AKPOSbaba's Posts
Nairaland Forum › AKPOSbaba's Profile › AKPOSbaba's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 11 12 13 14 15 16 17 (of 17 pages)
As a female, she get evritin wey woman dey get but if you see di reggae and dancehall queen Cynthia Morgan, make u no go do mistake call her female artiste but call am "musician". Akordin to di Edo born biutiful chikito wey dey sing wit plenti power, she say,she no dey di same class wit di rest female artiste dem bicos none of dem dey do di kind music wey she dey do. Cynthia Morgan, di Northside records first lady say,if u listen to her jams, u go know say she no dey sing soft like your evriday female artiste. She say she don reach dat stage wey be say, pipo no dey borda to compare her wit girls again but dem dey compare ram wit men wey sabi. READ MORE>>>>>>http://ogakpatakpata..com/2014/12/compare-me-with-male-musicians-not.html
|
Mr incredible imsef, M.I, don shook mouth for di quarel bitwin Wizkid and Saeon. If you rememba, few months ago, Saeon blast say,Wizzy no send her song,"Boogie down" wey two of dem sing as he neva one day promote am for twitter or facebook. Wizzy sef kon reply am say, di job wey dem payam to do naim he do, so diafor, make evribodi free am. Now di short blackboi imsef,M.I say pasonally,im feel say Wizkid no do wrong since na bizness naim bring dem two togeda. READ MORE>>>>>http://ogakpatakpata..com/2014/12/mi-to-saeonwizkid-dey-right-bizness-na.html |
![]() Wich chemist I fit see am buy for my babe? ![]() |
My brodas and sistas, now you fit make yor anus di talk of di town dis christmas season. For di fest time in di history of di world, to dey mess go dey make sense now bicos, one man from France,Christian Poincheval wey im frend almost kill with mess wey dey smell like kabad and soup wey don sawa for 40 days, don vex make one merisin wey go make yor mess dey smell like chocolate and habiscus flower or even dey smell like stew wit korect curry smell. He say, since di gas attack nearly kill pipo for di restaurant dat day, naim he vex say he must do someting about smelling mess. READ MORE/PHOTOS>>>>>http://ogakpatakpata..com/2014/12/new-drugs-to-make-your-mess-dey-smell.html
|
My brodas and sistas, now you fit make yor anus di talk of di town dis christmas season. For di fest time in di history of di world, to dey mess go dey make sense now bicos, one man from France,Christian Poincheval wey im frend almost kill with mess wey dey smell like kabad and soup wey don sawa for 40 days, don vex make one merisin wey go make yor mess dey smell like chocolate and habiscus flower or even dey smell like stew wit korect curry smell. He say, since di gas attack nearly kill pipo for di restaurant dat day, naim he vex say he must do someting about smelling mess. READ MORE/PHOTOS>>>>>http://ogakpatakpata..com/2014/12/new-drugs-to-make-your-mess-dey-smell.html
|
Over here in Baghdad, no matter how u crack Di joke reach, we no dey laff. |
Forget say Super Eagles and Chelsea star, Mikel Obi no dey get enuff playing time for Chelsea, but he dey get enuff time to play wit im Russian chikito, Olga Diyachenko and even find time to hang out wit her family wen di babe celebrate her birthday. CHECK MORE PHOTOS>>>>>http://ogakpatakpata..com/2014/12/check-out-mikel-obi-and-rich-in-laws-to.html
|
I love u more Soyinka. Dis bomboy from otuoke won't survive a day over here in Baghdad. |
KpakAm anytin dem like make dem do.I'm from Baghdad |
Here we go again...Pls modify dis pls. Thanks Modify wetin? Nah lie bifor? Boko haram na Christians? Isis, aqeedah no be islam dem dey claim? wich kain religion be dat? To dey kill don turn food.yeye dey smell. |
Kola Adebayor, Emmanuel Adebayor senior broda,don yarn say di Tottenham striker don brake dia mama heart since he call am winch. Kola say na so so cry dia mama dey cry since one fake babalawo tell Adebayor say dia mama and dia sista, Mageret dey do juju and otumokpor to kill im football career. READ MORE>>>>>http://ogakpatakpata..com/2014/12/since-emmanuel-adebayor-call-our-mama.html
|
Di Odidigboigbo of Africa,James Ibori,di forma Govnor of Delta State don show say him grip on Delta politiks still dey strong gidigba as im daughter,Miss Erhiatake Ibori don win Ethiope West constituency for PDP house of assembly primaries for di state. We still dey try to find out di reason why liver fail di rest guys wey sopose challenge her as nobodi contest against her for di election. READ MORE>>>>http://ogakpatakpata..com/2014/11/ibori-daughter-win-house-of-assembly.html
|
Na crime to born girl pikin again? Many celibritis dey make pipo feel say na crime nowadays to born girl pikin but di truth be say no be crime. Imagine di dress wey Pam Andrews wear,na lace material naim cover her nippos and her website if not,na evritin she don show di world be dat. READ MORE/PHOTOS>>>>http://ogakpatakpata..com/2014/11/chai-see-wetin-south-africa-actress.html
|
If u agree to dis topic, make u dey visit (www.ogakpatakpata..com) OGAKPATAKPATA Di FIRST PIDGIN ENGLISH BLOG AND YOR NOMBA ONE OGBONGE SITE WEY DEY SAMA YU FRESHFRESH GIST FOR ENTATAYMENT,POLITIKS,SPORTS TORI AND ANY TEAR RUBBER NEWS.. |
America rapper,Busta Rhymes don fall yakata from stage and brake head wen he dey on stage dey soport one of him new artiste wey he song dey reign for America right now. O.t Genasis di name of di new artiste wey Busta Rhymes compini,conglomerate records sign,dey perform for one concert for New York wen im oga, Busta, joinam dey rap all di rapping. READ MORE>>>>>http://ogakpatakpata..com/2014/11/busta-rhymes-fall-from-stage-and-break.html
|
Afro beat prince, Femi Kuti, di pikin of di Afrobeat king,Fela Anikulapo Kuti, don get di biggest shock for him life as DNA test don show say two of im children no be own. Out of di 5 children, Made,Afolabi, Dupe, Tosin and Ayomide wey di world don biliv say na Femi Kuti blood, Dupe and Tosin no be him children after all. READ MORE>>>>http://ogakpatakpata..com/2014/11/shocker-femi-kuti-say-no-be-him-get-two.html
|
Afro beat prince, Femi Kuti, di pikin of di Afrobeat king,Fela Anikulapo Kuti, don get di biggest shock for him life as DNA test don show say,two of im children no be own. Out of di 5 children, Made,Afolabi, Dupe, Tosin and Ayomide wey di world don biliv say na Femi Kuti blood, Dupe and Tosin no be him children after all. READ MORE>>>>http://ogakpatakpata..com/2014/11/shocker-femi-kuti-say-no-be-him-get-two.html
|
Yeye president. how south south won take get chance to rule again afta dis bomboy Don spoil our name? |
If you neva hear dat proverb wey say ,"evriday for di tiff, one day for di owner", naim be say you are on a long ting. READ MORE>>>>http://ogakpatakpata..com/2014/11/arm-robber-say-no-only-on-sunday-him.html
|
For dose men wey no dey fit bear hungry especially wen dia wife food dey fire and e dey take time to don,una sorry o,bicos, una go learn how to bear hungry like never bifor as federal government don conclude plans to buy one slow cooking machine for our rural women free of charge. READ MORE>>>>http://www.ogakpatakpata..com/2014/11/federal-government-dey-plan-to-buy-slow.html
|
For dose men wey no dey fit bear hungry especially wen dia wife food dey fire and e dey take time to don,una sorry o,bicos,una go learn how to bear hungry like never bifor as federal government don conclude plans to buy one slow cooking machine for our rural women free of charge. READ MORE>>>>http://ogakpatakpata..com/2014/11/federal-government-dey-plan-to-buy-slow.html
|
I wonda if di debate of who be di beta playa bitwin Messi and Ronaldo go eva stop since dis two footballers don swear say na so so records dem go dey brake for dia life. Messi carry record breaking dis week for im head like lakpalakpa( ringworm) as he bicom di highest goalscorer for Spain la liga history on sunday. READ MORE>>>http://ogakpatakpata..com/2014/11/dis-na-messi-week-but-na-ronaldo-year.html
|
Pus*y wot? make 9ice no hearam for your mouth o. Lol |
And your day... Of gibberish Na so u talk? Gibberish! We are here making money wit di first language of over 100 million nigerians and u are there talking rubbish. I know sure say u no know di value wen corperate bodies start to advertise for yor blog. Dem know say we dey do something right wey u no dey see. agbaya Oshi! |
I wonda if di debate of who be di beta playa bitwin Messi and Ronaldo go eva stop since dis two footballers don swear say na so so records dem go dey brake for dia life. Messi carry record breaking dis week for im head like lakpalakpa( ringworm) as he bicom di highest goalscorer for Spain la liga history on sunday. READ MORE>>>http://ogakpatakpata..com/2014/11/dis-na-messi-week-but-na-ronaldo-year.html
|
He bin dey call imsef "Party rider" but now you fit also call am "Horse rider". READ MORE>>>>http://ogakpatakpata..com/2014/11/style-na-style-as-9ice-don-ride-horse.html |
Hoax everywhere, devil has taken over Di internet |
Dis na veri sad news again as P Square don turn orphan. Dia papa don die two years afta dia mama die. He die yestaday afta he undago successful knee operation and wen he dey go hospital for follow up naim he collapse and die. No be beta year at all for di P Squares as na small tin remain kwanta nearly make Peter and Paul break up bifor dem settle demsef. Curled from....www.ogakpakpatakpata..com |
Numba one female hip hop star, Nicki Minaj, don notice and endorse one of her biggest Nigerian rapper fan READ MORE>>>>http://ogakpatakpata..com/2014/11/nicki-minaj-don-endorse-nigeria-rapper.html
|
