₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,330,371 members, 8,445,159 topics. Date: Tuesday, 14 July 2026 at 02:28 PM

Toggle theme

Theophorus's Posts

Nairaland ForumTheophorus's ProfileTheophorus's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 25 26 27 28 29 30 31 32 33 (of 114 pages)

EventsRe: How Nigerian Kids Celebrated Birthdays In The 70s And 80s (Throwback Photo) by theophorus(m): 2:41pm On Sep 09, 2024
Abeg leave the past for Past joor.
Na make everybody pay attention to themselves cause Mata dey ground.

Those days when Children dey wait make dem become Adult but now 14 years wan buy Benz instead make he dey read for Waec.
SportsRe: Osimhen Yet To Apologise For Social Media Rant – Finidi by theophorus(m): 1:27pm On Sep 09, 2024
Bros Finidi abeg leave the boy Na small pikin still dey d am.
RomanceRe: My Sister Would Have Been His Next Victim" Man Shares Chats Between Ayomide Adey by theophorus(m): 10:11am On Sep 09, 2024
Hi
PoliticsRe: Cut Down Cost Of Governance, Channel The Resources Into Education, Others – Obi by theophorus(m): 9:20am On Sep 09, 2024
Bros PO continue your campaign for 2027 joor, we see your work for Anambra body and you two successors don provide us with evidence.

Your investment for Hero show your drift.
Just continue the work you did in 2023 election, let Kwakwanso also do his own and help the vote of whoever would win.

Reduce cost of Governance and put in Education right? Continue ooo. Maybe Na Education be Nigeria ploblem.
CrimeRe: 20-Year-Old Man Killed In Cold-Blood In Lagos by theophorus(m): 8:57am On Sep 09, 2024
Cultism,
Ritual money,
Drugs,
Bandits,
Kidnapping,
UGM etc...

All probably helping Nigeria reduce population, hope we all wake up to our responsibility.

May God Keep Us all from any form of Evil
SportsRe: AFCON 2025 Qualifier: Lookman Named MOTM In Super Eagles’ Win Over Benin Republi by theophorus(m): 3:47pm On Sep 08, 2024
CAF Na the Chairmooo for this year be this ooo.

Since Oshimen like gragra abi Na Balablu things, well Lookman can replace him asap.
PoliticsRe: SERAP Gives Tinubu 48 Hours To Reverse 'Unlawful Petrol Price Hike, Probe NNPCL' by theophorus(m): 3:13pm On Sep 08, 2024
Una think say Na Oga Jona una dey talk to ba?

Sara abi sapa abi wetin be una name again?
Abeg make una park one side joor.

When NLC suppose negotiate Price control dem go dey negotiate Salary increase, Na some of the Salary increase don dey reach everywhere like dat.
FoodRe: This Is How This Fresh Fish Barbeque Was Prepared (video/pictures) by theophorus(m): 5:52pm On Sep 07, 2024
For this Economy, person wen still dey choose this kain thing Na Man he be ooo.

@Ereluroz, how far?
Help waybill two of that fish barbecue and 2 Cold Maltina (though I for prefer Zobo/Kunu but no worry, I go manage Malt).
SportsRe: Anambra State Team At Eko 2012 Turns Begger by theophorus(m): 2:02pm On Sep 07, 2024
Abeg make una leave that man and him uncoordinated fans.
PoliticsRe: Anenih's State Funeral Is the Reason Oshiomole And I have Issues - Obaseki by theophorus(m): 1:19pm On Sep 07, 2024
Chai!
Obaseki don dey see the handwritings on the wall so tey he don begin visit...

Abeg, when Obaseki go fight another politician abi traditional ruler?
Abi je don tire to dey fight ni?
PoliticsRe: Bandits Fed Dogs Flesh Of My Abducted Relatives’ Driver – Sheikh Bashar Danfil by theophorus(m): 6:00am On Sep 07, 2024
Careful wetin you dey support because your Share fit reach you.

Oga Scholar Na your share reach you so, pray make he no pass wetin you fit handle.
PoliticsRe: APC Accused Of Planning To Rig Edo Election by theophorus(m): 5:57am On Sep 07, 2024
Before Na NDDC Una claim say he give them 10B naw Na Rig be the accusation.

Abeg anybody wen lose this election make he no accuse anybody ooo.

Since una know say dem wan rig make una block the strategy.
PoliticsRe: Edo Unity Forum Showers Encomiums On Okpebholo, Says PDP Has Lost Its Direction by theophorus(m):
No be PDP lose direction Na Obaseki and he don make AI matter worse but Sha after Mr. Fighter Obaseki cause all the ploblem
PoliticsRe: Group Berates Rhodes-Vivour Over 'Taking-Over-Lagos' Comment by theophorus(m):
LP72
If wishes were horses.

Abeg I hear say PMS don become #75/Litres.
PoliticsRe: Nigerians Demand Probe Of NDDC Over Donation To Okpebholo's Campaign by theophorus(m): 2:35pm On Sep 06, 2024
If dem arrest who start this kind lie naw, dem go say FG dey disturb FoS.

Just because you wan disturb Okpebolo campaign and chances you dey spread rumour and lies.

Well, When is Obaseki going to Fight anyone again bayi? Abi Obaseki don tire ni?
Baba no know say 8yrs no be forever, him eye don dey clear say Power is Truly Transient.
PoliticsRe: Osinbajo Pays Last Respect To Yar'adua's Mother (Pictures) by theophorus(m): 8:31pm On Sep 05, 2024
Responsibility just full this obodo world.
Condolence visit on top say you be ex VP.

Abeg make dem leave the dead to bury the dead joor.
Fuel Na 900/Litre Na how we go take Bring price come 32/Litre we dey reason naw.
CelebritiesRe: Priscilla Ojo Arrives Tanzania To Visit Her Fiance, Jux (Video) by theophorus(m): 8:11pm On Sep 05, 2024
Who get Oraimo cord, we need to wipe the mod wen push this kain thing to FP.

Oga fuel Na 900 for nNpc ooo.
PoliticsRe: Edo Elections: Pictures From PDP Campaign In Esan West LGA by theophorus(m): 8:04pm On Sep 05, 2024
Judgement day don dey near small-small,
Reality go soon show.

Who go Win? ApC or PDP?
Well Na matter of time sha.

Mr. Obaseki abeg he don tey wen you fight anybody ooo.
HealthRe: Quack Medical Doctor Arrested For Killing A Patient In Nasarawa by theophorus(m): 11:37am On Sep 05, 2024
Man must wack.
But seriously Na only for Nigeria this News of quack dey pop up.

Well, he be like we like fake-fake things and short-cut
CrimeRe: Idowu Christianah: Alleged Serial Killer, Adeleye Ayomide Arrested (Pictures) by theophorus(m): 5:30am On Sep 05, 2024
Hmmm!
Wickedness just dey increase, may God deliver Us all from every form of Evil.
PoliticsRe: Nigerian Man Gets Arrested By FBI As He Lands In US For Millions Of Dollar Fraud by theophorus(m): 5:28am On Sep 05, 2024
I'm whatever you do remember say your Cup go full and you must to drink am.

Welcome to reality Mr.
SportsRe: Ballon D’or 2024: Super Eagles Winger Ademola Lookman Makes 30-Man Shortlist by theophorus(m): 5:26am On Sep 05, 2024
Oya
Congratulations.
PoliticsRe: Edo Election: PDP Campaigns In Akoko Edo LGA by theophorus(m): 7:41pm On Sep 03, 2024
Ooboy, campaign cost small ooo.

See those Sound Systems ehn, Na money to rent dem ooo and those crowd go still collect 2k each.

Abeg anybody wen like make he win the election joor Fuel is now #67 here.
PoliticsRe: Bandits Order Niger Residents To Vacate Estate Or Get Killed by theophorus(m): 6:21pm On Sep 03, 2024
Who be the C-in-C for that state?

Abeg, make nobody dey wait FG ooo.
Make dem better organise local vigilante if they NPF no dey listen to their pleas.
PoliticsRe: Nigerian Police Charge Whistleblower Isaac Bristol 'pidomnigeria' With 9 Counts by theophorus(m): 5:36pm On Sep 03, 2024
Labalaba can fly but if Labalaba is not careful the fire from Suya will fry it.

Careful with your Labalabaing because if caught within the web Na gbese be that ooo.

Mr. Brithon welcome to reality.
TravelRe: 3d Renderings Of Lagos Rail Stations Vs After Construction by theophorus(m): 1:57pm On Sep 03, 2024
You should have given Us the elevation abi point of View, then it will be easier to compare but still the reality make sense.

Abeg, all the South-South States, where una dey ooo?with all the allocations from FG abeg make una update us on Development for that side ooo.
RomanceRe: Poor Israel Adesanya by theophorus(m): 1:44pm On Sep 03, 2024
Chai!
This one think say Na rejection make Israel Adesanya rant, S/He no know say Baba see fine girl think say Na normal human being but as He approach am like dis, the girl just give am Bill.

The Boy probably talk to two more and discover all of them are after the bag and realise you can't even have a Normal talk with any of them around.

Well, Na Israel no understand Lagos Demography, if you dey find Wife, no reason those clubs and eatery ooo as he bad reach enter Church and you may be lucky. But for Street Na Street you still Jam ooo.

NB: When I write Church, no be those Club house/hall o dey talk ooo, Na CHURCH I mean ooo.
PoliticsRe: Edo Election: Photos From PDP Rally In Uhunmwonde LGA by theophorus(m): 7:55pm On Sep 02, 2024
Oboy ooo.
See as the face of the people be, any sign of hope?

Election wen suppose be Straight winning Obaseki use him performance spoil am.

Baba dey avoid campaign group because nothing to tell the people after 8yrs.
CelebritiesRe: Nicki Minaj Speaks Pidgin On Social Media by theophorus(m): 7:41pm On Sep 02, 2024
Okay, as she don speak pidgin naw, Fuel don become #67/Litre abi?

Wakadan iberiberism is this bayi?
Wetin concern us with person wen wrote/yarn pidgin? Abeg make una park well joor.

NB: Who get #1,000,000 wen him no need abeg make he send am to my Opay, I wan check the sound of 1M alert for Opay may be he different for other Banks own. I go rerun the 1M once o gallant.
PoliticsRe: Fuel Scarcity: Fewer Vehicles On Nigerian Roads, Falana Laments by theophorus(m):
Na who no commot for house no get the gist.

Just waka go main road, you discover say public transport plenty pass private wen dey road and no traffic at all cos this Fuel matter don humble people.

Who ready to buy fuel for 1k/Litre come dey use am gallivant up and down for street?
TravelRe: SA Opposition Party Outraged As Chidimma's Mother Is Spotted In Nigeria by theophorus(m): 5:22am On Sep 02, 2024
Abeg make SA people calm down and let make this things quick pass joor so that we can focus on more important things.
PoliticsRe: Police Arrest Akande Daniel In Church Over Alleged Role In Protest by theophorus(m): 5:22am On Sep 02, 2024
Instead make you jejely dey your dey, you go dey allow some state actors use you, you go tell stories ooo.

Wetin you for allow those Hatred infested people carry out their agenda themselves so that they can kollect in full.

People like Macaroni, Falx hide and Sowore run go obodo oyinbo but you go dey chest everything, my brother wetin your eye see Na you know ooo.

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 25 26 27 28 29 30 31 32 33 (of 114 pages)