Inoki247's Posts
Nairaland Forum › Inoki247's Profile › Inoki247's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 189 190 191 192 193 194 195 196 197 (of 580 pages)
Lol no be all of una dey say make Seun upgrade as he no see upgrade du he decide to take us back in time to the days of Black and white TV... So manage the update like that... |
Abg I even think say na my phone.... Why everywhere come dey turn black and white... Is Seun taking us back to the days Of Black and white President Television.... Seun give us awa old Font bak oh stop acting like Emiefiele we want our old note back.... |
obyno82:I know you guy's hate competition just tell us u want to dominate Agbero business.... |
Do your best and no allow the bank go dem Skye Bank and intercontinental bank way.... |
fastseo:Lol no mata what even if na half salary he go still dey pay cause I'm sure if person no see 2 to 3yrs salary colet there's no way they will go to work FG no du up to this to ASUU before dem go strike.... |
This one don go use him mumu deny himself of freedom.. You call yourself elders buh av the same brain with Simon Ekpa now I see na all this people poison all dere young ones true true.... Bkuz if elders dey reason like this how the young one go come dey reason.... More sit at home loading for our brothers.... |
Lol no more scarcity buh we are bak to old note at 40k daily limit at the ATM the new Note don come scarce like anything like say people don go dey keep the new Note for house like Dollar ... |
obyno82:Show me where I made mentioned of been violent maybe you're dreaming or quote the wrong person... Lagos Agbero as Neva harrassed me as a private car owner they only av business with Public transport while the one in Onitsha with Wheel barrow, Bicycle, Leg they don't mind exploiting you .... Format don cast when you've Agbero in ur state buh you're telling us your place is heaven that nothing like Agbero you guys are hypocrite you will defend anything that comes out of ur region or states so far is not coming from Lagos.... If is all lie people would av stormed here to deny buh all your peeps av gone into hiding to hide dere shame... |
obyno82:Point out my lie since you guys love painting Lagos so bad.... Dispute my lie with fact no just coming to accuse me as a lier without any fact to dispute it... |
Hope say the freezing no go affect the Little Salary wey e go pay the Abia people this month end.... |
People see competition in everything this days so far the Lecturer is contented with what he has... Youth of nowadays makes everything turn to competition... The Lecturer might decide to stick to his salary survive with whatever he earns everybody must not be corrupt.. buh you see all this nowadays youth if you put dem in doz Lecturers shoes dey will find the way to loot and rip the school... |
tuborme:Who dey supplier you people drug sef I'm Yahya case av dey Given Audu Certificate of return Election was on inconclusive u wan come use am compare election wey dem don finish already and know the winner... You guy's should continue with your drugs and fake News up nd down..m |
Lol some people work on earth na to dey drill Bore Hole like Indians.... While Indians are investing in Drilling real Bore Hole in real life Nigeria Men are investing on drilling Yansh up nd down.... |
Oro dey at least give the traditionalist dere own respect too for once dem Neva follow anyone drag Public holiday or even Govt dey are always peaceful and always minding dere business so far u no cross dere lane.... |
Lol the guy Lawyer na work he go dey du bkuz as you dey defend him he go don run pick him phone record post am online nd say na Lie him Lawyer dey talk say him du am true true.... Na just confused somebody na people wey fit Police also be dis dem too sabi deny things even if you've the event on record. |
enemybulldozer:You guy's Neva dey serious if you're serious you will rally round Your leaders not waiting for ur haters to be the one to give you what your leaders can't give.... Imagine waiting for Lagos to come and build you a Seaport when you've Onne sea Port around u abi u guys dey allergic to that.... |
Lol why you dey cry and why always joining SS to ur madness sef.... Same you people wey dey celebrate all the armor and military display in Lagos weeks before election dey cry up nd down now... You always celebrate what you can't take in ur own region did you see anybody crying in Lagos up nd down when the Military dey arrive for election in Lagos buh when he reach ur turn na cry and playing the victim card up nd down.... At the end of the day he fit be Fake news swf cos u guys like using fake news to look for sympathy.... |
enemybulldozer:So na Lagos go build SeaPort for SE and na Lagos People go submit petition for referendum for SE people.... Please tell me again wetin your Politicians dey even du for u people since you want an outsider to be the one to help you from ur chain... You people don't get anything from your politicians buh you want an outsider to give you what your political leaders can't give you..... You've Onne Port to always use which is not far from you guys buh u guys still dey cry Abt Lagos seaport like say dem bury una destiny dere... |
Blame Olu Omo Everybody from that side are Billionaire nd saint so I'm sure na Olu Omo export Agbero go that side to paint dem bad... Dere own Agbero dey more brutal Dan Lagos own na only Commercial transport Lagos Agbero get business with buh he be like say for that side Na everybody if you've Leg, Bicycle, wheelchair you mus pay ... Watchout doz hypocrite will come online to blame Soludo like the Agbero just start today once you catch dem and point out dere hypocrisy they will quickly come out and look for someone to blame.... There's no state in Nigeria without Agbero when you get to Abuja you will see just That in every state they're more coordinated than each other... Buh how some people jus wake up paint dere own region nd state as eldorado is what I don't understand... |
LoL He don turn fire for fire .... Una come turn this 2023 election to Season Film 📽️🎥.... |
Lol Abroad no dey for everybody..... You can be broke in Nigeria and run find ur friend to bill urgent 2k wey u go use survive in Nigeria that one no dey abroad oh u av to work for every Penny.... |
Nigeria soldiers should be calming down so far them no attack anybody I see no reason why you go dey shoot at them.... Na why I dey look at people crying up and down shouting the Military should take over this are the type of thing wey we go dey witness our military hate anything Protest nd dat SM wey we get access to Dem fit seize am from us so shey na that life we go come run bak to in this Century.... Buhari na jus one Military man in Agbada mode anything protest he dey deal with people make May 29 come mak he jus go make we enter the next chapter that one no fit worst like this.... |
Why're they on white are they doing Church Chorography or dem don get uniform now,... Make Police or Soldiers sha no shoot them so far they're not attacking anybody nor destroying anything Protest should be derr Fundamental human right... Bkuz this present Govt hate anything Protest... |
Lol Nothing dey work for the country... Even structureless party no dey organize.... Everywhere you go Saboteur nd Rippers left nd right.... |
Las las the boy follow him dream he no see money win buh he see girl win so all win na win... |
Ikd people really vote for him.... So dey deserve it.... While someone are still going to court to ask for Access to IREV and BVAS to claim is stolen mandate From Sanwo Olu... |
Lol the breakfast wey he avoid the other day don go jam him towards weekend... |
Nobody wey no go die age no even dey determine when person go die anymore.... |
Lol.... No wonder China dey reject our loan offer dem don go arrest Chinese people wey dey supply dem loan.... The 10million bail option too small the Judge suppose set dere bail with same amount we are owing Chinese at least to help us write off our debt with China |
Na this 2023 I know say we get more than enough Mumu some people are still waiting and trying to force dere Pastor to tell them who to Vote like they don't know dere right from left... With cheap internet wey u get u no fit go online du ur findings compare and contrast den u choose from dere buh dem still wait dere pastor to endorse candidate... He come be like say all this Traditional worshipers are even more organized you will hardly see Dem put mouth in election mata dere followers no dey wait for instructions from dere Chief Priest.... |
Lol for which country I'm sure no be Nigeria come go see Wu study Agric dey work for bank... Na man know man dey work for Nigeria bank so leave talk .... Like this you will see someone that Study accounting, Banking and Finance working on a farm while you see an Agric student working in the bank ... |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 189 190 191 192 193 194 195 196 197 (of 580 pages)