Theophorus's Posts
Nairaland Forum › Theophorus's Profile › Theophorus's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 11 12 13 14 15 16 (of 114 pages)
Eeyah! Just because allocation is not coming from Abuja for just one Month? Chai! Dem don collect feeding bottle for their hand dem don begin dey shake. Abeg, make una develop strategy to finance state monthly budget joor. |
Just continue until when your cup go full. Instead make you face Governance for your country, na Trump you go dey reason. Ogbeni face you front and Govern your people well joor. |
Oshey! When are Big; You are BIG. For every opportunity you have please do all the good you can because posterity will present the scorecard. |
Who dey really pay Ground Rent for Nigeria? Though Lagos dey Collect am steady and if you no pay dem go dey help you compound your Gbese. Why you go dey FCT where Land na investment and you no come dey pay your Ground rent? Bros Wike Abeg give them opportunity for negotiations ooo. |
Train your Children well ooo, make them no dey go Beat any or everybody ooo. They started killing Police no complain but now dem don begin dey enter Nurses. |
Today na Sunday, make una leave History and go to Church for Cooperate Worship. No be Entertainment ooo but True Worship which is in Spirit and Truth. #Maranatha. |
Constitutional responsibility is good if used positively but when used with selfish motives, then it will destroy the community. |
Beauty is in the eyes of the Beholder. Home training determines our discipline Na why dey beg know who stingy Na people dey teach persin to wicked |
Another away win? |
Life na turn by turn, make una manage this time too. |
Thanks to the management for taking prompt action. We pray our Higher Institutions become more safe for thorough learning and development. |
Kobojunkie Pay for me, let me join the Program. |
You get opportunity comot for Nigeria, still go out go dey Balablu-Bulala. Yeyenatu and Iberiberism. Unfortunately, dem go depot them after small prison things. |
Teekay213 If na only personal hygiene she be minus, then fill up for her naw. But how you and 41yrs old Girl go dey cohabit? Abeg una do old make una do the needful. |
This one na serious m*mu. Cut paper put for finger like Lower Basic children. Abeg, EFCC food don land ooo, make una come see. |
Abeg, who dey sign documents wen hin never read the summary abi details self? Natasha, should humbly relax, 6 months will soon be over and if the SP F-up na to treat am asap but for this one... Sope otilo. |
Oya! Begin blame Tinubu. You enter party today, wahala start same day. When you be Governor wen your Deputy self na Moslem, you no remember any founding principles but ordinary Minister wen dem no give you like this wahala start. Abeg, comot for SDP go Kowa from Kowa to LP... |
Agent Wike is still dere to help with the Secret work. PDP+LP+SDP+NNPP who will they present for President bayi? |
Abeg make una all park one side. Congratulations to Obasa on his reinstatement but Sha make he no forget say men mount. |
Well, actions get consequences and some are are not easy to reverse. Mr. Trump should do whatever he likes but na 4yrs Sha. |
Na one of the reason wen I no dey like eat out be this. Hygiene, you fit evaluate. |
Abeg, make una stop to dey disturb us joor. Simple Agreement wen one person no gree obey don dey carry many people enter gbege. |
What is "Fresh details" in all these Iberiberism like this? After Natasha collect for International, she still come back wan continue to collect? Well, the matter don dey pass gradually and Elrufai SDP matter don dey replace am. Very soon nobody go remember say she dey 6months suspension again, then gradually once she refuse to apologize that means say she no fit resume again be that. Senate go tell FHC say "Separation of Powers" so you can't tell us how to conduct our affairs. |
Is that not better than a Drug dealer or Armed Robber |
Na by force to pick call? Abeg, continue with the recall process joor. Life dey simple na you make am dey complicated by your actions. You sign agreement come dey form overwise abi na deceiver make I talk self. You and the people wen dey advice you make una continue to dey form Boss no need to dey disturb anybody with calls joor. |
Wetin be NPF own for this matter like this? Abeg leave them make dem continue the sit at home things joor. Na by force to go work on Monday? Make Ekpa and Kanu dey enjoy their home. |
Na how you Waka go determine wetin you go see. If you Waka around shege you go see shege-banza. Congratulations to the group wen down the guy but make dem no forget say dem self go soon collect. |
Budget you no gree present, you still want do another "Headcount" again? The one wen you do before Shebi you see the result? You still wan do another one? Well, dem dey increase the length of the rope for you to tie yourself ni. |
Just remember that some people live by comparing themselves to others. They derived happiness from thinking they are better than their neighbors. That's why even here they have a paid PR guy to publish anything dey think they have achieved. Well, Book of Books talks say "Those who compare demselves with demselves are not Wise" NB: Abeg who get link to the Condinator of "30k"/Month postings, I go like join. ![]() Atleast 30k can be used to do giveaway monthly. ![]() |
zombieHUNTER:Are you through? Here comes the Great Nation Nigeria. And Surely I will enjoy the Wealth of this Nation. Amen! |
zombieHUNTER:Nigeria is Emerging Great, Strong and Wealthy. |
We sabi as he dey go. Make he gather the evidences go court to seek change to last supreme court things na then he go realise say na straw those things be. |

