Nigerialabalaba's Posts
Nairaland Forum › Nigerialabalaba's Profile › Nigerialabalaba's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 45 46 47 48 49 50 51 52 53 (of 74 pages)
MikoB:hahaha.....na audio. take am go bank. Go tru d statutory voters for APC, u go see say for primaries, u need governors and others, especially national assembly members current and past wey be Jagaban caucus. Anoda tin be say, na only jagaban fit square up and defeat someone like Atiku if pdp give hin ticket to northerner. D tin be say, Osibanjo no get sw apc support. |
u are welcome. Dat na d best valedictory and send forth party of d year wish Amaechi happy retirement ![]() in more important news, dogara and bauchi apc leaders on solidarity visit to Jagaban today https://www.youtube.com/watch?v=13G9m6J-qH8 |
Jagaban don win o. Dis na d delegates wey go vote for APC primaries u see so o. Sombori dey for Port Harcourt dey do valedictory service instead wey hin go dey reach out to delegates . |
MikoB:homework no go give am d delegates. u go reach people and power blocs for ur party and get dem votes first before u go declare. no be to dey disgrace hinself like Amaechi do today. Go read Elderstatesman Yakassai interview, some power brokers don do first come to dem na d first to collect dem backing. Dis one ticket na Jagaban go collect am and na still win win for Osibanjo becos na hin political caucus still collect am. |
Tinubuadvocate:for real abi na for joke? |
MikoB:na Jagaban get d ticket. SW APC power bloc no go accept and vote for Osibanjo for d primary so Osibanjo no go wan risk am. |
Tinubuadvocate:even APC get 2 factions for Rivers. D faction of APC wey get grassroot support na d Magnus Abe APC faction and dat faction don endorse Jagaban. Dat faction full stadium for APC rivers rally yet dem no get minister position or hold federal political appointment https://www.youtube.com/watch?v=hT6RUYEVFDg
|
Cantonese:no be amaechi again? ![]()
|
Truthisunique2:u and Amaechi be awada kerikeri aswear2gud. u wan win APC ticket with only d vote of Amaechi and d vote of Giadom , d confam houseboy of Amaechi ![]()
|
Truthisunique2:Amaech d leader of Oshio Baba? Hahaha, u be learner wey no get hometraining aswear2gud. Las las u go drop dis momiker after Amaechi don rest |
wirinet: Giadom na local man so notin concern Fulani or Adamu. Baba don go on leave so forget dat lie u dey scope urself. Na direct primaries APC go do and d ticket dey go d ACN bloc of APC after nPDP faction collect chairman, CPC get current presidency.una dey waste una time if u tink say APC go dash Atiku and PDP d presidency by fielding a weak candidate like Amaechi wey Wike don chase out of Rivers. |
Truthisunique2:e 'send' Giadom the Amaechi house boy u mean. u neva c sumtin. u go cry ur eyes go tear finish. Las las, u go decamp back to PDP were una com from. u hia say Baba don go on leave?
|
LibertyRep:He no go fit become gov for Lasgidi |
randy01:na u need to change ur mentality abeg. Na d same hardwork Aboki wey dey dig ground for house foundation na hin Dangote go do to build a largest refinery for d world. D only difference be say Dangote get a head start and education. D men wey build America na d equivalent of dat Aboki wey u dey mock today. Some of dos diggers for America 100 yrs ago built companies wey still dey survive till today. I dey tell u, any money or wealth wey u get wey u no work hard to get , u go lose am las las. Go ask all d people wey get ur kind of mentality dos days of free petro money for naija, dem don die for poverty today. Dat mentality of money withoit hardwork na nonsense. U go cry las las aswear2gud. If u go close ur shop becos of crypto, na old age suffer head u dey sign up to sosey! U go suffer ehn, e no go get part two.in fact u go become failed motivational speaker dat time. na shoe shiners and bag collectors una be o.
|
JoyousFurnitire: His Management |
like Leke Adeboye like Will Smith |
udele1: op abeg who be dat old man beside d terrorist? ![]() |
Obe apon |
Saminu Turaki don fat o |
Jameselias:
|
IgiveLadiesBj:las las , people like u , na poverty u go still end. If at ur age u dey tink say real wealth no require physical hardwork, I guarantee u say na grey hair u go take do d physical work u no fit do with black hair. U go suffer ehn. U see dis nairaland wey u take dey trash talk so, na raw physical hardwork build am. u see dat ghost wey u dey show hin 'money', u go hia wheen b4 dat money touch ur hand. U wey be lazy yoot wey con be suegbe dey mock hardwork. All of una wey be errands boy dey form life coach on top crypto ponzi. shiorr. Las las, anytin wey u no work for no go ever last. If u no learn am now, u go learn am wen u don old and poor. notin worthwhile in life wey no involve serious physical hardwork. Even d smartest Profs for unis must publish serious wek. Na ur old age u dey trade off so. Walahi, as u dey tink say money easy to make so, na so u go suffer ehn, for old age, u go see number tokens ehn, u go call am money.shiorr
|
Na Jackson Ude start d nonsense. shiorr. FG should regulate dis yeye social media before dis idle useless evil people cause anoda civil war. Tey tey a don sabi say anybody wey still dey believe anytin from twitter na suegbe. |
our international policy na non alligned whenever west and east bloc dey do dem cat and mouse fight. Same west wey no fit caution and sanction Isreal wey dey kill people and force dem.out of dem lands now dey sanction Russia wey do same tin Isreal dey do. Dat one na double standards. Dat is why Naija condemn both sides by not voting. Las las, na dem weapon industry dey smile to d banks. |
Yeye... Amaechi say make dem donate money for am to take contest, d poor man won donate hin life. Wetin Amaechi go use d man life for? To play ludo? ![]() |
Anambra don enta one chance d moment I see soludo dey clear dirti upandan. ipob terrorist don vess gan |
Ezehillary:no time and mercy for terrorists o |
lightskinnigga:your head dey well so? dripping of blood of innocent people no be achievement o |
strike out wey FG go appeal. shiorr. FG no go negotiate with terrorists o. |
Abbas slams West’s ‘double standards’ on Ukraine, Palestinians. AFP -March 28, 2022 7:28 AM RAMALLAH: Palestinian President Mahmud Abbas criticised Sunday the West’s “double standards” that he said penalised Russia over its invasion of Ukraine while ignoring Israel’s “crimes” against the Palestinians. Abbas voiced his frustration to visiting US secretary of state Antony Blinken in a press briefing with reporters at the Palestinian presidential residence in the occupied West Bank city of Ramallah. “The current events in Europe have shown blatant double standards,” he told Blinken. “Despite the crimes of the Israeli occupation that amounted to ethnic cleansing and racial discrimination… we find no one who is holding Israel responsible for behaving as a state above the law,” he said. Blinken held talks with Abbas on the first full day of a trip that includes a meeting with the foreign ministers of Israel and four Arab countries that have normalised relations with the Jewish state. Blinken told Abbas he wanted to revitalise US relations with the Palestinians after they collapsed under the administration of former president Donald Trump. But with its focus on the challenge from China and now Russia’s invasion of Ukraine, Washington has spent less time overall on Middle East issues. The Palestinian Authority led by Abbas has sparked the ire of Western diplomats in recent weeks because it has not condemned Russia’s attack on Ukraine. Multiple Western diplomatic sources have told AFP of requests to the PA, a recipient of major EU donations, to condemn the Russian invasion. Blinken did not raise the Ukraine issue before reporters, or other topics including reopening the US consulate for Palestinians in east Jerusalem, which Trump closed and the Israelis do not want to see reopened. But he pledged to maintain support for the Palestinians, pointing to continuing financial aid for development and US$500 million provided for humanitarian assistance in the past year. “The US is committed to rebuilding our relationship with the Palestinian Authority and with the Palestinian people,” he told Abbas. https://www.freemalaysiatoday.com/category/world/2022/03/28/abbas-slams-wests-double-standards-on-ukraine-palestinians/ mynd44 seun lalasticlala dominique
|
Coldsperm:go ask Army nau. Abi Army don crack ur brain ni? |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 45 46 47 48 49 50 51 52 53 (of 74 pages)

Rotimi don't have ordinary councilor in his state and he wanted to be Nigeria president.