Starboytwo's Posts
Nairaland Forum › Starboytwo's Profile › Starboytwo's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 192 193 194 195 196 197 198 199 200 (of 267 pages)
Lol Kpele ee, missFarrginn |
We start from some where |
R |
See this life ehn, na jungle... |
I don't know who told our Alfa say I tell Memunot say "I love you"... Later I see my broda for nite, with cane marks all over him body Wetin be hin offense? Becuz he dey there when I talk "I love you" ![]() Alfa con dey wait for me, make I come ile kewu the next day omo na so I resign... |
pocohantas:gaddem : Make person con see better eba |
Merry Christmas to you all... No kill yourself cuz of no money, just enjoy the day, eat and drink with your neighbors if you nor too carry, nothing spoil boss.... God bless us all... |
Maybe you should kuku kill her tomorrow morning, christmas sacrifice |
Dicktion:na that derailment gan gan be the koko |
Dem try, but no reach wetin kwara united share |
iCauseTrouble:you did not say it well, jati jati suppose dey inside... U give am 1 slap, and she gi you 3 slaps, tiri slaps ![]() Unless she be Brock Lesnar sha |
Here's my advice Tomorrow morning just die ![]() You have failed all men, sorry everything masculine |
And I've never been sold on virtual, I remember few years ago, I was jonzing on my system and I entered nairabet virtual, the ones that have Madrid, Amsterdam etc, then I checked the score pattern, I saw if Madrid was home they win, while Amsterdam away is over 2... I kept following and from 4k in my account, my money enter 18bay, My babe came then, I don't want her to see what I was doing and when she left I open lapi carry Madrid home and Amsterdam 2.5, I play 2k, alabi sharparly collect am , I play one bay again, he collect am, ehn Kia kia, I log out....I don't play virtual, I don't even really enter bet9ja shops, and unless I purposely want to play with my money I can play like 150 Sha, and when they collect am, I just smile... I no dey pass 150 naira... One man food they say... |
OPONG:till now, I no dey carry dem |
Viking007:I know that mood shii, I remember when I fire some games back then 15k, I played hertha Berlin vs Stuttgart Btts = halftime 1-1 ![]() Then psv and one oloriburuku team like that, Btts = ft 4-0... Something do gbaun for my head... My chest first heavy like say Dem drop tipper for my chest,but my mood was somehow, I can't explain it, I felt very very ![]() I still dey stay with mum then, I know know say the thing show for my face, she ask me wetin sup, Me- hun ![]() Then my little sister did something I can't remember, if you see how I slap am Even she first shock before she cry( I've never hit her b4) I just left the house...I be like, 15k ![]() Betting na wahrah, I swear Modified- Make I add, that same day I been they think say money don land so me and one girl dey on paro, I don do research for her matter before but she dey gimme lamba, dey do anyhow, I no send, I don fire 15k on 2 odds, one done come, he remain psv(for my mind) as tickets go south like this and babe call won dey continue the mumu play, omo I swear for am nio the babe shock, me wey dey do lovey lovey before, I swear for him mama, if you no wan come again stay for your house, abi oloriburuku nie ni |
MizCharlotte:haha, I dey go sch go jack, base on say I get paper the next morning, na so I pass on bet9ja shop, I see boys dey holla(one guy chop big money) after all said and done, na 3h reach my side but change no dey, instead I just fire some games anyhow, 2 odd, 3 odd, collect ticket put am for pocket, na the exam dey my mind (na calculation, and local man no Sabi calculate)... Inside library, I dey try follow one guy wey dey try explain the subject, but the thing be like kewu(Arabic) I don tire to dey find x upandan Na so I stroll go front small, na him I see one guy open flashscore, I remember asap my ticket, I no even check am, na 2h the wahrah play for me, and outcome be like 270k, 13 games... I give the guy make he check am(no be say I get hope or anything) na him this guy start to they mark tickets, 1st one come, 2nd too, but the 3rd game red, ticket don spoil, I just turn corner go my seat, continue to dey look for "x " jeje... Na him I hear noise later, for one section inside library, wetin sup uuuuu , Na him the guy show me my ticket, 270 bay, na only that oloriburuku game spoil am, France national, Cretail na that team cast my ticket) 3 odd come, 2.80 come, wahrah 1.80 na him spoil am.... To say I won die that nite na understament... Money wey I for use build house, buy motor, buy car, carry my mama go Mecca, turn big boy overnight naso I Waka go back my seat, I no bother find "x" again, I just dey lookuu ![]() 8am early moh moh, exam start, na vex I use write am, as 1 person submit like this, I stand up straight... Abeg make una leave me to mourn jejely... Worse be say, na 50 naira we I go use go house remain for my hand... Cretail, french national, I reserve my comment... |
What's the meaning of scenereo ![]() |
CaptainMitch:sorry oo boss... Ile oba to jona, ewa lo busi(the king house wey burn, na fine he fine)na so yoruba talk am |
The first game I played didn't win, but the next ticket won, I chop 8k with 100 naira, that was far back in 2011 or 12, na 1960 gan gan I play... Na deola my sec sch paddy carry me enter the thing... Na so man pikin hook... From my observation, the less you know about it the better, the more you go deeper, more research, more sites blah blah the more your head dabaru... And if God bless you make those Kosovo and Macedonia guys sell fix match for you ![]() Oboy betting na mad something... In other news all Madrid player leg will break... |
Madrid reck me since yesterday walahi ![]() |
emmyboy162:nice one... |
Abeg wetin Porto play? As my sub just finish I hope over 1.5 tho |
ChrisKels:thought the same thing sometime ago... It's either he is performing in training or gots the presidents nude... |
Or maybe he was killed, I'm just saying |
Iheanacho to score winning goal |
TheSuperNerd:all of them cannot all play, but the bestest of the best should always represent us... Good for us the fans, excess good players is better than lack of quality players.... You play well everyday be that, the day you drop form, another prayer don answer be that ![]() |
TheSuperNerd:I think it's time, he has gotten our attention with his stats, if he keeps rolling the goals and assist then more headache for rohr..... oboy our striking department is |
andrewbaba44:yes I see your angle, but I would reserve that for Dem awoniyi, odey, okereke etc osihmen is special Talent, I'm only surprised he has wasted no time at all in announcing himself to the world... I don't know for you but I and many here(I'm sure) have always known osihmen will BLOW somehow, I'm no prophet, but I just had the feeling we have got a very good striker, since I first saw him, a player who rarely lose chances, fast, strong, Tall, good in Air, good link up play, aggressive and to top it all He can SCORE Goals Golden boot and silver ball at the u17 We needed to score in the second leg u23 against libya, so we called him, he came, he played and got an Hatrick, took his beer and left... no big deal here, you see what I'm saying, very dependable... He is our number 9, the only reason i(most) never lost 1% sleep on Tammy... Just a matter of time, he would leave Lille, sign for a top club with better players then una go see Goals...Who dey watch Lille, most people don't know him yet, let him get to Epl, Then he won't be able to hide anymore... I don't know what world class mean cuz he definitely not on the level of debruyne, sallah, mane etc, but definitely not average... If he scored 20+ goals for charlerio last season, this season with Lille he is around 12 and not even middle of season yet, maybe next season with far better players around him, he would be around 15+ by this time.... Upward progression with osihmen bro, osihmen = goal |
Mickael2:agreed |
jihday:etebo matter and balogun tire me, do we drop them? |
Damn, but our mama fine gan that time ooo |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 192 193 194 195 196 197 198 199 200 (of 267 pages)
Wetin be hin offense? Becuz he dey there when I talk "I love you" 
omo na so I resign...



