Nigerialabalaba's Posts
Nairaland Forum › Nigerialabalaba's Profile › Nigerialabalaba's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 47 48 49 50 51 52 53 54 55 (of 74 pages)
trutharena:Olodo, if u dey move money daily,na dat money dem dey collect commission on. Dat na value wey dey fetch money per second and no be yeye valuation of software company U be native inferior black man wey be say if u hia America like dis, u go dey foam for mouth and dey smell ur mouth armpit for body odour. Na because of dis yeye valuation na hin dey make warren buffet no dey buy dem. Valuation no be d koko until u dey fetch real cash. |
trutharena:u no dey house wen dem dey share sense aswear2gud. olodo, na inferior complex dey worry u. All dat yeye bloated software coy valuations na hin u dey compare with real coys wey get real money , dey cash out daily and a whole systemspec wey dey move billions daily. U tink say na by one yeye valuations dem take dey do am. I don see say u be one of d native people like u wey neva achieve anytin for life go dey share chart upandan. Shiorr. |
E try o but still na money wey no reach wetin same Nigerians dey make for Naija. Remita by systemspecs alone go buy am. which one be dis yeye negative sterotype all dis refugee Nigerians dey use to take claim sympathy for US sef. Which one is Lagos, a city of 15 million, is economically vibrant but dangerous" like say no be d same Lagos all d richest Nigerians wey dey same forbes list dem make money. All dis omo oju ori ola ri wey go dey answer Olaniyan sef. Imagine pesin wey neva step foot for Naija con dey write trash like say no be dat same yeye US wey every week crazy people go dey enter public space dey shoot kill every innocent pesin in sight hin dey. Shiorr Na like so d parents of dat chess boy take lie say na Boko Haram chase dem come US wen even d chibok families wey Boko haram carry dem daughters sef still dey for Nigeria.
|
Rugaria:ipob terrorist ![]() |
see as a lazy reporter blogger use una catch cruise. Jagaban wey dominate d newapaper reviews today na hin slow down. na una own brain don dey slow down. shiorr |
2saviourfriday9:no wahala for as long as u go link am. No telco wan chop fine like mtn chop fine of billions of naira dat time. |
Eeyahhhhhh
|
2saviourfriday9:walahi, u no need dat line. Las las mtn go bar u permanently. Terrorists and internet fraudsters and ponzi crypto lazy yoots go hia am
|
AntiBMC:Na ur side of Nigeria be dump site. I no say too much suffer head dey cause mouth diarhhoea. Shiorr. If dem bar ur line, if u no get issue,dem go sort you and even compensate u. NL no be airtel customer care. Na wetin u suppose tel op be dat no be to dey use ur dumpsite side dey generalize. Na only yeye pesin go dey wan terrorists to continue dey run us down. He don reach 2 years wey FG don dey beg everyone make dem sort dem line, if u neva sort am, na ur fault but if u go settle people to do am for u, find out weda dem do d authentic reg for u and if u don do am, u no get wahala, dem go restore ur line. But if ur numba na d one wey don commit , na soosey be dat. Ur own customer care officer go come from efcc or dss. Naija go hot for yeye people since after dat train bombing, chinmark and crypto ponzi. Make una go find work do. To dey trash talk Naija from morning to night jan to december online no be work o. |
Jagaban d compassionate leader. |
no let anyone decieve you abeg, nothing wey fit beat hardwork. smart work na anoda name for yahoo fraud, ponzi, drug momey, oloshoism, yeye crypto for lazy greedy fastlane yoots ati bebelo wey go end for premium tears las las. to anytin wey grand, u must do d heavy lifting first o |
BabaIbo:u no tink am wella be dat. http://saharareporters.com/2021/03/01/exclusive-agf-malami-plans-pursue-2023-presidential-ambition-firm-control-efcc-funds
|
e no do president again ![]() all d sumol sumol yansh wey want to dey shake go collect las las. hin own na from aso rock cabal to kebbi, yahaya bello go be from Lokoja to Nigerian ambassador to papua new guinea while the grand patron of Momoh and Son enterprise , ameachi, go be from aso rock to efcc. shiorr
|
Grgton:u no get point if u dey count a needless war ibo started and lost as yeye achievement or survival. na Nigeria survive d war joo. Make all of una ibo boys hia calm down, na ibo wey still dey under tafawa balewa curse dey burn bridges and still trash talk oda tribes so tey dem no dey vote for ibo candidates. no war again for naija and no victor nor vanquished for d one una cause before. |
seunmsg:Abeg leave my ibo brothers,na ipob terrorists and dem supporters dey demarket ibo. |
Jagaban and Osho Baba na brothers from different mothers o. Edo sure pass for Jagaban |
southsouthking:U mean where una place una sef after Obaseki use una N8 billion take buy pdp slot and now una dey wail as he dey pepper una and pdp. shiorr |
Yooruba1914:Las las u go cry beta cry o |
Oshio Baba awon ti Jagaban. This one na straight to Senate o. Edo sure pass for Jagaban o |
GooodHardDick:Oga, no yoruba town or city share border with ibo. Forget nl trashy talk, d worse case na for yoruba to send ibo comot for Yorubaland but face 2 face war no possible. Since u be ibo, worry about ur neighbours like benue, kogi and Niger Delta. dat na why I tell u say ibo no dey go anywhere aswear2gud. naija no dey divide.forgerritt |
GooodHardDick:Yoruba fit dey alone na ibo no get access to sea so go be country next to ND for south and kogi for north and Benue for East ( dos 2 states sef na d butt of jokes for dem mediocre governors) and ibo go dey need visa to come Lasgidi. Posh sensible ibo people no go waste all dem done build outside iboland for one yeye Lesotho for inside Naija. Naija no go divide, any part wey try am, e go suffer pass wetin Russia show Ukraine. Naija na one . Make ibo change from dem bad ways and make Tafawa Balewa and Oba of Lasgidi comot d curse for d sacrilege some yeye ibo people comit |
waterbrown24:u just dey use style dey confirm d curse. u no fit dey type trash like dis make u tink say na ordinary,dem don cast u and na dat curse fit make u dey type tins wey go dey do ibo strong tins like d curse of Tafawa Balewa. Nobody go vote for ibo wit dis ur yeye and forget say u go create anoda yeye lesotho inside naija. U no see say na curse make ipob terrorists reverse all d ibo gains since 1999? Na only native ibo people remain for ibo land, beta posh ibo people don japa comot leave ibo land for native people like u |
eleyigidigan. Hausa man curse ibo and Yoruba man wan remove d curse ? Kolewek. Na family of Tafawa Balewa alone fit remove dat curse so dat ibo go dey alright. Be like say Oba of Lagos curse ipob terrorists too for d sacrilege dem commit for hin palace and dat na why ipob terrorists dey burn iboland. ipob own alone don cast on top potent double curses. Btw,op a.k.a olisaibotv, I no believe say dis no be fake news. Edited: OP has added the video as proof. |
dis diversification comot from oil go shock una ipob terrorists and odas in few months from now aswear2gud. E get some companies now wey be say na only export proceed alone be dem inflow |
OP, notin for dis random pictures confirm anytin but even if e no be fake news, d broken decrepit background alone don tell d whole story of d kain pesin e be. Na hin legacy for Rivers u see so for dat background. Sometimes,I dey even dey forget say na Amaechi be d predecessor of Wike because d kain relegation e don suffer for rivers shock me. Btw, I no see the authentic Sen Magnus Abe APC faction dia o |
warridis |
swaggerjack:Go read about Pa Benson Idonije wey be hin grandpa and listen to d Yoruba lyrics of Burna Boy in all hin songs. How many lasgidi boys dey sing in 'dead' PH language? Abegi joor,after Lagos na Lagos. In fact , for musoc , u go pick Ibadan, Abeokuta & Jos next for d top Musicians wey grow dia before PH. PH dey known for soot and oil. |
political witch want to cash out. Na 4 groups form APC oga ur 30 na scam
|
There was not a single Minister who supported the memo due to dubious issues, Investigation reveals A FEC member told Quest Times that in the last 7 years, Amaechi has lost the trust of many of his colleagues in the Council and he has become a laughing stock for producing memos requesting contracts with “dodgy owners and companies”. This has gone on to irk the minister himself and he has openly tried to fight back angrily during FEC meetings. But the source said each time, Amaechi could not prevail because the questions raised are so critical and revealed clear potential for bare-faced corruption. O pari. Amaechi don run hin mouth enter efcc gbege
|
swaggerjack:wobbish!! Lagos no get mate for Africa. |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 47 48 49 50 51 52 53 54 55 (of 74 pages)

