Hungryboy's Posts
Nairaland Forum › Hungryboy's Profile › Hungryboy's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 68 69 70 71 72 73 74 75 76 (of 119 pages)
tempem:na the same thing Wizkid talk, the time were him been dey hustle for street |
Nice one madam,
Make me too follow find way come open cutlass sharpening business |
Fear 'We'men,
Make dat man rush go do Dna test for those two children oh,
E fit be say, na him neighbour Baba Alabi get them,
Make him no come raise another man pikin finish,
When dem big dia, their mother go come confess say no be him children dem be, |
I always tell people that the best advice, is the one you give yourself, Nothing we go tell you here were go help you, except you resolve by yourself say u no wan be jealousy again, ***Make i put my earpiece back dey listen to this jam by Mandylozz ft Selebobo titled Jealousy*** |
Oga, bring sauce make we take chop the rice nah |
Imaobong Essiet of Akbc radio, Sweet african voice, Not like all this other Radio OAPS forming Made in America |
To blog no be by force nah,
Wetin dey newsworthy for dis thing now?, |
Laminwise1:put am for tray enter market nah, Homefront bro, abeg people were no even get Ssce nko no fit apply? |
The same toto, you are paying bride price of 1million for license to knack,
Many guys have already knacked it with just 200naira suya and can malt |
I came, I saw, I walked away, Call me, when am receiving alert on their behalf |
Majority of Nigerians are so greedy and self serving, The dollar issue has been a boon for many of them, from the transporter, to the buka owner, to the clothe seller, to the phones and accessories retailer, business have never been so good, Majority of Nigerians are just looking for an opportunity to cheat others or the system. |
This is tragic, Let the people in charge of markets, start having an in house fire fighting department, that's always on standby 24/7, it won't cost them much to set it up and maintain it, if all of them pull their resources together. |
I just dey look this Money, Because of am, i dey call people were i senior, Sir, Oga, Boss Because of am, I dey chop garri three times a day, Because of am, i no get girlfriend, Because of am, i dey trek for leg dey go work, Money wetin i do you? Why you go full one man hand, till him come resemble elephant, Come even marry him daughter mate, Money why you wicked like this, you too dey partial oh, Spread the love nah, abeg. |
Sounds like a good handbook for someone, Trying to learn how to be a slave to the killers of his kinsmen, This Idomas are so pathetic, for all your kinsmen this fulanis killed, you are not even talking about bringing the perpetrators to account, you are talking of peace, This is capitulation, this is a disgrace, Fulanis are a warring tribe, the do not love peace, The only way, you can gain their respect is by, playing their war game, and winning them at it, Let's just wait and see, it won't be long before another Benue community is invaded and destroyed by this guys |
Na wetin Jesus die for cross for be this? |
Nice one, But Oga soldier, why una never arrest any of the fulanis were destroy communities for Benue? |
Looks like an inside job to me |
this is tragic, R.i.p to the dead, Pakistan is a very dangerous place for you, if you are a Christian, Hindu or Shia muslim. |
Abeg how much pesin fit get Homtom Ht7 here? |
FOR1234:OK Sister, i dey wait for your alert |
'each time he sends money to you, you feel very guilty', Aunty leave trash for lawma abeg, If na so you been feel guilty, why you no reject him money, tell am say you are not interested in supervising his project, Aunty,you don't need a bible to tell you what is right or wrong, na your conscience you need, But in case you wan wash away your sins, Abeg send me small thing, make i take chop |
Who her picture help?, |
Bros, bone that thing were you wan go so, Do your business, With happiness and a smile, Always treat every customer with respect and a thank you, You are just going through a rough patch, When your goodluck go start, your competitors go think say you go collect goodluck jazz from India. |
josephwilliamsd:bros, you don forget to add 'oh ah' |
nollwood been almost make me start to believe say wheelbarrow pusher fit marry Governor daughter, Na now my eye come clear, the rich marry the rich or stay single, if you think say i dey lie ask Genevieve, if she no dey house, go ask Rita Dominic her neighbour |
Na dis kind news make garri now, come be 4 cups 100naira, |
So, na wetin dem dey call news be this now? |
God bless you My able Governor, But hunger wan kill your die hard supporter here, I just dey hear say jobs have been created , but i no dey see am, But continue with your good works sha, Mme Dakka nda |
I'm silently studying the jollof rice politics this man is playing in Ekiti. Where are your infrastructure projects Mr Fayose?, Or you telling us that your people are so hungry, that the will prefer rice to roads? |
Oga, General overseer no come to look your face oh, even if you wear slippers go that church, with tattered clothes, him go still collect the small one were you get add for him own |
Oga for our church, we no dey celebrate Hisster or Christmas, Because Jesus die for your sins, no mean say you go come chop rice and stew ontop him head, |
Funny thing about all this critics, is that the can't even give any solution to the problem, Tell us Sir, how can the naira's decline be reversed?, Tell us how we can make the dollar to naira exchange rate 150naira again or shut the Bleep up. |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 68 69 70 71 72 73 74 75 76 (of 119 pages)
that girl is no where near talent, what is the meaning of the gibberish s she shouts in her songs like kokaaaaaaa, aburukututututu yemi aladeeeeeeee, salambolo, and the worst is when she is on stage shouting 1.....2....