 10:44pm On Sep 10, 2021
Therock5555:
haaaa, so una Sabi comment like this, see as my belly dey sweet me....




oya na, I'll resume tomorrow....
No dey whine us na
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Therock5555(m): 11:58pm On Sep 11, 2021
~~~TWENTY~TWO~~~

At least if there's one thing they did right was to keep food for me till the next morning.

I woke up to an already set table. Collins and Becky were gisting as they fed each other. I pretended like I didn't care. Ofcourse I didn't care, I'm all about the food.

Becky couldn't even look at me. Who them help jooh.

Francis called to inform me that there would be chilling later cause somebody won about half million from his shop from sports bet and dashed him about 30k, so na total flexing we dey that evening.

"Dude, abeg you fit bring babes make our tables lively, Collins and Victor fit come with their babes also." He informed me.

Na why I like Francis be that, him no dey stingy to flex awoof money. Na very cheerful giver, he doesn't flex much o, but when ever he has, him dey remember flex him homies also cause him know say I dey over try for am.


When I informed Collins and Becky, they were elated. Na that kind things Collins dey like, flexing wey him no go contribute one Kobo. I also put a call to Victor. The werey be wan carry two girls come, I yarn am say I go chase them like cow if him try am.

Now back to me, who was I gonna take out with me. Definitely Ruth was the best choice cause since Becky and Collins were also tagging along, I couldn't bring another girl cause that would be crossing the Line. So I called Ruth to bring along a friend.


By evening we all tagged along to a nearby bar, the same bar where Jago and I met Stephanie some days prior.

The moment we step into the gate, I had a very bad feeling so I stopped for a second. Nobody observed my reluctance, Ruth just held my hand and dragged me along.

I was observing my environment codedly. I didn't see anyone I recognized so I calm down alittle bit, still my heart was still pounding for some strange reasons I couldn't lay my fingers on.

The bar section we entered had only one other group of occupants. There were about four men seated at a round table with more than half a dozen chicks.

I knew each and everyone of the men there, na confirm sugar daddies those men be. All of them na married men, infact, you can't sit with them as a man if you ain't married. And if you carry chick wey her eyes dey chook anyhow, them go collect your babe for your front cause if she sight their doings, she fit disboyfriend you ASAP.



E get day wey Victor, his babe and her sister were chilling with Ruth and I. Naso one of the men just dey signal Victor babe sister to come join them.

The babe no gree, the men vex eh, one of them staggered to our table and asked us to order what ever we need on their tab if only the girl would come join them to chill.

The babe still been dey form jagaban, na even Victor babe encourage her to go. Naso we flex that day till infinity, as we dey comot, we go meet them to release our girl.

The men no even care, they just collected her number, another squeeze some crisp 1k notes into her palms for thanks for coming. I swear I weak. Money dey this life o.



So as we dey pass them, to avoid temptation, I hold my babe tight, usher them go two rolls of tables. Naso we sef start our own doings o in a mini way

Eh, we know say na vodka and barbecued fish and chips Nai choke their table. We sef, green bottles and soft drinks choke our table. We manage buy enough suya to code.

See, doings na doings o. Everybody get their standard for life, if your hand no reach top shelf, no go carry ladder to quickly reach cause you fit fall from up. Everything na time.


Because you drink Pepsi today no mean say you no go fit afford 'champange' tomorrow. Everything na time.



As we dey blow our cigar dey go while having fun with our women, my phone began blowing up. Ruth was facebooking with my phone when the call came in.

I frowned as she showed me the caller ID. Na Blessing dey call me. I just weak. If the babe dey call me like this, I dey sure say na Bleep matter she dey call me for. I just ignored the call.

Well Blessing wasn't done with me, another call came in, and another, and another, and another. Okay I was super pissed already. So I collected my phone and was contemplating how to stand up to a less noisy section to call Blessing back.

Barely a minute after I collected my phone back, a text entered. It was from Blessing. I codedly opened it as my eyes opened wide in horror.

The text read; Peter, look behind you.


Behind me was where those sugar papas them siddon, wetin come concern Blessing for there. Wait, Shit.

I turned slowly only to find Blessing's eyes fixated on me. She was sitting in between her friend and one of the men. Funny aspect was that, she wasn't smiling as our eyes met. I quickly turn and face my table again.

I wasn't too perturbed, she was with men, married men for that matter, some could be her father's mate. Me I dey with chick also, so last last all of us na sinners na, there's no need throwing stones.

The funny thing was that she continued calling my phone again. If I turn, na her eyes I go jam, she no even send for wetin dey happen for her own table again.

One of the men called barman to go tell people wey dey sell fish to bring two more wraps of the fish and chips come their table.

Blessing and I were still playing the looking game when her phone rang, she stood up to go pick the call. I was relieved for only thirty seconds cause as I sight the person wey carry the fish come for those men, the person sight me too. Naso both of us open mouth. Omor which kin wahala be this?

Na Stephanie come serve them the fish and chips.

Ruth, Blessing and yours truly Stephanie dey one location. I begin pity my life that moment as Stephanie pretending to get over her shock, collected the money for what she brought and dashed out, her eyes never leaving mine. Mehn she was furious to the core.


Na only Victor realise wetin dey happen cause he knew both Blessing and Stephanie. The dude was just smiling back at me.

I needed something to cool my nerves that moment so I asked him for a wrap of dope, he passed it to me under the table, I quickly pocketed it and grabbed a lighter and told them I'll be back soon.

Them no dey allow smoking of weed for the general bar, I had to go outside to a secluded corner and light up my blunt. As I dey blow, naso inspiration dey enter my head.


I thought I had things under control with Blessing but Stephanie, that was a different ball game. Since when we had sex last, she had been forming loving you on me, begging for another date or visitation, I told her I was even out of town when we spoke that morning. How did I forget that she usually comes to help her friend time to time to sell? Shebi I for respect myself and go to another hotel.


Omor naso I dey blow my blunt dey go. I no know say world war 2 dey happen for inside.....

10 Likes 2 Shares

Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Therock5555(m): 12:02am On Sep 12, 2021
ismaxx
obisteve42
konphido
lanreabbey
carterj007
waacut
bennyflipy



make una turn up o, update don show.

2 Likes

Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Therock5555(m): 12:12am On Sep 12, 2021
emmaebube

hottadiva

gstelly


I dey sight una ooo
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Carterj007(m): 1:09am On Sep 12, 2021
Thank you oooo. Abeg bring anoda update tomorrow.
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by bennyflipy(m): 9:37am On Sep 12, 2021
Therock5555:
ismaxx

obisteve42

konphido

lanreabbey

carterj007

waacut


bennyflipy




make una turn up o, update don show.
E don happen grin
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by WAACUT(m): 9:47am On Sep 12, 2021
BABA I DEY HAIL OOOOOO... HAPPY SUNDAY....OMOH..BE LIKE ME AND YOU DEY SAME TABLE BASED ON BABES....
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Konphido(m): 10:50am On Sep 12, 2021
kasala wan burst like this oh.. Lol.
Happy Sunday BrotherMan.
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Therock5555(m): 2:10pm On Sep 12, 2021
bennyflipy:

E don happen grin

wetin you reason say happen?

WAACUT:
BABA I DEY HAIL OOOOOO... HAPPY SUNDAY....OMOH..BE LIKE ME AND YOU DEY SAME TABLE BASED ON BABES....


hahahaha, you na play boy Numero uno abi...

Carterj007:
Thank you oooo. Abeg bring anoda update tomorrow.

I dey type new chapter now sir...

Konphido:
kasala wan burst like this oh.. Lol.
Happy Sunday BrotherMan.
happy Sunday sir.... new chapter would be available in some hours...

1 Like

Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Therock5555(m): 2:11pm On Sep 12, 2021
hello guys... hope Sunday dey progress Wella.

make I type una update for una, hopefully before 6pm, I'll be done..

2 Likes

Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by lanreabbey(m): 2:17pm On Sep 12, 2021
kasala don burst grin
laughing in Swahili
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Therock5555(m): 4:06pm On Sep 12, 2021
~~~TWENTY~THREE~~~
I dey nod my head to the music from inside as I dey blow my kush dey go. One thing wey I like with cruise be say, your problems take a back seat after multiple drags, you no go know when you begin do something entirely different.

Ruth had collected my phone before I step out, so I had time to think plenty rubbish things.

Cause if you ask me, shebi I suppose dey reason how to disappear from there with Ruth before kasala happen, but see me here, relaxing like the king of Ibadan, like say I no get issues to solve.

As I finish, I begin bounce go inside. By then the alcohol don dey do me turninoninon, but my senses were heightened, my eyes just dey spy everyone suspiciously, Kai.

Naso I wan enter the bar where my folks dey Nai Victor wey don sight me from afar just rush come drag me go toilet side.

"Guy, you know say you get luck?" He asked.

"Wetin happen?"

"Mehn, Stephanie came to our table o, she carry knife come. Omor she been dey vibrate dey come, she no sight you again, and she no know say Ruth na your babe, if not I no for know wetin that babe for do."

Instead of getting scared, naso I burst Into laughter. The talk wan dey like American film. Infact e dey like science fiction. Like the Bleep. Who the hell is Stephanie wey she go carry knife come confront me cause she catch me with babe. Is her brain shaking. Infact the gist sounded like lamba.

"Haba bro, why you dey Bobo me? Stephanie no fit try that rubbish na."

"Omor ask Collins and Francis, I been sight Stephanie dey come Nai I rush jack her before she go reach our table, she was vibrating anyhow and trying to make a scene, people think say na my babe sef, I had to tell their Ruth and co say na one of my ex. She even wound me with the knife."


Omor as Victor show me him sliced thumb, my heart cut. Like no be fabu the brother dey yarn me o. My heart begin dey beat anyhow.

"So how una take finish?"

"I beg her tire, she was crying and saying that you go collect for this life. Say instead of taking her out, you come lie for her and brought other babes instead. I tell her say none of the girls there be your babe, but she no believe, cause na four girls and three guys remain for the table when she came, so definitely she knew one of the girls were yours.

I try calm her but she insisted on seeing you first make you confirm wetin I talk cause she say hell must fall if she doesn't know the truth.

She call you tire but Ruth hold your phone, I'm sure na wetin save you be that. She came back and ask where you went, I told her you went to get stuffs outside, naso she run go toilet go find you, she check tire Nai she go back her friend side. I never sight her since then." He concluded.


"You don't mean it. Jesu, na small Stephanie wan fight me cause I carry babe comot. Like she dey mad. Omor this matter dey chop me, I suppose nod sense into that babe head o. Make I go check her sef, this rubbish gats stop." I said as I brushed Victor off and went to Stephanie's friend shop.


Stephanie was nowhere to be found. I asked the fish seller, her supposed friend.

"Na you be her guy wey carry another girl come chill abi?" The fish seller asked, her eyes were blazing red also.

"Her guy dey here? I no know wetin you dey talk of, she na my former classmate, I saw her awhile back but I was going out, I thought she was still around, I be wan greet her." I explained.


"Oh, I thought you were the stupid guy that broke my friend's heart. I don't know why guys are wicked like this, Stephanie been hook up with her ex boyfriend, them reconcile just few days ago, and today he's already chilling with another girl. Why are some men so heartless?" She explained.


"Chai, the boyfriend no try o. Why him do like that na?" I asked.

"Men, hmm. Anyway be like the guy run cause she find am tire, and she has been crying so I told her to go home. Walahi, I'll help her hunt that guy." She swore as I drop my condolences and walk away.



I just dey smile wickedly as I went back to my guys, Blessing eyes were following me as I passed them, the men don increase reach six and the babes twice that number.

Ruth gave me a naughty look when I sat next to her. My phone was on the table next to her, she wasn't pressing it again. As I pick am up, the kin missed calls I get fear me, dozens of calls from Stephanie with about three messages.

Ruth informed me that my line had been burning up with calls so she couldn't Facebook anymore, she gats drop am till I return.

Now you might be asking why Ruth didn't pick my calls. Well, we respect each other privacy to the core, no opening of messages or picking each other calls, na one thing wey I like with the Barney, she no care who I flex with, as far as she's still the madam at the top and my attention on her haven't waivered, she comfortable with that. And by the way I always have all everything under wraps, she ain't scent a wimp of cheating aroma from me. She trust me one hundred or so I thought....


Another text entered again.

"Peter meet me outside." The text was from Blessing.


As I turn look her, she signal me and stood up, carried her bag and walked outside towards the gate direction. I waited for a minute or two, picked my phone and excused myself and walked outside to meet her.

She was walking around restlessly outside when I step out of the gate, as she sighted me, she quickly started walking towards me, I sidestep her and grab her hand, drag her to the corner she was walking towards me from.

"Peter what's the meaning of what you're doing?" She fumed.


"Are you kidding me? Why you dey ask me that kin question? What did I do?" I fired back.

"Peter, I said who is that girl you were with?"

"Me too, who was those men you were with......"

"TWARPPPPP" one hot slap land for my cheeks before I complete my sentence. I shock like say na electricity touch me. Na me babe wooze slap for public like this.

But like winch wey she be, Blessing quickly bursted into tears and wrap her arms around me, apologizing profusely. How person go slap me, still dey cry join, abi na my red eyes make her cry?

"Babe you slap me.."

"Sweetheart, I'm sorry, I was so angry. I didn't mean it. See I've been pissed since I saw you with your babes and guys. I've been calling you so we could talk but you were forming big boy."

"And what is there to talk about? I dey with babes, you dey with men, not even men like me, men wey fit born us. And you get liver dey vex for me. What sort of rubbish is that?"

She was still hugging me tight, supposedly to prevent me from hitting her back or for what ever reason, we just stood there stuck together as we spoke, she never realised her grip for once.

"Babe I know I was with matured men but that's not the truth of the situation. Na my friend call me say some magas dey wey need enough babes so I just went to chop my share then go back home and sleep. If you had called me to come chill with you, I'll have gladly left that table sef. But In stead you brought your babe to show off abi. Do you know how bad I felt when I saw you with that small girl. Babe wey no reach to Waka with me, Nai dey drag you with me. I felt ashamed. Na why I slap you, I felt hurt."

Omor that babe think say me na 2 years old. See talk like say na gongoni we use dey do mama and papa drama. I dey like this kin lamba Sha.

"Eh, that one don pass now. Can you go back to your men, lemme go back to my girls." I asked.

"Noooooo. None of us is going back in there."


"Why?" I asked.


"We are going home together. Shebi Na woman be your problem. I'm available, you can't leave me and take another girl home."


"Shebi you know say na my main babe be that, and na me dey sponsor the chilling?" I asked

"Peter, I don't care. I am not leaving you. We must go home together, except you want to beat me outside here. Abi don't you realise that I also left my friends and people that I was with. Peter let's go home."

Before I know it, this babe don jack my prick, dey romance am gently. I no know when I comot phone, text Victor to cover for me, and text Collins to avoid Ruth from returning back home with them. Naso we Waka ooooo.



"Babe, you'll pay for that slap when we get home." I wisphered to Blessing.


"I can't wait.." she said laughing......

8 Likes 2 Shares

Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Therock5555(m): 4:07pm On Sep 12, 2021
lanreabbey:
kasala don burst grin laughing in Swahili

you think so. oya read the above chapter and find out how e go....
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Therock5555(m): 4:08pm On Sep 12, 2021
eh.... make I go flex my Sunday.....



see una tomorrow homies.... hopefully we'll get our second sex scene tomorrow....
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by lanreabbey(m): 4:27pm On Sep 12, 2021
May God help this your ministry o
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by gstelly: 5:15pm On Sep 12, 2021
Therock5555:
emmaebube

hottadiva

gstelly


I dey sight una ooo
grin
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Rumpleslitskin: 6:11pm On Sep 12, 2021
You no call me abi I gats dey refresh page like madman wehdone
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by WAACUT(m): 8:27pm On Sep 12, 2021
Na this kind thing..me dey like...guy..u sure say u no be my lost twin
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Therock5555(m): 10:35pm On Sep 12, 2021
WAACUT:
Na this kind thing..me dey like...guy..u sure say u no be my lost twin


guy hit me up on WhatsApp, be like you and I suppose get unfinished business......

hahahaha

1 Like

Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Therock5555(m): 10:36pm On Sep 12, 2021
Rumpleslitskin:
You no call me abi I gats dey refresh page like madman wehdone


sorry sir, I'll tag you next time....
Re: Na Man Wey I Be: A Breaking Bad Story... by Carterj007(m): 4:02am On Sep 13, 2021
You do well o. You made my night/morning.

1 Like

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (26) (Reply)

Magic Doctor: CEO Lady's Humble Husband [A Story] / <<<The Tri-Paternal Son>>> / "Wole Soyinka And I On Our Way Back To Nigeria" - Prince Adeyinka Success Says

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 78
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.