Nigerialabalaba's Posts
Nairaland Forum › Nigerialabalaba's Profile › Nigerialabalaba's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 69 70 71 72 73 74 (of 74 pages)
Jiamed:so wetin happen to his ward in ile Ife or Lagos? E be like say di hustle is real ![]() |
MrBrownJay1:Na d story of his life he dey share,no mind the guy man. He don find another babe and just dey look for excuse to japa, now e don jam craze girl who get him time. Ehen, OP, kwantinu.
|
cutecommend:Second daughters don cast for your side. Abeg chill, Jesus loves you o.
|
nanoprado:Oga, no be by turenchi o. If you sabi write grammar like dis and u no get sense to make clean money and na to dey use your yeye sense teach people how to collect loan and japa, na dat kind sense dey kill. I dey warn you now, no play with those people. Na you go lose las las aswear2gud! By the time you run mad or get poisoned in your sleep or killed by a hit and run vehicle ,NITDA no go save you. Go site go carry ponpon instead of using grammar to dey form upandan and go dey do pass yaself. |
nanoprado:U tink say I be ' aneva chop ' like you. You wey dey tell efryone how to collect loan and japa, you tink say you well so. Dem go swear for you and your family las las! Yeye! Sense to get money legitimately you no get, na sense to dey defraud others you get. NITDA ko, NITDA ni! Go pay your gbese joor, onigbese. I don see pesin wey people like you don put for trouble just because dem borrow you co-operative money and una japa. Till date, whenever I remember the suffer dat man face, I don vow to dey expose fraudsters like you. I no even know all the yeyenatu sharks you dey mention because I no be dem customer daada like you. One thing be say if you dey my contact and I hia say you collect loan and you japa, your own don cast for my side be dat. |
nanoprado:No wonder most of una dey run mad enter market. U dey tell efryone to become a fraudster like you abi? U think say the worst dem fit do na to dey send messages to your contact? If you collect person money to cheat the person, you dey play with your life. The calamity you go face go worse pass messages. Very soon, dis people una dey defraud will soon go diabolical with una. Wen we dey young, d pesin wey I no wey dey use dis your kind of cunny sense, na him only son dey use juju kill las las. If you no go pay back loan, no go collect am. Shikena. Even bible say the debtor is a slave.. Dem go soon send afflictions to you and your family if you think sending texts to your contacts is the worst dem fit do.
|
FAKEPrinceOfLagos:Make I borrow pocohantas wise words. You be one of the first-to-comment-politics section hoodlums that when dey see anything tribe your antenna go stand at attention " and dey foam like bingo wey don catch rabbis. If you sabi Uzoma, you no go read say Uzoma raise $3.1 million come dey jump up and down like Prof Bieier's pet dog, Tantolorun, when it got struck with charm by the Ifa priest in his memoirs . Uzoma na the one wey use him big boy lifestyle kill diamond bank but I believe now him brain don reset. So carry your hoodlum tribalism comot hia sa |
I dey here o |
omowolewa:Abegi! Dat one na for Romance. For big ticket project in Africa, you no go fit find Ghana there when Ghana GDP sef no reach half the GDP of Lagos. Big multibillion dollars project na for the big boys like Nigeria, Egypt and SA. Even that Mauritius on the list na SA mirror. Giants like MTN still claim that they are registered in Mauritius becos of tax incentive. I happy for SA shah becos dem economy don nearly pafuka with covid-19.
|
Honey don land o. God bless Oba yanfu yanfu. Like Oliver Twist, please give us more next year sa. Igi pawpaw o ni wo pawa o. |
salanda:Oga, cool down. As you take type I dey sense dat you never do your DD. Go do am first, especially on that 2019 wey na only q4 release remain . I dey look as people dey hype champion too. Make I beg una, no go buy empty beer bottle o. If you want to buy champion, remember say the company no dey do well and na from the FP dem go take calculate the book value, I never see dem strategic asset wey go make NB a.k.a raysun pay extra premium. So as you want to dey load am from N2.50 and above, abeg use sense o so that if raysun decide to pay you N1.20, you no go choke o. If you take the offer or not, dem go still go ahead and las las give you one NB for every 20 champion. N.B. all dis na ma sense work, abeg no vex, still do your DD. Igi pawpaw o ni wo pawa o. |
Baba Ijebu na legitimate business o and some opa eyin na olomi but if dem drink the one wey get alcohol, na sack be dat. |
yMcy56:Authentic madam, see, right now, na FBNH dey do magomago, na dem you suppose remove before people go burn demselves. D magomago inside FBNH neva stop and dem result sef no justify dem to pass access . Dat is why I dey smh wey dat Oga dodge that FBNH bank wey dia directors get elephant-sized egos and don hijack every of dia bank contracts with dia proxy shell companies. FBNH right now, extra DD sef apply o. |
yMcy56:Madam, nothing wey you write on top Oando go change dem mind. Dat Oga no go see FBNH wey dem managers and directors , on top d millions dem dey collect as salaries and emoluments wey full everywhere for their FP , still dey do magomago so tey dem carry $2 billion dash for wire fraud and all of dem go cac incorporate companies, put dem husband/wife/ relative/friends dia come dey use those shell companies dey collect multiple multimillion naira/USD contracts from dem bank like Mr Peter Obi Pandora do Fidelity bank yet some people hia dey hype same fidelity and FBNH . smh Abeg just do your own and end am with DD applies. I sabi pesin wey buy 2m units of Oando for N2.50 wey sell am N5.50 , within 2wks made almost 5 mila and you dey hia dey preach. For dat Oga, na one company be d oga permanent foe . #dropsmic |
Mpeace:Lagos no be one obscure village and town where people go to farm and market three times in a week. Dis one no be market for people wey no go school. The only thing wey fit shake this market na wetin dey go on for Lagos and SW o, no be one obscure village or town wey village people dey run tins. Even when some states block telcos, na dat week sef Airtel tender offer to buy out minority shareholders. From my experience for dis market, it is it Lagos first, SW next and others no dey important. |
Nice . |
locodemy:Hahaha....all dis people wey dey share garawa no go fit make heaven o. The last insurance company I buy for morning wey I see eps for 45k, I weak wey result come out for afternoon eps 45k turn to negative eps and las las, e reach 3 days before I come out because efrybody wan run come out at the same time. If I stay one more week for that stock, I for don lose 50% of my funds. Na only one insurance I still dey take one eye dey look and monitor because I no say dem go soon dey chop remita money too ![]() I shah no know why insurance dey do me shege. From IEI to that one that I mutually agreed to be maga, na stories that touch o. |
locodemy:Oga loco, Happy Independence Day and new month. e don dey and tey small on nse website for days nau. Oya now, take am sa https://doclib.ngxgroup.com/Financial_NewsDocs/34194_COURTEVILLE_BUSINESS_SOLUTIONS_PLC%20NOTICE_OF_BOARD_MEE.pdf |
Raider76:The way dis Oga make dis fallacy of generalization weak me. Una go dey write with authority on top wetin no correct. No be dis same market I dey wey dem dey sell DF wey I see for N8 and I no buy because of dis kind oversabi fallacy and I dey see loss loss for dia account, I no no say na I just get eyes, I no dey see! until my eyes clear when I come see DF shareholders carry N24 loot away. OLAM dey do fine o and dem plenty like dat. Oga, no dey talk dis kain talk. Dis month alone, Nigerian businesses owned by Nigerians don bring new investors on board and you sef no know. You dey see person wey buy 400m units at once worth billions you still dey write turenchi. Pesin wey buy 400m units of one company come play for your eyes? Oga, follow the money make you no be like me wey miss DF because of this your kain oversabi. Whoever dey mop HW no dey NSEMPA level o and the pesin don see wetin me and you no see. You dey see 7k dey complain when ordinary 1k sef, DF no pay for dividend and still cash out for N24! Guinness nko, Guinness wey touch N30 no pay shishi las year and now come dey pay a paltry 46k yet Mr Market no punish Guinness , Unilever, Cadbury, PZ nko? Oga, follow de money. Na so someone don carry Eterna go finish before we come see result that H1 revenue of Eterna went up by 90%! The person wey buy Eterna don see dis value tey tey since the time Eterna dey N1 but we dey hia dey write turenchi. Person wey move money into Eterna, HW, Capital Hotel, DF, M&B etc no be NSEMPA mate o. In this life, levels dey o, dem no be NSEMPA mate o. |
Biafran4life:Na serious wa for you and I just see two different personalities here and NSEMPA. I no sabi say you are a murderer and this your blood thirsty version no even dey wise. You wey people know the house you dey buy and sell Nigerian Stock Exchange stocks and so much clues about you full NSEMPA thread na you come here come dey here dey para. Those people you dey follow na sensible people and before you put dem for trouble , I go copy dem again. Cc Emmanelewumi RabbiDaoracle Onegentleguy This your follower dey threaten to kill somebody and him family and he don confirm say him na murderer. Henceforth, I go dey tag your message for NSEMPA with screenshot of your messages threatening to kill someone and hin family. Sebi u think say as you dey decieve yaself, nobody sabi you. Na lie o. As you don confirm say you be terrorist, you don cast yourself for DSS be dat.
|
Biafran4life:I just dey here dey shake my head. You dis Oga wey dey always make sense for NSEMPA dey among killers and terrorist IPOB. You no try at all aswear2gud. You wey FG fit trace easily dey threaten to kill somebody and him family. Na now I believe say all una wey dey dat IPOB terrorist group no sabi anything. Na all brawn and no brain. Chai! Cc all the people wey you dey follow like Pa Emma suppose read your view hia before you use your blood thirsty nature put dem for trouble with those security experts if dem dey track you. Cc emmannuelewumi RabbiDaoracle Onegentleguy |
leo1234:So you don't have dollars Cc Dominique Mukina2 Myndd44 Seun Lalasticala Please come and help us clean this tread and ban these people wey want to derail this tread. This thread na for Nigerian Stock Exchange Market Pick Alert not forex pick alert. People don abandon this thread because of dis people MOD Abeg help us ban or remove dem here and their endless foreign exchange comments so dem go move to forex thread and we go fit face our NSEMPA business here. |
leo1234:You for go through the history of the comments of the pesin you are responding to and learn one thing or two before falling for every online comments . He is so much filled with negativity, hatred and bigotry against everyone not from his tribe and religion especially President Muhammadu Buhari. If Nigeria don finish as him and you dey write in most of his comments, wetin una com dey do for NSE? I pity people wey dey buy shares of companies wey all una negative people dey buy dem shares. Una go use una bad belle finish those companies. If una buy Gtb, na dat time Gtb share go dey go down because na so so bigotry and bad blood full una mind. Dis same country stock market wey I see people use sacks carry plenty millions for money from vitafoam, Oando, Cutix , Livestocks and Honeywell , na him someone dey curse? Na all of una no go partake For d blessing o. As una no see anything good for this country , na so una go dey lose lose for NSE, no be curse o. Make una leave our NSE for us, go una US or whatever stocks, abi na by force to do NSE? |
wanaj0:Which kain school fees whey some people hia don hammer 300%. In fact, na from the profit we go pay our children school fees o. Btw, if you are one of those still dey buy only nestle, mtn, access, gtb, zenith and uba, abeg you go need to unlearn sumol, abeg no vex. This market don dey shift and my guess is that it has to do with the direct intervention funds for some critical sectors. Government dey give these rejected stones massive support. Augusto and co talk say naija banks earning went down by about N500 billion in 2020 yet company like Honeywell flour wey you dey badmouth do almost 100% increase in revenue. Abeg reason am wella sir |
locodemy:Very good day to you my Oga Loco. Tuwale sir. You remember this exchange you had with authentic madam @Mcy56 , if only you listened to her wise counsel sir. In my opinion, you are repeating the same mistake. The kind of funds going into dis Honeywell is serious. Be open minded and not close minded. After all, na you dey remind us to remember that we are in the market to make money. You that sold Honeywell with less than 2 billion units available for around 1.20 to go buy Dugbe market Transcorp shares for same amount, e get as e be and I know that you have your wise reason for that decision . If me I wan beg our people here, I go beg dem make dem no near or touch Transcorp with long spoon with rope sef but I dey open minded to find dat thing wey you dey see. As for Honeywell, I no go choke if he reach N20 or N30 sef it Oba dey plan to sell am. Dangote Flour wey get loss upon losses sell for N21 and heaven no fall. N:B. Dis no be recommendation o.
|



