Theophorus's Posts
Nairaland Forum › Theophorus's Profile › Theophorus's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 11 12 13 14 15 16 17 18 19 (of 114 pages)
Eeyah! See how Bros Calm down dey careful choose him words. Him don understand say the "Headless mobs" way don carry go where he no know. Initial gragra don pass, him eye don clear. If na before he go don begin yab Wike but now he no fit mention the name anyhow again. Oya, throw Jab now. Dem say make you do like Obaseki, you no know say people don learn from Obaseki betrayal? No do LG elections, you say no but now you don see say na waste of effort. DON'T SIGN AGREEMENT THAT YOU WILL NOT FOLLOW. |
Abeg, make una park well. Everybody just dey talk wetin dem like. |
Balabluing. Everybody just dey talk wetin support their interest but shall all intentions na intention but laslas na only Good go win on the long run. |
Hand go soon touch am. Instead make he find legit hustle. |
Abeg, make Governors stop running to FG for bailouts and make FG stop to dey give bailouts so that we can know the Governor that is really Governing. |
Good. You will soon read alot of ranting from children of Hate and hatred. Well, good people celebrate their Country. |
Well El Rufai and him family no go ever reply lailai because dem don enter the Month wen dem no fit lie or insult anybody. Just wait till after 30days and you will get enough Lamba. |
But PDP can speak on behalf of the North abi? Abeg make all of una park well joor. |
Don't bite the hand that feeds you cos he no go end well. No bring people wen lift you up down cos he no end well. No wish anybody bad cos he no go likely end well. For this Life maintain fairness and get good mind and run from people wen Hatred dey their blood. |
SugarRay001:This account was opened on February 26, 2025. And you expect me to take you serious? Well, it understandable why you agree that Senate = University abi na Polytechnic you call self. |
That's Good. Atleast make dem fit continue their legit hustle. But those guilty must bear the consequences. |
Ruforofo fight. Madam, hope say you get receipt? Dem tell you say na Principle for Senate make dem change your sit, you enter Arise begin provide content. You are comparing Senate to Higher institutions? |
Well, let's hope these allegations will matter where it matters. Arise na where everybody dey go allegate now. |
dustmalik:Hmmm! You are doing well. In your Life you have start viewing people through the lens Tinubu Supporter and Non Tinubu supporter just because your candidate lost the presidential election. Your hatred for everyone and everything that does not fits your bidding reflects in your comment. If you like Repent and if you like Continue. |
plsdisvirginme:Okay, where do we meet? Let fix meeting for this weekend. |
Some people before leaving Nigeria, they only lived in their village so when they travel and see good access road and skyscrapers they think no place like that in the country where they grew up. |
She go soon understand say Senate different from all the ones wen she don meet before. Senate get rules and you gat follow am. These court wen you carry matter go ehn, body go tell you ooo. |
![]() Baba taste different version of the Party Rice come confess say, Kakhi no be Letter. Say the labourers party na original swegbe. |
Won ti gbe PDP ni Handicap. ![]() Show evidence where dem for sign and collect their card as APC member. Show pictures of organized reception for them and their followers to APC. Anybody can hold any flag. Some even put US flag for the dash board of their Car but dem still dey Nigeria. So that flag-holding things no go fit fly. Kai! Dem go do PD* dirty from inside. ![]() |
Na the work of Ndi-developers be that. Audio Billionaire people. Dem go dey gaslight others so that people no go reason dem but unfortunately their matter don enter express now. Ordinary elections wen dem lose dem begin wish Nigeria evil but God is not mocked, na wetin you Plant you go Harvest. |
Hanty, you for don clear the matter since a d hope say you get evidence(s)? If you no get evidence, you go explain tire ooo. If Natasha go do pass herself for public because Akpabio ask am for Sxx na she know ooo. Hope say she get receipt and evidence, if no na mere allegations and beta Lawyer go collect change for your head ooo. |
Bigcowhorn:Heeya! FYI, I have info as far Medical sector in Nigeria is concern and I know for a fact that it cost less than 500k to do CS in a University Teaching Hospital (except Fraud get in between) and Standard Private Hospitals still charge less. Except you're paying the Price for packaging. I won't say more than that. |
Bigcowhorn:Well, By God's Grace some of Us have hang boot already. Thanks. I can see some people reason like her. |
Oshey! Oya, enter Studio with Rufai make you go talk anyhow you like but Sha no forget say you get Freedom of Speech ooo but Freedom after Speech, that one me I no know ooo. Enter studio with Rufai and provide content for bloggers. |
Walai! You go explain tire ooo. Coup wen killed Ladoke Akintola; Adekunle Fajuyi for SouthWest but None of the SouthEast Snr. Officers died and then Aguiyi Ironsi was Enthroned na him una dey claim say na Awolowo Plan am from Prison? Kai! Una go explain tire ooo. So, SouthWest officers were so powerful and they sent SouthEast officer message of Death? You mean the Coup failed but the Government was overthrown Ed and the Coupist installed Aguiyi Ironsi? Oboy, you go explain tire ooo. |
Abeg, who dash this one Dr.? Abi she be one of those Upper-Iweka product? Cos, I don't understand which part of her brain she is reasoning from. Everything Money; Money... Na only Money dey her head. Na why some people even dey ask make NAFDAC open Fake drug market wen dem close. So her Papa keep NGN2M for savings account before her Mama get her belle shey? Well, some people don't know that though Money answers all things but Money is not Everything. |
Poko-a-poko. Small-small, he don dey come down. And gradually, He go reach USD1 to NGN130 ![]() |
Na to Blame everyone except una self and na this hypocritical things still dey affect una. If una like make una gaslight others till tomorrow, still the Truth will never change. 70-80% of Coup plotter = Ibos Aguiyi Ironsi took over =Ibo Unification decree = Ibos Who made jest of North = Ibos Whose Nationalist were not killed during the coup = Ibos. Which Region took all the spoils of the Coup = Ibos. On the Civil War. Was there an Aburi accord? Who looted the CBN buildings in the SE and Western Region? Where/when did the defeat of the Biafra soldiers started? At Ore When they choose to march to take over Lagos. Nsogbu-Nsogbu things without reasoning. Una don start again. |
justtoodark:Na FG una wan dey blame naw? No be una dey shout say na una dey travel out because of Busyness and dem dey stress una go Lagos and so una need more Airport and Seaport and all kind of things. But ordinary Airport naw, una no fit use am, so tey una wan turn am to event center. Chai! |
Abeg, make dem park well. All na hustle for here. Where una want make we get sand to build all these houses? Abi na una wan dey control sand packing again? |
Kai! Mancity and ManU thread just dry. If you get Money and dem dey rush you Abeg no look uche face ooo, see as dem desert the Manchester boys just because dem dey Balablu |
Chai! See as Mancity thread dry, despite say na Tottenham dem dey play. If you "Rich" and people dey rush you Abeg dey Humble ooo see as dem desert Mancity just because dem don become "Poor" |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 11 12 13 14 15 16 17 18 19 (of 114 pages)
