Came's Posts
Nairaland Forum › Came's Profile › Came's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 11 12 13 14 15 16 (of 81 pages)
This woman go push well well if any of her children carry this man head.... See person head!!!! |
She be torch now, see as she dey shine. Na wa . |
woman leave your bag make Doctor check you well well, she say she no go gree... I dey suspect that bag way she hold tightly even when checkup was going on. |
Twoface no just wan bring himself down say na blackface write that song way blow am, but the way blackface take go about the matter self , na wa. Songs way blow people na people write am for them , but for africa here people no dey give their song writers credit because of pride. |
Na bra that married woman wear go? Make person marry understanding husband good ooooo... Hmmmmmm!!! |
"We are happy" she don even dey talk for her fellow baby mama... Some people no no shame oooooo...why una no go happy? una dey chop money way una no work for all because una just open legs born for person because he get money. |
God forbid make i carry my daughter way don grow like this for this kind thing. Wetin this one mean now? Hmmmmmm!!!! |
That lekpa way go marry Hausa man,,hope say she get for mind say Hausa man fit marry as many wives as he wants,so that when the time reach she no go dey jealous.Hmmmmmm!!! |
Who be this guy, is he an actor ?I no no am ooooo... |
They are future headmaster, and headmistress. |
This woman eyes don over tear since way she leave her husband.. Na wa oooo |
Nothing way person no go see ... Hmmmmmm....juju for pole... The thing funny ooooo.... Hahahahah.... |
Madam, she be star, and person no fit cover star make he no shine... Una life no dey hidden again ooooo, as una don make una self star abi na celebrity una call am.. |
If this your hide hide go save you from being divorced, then hide well well ooooo.... Hmmmmmm!!! Stay married pls!!!!! |
He good like that, after dem cry finish dem go do owanbe take cool temper... R.I.P. to the deads. |
Ebube too set,i wonder why she never marry, Juliet too beautiful,i wonder why she is divorced . Two of dem fine sha!!!!! . |
One be Ibo, and the other na Yoruba, madam try complete am with Hausa , so that you go be wazobia mother . |
Can't they contribute among themselves and bring the body home,dem no get association? The lady na Muslim, and ought to have been buried, all this bringing body home,no dey Muslim rite oooooo....make nobody blame any body oooooo... R. I. P. to the dead. |
You just carry person pic post without the person's consent... Hmmmmmm.. Many things are taken for granted in africa.. This guy can make money out of you abroad by suing you.. You fall my hand John, marry you no gree marry na people you dey take do yeye... |
Which career he go affect, just talk true say he go affect the rate at which you dey pursue women up and down, and you no ready to stop to dey change women now .. |
Na everytime she dey change wedding ring.., na you sabi Jenifa . |
Tiwa carry her papa cheeks go the party. It will soon be her birthday. |
It is good to put people in their place, if you don't they will continue with their nonsense. |
Madam way say she don grow thick skin, this picture way you post good for your eyes. Na wa ooooooo...you can do anything, but you will pay for it. |
Hope say you dey handle your mouth too, because na talk talk you take spoil your marriage oooo ... I wish you well. |
How many wives this man wan marry, na wa oooooo, some men no get plan for themself on marriage at all. |
No put any wig again pls, this bald too dey nice on you. Na now i no say you beautiful. Thank God for a successful surgery. |
Na now i no why dem dey talk say something way don already good still need prayer...people still dey happy say she born after a long time, na him death come carry him wahala come meet am ... Hmmmmmm..,, R.I.P. Moji. |
Na this kind pant make dem say make we no spread our dirty linen for outside .. See wetin the person way get this dirty linen cause now... Hmmmmmmm!! |
If to say she no go turn Muslim now, dem for plan better as Christians,but dem suppose don bury am as a Muslim . R.I.P.Moji. |
I suspect this girl, i sure say she don catch one Alhaji way get serious money, and this thing way she do herself na make she for gain favour from the Alhaji . |
Wizkid vomit this boy?... He no need DNA for this one at all. |