Nigerialabalaba's Posts
Nairaland Forum › Nigerialabalaba's Profile › Nigerialabalaba's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 67 68 69 70 71 72 73 74 (of 74 pages)
Nwodosis:Na IPOB terrorists own don cast. D curse dem jam for Lasgidi strong wella! Dey won't stop until dey destroy alaigbo and fall to the NA. |
Akukor! Las las, na Oshiomhole, the constitutionally elected chairman court go return. |
tmtech:Tarrh!! No be Naija ! No be us dey owe China money wey go bend dia economy, na Europe and US dey owe dem pass. |
Nonsense and ingredients! China wey no get himself for like 2 years now with the serious covid-19 palava and Hong Kong/Taiwan and Donald Trump attack until dey sack am last year, na hin go get time for currency swap? Anything like this must wait until China recover fully! As I type here, some companies don shut down and some parts of China dey in darkness due to the soaring energy cost. |
lexy2014:As you no sabi book, na my fault, abi? Oga, go school, maybe any school wey dey your area,as for a good economics teacher or go ask your teacher make him break am down to dumb dumb level wey you go fit grab. Dangote Refinery no be charity and no be state owned wey no dey motivated by profit. CBN get sense wella pass all of una. |
Na the PIA scrap dem , no be FG. As dem no dey recognised again under law, anything dem do is void ,including contract. Before anyone starts using dem to dey scam and steal, FG kuku make am public but e no matter since the law don scrap dem . |
lexy2014:Because people like Olumide abokiforex and other yeye people like him no dey manufacture anything and as dem no get sense to remember say CBN took a strategic business and national interest decision on Dangote, it's dia own problem. For donkey years, dis same people like Olumide abokiforex dey manipulate forex and some dey chop for every year TAM of those our national refineries and when dey pump petrol, another set of yeye people go go damage oil pipeline to dey siphon the fuel . Now God help us with Dangote Refinery so dat for once we will stop putting all our hopes on those refineries, dem still dey try to dey condemn CBN. Tell dem o say CBN sef go chop for Dangote Refinery because na business no be charity. All the discos wey CBN lend money, you sabi how much CBN don make? As people dey buy electricity, na CBN controlled account e dey go. Na like dat Dangote sef go be until e pay back some facilities CBN guarantee. Within 5 years max, Dangote Refinery go become profitable, pay him debt and na win win for everybody. Dis na d plan those yeye people like Olumide of abokiforex want to frustrate so dey can continue with free dirty money wey no dey create job like dat of Dangote. |
Philipponzaghi:Dem be jokers nau. As dem no get any single death , dey need to create the lie and dat tells you say their mental state no balance. If Twitter and odas like make dem allow terrorists and failed politicians like sowore kill dia platforms na dem sabi but for Lasgidi, dem go hia ween. D place dem burn we don see but it's 1 year now, we know see one single pesin wey die for Lekki, abi soja kill dem and go dem family house go kill all dem family ni. As dem no get home training, Lasgidi go teach dem. Na like dis Sowore wan win election nau
|
Racoon:APC governors eyes go clear las las. As APC go still go beg Oshiomhole and him exco to either resign properly or conduct convention and na so PDP too go beg Secondus. People wey get elephant sized egos wey dey call demselves governors go soon learn by force say convention to elect una national executives na serious business no be d one wey people go gather to elect national officers and one single governor go bribe 5 hungry people for ordinary ward level to remove chairman wey thousands from all over Nigeria elect. APC no go get the nod of the court based on the supreme court judgement and like dem no gree take the advice PYO advised dem,no be only Anambra APC d court verdict go affect , e go annul even the noisy state congress dem do las Saturday. Shiorr. PDP and APC dey behave like ipob and boko Haram terrorists. |
Hmmm. For me, ehn, na to sabi say after God, na your books o . As I go beta school and comot school with beta grade. As I dey leave school like dis, I use my shikini savings take buy beta books and tapes( dat my time na Brian Tracy dey reign), make u listen to dis tapes, read dis better ogbonge books and use d sense you pick dia and ur own beta be dat. You go suffer o but no give up and no take short cut or do crime. For me, ehn, that time till now sef (although my daily physically demanding tasks no dey loaded like before) my day never end until I tick all the boxes on my to do list dat day o. E dey vex me dat time as I no get time to flenjo but now, chai, I thank Eledumare Oritse o. A don make am today and 2moro sef dey sweet my belle. Na baba God o. The lesson be say: No short kurukere cut to make am in life, the only short cut na d one wey go land you for prison las las o. Find beta mentor too ![]() |
"Ballistic expert Steven Howard once told Business Insider that the world’s smallest revolver could theoretically be used to kill someone, but only “ if your shot is absolutely perfect” and you hit the “thinnest part of the skull at point range and under perfect conditions.” Den e no be gun abeg. If na so, correct size of ako okuta stone na gun be dat na. |
Simdyofficial:u no try at all as u dey mock the accursed nonentities wey dis ipob terrorist Nnamdi Kalu wey be like boko Haram's Abubakar Shekau commot dia brain and pack sawdust full am so tey dem con burn down Lagos. |
CBN just ignore dem o, no listen to dem. Na God we take beg una for CBN. Na dem, not you or Dangote, be d enemies of progress wey dey benefit for the forex manipulation. As dem dey so, na to siddon dey talk but behind, dem go dey do worse pass even dat useless abokiforex Olumide wey hide for UK as British citizen and con dey manipulate forex and profiting from arbitrary rates he publishes with him fellow robbers yet dem no get a single manufacturing industry here for naija. We wey be true Nigerians sabi wetin dey and no be enemy of progress. Some of dem steal money hia go use am build refinery for overseas and con dey collect fx here to take import the petrol com Naija. Oga CBN governor Godwin Emefiele no mind dem o!
|
D gain brekete o but one be say if you hide for obodo oyinbo come dey disturb us for naija, the long hand of the law go catch you. |
Rebuke:Na only you dem write the book of lamentations for aswear2gud. |
Celebritychef01:Smh. Dis fruits no dey work for any vagina abegi no confuse people |
TheGiftedOne:U be beta pesin u no be like those social media mobsters for veranda upstairs |
paramakina202:kikikiki. Isreal wey na only to dey bully Palestinians dem sabi Abeg compare SE to Lesotho no be isreal sef ![]() You see dat green dot, na Lesotho o. Like Lesotho like SE, shikini landlocked with near barren intra-economy. Why Lesotho is a poor country? Unemployment is also one of the major causes of poverty in Lesotho. The lack of opportunities for earning has led to some families going without income and being reliant on subsistence farming, however, this often leaves them open to the threats outlined above and, as such, further decline into poverty. https://www.borgenmagazine.com › ... The Complex Causes of Poverty in Lesotho - BORGEN Magazine Na the story of SE you dey read so for Lesotho.
|
Sebi a talk am! Dem IPOB terrorists own don cast patapata! Dat ibile spell no go clear till each IPOB terrorist finish him own papa and mama, finish dia own people and destroy alaigbo progress and development ,den after dey finish dat, soldier go finish dem one after the other . Na d cycle each of dem go complete before each of the IPOB terrorists dat burn down Lasgidi last year kpai . Dey committed a sacrilege in Lasgidi and now don carry their curse go alaigbo!
|
vedaxcool:https://www.thecable.ng/mambilla-sunrise-power-files-fresh-400m-compensation-claim-against-nigeria/amp Na d same Femi Falana wey dey call for EndSars protest in Lagos be dat. Yeye. Make dem use their share charter aeroplane full of arsonists and terrorists to him village for Ekiti. No wonder dem no give am any sensitive post because he's not different from Ozekhome wey dey always collect job to defend people wey chop our money.
|
Op, na true, dis one na a real ancestor |
FakePrinceOfLagos:From an impostor?
|
FakePrinceOfLagos:No worry. U still tink say na play to dey impersonate online. |
FakePrinceOfLagos:Oga, which lie? Abeg which royal family you come from for Lasgidi? Very soon, DSS go recieve petition about you impostor wey dey here dey impersonate. |
FakePrinceOfLagos:You wey be impostor dey preach too?
|
FakePrinceOfLagos:lailai! No be me. Me I no get wahala with the ibo race, na those IPOB terrorists in the day and overseas drug pushers and criminal igbos for night wey dey give ibo bad name dey vex me. How sufferhead like you dey support dem I still never reason am well,abi you be terrorist or diaspora drug pushers too. I no think so. D only tin I know you be na impostor wey dey impersonate authentic princes from Lagos . |
Fahdiga:I don fix am for u |
|

